₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,026 members, 8,448,263 topics. Date: Monday, 20 July 2026 at 06:09 AM

Toggle theme

Youngzubi's Posts

Nairaland ForumYoungzubi's ProfileYoungzubi's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 (of 29 pages)

LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 6:17pm On Sep 09, 2018
Iceberg41:
Yungzubi I don text you for yr mail kindly reply me bro thanks
bro you'er such a nice person,only if you know how honoured I'm feeling

God go bless you...

i don reply brotherly
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 12:19pm On Sep 09, 2018
Thread for season 2 is now officially open


click here


https://www.nairaland.com/4723666/fit-second-jesus-sex-na#71041088?_e_pi
LiteratureRe: I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(op):
Welcome my people,as the matter take dey be,we go soon enter another gbeducous journey full of joliment,for the tori reader dem,as E dey hot,the matter go dey drop without long tin,biko i take baba wey sidon jeje for up wey nobi ontop our roof but heaven,abeg make we change our mind set for this season 2,wetin i bin try yan una be sey make we dey try comment,see eh! if comment dey land as the tori sef dey land,both me wey dey write am and una wey bin read am go dey happy!!,the tin go dey mix like beans and bread as we go dey use likes and shares to dey dilute am,

Tori lenez!! the tin go bam die!,as oyinbo people sef don shuk head join the matter,make una remember o!


nobi sey i won begin long talk for hia,but i go like make everi body join body follow dey contribute,i nor fit know how good abi bad the tori take be if una nor talk am

if e get mistakes wey bin dey trouble ya mind,biko no delay!,kai kai samah the gbaski and halla my name ontop am,believe me i go tear race shuk mouth for the matter


so my people una welcome..

THREAD OPEN.....

STILL YOUR GUY YOUNGZUBI



click here to read season 1

sex na food(PIDGIN comedy edition)story of a rugged guy by youngzubi

https://www.nairaland.com/4604676/sex-na-food-pidgin-comedy?_e
3 Likes 1 Share
LiteratureI Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:50am On Sep 09, 2018
No part of this work should be republished or copied in any form without the writers prior permission

any interested person(s) should reach the author in any of the contact below

email: youngzubi@gmail.com
Facebook: Desmond nona
Beware! Be warned!
4 Likes
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:38am On Sep 09, 2018
Asek1:
For keeping me entertained
For making me laugh like a crazy fella
For completing this story
All I can say is Weldone

I never wanted to comment all through the course of this story cos I have a phobia for being part of an uncompleted project but am happy you proved otherwise.

Weldone again and pls remember to mention me in the sequel of this story.

The sky is surely your starting point cool
thank you bro.....
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 3:44am On Sep 09, 2018
MummyIMadeIt:
Weldone Op for your creativity... Meanwhile I be wan understand how una take survive the assault for Florida house; unto say bigmama yarn u how spata use exchange una juju bead with ordinary one.

Remember say the bullet wey them waste for spana leg enter am...

So I come confuse how e take be say ur spider squad survive dat plenty bullet wey dem collect for that compound
yea,you know since the story have season two i was planning to lay more emphasise on their survival there, but incase if i did not do that

remember i wrote in that area that,the bullets was tearing their skin which was unusual,and to spana he tot that it was cos of the kind of weapon those guards were using,,,,,

NB: the neckles will protect them from bullets penetrating through,but without it though they can die but by more than 2 bullets going into their heart or head

so non of them got shot on any of those areas,cos they were carefully dodging the bullets by taking shields


the story have season 2,although it will be filled with more of actions,but i will also lay emphasise on some hanging issues in season 1,like the family,both baby mama and baby inclusive...
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 3:25am On Sep 09, 2018
Iceberg41:
What yr Facebook id bro or check yr mail
i have replied your mail
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 9:10pm On Sep 08, 2018
HazardMan:
Ogbeni, that boldscholar stuff is really competitive o, there was a time i tot u already won. I wonder where the other guys get their likers from.
hahahahaha!!!! naso i see am o!,me sef just sidon dey look,i bin dey reason whether my like dey increase Abi reduce


but anybody wit fake likes will be disqualified....

i just sidon dey watch am like tv
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 7:12pm On Sep 08, 2018
Iceberg41:
Bro youngzubi na u be Nobel laureate of nairaland
After you na you boss I just sai make I bam my pride my pride make I comment
My mind no go 4give me if I no bam you with a gift even as token as it is I will have to


Abeg text me on whatsapp 07037063013 to get yr reward 4 yr hardworking and wonderful skill
I go dey wait for yr text abeg no impostor should follow me yarn as youngzubi on whatsapp abeg �����
thank you so much brotherly,please can we connect on Facebook or through email, am not using watsap currently
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 7:09pm On Sep 08, 2018
Tolezy001:
Bro zubi abeg kontinu wit ya pidgin.Ghost mode deactivated
u do well my man,surely i go halla ya name
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 12:00pm On Sep 08, 2018
chrischike:
I confess
Abeg mention me when you create season two thread
I promise to be commenting more often grin grin grin grin grin grin
good guy....
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:57am On Sep 08, 2018
rockhillz:
GHOST READER's ASSOCIATION

After the convention of the BOT's,NEC,Major stakeholders of the above organ......we yan say na PIDGIN be the way

~RockHillz~
noted....

gather yo people to follow dis ur step....
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 10:12am On Sep 08, 2018
rukidanty:
continue with your pidgin English o.. your ghost reader
you bam! ruggedly,as u shuk head comot for yo ghost sef

welcome..
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 9:27pm On Sep 07, 2018
ATTENTION!! PLEASE

I need everybody to make his or her choice here


SHOULD I WRITE SEASON 2 IN ENGLISH OR I SHOULD CONTINUE WITH THE PIDGIN


DROP YOUR CHOICE BELOW,YOUR CHOICE DETERMINE WHETHER IT WILL BE WRITTEN IN ENGLISH OR PIDGEN


thank you all for your encouraging comments so far,and for those who are impatiently waiting for season 2 without dropping any comment,just go fin stone touch it to see how strong your heart is!.....

still your guy youngzubi
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 9:19pm On Sep 07, 2018
donaldphilipizu:
Wen r we,,,, expecting season 2 pls reply @ youngzubi.
currently working on something right now,but i promise to start season 2 soon

it won't take long

i don already mark ur face well,tanx my man,i go personally mention u by my sef once i start season 2
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 8:48pm On Sep 06, 2018
Donspicey:
Bros 4 Diz Ur Talent Abeg Na Wetin Dey Behind Am??..If Na Jazz Na Wich Type U Chop And If Na God Abeg Na Wich Kain Seed U SowhuhU Too Bam Ma Nigga,,abeg Mention Me 4d New Thread
Hahaha!! bro nobi jazz

yea nah God!,and nobi matter of seed sowing bro,God nobi give and take type,just believe in ur sef and God,surely you will see your sef doing just great
1 Like
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 8:32pm On Sep 06, 2018
sensitivity1256
pradoic
johnsown1
youngimporter
warrifirstborn
okarfor200 (madman grin)
i dey fear ban o!,abeg make nairaland no samah me another one


if i no mention u just know sey you dey my mind,i dey see una and i dey feel una too!







*******************
as long as sey u drop ur comment my bro pradoic go halla your name for season 2 thread

but i go still come drop the link for here so that both my ghost readers go join,all of una na my fam!! so i go still carry my ghost readers along grin
1 Like
LiteratureRe: YoungZubi Wins August 5K Award by Youngzubi(m): 5:36pm On Sep 06, 2018
Pre pre pre pre praise!!!! dah lord!!!

hallaluyah!!!!!!!!!!

yes o!, the very first amazing step...

first of all i give thanks to almighty God for the wisdom,life and grace to see me through

and to the sponsor of this wonderful award,ma/sir God will also reward you,your pocket will over flow with blessing,may the almighty God in his infinite mercy favour you...Amen!!!!!!!!,clap! clap! clap!


thank u thank u thank u!!

now let me thank my lovely fans,mehhhhn una too much jare!,no shaking noting do una,i pray sey baba God go bless una one by one,if nah woman u want like okarfor200 gawd go dash u one like ann2012grin
you guys rocks!!


thank you so much princesa, much more love for u!

divepen1 boss i remain loyal
4 Likes 2 Shares
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 4:58pm On Sep 06, 2018
thank you all for the encouraging comments,please keep them coming,dont keep mute it won't help at all


honourable365
rowdymind
centino
souloho19
swiz123

and all other family members please i beg una pardon if i no hala ur name,nairaland go ban me sharpaly if i mention plenty people


i don drop pen o!....na una own comments i go dey read now
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op):
Sex NA FOOD written by youngzubi

Episode ...53 written by youngzubi

LAST EPISODE
************

WARRI NO DEY CARRY LASS
-------------------- ------------------



for wia i sidon for ground,plenty tins just dey run inside my mind,the injury wey those wicked officers give me nobi my wahala at all,dem beat shege enter my body,dem yan sey i won kill fellow prisoner,but dem nor allow me make i yan dem how e take happen,dem nor gree sey nah the macho guy waka come find my trouble,just becos sey nah me over power and injure am, dem just allow me make i recover from my fainting for two days before dem come carry me enter dia torture room beat rubbish enter my body,since den nah so so punishment i dey do,the one wey dey pain me pass be sey dem still charge me for attempted murder join the one wey i don murder

tomorrow nah the day,my trial for court,whether i go live abi die nah tomorrow go determine,as malaria don nack me sotey i begin see illusion for dream,that stupid old man nah handwork of malaria,e bin get wen i dey possessed wey be sey i dey always cause trouble for street like madman,i don stab plenty people,if i never shuk you knife e mean sey you never provoke me,but nah the day wey i almost use knife stab one area boy for street to death,the case carry me go station tire!,nahim my ma'le begin carry me shuk head enter different church for warri till one pastor like that deliver me,im yan sey nah possess dem possess me but i don free,naso i take stop my violent life but if i dey nack woman em! i nor sure sey the pastor see that one and i like am,

as i sidon dey tink,i begin hear noise for outside but the prison structure nor fit allow me see through the iron door,i try stand up but the chains nor gree me move at all

boooomm!!!!!!,the noise too loud as a very bright light flash everi wia,i begin try free from the chain,e be like sey the prison get attack,i begin hear scream as gun sound fill everi wia,with sound of the gun i nor need make peson tell me sey nah correct one,next tin i begin notice sey all the prisoners don free as i begin hear dia scream as dem flood the whole compound

i just dey wonder watin dey happen as hot we-we begin catch me becos explosions just dey happen for everi corner,then i notice as figure rush the cell wia i dey,the peson kneel down begin fix something for the entrance door,as im finish naso he shift go back


"are you in there?,Step back!,hope you heard me move back!!

gbooo!!!,the prison door wia i dey scatter as i sight white guy figure with sniper for im hand as im begin rush me for wia i manage squeeze my sef

im rush me and shine touch light for my face then look one pad wey im carry for hand

"good,hey! dude you gat to be quick,we dont have much time here,the white guy yan as im comot something from im pocket begin unlock the chain wey dem use chain me

i just confuse as i just open mouth dey look the white guy,pkeekim nor gree me talk as i nor expect any tin like that

"have this,he yan as im trow one pistol gun for my body,i grab the the gun and stand up,i look the guy then yan",thank you bro,viam! i dash outside

"hey dude no no!!,you have to follow my lead!!,the white guy yan but i don already reach outside


immediately i reach the compound i sight fire burning everi wia as smoke full the sky,human flesh just dey smell,i tear race as Stevo dem enter my mind,i begin run go the long prison but everi wia don empty wen i reach,so i run go back as me and the white guy wey free me jam

"here!,he yan as im point one place like that 
"yo people is safe there,so quickly lets go join them we dont have much time we have to leave!! now


(note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond)

"i follow the white guy as we begin run,some dead officers dey ground as some prisoners wey never run begin butcher dia body with weapons,dem nor even won hear sey the officers don die


we burst out shuk head enter one place like that,nahim i sight my guys all of dem rush me immediately i surface


"spana!!!,so dem nor kill you!!,sentino yan

"rock man no dey die!!!,Stevo yan as we begin dey shake ourselves with much more united happiness 

then one huge figure jump down from one truck wey pack beside the road,as i sight am my heart shake,if nobi sey i stand with my guys i for don pick race

i leave my guys sharpaly as i begin match forward near the big figure step by step jejely in slow motion

im don too huge,as all him muscle pose ruggedly,i begin wonder if im inject himself becos all the veins wey dey im hand stretch dey show,im body structure don over change as im chest now stand,im just resemble ( the rock) i carry head up look im face and call am

"mike!

"kid bro!,im macho voice echo deeply


"how come?,you still dey alive,how you take locate me


"its a long story bro

"so you dey around all this while,i yan still confused


"not so bro,after the incident i had with big mama,i left the country,i planned everything perfectly well,everything was ready so immediately i hit my target i flew to Jamaica,am sorry kid bro,but i must commend the strong man you have become,here is my crew members,they are all my boys,we work for the top white bosses,as assassine and mercenary, this guys here are gods with weapons 


"i look as four whit guys wey dress ruggedly with bullet proof vest and different types of sniper in dia hands,the guys look sharp

"but how come you take locate me here,i yan

"he did,mike yan pointing a figure wey match outside with Bluetooth wey dey blink light for im ear

"bobo!!!!!,i shout as i rush am

"bro thank gawd you survive, i for no forgive myself,bobo yan as we begin shake


"we met in China months ago when we went down there to assassine a Chinese master,we jam ourselves for hotel wey we log,but i yan am sey make im no tell you or anybody as i carry am go back to Jamaica after we don accomplish our mission,wen im receive ya massage we begin prepare sharpaly even as ya massage yan sey if you nor reply am by evening sey make im fly come niger begin find help,bro you wise die!,like you yan as we nor see any reply that evening we begin prepare to come nigeria sharpaly,we go your house but every wia don luck,we begin spy till we jam one Bola lady we dey parade around ya house with moto every day,so nah she give us all the info wey we take locate here,"mike explain

"wow! wow!,"bobo you try my guy,i yan

"wia spata?,bobo yan


"nah spata betray me,im just sell me!,i yan


"watin!! ,h-how??,bobo yan


"nah long matter,i yan


"we go hit Mrs jolade hard!!,but for now we go lay low,i don work for big mama for years,she nobi wetin you dey see,that woman nah devil, if we must destroy her and take our revenge then we go just leave her for now,we go return for her matter,we go die her matter for years if we must kill her,so kid bro calm your heart,we go revenge but for now you need to rest,follow me back to Jamaica,mike yan


"i turn look my guys,dem give me thumbs up,then i turn and face my brother

"till death do us apart bro,i yan

"till death do us apart kid bro,we die for each other as blooders,but for now we lay low


(note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond)

THE END........
19 Likes 5 Shares
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 6:59am On Sep 06, 2018
maduenu531:
na only one thing go make this story end like this for this una trend abi thread i nor nobut if una no fit comment after reading ....then make una forget am becos me sef get plenty work for hand,i no go find time write finish una go read without saying kpeekim ... no e dey vex me reach bone
gringringrin
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 6:57am On Sep 06, 2018
pradoic:
thank you brotherly...
bia prado why u dey do like this nah,replying for me,nah me wey go creat account for u cause am,this ya igbo smoking don dey cause u too much harm
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 6:55am On Sep 06, 2018
brunxy:
Youngzubi if u understand my comment correctly u will know i am not doubting u in any way but rather amazed at ur ingenuity...young man dont get it twisted cos i am proud of u and i am a strong advocate and supporter of young people doing great things in every field of their endeavor...I understand the emotion behind ur comment as it is obvious u hve been doubted in the past because of ur age even without being given the opportunity to prove urself.....But learn to use it as a motivator to better urself rather than a weapon to attack people and be on the defensive and offensive always.

Kudos and keep improving urself in every positive things u re good at.
i gat you brother....thanks man
1 Like
LiteratureRe: Bottle Warriors(beer Parlour Night Tale)story By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:32pm On Sep 05, 2018
lotanna341:
I perceive a great story here... Will be waiting for more updates to make my assessments
huh
LiteratureRe: Writertain Writers League .... Registration Thread by Youngzubi(m): 9:46pm On Sep 05, 2018
Divepen1:
Meaning, you're in ?
yes bro am in....
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 9:43pm On Sep 05, 2018
brunxy:
;Dhow a young dude like u is able to paint those sex scene in ur story with the description of an experienced mind is a wonder i am still trying to fathom...


Kudos all thesame..nice work
bro once you'er creative believe me nothing will be so hard for you to put down,i know that alot of people wont believe that I'm the one writting the story"African mind" our mindset is just too poor,we believe that age matters in achievement,but believe me bro youngzubi is just starting

i do music too

computer nah calculator for my hand,i fit do you shege!!

then my writting skills is just the least and latest that i just discovered


abi should i talk about comedy,that one is inbuilt ask my school mates,class teachers they will testify to this one


i just dont like it when people under rate my effort due to my young age,is it because am black!

white people are doing greater things starting from their very young and tender age,and we blacks praise and adore them

but here i am coming up trying to do what i see people do and become great only to see people doubting my effort


i think them,write them and post them!
4 Likes 1 Share
LiteratureRe: Writertain Writers League .... Registration Thread by Youngzubi(m): 9:23pm On Sep 05, 2018
i love competition alot,this looks nice and interesting

although i dont really know much about it,but will be waiting to see how it goes..
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 9:14pm On Sep 05, 2018
shen05:
na the award money you use buy watch abi
lol,brother you no get church mind o!
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 8:05pm On Sep 05, 2018
tomgab:
wow, I love this new twist in the story. I kind of expected it though, since spata didn't look sick to spana.

Again, your work was professional. keep it up and coming
thank you bro...
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 8:01pm On Sep 05, 2018
uchman48:
You guys should come together lets vote for our youngzubi on the boldscholar contest, we did it on Nairaland, we can do it again. Please dont ignore this young talented guy. He needs our likes to win the contest.
thank you brotherly,i really appreciate this....
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 8:00pm On Sep 05, 2018
Olivers2J:
Small boy with big God cute and intelligent full package 4 single's searching & ready to groom.

That said no dull this area update sharply sharply



He smiles
lol!,are you trying to advertise me or waaa!!

thank you dearest....
1 Like
LiteratureRe: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op):
sex NA FOOD written by youngzubi

Episode........52 written by youngzubi



I Get sho-ko 
------------------




kill am!!! boss show am pepper!!!, boss!!! boss!! boss!!! 
boss!!!!

all the prisoners dem just dey shout dey hail the macho guy,from wia i bend down, i fit hear the guy footsteps as im waka dey come my side,everi body dey hail am,dem dey jam dia hand for iron as heavy noise just full the whole prison yard


i begin feel hot as vex begin boil for my head,for wia i bend down i begin remember everi tin,how we take start,how i don help spata starting from our childhood,but see as im do now,

nah like this im won take pay me back,no i nor fit die like this,either i fight for my freedom or i die fighting,but i no go die like this noo!!!!!!!,i shout and stand on my feet,i begin see differently as my breathing method change,

"spana noo!!!! abeg no do am!!!,i hear as a guy voice shout from the other prison


i turn look the peson,nahim i sight Stevo for wia im dey hold the iron protector,i begin turn my head as i begin find others,then i sight erotic for wia im stand,the guy just frown face dey look,im nor talk pkeekim

towwaaa!!!!!,the macho guy jam me heavy punch for belle

aaahh!,mm!! ah!,i kneel down for my kneels begin cough

the guy still rush me grab my head then raise up im hand to land me blow but i seize im hand as i grab the hand tight,i jump up stamp my feet for wall and land the macho guy superman punch for face tooowww!,the guy groan and begin stagger go back,the prison turn silent,you fit hear pin drop


(note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond)

i look up as everi wia turn bloody for my eye

"i need blood!!!!",no you'er delivered!!

"blood!!!!,"noo!!!

nah those two voice i just dey hear for my head,the voice turn very loud as my head begin crack,i close my eyes tight,grab my head and begin shout noo!!!!,then i tear eye open nahim all the veins wey dey my hand begin showcase as nah to tear peson apart dey hungry me,the energy wey begin flow for my body too much as nah to scatter blood i just dey hear,feel and won do

i look the macho guy,i sight am wia im don tear race go rest for wall as fear full im body,i begin take one one step go meet am

"no no no! abeg!!,im begin yan wit im macho voice,but blood must spill before i go get my sense back as im don free the evil wey be sey dem don cast comot for my body tey tey


as i reach wia the guy rest im back for wall dey shake wit fear,with my right hand i dig am inside im eyes,the guy shout in pain as some fluid begin run down my fingers,i comot hand and jack him up

"heeeeyyyyyy!!!!!!!, the whole prisoners begin shout with joy as some dey clap while some just dey hit the iron dey hail me


just for me to jam the guy for wall and then tear im stomach apart nahim one sharp object pierce enter my hand,a drop the macho guy and groan,i turn around only to sight the prison officials everi wia inside the cell, all the prisoners don already keep qa-yet as all of dem just stand back dey watch


with vex i begin near the iRon protector but dem begin shoot me watin be like needle,jejely my steps begin slow,all my body begin weak as my sight turn blur,i stand for one place begin stagger till i collapse everi wia turn dark 


"welcome my pikin,dem tink sey dem fit comot your spirit from ya body,but nah lie,i don already put am inside you nah just for your to bring am out then sabi how to use am,......i just dey hear as old man voice dey yan all this rubbish but i nor fit understand my sef 


"who be you?,i manage yan,but i just dey feel like pikin wey dey inside belle as everi wia dark,


"you nor go know me my pikin,but ya people separate us wen you begin know me,just try sabi how to enter ya dark side since you don finally come back after 15years wey dem cast me comot for ya body,"the old man voice yan

'"i begin struggle to open eye but all my body and the surrounding environment just seize up,i dey feel my struggle but my eye nor fit open,i just know sey nah laying position i dey




"my pikin nor worry,you go overcome but e nor be must,you fit or you fit not,just make sure sey you run for that woman wey put you for this wahala wey you dey so,if you get any chance escape at all at all,no go back for revenge abi anything,she go just shrink you like creyfissh 



"i bin won try ask the old man who im dey talk about,but i feel heavy current wey vibrate enter my body

"aahhhhhh!!! i shout and jab up,sweat cover all my body as i begin blink my eye onto sey the brightness of the place dey enter my eye


"welcome back Mr man,one officer yan holding two electric wire wey dem connect for one box like that


two other officer waka come drag me up as dem chain me tight sotey i nor fit move even my leg,dem use one tin like that wey get tyres take transport me go another prison wey be like cage,nah only me dey inside that one as nah only small small dot openings dey for the iron door,dem luck the door gbim!

******************** *****



DAYS LATER
-----------------

as nah only wen dem won come give me the rabbit shitt wey dem dey call food be the only time wey dem dey open the iron door,this early mo mo four officers waka come drag me out,omo i begin yan thank you Jesus as fresh air begin blow my body,i begin pray make rain fall wet all my body but for wia,dem just toll me enter one room like that,nah dia my eye jam Bola and my lawyer,i see as Bola eye cover with tears but that one nor even be my business at all,as i don cry wen i see cry, my lawyer yan me sey my trial nah few days ahead,sey she don gather all the information wey she need,she still ask me plenty other rubbish wey be sey at the end,she yan me sey",Mr chinedu am sorry to say this,although i will try my best but your chance of coming out victorious is very tin,i wish you goodluck

(note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond)
to be continued........
4 Likes

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 (of 29 pages)