₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,387 members, 8,445,250 topics. Date: Tuesday, 14 July 2026 at 04:59 PM

Toggle theme

Wendoworld's Posts

Nairaland ForumWendoworld's ProfileWendoworld's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 15 16 17 18 19 20 21 (of 21 pages)

European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:50pm On Dec 12, 2009
this john terry if the guy no kill him self for chelsea e go kill person grin if the useless long joe don die make dem commot am for field go trow jo angrysee aiyegbeni as e be belle no let shirt balance for body embarassed embarassed
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:33pm On Dec 12, 2009
as much as i no like drogba i still dey accept say the guy na world class striker, olowun, see that finish classical, those our old papa dem no even fit match the guy grin coolwetin do mikel angry huh
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:27pm On Dec 12, 2009
no be say dem useless dem do wetin yoruba dey say everton ti yaju grin grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:24pm On Dec 12, 2009
see everton as dem dey beat them like baby embarassed
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:20pm On Dec 12, 2009
OMO THIS DROGBA DON SPOIL THE FUN OOOO cry cry CHAI
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:15pm On Dec 12, 2009
drogba dey form VIP cool
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Everton [3 - 3] on Saturday 12th Dec by wendoworld(m): 4:13pm On Dec 12, 2009
hmmm and everton is on with a shock lead , kiss grin
RomanceRe: New Era Of Word Censorship On Nairaland by wendoworld(m): 9:33pm On Dec 10, 2009
@dhtml bros i no swear now abeg help me out if you know where i do mistake swear ooo shocked abeg, but moreover banning no dey fear me oooooo, no be nairaland be the only website wey naija people dey i get many abeg, e just be say na here decent small and fun dey for here, even though i know of some wey start to they ban people to the estend wey be say even ur fellow member fit ban you but as i dey follow you talk now d site don get k leg, so i just dey laugh seun with em banning wey em dey use dey treatning us, grin , well make i stop dey make noise make i dey look where this thing go end, but the one wey dey pain me pass be say the guy no gree come back come answer questions angry angry
RomanceRe: New Era Of Word Censorship On Nairaland by wendoworld(m): 6:09pm On Dec 10, 2009
[quote author=ԁhtml link=topic=362872.msg5087166#msg5087166 date=1260463751]@wendoworld, that was what i have been tryin to get him to do in so many ways, but no, he will not do it[/quote]@dhtml bros abeg live the maga em no remember when em still dey beg people to come nairaland, now wey em don hold, em believe say he is above everybody. but seriously i dey hear of this guy since i no know say em dey pompous like this even to the people wey fit born am self abi seun think say na only small small pikin dem dey come hear huh wey he fit just ignore or answer any time HE likes, @seun no worry if God wan catch person na so e dey start (from pompousness) grin
RomanceRe: New Era Of Word Censorship On Nairaland by wendoworld(m): 5:37pm On Dec 10, 2009
@seun the only thing i fit tell you be say you can go and jump into the lagoon for all i care my man, why? becos you dey feel like say na you dey inside 1000 naira note? you made a notice about something that had to do with all of us and some people are here that did not understand what it all means, and they are asking you questions that demands answer but no you feel like you are the boss and anything you say is final, ur ego no allow you come answer the people wey dey patronise your company.u don dey too big to answer our question now? you dey scare us with ban like say if dem live only you for nairaland you go fit reach where you dey today alone, make i tell you if say na true google complain then come here make we all understand how the thing dey go. abi you believe say after you don put order down ur banning everybody go solve your problem huh abegy o jare the place don dey sawa already self grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 7:19am On Dec 09, 2009
mukina2:
eldee wants to lay borat shocked shocked grin grin
and then na new thing? grin
PoliticsRe: Yar'adua 'Unconscious' In Saudi Arabia: Fears Mount In Nigeria by wendoworld(m): 10:13pm On Dec 07, 2009
SOME PEOPLE HERE ARE TOO BLIND I DEY WONDER HOW DEM DEY TAKE USE COMPUTER SELF grin wink
RomanceRe: New Era Of Word Censorship On Nairaland by wendoworld(m): 9:55pm On Dec 07, 2009
Mr. seun abeg try answer us some of this question wey we dey ask you o jare no be say you go just post once dey look us make we dey make noise, abi which one you dey now angry, i swear nairaland don dey sawa for my face with this report, wetin you think say e make nairaland wetin e be if no be the freedom of expression, i understand say na bizziness but at least follow us rap make we for understand each other because me feel say we all get hand in taking nairaland to where it is today so please try relate with us abeg, chai see INTERNET SLAVERY angry
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 9:18pm On Dec 07, 2009
ME I DON GIVE UP OOO JARE embarassed THE MISTAKES WEY I DO FROM THE BEGINING DEY DISTURB ME, I NO READ WELL BEFORE I JUMP ENTER GO DEY BUY GOATS PUT FOR MY TEAM cry , I GO WAIT TILL NEXT SEASON MY HEAD DEY ACHE AS E BE SAY ALL OF UNA CHOOSE TO SIDON FOR MY HEAD, I DEY GO DO CHANGES FOR MY TEAMS NOW AND I KNOW SAY THE GBESE WEY I GO CHOP I NO GO FIT PAY AM FINISH TILL THE SEASON FINISH
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 9:01pm On Dec 06, 2009
i don dey wait you tey tey for my salah meat oooo wink so make you no tell me say una ram escape from where una tie am abeg
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 8:53pm On Dec 06, 2009
muki welcome back angry muki welcome back angry muki welcome back angry
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 10:58pm On Dec 04, 2009
grin @bandely, abeg oo i dey look for aburo jo cry as borat talk you think say e easy to carry all of una for head? grin
Music/RadioRe: Upcoming Artistes. . . .discuss Here by wendoworld(m): 11:42am On Dec 04, 2009
ysgent:
Vector Freestyle
http://www.youtube.com/watch?v=vLbjboXgda0
that shit tight my guy, the song dey very ok e just be say dem no play am finish
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 10:25am On Dec 04, 2009
@ borat no make mouth because you check where i dey but you no check the time wey i join.and i know say with your copy copy if say we start toghether i fit no even see you for my back self

[quote author=~Borat~ link=topic=302710.msg5046843#msg5046843 date=1259918145]Weirdoworld,
I understand how it feels to carry the weight of 63 teams on your flat head and still have to plan your way to the top! grin
You know i was wondering where the hell you were in the league until i clicked on NEXT! grin grin
I study the teams of my opponents, guess whom they've purchased or sold, and mostly get it right. How i make use of that info is left to me tongue
I'm headed for the top and there's nothing anyone can do about it cool[/quote]no matter hw u use am you are still bocat


Grizzly:
How do i get in?
Izzit too late to join?
no my guy it is not too late abeg join make i atleast get person wey me too dey top grin so i go fit make mouth small grin grin cool
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 9:57am On Dec 04, 2009
omo i don waste money go buy this aboki wey dem dey call yakubu and the guy no gree repay me the dog just dey there sha,

abeg no muslim share ram meat for here na wa ooooo huh cry

@ borat , you mean say you no fit think by urself? na copycat you be shocked i wonder why you no name urself bocat,
PoliticsRe: Yar'adua 'Unconscious' In Saudi Arabia: Fears Mount In Nigeria by wendoworld(m): 6:35pm On Dec 03, 2009
@ airzee grin grin i laugh in kuvuki land, apologise ke for forum? come first who you think say you be? na you dey inside 1000 naira note ni? huh undecided abi na only you get eye see wetin the guy write? o boy abi na o man if you dey look for respect make you go search for another website because i can guaranty you say nairaland no go give am to you, calling for the guy to be banned is a mature opinion abi? abeg wetin happen to the saying that everybody are entitled to their own opinion.? if the guy say nigerians are fools then he is right in his own opinion my friend, abi we no be fool huh when we dey wey some people carry dead body give us say na president we no talk. some people sit down for one place they do a 150 million people anyhow them like and we still sit down dey look, some people even run commot for country go sit down for another man country dey enjoy there not remebering that the enjoyment they are enjoying in that country was fought for by some people who love their country some people even died for it, so na who be the fool? the government wey dey play with nigerians or we wey them dey use dey play kalo kalo?, IF YOU NO KNOW BOOK MAKE I TELL YOU WHY THE GUY CALL NIGERIANS DEM FOOL, After the whole rubbish wey yaradua do some idiots still say make dem pray for am. so i think if the guy word touch you na em be say you fall enter the category of the blind people wey still say make dem pray for the mumu president, angry , so if you know say you no padun wetin dey happen for nairaland abeg stay for your house we no go miss you, Responsible people my foot, tongue.

@ phuk_NL guy no mind dem na people like dem no wan hear the truth, e be like say na government agent em be or make e be say the guy dey gain from nigeria down fall, but guy make you take am easy now why you go blast moderator like that? make you try to dey take am small small abeg,

@kosovo abeg moderator if some people they look for responsible people make dem find am go some wher else or make dem beg seun make e create integrity trend for them abi we no go talk true again because airzee dey for nairaland? make i tell you some of this petty fight dey among wetin dey make some people dey visit this site, and even some times thier hashness and arguement make the site lively, i dey one trend wey one person say the reason wey she signup for this site be say nairalanders dey yarn true no matter how it is, please make you think before you give that attention seeker the thing wey he want

@ndeewonu you i no understand you oo shey na taba you take? why you post some thing still dey thank your self? huh undecided that is why i always tell people PLEASE DONT DRINK AND TYPE. IF YOU MUST TYPE PLEASE DONT DRINK AND IF YOU MUST DRINK PLEASE DONT COME TO NAIRALAND AND SHOW THAT YOU ARE DRUNK tongue, moreover after phuk_NL don thank you finish you still come here dey support say make them ban am. shey e good? hmmm na bros we call you ooo embarassed
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 10:00am On Dec 03, 2009
@ibime,tkb417,eldee
grin grin e be like say una dey high on taba (snuff) grin
@borat dey ther make you dey shift your resignation date. i think say you talk say if lalaboi pass you say you go retire? wetin come happen? undecided huh
PoliticsRe: Spreading Rumors That Our President Is Dead Is Unpatriotic And Ungodly by wendoworld(m): 10:59am On Dec 01, 2009
@ssn
grin lol, na today? yansh don dey for back? o boy live story jo, wisdom and wetin you call am? we don see many people wey talk pass you at the end hmmmmmm lipsrsealed , as for here, no maga please check the next trend tongue kiss
PoliticsRe: Yar'adua 'Unconscious' In Saudi Arabia: Fears Mount In Nigeria by wendoworld(m): 8:51pm On Nov 30, 2009
Abeg CyberG tell those fools what dey dont know.They believe say dem fit just come here come make ppl blind like dem. As for me no matter wat ANYBODY say it will never change my feelings towards dat rag called yaradua. O boy if u know how my body dey do me whenever i think about d future in dis country eh, i dey predict very bad things are yet to come. because na so naija ppl go put hand for their chin dey look so tey dis leaders dem drag dis country and d ppl in it enter ground.Unless we stand up and take our own destiny into our hands because na so me i believe say e happen for other countries wey dey enjoy now, Talk about prayers. wen u come naija, make u try visit any catholic church wey u see u go see say dem get one prayer wey dem dey pray 4 nigeria every sunday(na must say dem go pray am). Na since i small dem don dey pray dat prayer till now.
Omo for ur last post.Na correct reply be dat to some thick ppl wey believe say yaradullard na virgin,
PoliticsRe: Yar'adua 'Unconscious' In Saudi Arabia: Fears Mount In Nigeria by wendoworld(m): 8:51pm On Nov 30, 2009
Abeg CyberG tell those fools what dey dont know.They believe say dem fit just come here come make ppl blind like dem. As for me no matter wat ANYBODY say it will never change my feelings towards dat rag called yaradua. O boy if u know how my body dey do me whenever i think about d future in dis country eh, i dey predict very bad things are yet to come. because na so naija ppl go put hand for their chin dey look so tey dis leaders dem drag dis country and d ppl in it enter ground.Unless we stand up and take our own destiny into our hands because na so me i believe say e happen for other countries wey dey enjoy now, Talk about prayers. wen u come naija, make u try visit any catholic church wey u see u go see say dem get one prayer wey dem dey pray 4 nigeria every sunday(na must say dem go pray am). Na since i small dem don dey pray dat prayer till now.
Omo for ur last post.Na correct reply be dat to some thick ppl wey believe say yaradullard na virgin,
PoliticsRe: Yar'adua 'Unconscious' In Saudi Arabia: Fears Mount In Nigeria by wendoworld(m): 9:36pm On Nov 29, 2009
@ nas oo
guy na the mentallity wey all those useless ppl don force untop ppl be dat, Imagine small pikin for ghetto if u ask dem waiting dem wan be in future?dem go say president or governor.If u ask dem why dem go say because dem wan get money.So d impression wey all dis ppl wey dey walk for govt dey give be say for up there no be walk dem dey do na money Dem dey go make there. So my point be say na the leaders dey show dem followers way.

@ s@mi
nigeria dey forwardness before? undecided na people like una with una passive lifestyle dey let naija still dey where dem dey today , Una go see truth una go jump am go choose lie, ,other countries dem dey 1million miles ahead of us in EVERYTHING and una dey there dey solve 3500megawatt before december, shey dat wan dey among d thing wey u dey call forwadnes? Abeg me i know see anything wey i fit say e dey well for naija o.Abeg u fit help me out if u know, And why the president go anoda man country go recieve treatment self, shey doctors don finish for naija ni huh Abeg o i also need answer for dat wan too because i no understand why.

D foolish man self no dey patriotic since he no even fit patronise d doctors wey dey em own country. Some fools wey dey talk of we not being patriotic to our presido why em no dey em own country recive treatmenthuh . grin make story change 4 am. wink
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Arsenal Vs Chelsea [0 - 3] On Sun 29th Nov by wendoworld(m): 6:11pm On Nov 29, 2009
Omo see strong thing embarassed , A Gunner till the end of life time
PoliticsRe: Spreading Rumors That Our President Is Dead Is Unpatriotic And Ungodly by wendoworld(m): 8:38pm On Nov 28, 2009
Omo the person wey put dat picture u try ooo! U like d guy so tey u go bring dis picture wey be say d man still fine for here. cheesy e get one time wey i dey watch news dem go show my own presido with d presido of benin republic wey dey for our backyard here, I swear i no first recognise yaradua for d man side i think say na d person wey dey help the benin rep. presido hold em agbada.Na wen i look well i realise say na a whole yaradullard be like house boy for ordinary benin republic presido side, Chai naija don surfer for d hands of dis useless people wey call themselves lawmakers cry i pray say nemesis go catch up with dem soonest
PoliticsRe: Spreading Rumors That Our President Is Dead Is Unpatriotic And Ungodly by wendoworld(m): 8:20pm On Nov 28, 2009
I will wish him speedy recovery just because i want him to use his sickness to lead the revolution dat is suppose to happen in naija before things go start to dey move fine, I know dat this forum is a well known forum even to the top men or their kids or family members wey know yaradua.Abeg make una tell presido say me i wish am well just becos i dey expect am to suicide bomb him sick self with those corrupt godfathers of his. since dem no let am do better thing for d country wey he claim say em like, At least with dat em go convince people like me say em wish naija wel.l no be to just sit down there dey let dem dey use am like rag,dey drag em name for ground just because of d money wey em dey see, Well sha i go wish am good health just because of say i know go like make em die (ALONE!) angry
PoliticsRe: Yar'adua 'Unconscious' In Saudi Arabia: Fears Mount In Nigeria by wendoworld(m): 7:51pm On Nov 28, 2009
Well as for me d only reason wey i go take wish am early recovery be say since dem say the guy na correct guy and he get am for mind say make e better for naija but na those godfather dem no gree am, then me i go advise am say since em go still die because of dat sicknes, make em kukuma become naija jesus by calling all those corrupt pigs toghether for meeting den make em suicide bomb everybody together. I promise am say naija no go ever forget am.Even self some people go dey ready to worship am like thier own god.At least dat wan go better than him dieing for nothing on a sick bed and people dey use swear dey escort am, E get one country wey the thing happen like dat for europe but i no fit remember the country name wey a whole presido kaput emself and d other corrupt lords together, But for naija,longtroat no go gree, a whole sick yaradua eye still dey for d money wey em go chop forgeting say 2morrow story fit change for am, Na wa ooo, Wel sha i wish am quick recovery for d sake of suicide bombing but for another thing sake well lipsrsealed
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 6:23pm On Nov 28, 2009
Am laughing in old traford for now becos na their be my work- CHOP for now with my sturbon skipo. As the guy don chose to repay me in seedies currency, for me faith in him. I dey come back come give una d remaining gist as e be like say office go sweet today. cool , Jo oo i no fit shout 4 now.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 15 16 17 18 19 20 21 (of 21 pages)