Youngzubi's Posts
Nairaland Forum › Youngzubi's Profile › Youngzubi's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 (of 29 pages)
jawarareloaded:ok have replied,you can now send the email now stating your reasons |
i fit be second Jesus by youngzubi Episode..2 written by youngzubi escape ------------- lascard sabi die ----------------------- Jamaica ************* as i see sey Mr Gimmet body guard don enter action,all the entrance and exist don lock tight,no entrance no outrance Chai,i calculated my moves sharpaly,as better idea enter my head,good" i yan as i arrange some tiny wire for the door post,then i opened the roof and enter the ceiling, i followed one passage wey dey inside the roof climb go ontop the roof,i look the timer wey i Hold, E remain just 30secs before the time wey dem give me go run out,i begin run near edge of the roof as i sight mike dem coming with helicopter,immediately the helicopter near me i grab Stevo hand as im drag me enter the helicopter then boooom!!!! explosive blow inside the room wia i lodge as those guards enter inside there and match the tiny wire "nice good" "clean job bro,mike yan and push something nahim the helicopter move forward and speed off.... ****************'****** Lagos --------------- i swear laski that chioma go soji for my matter o!,sambisa yan as we sidon for Sky-b shop dey watch film "which one na,i yan tinking who bi chioma "that girl na,the one wey her pa'le dey sell water na,sambisa yan pointing outside to show me wia dia house dey down the street "o! wait o! you mean shioma that fine girl wey dey stay for her mama shop for fasheki street,i yan "gbagam!!,na she i swear i won parole that girl fish role,i won ice her water asin i won "E don do,i go help you, but you go pay 1000,"causetrouble yan interrupting sambisa "1000 !!! ,if you sell my life sef u nor go get 400 naira talkless of 1k hia! which time i turn politician to get that kind money,sambisa yan "Erm! sambisa dont worry i go help you get that money,even pass am sef,i yan opening one satchet of tramodol "i trust you laski ,abeg u go fit make am 5k?,sambisa yan "Er!!,me and causetrouble shout as my tongue display blue colour onto sey i don lash the tramodol "Erm yes na,see i won buy her gift,sambisa yan "gift??,we chorus "you wey never chop" "you wey nor get house dey buy gift,i laff ya destiny that one nah if u get destiny,"i yan "abeg make una help me na,shey make i kneel down eh?,sambisa yan "oya no worry,i get plan,i yan "oya!!! laski baddest!",causetrouble yan "abeg yan the level make we feel am,sambisa yan "ok oya here na the matter,we go thief the money,i yan "that one nobi new thing na,sambisa yan "no this method sure well well,we go get pass all this 50 and 200 naira wey we dey thief up and down "oya na explain wella" "see eh we go use pipe",i yan, "pa what!!?," "pant,i yan "Hahaha!!,we begin laff "wait o laski watin we won use pipe for kwanu? "we go use am thief this night",i yan, "so how we go take fit do that one?,see laski i confuse for this matter o "wen time reach una go understand",i yan and face the tv (note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond) ******************* Time 8:47 pm lascard i don see better iron pipe o!,sambisa yan as he begin run come meet me and causetrouble for wia we bend down dey find iron pipe for dumping, "confirm! na something like this we need i yan as i collect the pipe from sambisa now see watin we go do,once we sight any woman wey hold purse,hand bag abi eco rack we go near am jejely then surround am,i go show for her back then point this iron pipe for her neck,she go think sey na gun so she go fear and obey our order as everi wia don dark finish,"i yan give my guys "o boy you be correct peson joor!!,causetrouble yan "i fear you o!,sambisa yan as we begin waka go Ajanla pipe line because na there people dey stop for moto,trek down go enter moto for jolasko market "so we no go confront man,"sambisa yan as we trek dey go Ajanla pipeline "man ke,im fit notice quick and again im no go quick give up him wallet as woman go take dash us her handbag once we point this pipe for her neck",i yan, "abi na true u talk,causetrouble yan, "laski see that woman,oya oya",sambisa yan as im won tear race run go meet one woman wey just come down from keke,dey trek go ajanla pipeline "come back joor!,"i yan as i drag sambisa clothe draw him back "watin na?, see she go comot o!,"sambisa yan "you no smart at all,see before you go do this kin thing you need to watch ya environment wella,and nobi all of us go waka go meet that peson,you go stand for another place dey watch if peson dey come,so you go fit alert us "so na only you and causetrouble go go na,sambisa yan "yes na,you go cross go the other side dey watch how people take dey come and go",i yan "ok na,sambisa yan as im tear race run cross go stand for the opposite road facing me and causetrouble i stand with causetrouble dey watch as two women waka come down from danfo bus,sharpaly dem begin trek go pipeline junction,with better amebo gossip wey dem dey yan as dem waka,we increase our step sharp sharp till we near them "stop dia!,i fired as the two women shock onto sey causetrouble no hold pipe and the women two,im rush go push one of those woman nahim she land for ground as i rush the one wey stand before she go turn ya handbag!,i shout as i point the iron pipe for her neck,she begin shake like chicken wey cold dey catch "please dont hurt me take the bag,she yan as she fling her handbag,i rush pick am as causetrouble grab the second woman handbag,we tear race with full speed viam!! (note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond) to be continued........... |
Mariomadiba:copy**g ![]() |
Holywizard:hey bro dont sound that way, my reason for not posting yet is simply due to some personal issues,i got life outside nairaland,so things can always happen as i dey so eh!,i don carry lappy several times now trying to type update but i just have some personal problem that is affecting me,kindly have patients,once i sort those problem i will definitely start posting,u should know that i wasnt like this before! |
hello fam! it feels great to be back! now that am finally back and better be expecting next drop soon!! thanks guys for your patient youngzubi...... is back ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() |
the deleted episodes was due to pirate issues,for those who were going against the copy right you can reach me on any of the contact below to get access to the remaining episodes Facebook : Desmond nona email : youngzubi@gmail.com |
YINKS89:i gat u bro,waiting |
surly it feels bad but not when reference is clearly made to clarify who the author is,i will put his name there to show that he owns the story but better still i will wait till he comes online,i never planned to receive anything in his place so mind what you say when quoting me... |
CruzJoe:yea u said it bro |
bro @ centino I'm here to seek your permission to post your story in my fb group,although i sent you an email month ago but you didnt reply,since you'er not around for now i think i will go on with the posting,but i promise to stop posting at your will,if you see it as a bad idea please kindly notify me to stop the posting thanks for your understanding |
WarriFirstBorn:hmmm you are right bro,to be honest with you,the pain i felt was unbearable,i almost gave up the idea of writting but i refuse to be discouraged,thank you so much bro,you really built up my moral and confidence back,i will continue the story here no matter what,God will see me through |
here is the link to join my Facebook group click here to join https://m.facebook.com/search/top/?q=youngzubi+stories&refid=18&ref=opera_speed_dial_freefb&_rdr |
Horlaslim:here is the link https://m.facebook.com/search/top/?q=youngzubi+stories&refid=18&ref=opera_speed_dial_freefb&_rdr |
baryour769:here is the link https://m.facebook.com/search/top/?q=youngzubi+stories&refid=18&ref=opera_speed_dial_freefb&_rdr |
[quote author=MhizFavour post=71174907][/quote]only in my system where i saved it,were u posting it? |
swegiedon:no i won't |
Harlaan007:atleast it would help wider range of people to know who the author is as they would be visiting my fb profile... |
Donspicey:i had a serious issue that needed immediate intervention |
ATTENTION! ATTENTION!! unlike me i have posted only one episode so far,it was due to some issues that i encountered after i carried out few research about 10 different persons were copying my story and posting it to different Facebook pages and groups and they were all claiming ownership of the story,,,here is one of them "Cceeboi" a Facebook page apart from prosper vibz who admitted that he was sorry i have already deleted from.episode 44 to 53 of season 1 to prevent them from going further,let them use their head to complete it! it was really painful but God will surly judge and reward them,something will hit them So fam! i have made up my mind to start posting the season 2 and many other stories on my new Facebook group i invite u all to follow me and support me,join my Facebook group "YOUNGZUBI STORIES" to continue reading season 2 here is link to the group click to join https://m.facebook.com/search/top/?q=youngzubi+stories&refid=18&ref=opera_speed_dial_freefb&_rdr i will be waiting for u all to join the group before i proceed wit season 2 thank you for your understanding still your guy youngzubi |
MhizFavour:apart from prosper,people are claiming the story they claim that they own it so thats why i did Wat i did,i discovered more than 9 people claiming the story |
uekejiuba:bro season two don kick off |
help me win short story award!! kindly click on the link to vote for me on facebook by LIKE and COMMENTING my own my short story,remember the writer with the highest LIKES and comments wins the award so brothers and sisters support youngzubi,help me win the award by clicking onthe link below,mention your Facebook friends to mention their own friends,together we can do it!!!!,,ghost readers you can also participate just click on the link,or you search"boldscholar" on ur fb search scroll down to the one of Desmond nona..LIKE,...comment and mention your friends God bless u as u do so click here! https://mobile.facebook.com/story.php?story_fbid=498512433955386&id=3 |
moneypussyweed:yeeeeeee!!!!! gbosaaaa! gbossaa!! gbooooosssaa!!!,for u my man moneypussyweed Chai nah spana second u be o!!!,i can see dat spana don motivate your moral ![]() thank you brotherly,you over do well my man you bam my manchi noting do u,oya nah make we move to our new sight ![]() |
NOTE! THE SEASON 2 IS BEING TOLD BY TWO PEOPLE,AS I WANT TO TALK ABOUT STREET CHILDREN AND HOW THEY LIVE,THINK,HUSTLE AND SURVIVE AMONG US CHARACTER ONE: LASCARD --AJANLA STREET LAGOS CHARACTER TWO: SPANA ---JAMAICA season 2 Episode.......1 I Fit Be Second Jesus ------------------------------ Years Later --------------------- Inside ajanla street for lagos,you fit see as everi wia take dey tattered,dirty water full all the gutter come dey flood the whole road,school children dey comot dia sandals together wit dia socks enter the flood water pass after wich dem go clean dia leg and then wear dia sandals begin trek go school,the street busy die,as people dey struggle go dia various place of work ajanla street notorious die as nah street children,area boys,cultist,drug dealers,gamblers and ritualist dey dominate the whole area,notin goes for notin inside ajanla street,the life wey we dey live nah the impact wey ajanla street implore in us as i sidon jeje ontop iya basiru firewood wey she park for main road,i just dey enjoy the beta jam wey dey boom from Cana-B speaker tekno "pana",cana-b nah the top hair barber wey dey for ajanla street,another 18 hair barber still line up go down the street,wit dia songs wey dey loud 24/7 ajanla street dey noisey die,although e don already turn part of our life,noise,fight,drugs and bad life nah our trademark,nah wetin dem take know we the street children,if only i fit sabi my parents dem,life for nor be like this,we live in the street,we chop from hand to mouth,hawking nah our only means of lively hood,people see us as aliens,dem treat us without love becos of wetin street don turn us into,anytime i see those pikin wey get family i dey always feel bad,why becos i never for my life know as E take dey be to get mama and papa,pikin wey get mama and papa no know wetin God do for am,anytime wey i carry my bread dey hawk for express and see people wey carry dia pikin inside dia moto,i no dey fit help but to dey wish sey i get even if nah only papa,but E just dey impossible,i grow inside street, all my life till now wey i don turn teenager nah street be my only home,we suffer from day to day only for our superior dem to come and collect the small money wey we make for the day,nah even the female children among us dey for the receiving end as all the area boys dey always rape dem every night,for inside store wey we dey always squeeze our sef like sardin,we go dey hear the small small girls cry everi night as those big boys dey nack dem,we nor get anybody to run to as the government sef nor recognise us,we only live in the street to serve the street gods as we sef nah dem slaves,this nah my life story,i dey evil,even as i young reach nah evil full my body,i live and grow inside evil,so evil nah part of me,nah wetin the environment implore inside me,i no fit introduce my sef becos me sef nor sabi myself;i still dey find wia myself from come and nahim make me yan sey i fit be second Jesus just maybe,my life nah one kind bad movie abi fairy tale,my name nah lascard naso my journey take begin "i sight as some street children dey sing dey follow one mad woman,nobody wey nor sabi jagi the mad woman for inside ajanla street,even those area boys dey fvck her wen dem don over high,jagi too dey sleep anyhow,ontop sey she nor well,she fit sleep tear leg open as her laps fresh die, those rubbish guys go dey rush her tin like hot akara "lascard!!,sky-b voice jab me for wia i bin sidon ontop iya basiru firewood, "area!,bros i dey hia,i yan as i stand begin dust my yansh as the pkako sef don add more dirty to my shokoto "you dey craze abi?,lascard you dey mad??,so nah we you take dey learn hide and seek abi? "no o! bros abeg nor vex,i bin dey get running stomach since yesterday, so i nor hawk at all since dat yesterday,i yan as i begin look dia red eye,i sha know sey E don hot for me,but E nor be my fault as i no hawk bread for express yesterday so i nor pay my daily due to our oga danbito,nah him dey rule over us,all our stress nah im dey chop am,everyday we dey pay am 500naira whether we hawk or steal E nor just concern am wit im boys,as nah sure tin sey we the street children go dey pay am the money "see this pikin o!,so nah to just stand dey tink you dey hia dey do abi?,you tink sey nah play we come do eh!,gashiki para as im tear me one hot slap wey turn my eye blind,nahim i begin boil inside,but i be just a small boy notin wey i go fit do as nah dem be our oga boys "bros abeg make una know vex,i go pay am today if don go hustle finish,i still dey yan wen bottle hit my head pkosaa!!!,iyeeee!!!! i grab my head fall for ground as i begin shout for help,but nobody go dare try near dem,the bottle wey dem nack me never do as dem begin flog me wit belt "bros abeg take the money and free am abeg,causetrouble yan as im kneel down wit 50 50 naira note wey make up 500naira for im hand, "how much be that?,sky-b yan as im stop flogging me and face my friend causetrouble "bros nah 500naira,causetrouble yan "we dey sell pepper?,why you carry change full the whole money?,abi you dey mad!!,sky-b yan as im kick the boy for face "ahh!! bros nor vex iyee!!,causetrouble begin beg as im hold im face still grab the money dey beg dem snatch the money comot for im hand and pass,all other street children rush us immediately sky-b dem waka comot "iyeee!! lascard you don get two head o!,mento yan as im stand wit plenty handkerchief wey im dey hawk "o boy!,make we go clear mind first,causetrouble yan as im waka com drag me up for wia i lay down dey press my koko wey don swell for my head we waka move to one uncompleted building wey dey down the street,as we shuk head enter the building everi wia don full wit street children both boys and girls,our reasoning no normal again as life don change our thinking,as we young reach we dey smoke anything,we boys dey nack the girls as we take like,evil don grow root inside us,as nah wetin we grow up seeing nahim we sef dey do,for our eyes notin bad in it at all "gbosa!!!! for u laski!!,dem begin hail me as i chase one boy comot and sidon jeje for ground "ahh!,laski wetin do ya head nah,you kiss wall?,sambisa yan from wia im sidon for ontop window dey puff smoke "i no even look up sef as i light the igbo wey i just rap finish,wit one long draw all my body begin boost sharpaly few minutes later,some cultist guys shuk head enter the place nahim everi body scatter,except for me causetrouble,sambisa and mento wey be part of dem ************************ clarendo Jamaica ---------------------------- along the years,man don change mentality,as we dey believe sey before you go fit succeedas a killer nah ya jazz go determine but not again,all that rubbish believe don turn pass tense as man is now a hardcore killer,wit all the training for the past few years, just to train as assassine,no jazz this time but brain work,no jazz but determination and skills,i work wit my big bro as assassine and nah this one be my first mission wey i go carry out single handedly the taxi man stop for front of one tall giant hotel "rockhouse" nah the name wey dem write boldly ontop the hotel wit my well shined shoe,black suit and black glasses i shuk head come down from the taxi, settle the taxi man then grab my suitcase and begin waka go inside the hotel with fake identity,as my mission nah to kill Mr Romone Gimmet,a very rich drug dealer,the man bad,smart pass anything you fit imagine with tough security wey dey always surround am,but as my mission nah to terminate im life,nah only time go tell if i go succeed "good day sir,please how may i help you sir,a female receptionist yan enter my brain immediately i step in,omo i won comot the black eye glass and look her packaging well but i get target,so i just bone her big br**st wey just dey point my mouth "goodafternoon,please i need a room at the last floor,i really want to have a nice time here looking at the whole city as this is my first time here in Clarendo,i dont know if there is any vacancy there,i yan "she purse for a while,released her breath then replied",yes sir we have about 10 vacancies in the last floor,she said calmly as i just stand wit my suit case dey look her "good!,please i wonna lodge inside one she face her computer after clicking some button she pass me one file wey i take fill my details then paid for the room as she carry the room key give me,i grab the key and waka straight enter the lifter,i seize my breath till the light blink indicating sey i don reach,jejely i waka comot and quickly locate the room before people go surface for the passage,the door tear open sharply immediately i drive the key enter,as the the door jam tight i drop the suitcase ontop the bed and begin comot all my clothes "as nah only boxers i dey wear now,i carry phone type short massage and forward am to mike,the suitcase tear open immediately i press one red button nahim different materials surface,scattered pieces of iron metals,timer and a male hotel uniform,sharply i change into the hotel uniform then begin fix the iron metals till the whole tin form a long sniper gun "i carry the sniper and the timer rush go slide the window open just small,i position the camera so that e go fit dey record anything wey dey happen for front of the hotel,then set the timer as the tin begin count in minutes down to seconds, "i watch as different cars line up begin enter the hotel premises,Mr Romone Gimmet get meeting wit plenty other business partner and nah rockhouse hotel dem won stay do the meeting,i watch as four security men jump down sharply begin survey the whole compound,dem use something dey check all the window so i kukuma comot,as dem nor see anything one of dem waka go inform dia oga as more security guards surface with different weapons,all of dem scatter stand for different position then Mr Romone Gimmet comot one leg outside as im security man slide the door open,jejely sweat begin gather for my forehead as the fat,black and tough looking old man step out wit im walking stick,i shut one eye then begin look the pointer camera wey dey ontop the sniper,i begin turn one button as the tin begin zoom,wit the red cross sign well positioned on Mr Romone Gimmet skull, i release better tap on the small metal as a very fast moving metal speed comot viam!,the whole security scatter as dem begin rush dia oga wey just release im last breath,blood full the tinted glass as Mr Romone Gimmet lay down dead for ground,sharply the hotel was locked as the guards begin rush inside the hotel To be continued.... in other not to disappoint i have to type and post this update at the midnight,nah wen i get small chance be dat make una no para for me o!....... |
help me win short story award!kindly click on the link to vote for me on facebook by LIKE and COMMENTING my own short story,remember the writer withthe highest likes andcomments wins the award so brothers and sisters support youngzubi,help me win the award by clicking onthe link below,mention your Facebook friends to mention their own friends,together we can do it!!!!,,ghost readers you can also participate just click on the link,or you search"boldscholar" on ur fb search scroll down to the one of Desmond nona..LIKE,...comment and mention your friends God bless u as u do so click here! https://mobile.facebook.com/story.php?story_fbid=498512433955386&id=3 |
Karrisleo:move to the next thread,I will soon start dropping, just working on some stuff now |
izaray:season 2 is about to start |
youngimporter:true talk bro i understand, man must hustle so as long as you'er in good health no problem.. |
Iceberg41:ok bro. |
Holywizard:today wey be Sunday,bro repent for the kingdom of God is erm!,Chai wait lemme check my bible...... i go begin drop soon,maybe by Friday...i just want make una begin gather as i dey fear mention ontop ban,but i try write una names maybe peson go help me drop am for here.. |


Chai nah spana second u be o!!!,i can see dat spana don motivate your moral