Youngzubi's Posts
Nairaland Forum › Youngzubi's Profile › Youngzubi's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 (of 29 pages)
Therock5555:I know sir and i also wish you could come back to the story boss,this story is a hit!,number one in my list.......... |
Therock55555 baba, please i seek permission to post this your story in Facebook group |
Click on the link below to join youngzubi Facebook group, also add members to the group https://m./522542228206163?ref=bookmark |
Click on this link to join youngzubi Facebook group, also add and invit your friends to the group https://m./522542228206163?ref=bookmarks |
Pinkfeet:Dear, school stuff just hooked me up |
Silver1996 It can only be him....... |
lakkyflow:Thanks my man |
I FIT BE SECOND JESUS 5 BY YOUNGZUBI SNF S2 EPISODE 6 BY YOUNGZUBI GBEDU TORI WEY LENZ ******************* LASCARD as everything now clear for my eye, as E take start and happen but i tank God sey na like this E take end, if yan una sey i dey happy as i take get this accident eh some of una go dey wonder why, from wia i lay down ontop hospital bed i begin watch as a man at his early 60's walk in together with the doctor, with him look and composure i believe sey na better good man he be, he walked up to and placed a his palm ontop my forehead, chai for like 5mins i begin feel fatherly love.... "hello young boy, how you doing now" the man yan.... "i dey fine sir",i yan.... "oh glory be to God, dont worry my dear all will ok once your parents alive", he ya as i jab up instanta at the mentioning of parents, does it mean my papa and mama dey come, to comfirm my ever burning corusity, i asked "who be my parents??..... " what?, the man replied with a confused and questioning face.... "boy dont you know your parents," the doctor asked as i nor gree talk again after the man's question "i no get parents" i yan feeling disappointed as usual, so dem nor even know my parents i thought inwardly... "are you an orphan?, the man asked.... " wetin be orphan sir, na street boy i be, since i begin grow up i never see my papa and mama even i nor get name sef, i yan as tears just dey drop from my eye.... "boy stop crying ok, there is no need for that, oh doctor lets stop this conversation please it seems the little boy is hurting emotionally, which I dont think is good for his current health condition,can we discuss in your office?, the man yan facing the doctor who nodded his head in affirmation to the mans request, he wiped my face with a handkerchief before they exit the ward...... ********************************* SPANA "finally network gree enter the sim card, i bin struggle with my old sim since but the tin just dey write emergency call only, i don remove and put am back like fifteen times now, since morning nahim be the only tin wey i just busy dey do chai see as sweat take gather for my head,i grab a face towel and wipe off heat because i dey sweat inside AC, i enter my phone contacts begin scroll through my contacts till i came accross my ma'le number, i begin sweat uneccessary again as i begin fidget with my phone, chai the truth be sey i don do my ma'le bad tin, i don over do am, for the fact sey na she born me i nor suppose follow am talk the way i did the last time we yan for phone, but never relent i still gather mind and dial the number "tuuu tuuu! The phone begin ring, i kukuma seize my breathing as i begin pray sey make she carry her call, i nor sey she go dey vex for me asin hot one..... "i nor get choice than to go increase the AC as my mama never picked up after i don call her three times.... " i begin feel somehow, E nor just normal for my ma'le to dey side my call like this, normally she go pick the call and begin bombard me with insult wey no go even last before she go calm down,i released a long sigh as i made to try her line again when my phone indicate an incoming call,...... Sharpaly i press the green icon and placed the phone on my ear.... "hello!, hello!, i yan enter the phone with out checking who the caller is... " hello spana welcome back! ", a deep voice narrowed into my ear through the speaker, i was taken aback but onto ruggedness i jab moral and follow up", "hello na who i dey follow yan", i yan "hahaha, na person wey you no go like see again" the voice reply "onto wetin na, area yan clear make i follow you rob mind, which one be person wey i nor go like see" i reply back "hmmm i see, but make my word, check wetin time dey talk now and todays date, spana your fall is near, you go cry and beg!!" the voice shouted "guy wetin happen why you dey shout enter my ear" i reply still trying to process tins, becos for the fact sey the person tell me welcome back E mean two tins either the person follow me from jamica or the person na bad witch to notice sey i don arrive nija, so i begin co operate jejely.... Abeg na who i dey follow yan, i replied still... "no rush to know me because i go show full soon, i don return for revenge, now na my turn, i don return for you spana, your fall don come as i dey follow you talk so, your pa'le and ma'le dey under my custody that one na just for a start and believe me i go forward you a photo of your papa head once this call end, red shadow don rise!, i don return for you get ready for battle!!!........ Tuuu tuu tuuuu!!!, the phone rang off as i was left in deep confusion, no not now, only if my parents dem go fit dey out of this matter, i ready to fight with my last blood!!,now the AC dey blow hot as sweat just dey drop like water oh no i nor fit I text enter my phone interrupting my thought, i slide through the screen and wetin my eye see no gree me breath well....... Nooooo God why!!!!!!! To be continued still your guy youngzubi |
I FIT BE SECOND JESUS BY YOUNGZUBI EPISODE 5 GBEDU THE GAMER (2) I tear eye open as heavy headache begin hammer me for head, like sey my village people dey pound yam ontop am, i begin feel the environment slowly, although i still dey feel pain all over my body and again the smell wey i dey inhale, everything around me just dey smell sick and hospital, na when i sight a lady wey wear short gown, gloves and white scarf standing and facing one table like that, with injections and some contents wey dey inside bottle i confirmed my curiosity sey na hospital bed i dey lay down so... "i begin try sit up but E just be like sey i forget my body parts somewhere, ahhhhh!!!! I scream when sharp pain pierced through my skull as i try shake my head.... " oh no!, the lady nurse shout as she forget wetin she bin dey do and rush me for wia i don dey cry ontop bed.... " Heey! You don wake, ewo! Chai stop crying make i rush go call doctor"although i know sey the lady nurse dey follow me talk, but if i yan you sey i understand wetin she dey rap just know sey i dey fistyle una better lie because na pain i just dey feel all over my body..... "E no tey after the lady nurse run comot, i sight one young man dressed in the same uniform with the nurse rush inside with the nurse,the man reach out for one machine like and begin scan all mybody after him don use something check my chest, maybe him won know if i still dey breath well... "he shift the device go one-side as he motioned the nurse to bring him the tray, sharpaly he grabbed an injection and pierced it into my vein and released the whole contents, like sey nah jazz the man nack me, i begin feel somehow, the pain begin subsidize till i enter better sleep.... "nurse!" the doctor yan as he turn and face the lady nurse... "sir, she yan.. " you can now call the man that brought him, let him know that the boy is now awake"the doctor yan as he exit the room.... ***************************** SPANA ======= with better sun wey dey waya peson for head as we begin come down from our plane wey just land Nnamdi azikiwe international Airport, omo who yan sey nija no be better place, the feeling wey i bin get now shows that nothing fit be like home, as i no won make people so or notice me i begin do everything swiftly and fast, immediately i grab my mini traveling bag viam!, i dash outside through the exit door, xain on the other hand just busy dey yan like pikin wey breast milk don over sweet..... "as i don book better hotel online, so all i need na to direct the taxi man, as time no too dey for myside onto sey i still get some other jeenz wey i won settle before the day runs out.... " siiiiiiiiiiiii!!! Bros you dey go"one slim shout as he interrupt my thought, still waving a bunch of keys he yan" bros come na make we go, my taxi still clean and intact"he yan "ehn, ok bros na baystar hotel i won ball" i yan walking towards the guy.... "ahhh!! Alaye you na better nija brought up sef, oya enter make we dey go... " sharparly i shuk head enter the taxi, as the slim guy enter and start the motor and enter road.... Everywhere just quite as we experience small holdup, after about 28mins later the taxi pull up for front of baystar hotel.. " oga we don reach baystar"the taxi guy yan she he switch of him motor engine,.... " ok, you go follow me reach inside make i withdraw from ATM"i yan as i tear the side door open and begin match inside the hotel in the company of the taxi guy "immediately i step inside the hotel premises, as i won begin find the atm stand, the taxi guy onto sey him nobi new comer for there shout" oga na there the atm dey".... Ok i yan as we move towards there sharpaly "jejely i slot in my card quitely onto sey i nor trust Nigerian atm, but thank sey the tin no fumble as E just begin vomit some cashes... " i count some naira notes and foward am to the taxi guy, who begin poo teeth dey hail me as he waka go drive him taxi comot... " pheeeeew!!! “i sighed and begin match enter the hotel, since my room is already booked, no need for long tin so sharparly i located room 115..... "slide in the key as the door jah open and give way as shuk head inside and jam the door... " wow" i yan as i relax well ontop the massive bed wey cover one corner of the room, i go like go see my people for village at least before i go enter big mama matter, E don too tey wey i see abi hear from my ma'le last, and again i go like see my piki, that reminds me sey i be person papa, chai i no do well at all!, how i go just heartless reach like this, i just abandon my only true and real achievement in this life so far, wether na boy abi girl i nor even know, what if agness abort the pikin chai Godforbid bad tin, no i must go settle things with my family them, see my pikin before i go come face this battle wey i nor even sure wether i go survive am, but if i die in peace with my family and knowing who my pikin be omo i go just dey smile as my spirit go fly go meet baba God... "God abeg make E be sey my pikin dey alive, i begin pray dey wait make tomorrow come.... To be continued Stay tuned Still Youngzubi |
SNF SEASON 2 EPISODE 4 STORY BY YOUNGZUBI GBEDU ------------ THE GAMER (1) -------------------------- As i waka comot from the hotel through the exit door, i checked time on my wrist watch, i still get like 45mins left before my departure time, so i carry head up begin find taxi wey go concvey me from the hotel go airport, to show you sey bad market dey, three taxi men rush me for wia i stand as them begin drag who carry me... I just stand dey watch, onto sey time no dey my side again, jejely i point one taxi guy wey wear joggers..... "hey lets go" i yan pointing at the guy.. "yo man" the taxi guy yan as him grab my bag we begin match go wia he park him taxi..... "no need for long tin, so i made myself comfortable ontop the back seat with my mini traveling bag well placed beside me, the taxi guy took him position as he occupied the driver seat, jejely he begin touch some botten, within 7 second he give the taxi engine life as he twist the key nahim the moto release one kind mechincal sound zuuuuuuum!!!!!! and took off....... Inside the taxi i begin watch the beautiful city of Jamaica through the side glass, i watch as people move around the streets, i bin won ask the taxi guy why E be sey nah mad and crazy people full Jamaica, but on a second thought i kukuma kick against the idea as i remember sey the driver guy slangs too much so i nor go fit understand wetin him dey talk wella, i just swallow the question sharpaly, life here good but man gat to face him life battle........ ******* I sight as plenty taxi same as the one wey carry me line up in a straight line, the taxi guy match leg ontop the brake as the moto stop abruptly in response to the brake, i move foward as i nod in response to the effect of the brake wey the taxi guy natch...... "yo man here we are" the taxi guy yan...... "i look around nahim i see sey we don reach airport, i deep hand inside my pocket as different colured Jamaican currency accompanied it outside, then the thought of wetin i go fit use Jamaica money do for nija enter my head, E go just useless, for sure i know sey the money pass wetin the taxi guy go fit make in a month but i nor get choice than to give am the whole money.... "have it man" i yan as i foward the cash to the taxi guy..... "what!!!!!, man whats this, you wonna buy my taxi??... The taxi guy yan with him mouth wide open " no man, i dont need yo taxi but i just wonna bless you, take the money and goodbye am off to my country"i yan as i hit the guy shoulder and begin match enter the airport ruggedly leaving him in confusion...... " immediately i step inside the airport, i begin go process everything wey need process, from one paper to another, check up to scan, after all the wahala i waka enter the awaiting room, as i shuk head enter inside there omo i sight as people take full everywhere, jejely i made myself comfortable ontop one chair, i notice as people just dey stare and steal glance at me, especially ladies but i nor even send as i no just get time for woman again, women don do me shege, God and him family members know sey nothing fit make me look woman twice again lie lie..... "hello!"...... "deeply in my thought i hear as the angelic voice resound inside my brain, with a heated verocity i turn my head 360 degrees as my eye jam her, although she nor get smile for her face but she still melt my heart, i bin think sey nah anger go full mybody anyday i jam my eye on her,from head to toe she get wetin blind go see clearly, only her yansh fit turn scientist to mumu, like sey i bin dey sleep since i jab up instantly to grab her but unfortunately a female voice emitted loudly from the speaker wey dem hang inside the waiting room, announcing our departure....... "since you dont want to respond to my greeting, i think i should just do a quick introduction so that you guys will get along later, maybe when you get to Nigeria" she yan, na that time i sight one guy wth well built body with a crazy look standing beside her.... "spana meet my boo xain, and you xain meet my friend spana, i think thats enough for you guys to get along since you're guys i dont think i need much talk, she yan as we match towards the plane " i nor fit believe sey na she i dey see so, i begin tink when all of a sudden i sight her pecking the zain guy, then she hit my back and said goodbye and safe journey guys....... " through the open steps i found my way enter the plane, as i locate my seat and relax, plenty thoughts running through my mind, 5mins later the pilote announced through the mega phone sey make everybody hook him or her seat belt, i grab the belt attached to my seat and and hook it round my waist, within 2mins everybody don ready,i begin feel am as the plane begin vibrate slowly and begin move forward..... The vibration increased as the plane tear one kind better speed with one kind zuuuuuuuuuu!!!! Noise, the sound too much as some people begin cover their ear while some begin wear earphone, the speed increased to the extent that person no fit see anything through the windows again then the plane enter edo people midnight style "E begin fly for air"..... "i let out a very wide grin as the thought of landing in nija enter my head, na time to face battle..... " hey dude wassup man"xain yan from my back... ***************************************** LASCARD ----------------- I sidon dey watch as sambisa serious dey dress, as him don buy some better better clothes, fila palm with some gifts, he turn begin look himself for sky-b mirror, the guy fine sha, and i know for sure sey that chioma girl go fall for am, that na if him no fumble as he never get strong mind to face the girl.... "oya oya o!, sambisa she don dey pass, causetrouble shout as him burst inside where we sidon for sky-b shop,viam sambisa dash outside forgetting the gift pack... " i sha stand up, grab the pack and waka go outside make see how things go unfold.. "sambisa rush go stand for main road dey wait for chioma, wey dey come down the street from the junction, him heart beat begin change dancing steps, upon sey he be bad boy he still dey find am hard to follow the girl yan, cold, fear and anxiety took over him as the girl near am, he just fold hand begin turn head like standing fan dey watch the girl like zombie, as she waka pass..... "chai i no fit believe wetin just happen now, sambisa!! I shout as i begin rush am with vex for wia him stand like dry wood and fold hand, i bin won hit am for head but i sight danshiki boys coming towards me with pkako, as i don already know wetin i do, i tear better race leaving sambisa with him love blindness, if those guys catch me eh, omo na my body parts go full ground so i begin run as fast as my small leg fit carry me... "i never know sey i fit run with this kind speed, but i know sey na just matter of time before them go catch me which i no want make E hapoen, so i increase my speed as i turn to see if them don near me not knowing sey i don reach express already, na the brake sound wey the car wey don near me make draw my attention but E over late as i hear people shout from different directions then the moto hit me gbooooo!! As E loose control go jam electric pool, i sight myself fly for air without wing before i land for the express road gbosaaaa!!!!!!, the pain nobi here as everywhere black for me eye and i pass out.... To be continued... Stay tuned still your guy YOUNGZUBI |
I don't really know what the cause is, but I have being updating season 2 of sex na food(I fit be second Jesus sex na food 2) everyday only to get ban upon ban, the update will be automatically deleted by anti spam bot as soon as I post them, my fans have been dropping a lot of awful comments concerning my delay in updating, not knowing what the cause is.... I don't know if it's because I write the story in pidgin.... Please I plead with everyone of you as long as you are a nairalander and could read this post, kindly assist me, am fed up already because I have tried all I could but to no avail, your suggestions are highly needed that's if this one is not deleted too Still your guy YOUNGZUBI....... |
MrsEvakinqz:True fan will always be true, not those who only care about themselves and what they get not minding what the situation is like on the other side, before they place judgment and conclusion Thank you bro for standing by me, na naira land anti spam cause my delay o, I don dey post update since |
goodnessme1:Thank you dear..... |
Holywizard:Thank you........ |
WarriFirstBorn:Lie lie Facebook ko, i write the story directly here before I copy it to Facebook, but I always get banned here once I post them, I don't really understand be because it wasn't like that before See this last update it was seized like four good times with 24 hours ban, so I told my guy pradoic to help me post it, he did and got banned too But it has been released now |
Since last month I have been dropping episodes here but I kept getting ban upon ban, each update i post got deleted by the anti spam bot, am really worried as hell, please if you know what I can do kindly help so that we can continue our groove, sorry guys it wasn't my intention to abandon my work , do suggest something YOUNGZUBI is still here I check everyday trying to post episodes but all I get is ban upon ban, maybe it's because of the pidgin |
I FIT BE SECOND JESUS BY YOUNGZUBI SNF EPISODE 3 SUNDAY GBEDU!! AS E GO BE NA TIME GO TELL ---------------------------------------------------- I Sidon ontop my bed, as my back rest for wall with plenty things wey dey run through my mind like electric current, jejely I drag one stick comot from the packet wey position well ontop my bed and light, I shuk am enter mouth as I drag one long draw, omo I begin see how God take mold buhari inside him mama Belle, ahhh!! I sigh as smoke begin evolve go ceiling through my nustirls,life no fit be worst, my life my trouble, everything begin display ontop my head again but E dey more bright this time as anger begin find im entrance door into my body system, all the whole palava wey I bin pass through just because sey I get one bastered wey I think sey na my friend, spata!!! Sparta!! Revenge begin ring like alarm for my head, na time to show big mama,Mr frank, Florida and spata sey peson nodey shuk hand inside dragon mouth, I care wetin the outcome go be, but na time to show my real self, I go show dem pepper, I don kill people, governor's, business men, military men, so big mama and spata no go be hard matter, I no fit wait till Mike ready to help me, as the matter take be now na one man gang I dey, both Stevo and Mike dem na long tin, I ready to face my life battle alone after all na man wey I be, and na something must kill a man, if ever nobi money then ever go be woman, God punish devi!! With my mini traveling bag, I begin arrange the most important things wey I go need onto sey I no need plenty loads, once I land naija I go buy anything wey I want but for now make I find my back to naija 45 mins later ------------------------- With my small bag for my hand I begin descend the stairs, I sight Mike, Bobo with Stevo dem for parlor relaxing, sharply I coordinate my self well, with better lie we I go smah dem well arranged I shuk head burst out for parlor, everybody jab up instanta "spans! Which level na?", Bobo yan. "o! boy relax, E get one mission wey my agent just assign me, so I won go do the runs as him don put better money down," I yan. "na man you be, just dey careful, and incase things no work as planned, no fail to Halla us" Mike yan as him stand up shuk my hand, "so na which side you won ball go na", Stevo yan "na Colombia, but I don plan my moves already, once the agent man forward me the details about the person wey I won go killna to complete my map be that" I yan "You gbaski, no wahala we dey ya back, so no shaking" simple yan as dem begin shake my hand one by one, after the whole long thing I grab my back to Waka "make I drive you go wia you won drop" Mike yan standing up as one of him white guy trow him car key for am "no need, I go find my way brother" I yan then shuk head outside comot for gate and enter street I trek down small till I sight one taxi, after I don yan the man my destination him fire life enter the taxi engine nahim the motor release vooom! Sound and zoom off to the hotel wey I go lodge and arrange my travel back to Nigeria, time Don reach, I no dey lay any low again! ***********/********** * * ************* AJANLA STREET LAGOS ===================== "O! BOY WOMEN get serious wahala on, dem get problems Sha, see na so so makeup nonsense full this handbag" sambisa Para as him just dey bring out powder upon lipstick, mirrow and lady care pack inside the handbag wey we just successfully thief from those two women for ajanta pipeline "ogbe ni cool down and search am well, look well money go dey inside, better money definitely, just relax and nodey make noise so that you no go attract people attention come here, you hear me so?" I yan give sambisa. As I turn won continue my ultimate search ontop the small purse wey I bin scatter dey search like sey my destiny dey inside when I sight causetrouble grab something wey be like poly bag from the handbag wey him bin dey search and raise an up, I snatch am comot for him hand sharpaly "guy wetin happen, why you drag the bag comot for my hand na,?" causetrouble yan as him dive me but I quickly shift one side, nahim he land for ground, but I nor even care as I begin loose the bag mouth sharp sharp, everybody just focus their attention for my hand dey wait to see wetin dey inside the bag " jejely I begin comot everything wey dey inside the poly bag, but na something wey be like card just dey fall comot from the bag as I turn upside down, " hahaha!!! Sambisa tear better laugh as him begin release mess up and down "I sha continue bringing everything wey dey inside the bag till another small nylon fall comot, I nor waste time as I grab the bag and open it, omo wetin I see shock my hand, as I begin see myself inside range rover cruzing street of heaven.. " jesu!!"I shout " omo na money be this??, causetrouble shout as him open mouth begin drop spit "on boy we don hama, sambisa yan as him near me begin touch the bundles of money wey them use robberband tie into five bundles I grab one card from the ones wey full ground and open it, na that time the whole thing hit me, ahhh!!!! I shout " lascard wetin happen, why you dey shout na?" sambisa ask me but him no comot eye for the money him just dey busy dey touch the money as him continued dey ask me wetin happen "the woman wey get this handbag dey work for micro finance bank, she dey collect daily contributions from customers wey dey do daily savings for their bank, nahim make this cards full the bag, see naw the customers names the amount wey dem don save full the cards, I yan to my pady dem, but causetrouble don dey share the money into three equal places To be continued.......... |
Youngzubi! My man...Go ahead jare. You know the drill na... Justlet them know it's one coconut head called Centino that did that.you welcome back boss man,thank you for giving me go ahead,jah bless we dey await update brotherly Atleast make nairaland begin dey fun again |
if am right,this is your first story you'er really doing great,believe me if you continue this way you l'll make a big name for yourself here and outside nairaland........ keep it up you gat what it takes |
cool |
abeg wia my people dey,for sure i don make the story cold asin i don Bleep up big time but challenge na watin dey always face us,na the ability to overcome am and still stand strong and bounce back be the main thing my people abeg i take God beg una,i dey sorry o,as personal problem wey i face comot my mind for the tori for sometimes,but i don overcome and am back now as ever watin no kill a man go make am live longer,without challenge we fit no see watin go make us climb to the next step,so brothers make una come show me love,come welcome youngzubi back as we continue our tin.. |
Dehuthmahn:lol,brotherly noting do u,kpokkaa for ya head nobi bottle o! |
Dehuthmahn:thank you sir,stick tight as we ride on.. |
rowdymind: ![]() |
rowdymind:bro hustle tight gan!, we still pushing hardyea my nigga tank God you'er back! |


cool