Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,879 members, 7,824,669 topics. Date: Saturday, 11 May 2024 at 02:53 PM

She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday (2739 Views)

I Thought She Was A Friend,now She Wants Sex in return for a Favour. / His Brother Wants Him To Sleep With His Fiancé / She Played Hard To Get, It Failed, Now She Wants Him (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 12:11pm On Oct 01, 2012
Make una come see wahala wey dey ground ooo.one of my close pally wey dey work as cheif security officer for one chinese company currently dey quarrel wit im girlfriend.from how me take hear the matter the babe be ask my pally for ninety thousand naira for her upcoming birthday party and he come say the money wey she ask too much and instead na eight thousand naira he go give her.na so matter come be and suddenly the babe come start to dey vex and dey call my pally selfish man.no do no do na so the babe come dey refuse my pally sex.he say any night when im dey in the mood if he come touch the babe na so she go jus close her legs hiss at am then come face wall.he say im don try dialogue with the babe but she no wan listen.anyway to cut a long tory short dis early morning me come surprise as the babe come cry come my house.i ask the babe wetin be the matter and she say my pally don pursue her comot from the FACE-ME-I-FACE-U wey he rent for her.she say she no jus understand which demon don take over my pally.me sef come call my pally for phone to know wetin be the matter.He come dey vex and dey say make i no disturb am.he say the babe na very ungreatful girl.he dey pay her house rent and school fees without compliant and just because he no give her 90k for her birthday she jus dey treat am like say im na rubbish.omo na so my pally jus dey provoke for phone and me sef come dey try to cool am down.he say if im girlfriend no gree perform her girlfriend duties and she still insist on starving him with sex then he will have no option than to stop paying her school fees.he say he don try for the girl but she no fit understand say these days money no easy to get.me sef come ask the babe her side of the tory and she come yarn me say the only thing wey my pally don buy for her na the second hand nokia torchlight phone wey she dey use and two pairs of okrika pant wey he buy for her last christmas.she say my pally na really stingy man.she come also say her mates their boyfriends dey buy blackberry for them but just becos my pally buy common nokia torchlight phone for her he no wan let ppl hear word.My fellow esteemed members abeg dis matter don pass me ooo and i no fit solve am ooo.i need una advice urgently oooo b4 dis matter come turn into a second biafra war sad sad
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 1:00pm On Oct 01, 2012
o boy that guy stingy true true torchlight phone? grin Why hin come tell the girl make she pack comot. He no try at all. Make him try support the girl, na him babe no be him sister. even if he no hold 90 ton, hin suppose give am money wey make sense, come explain palava wey dey hin side. she be babe, she suppose grab cos this thing na small wahala.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 1:21pm On Oct 01, 2012
O boy, your pally is a du.mbass, he should have stopped paying her school fees TOO. Why give another chance to this ungrateful animal called a girlfriend?! Her gf's bf buy BB, right? So why didn't he tell her to go date them (since they are so good), and be done with the misery.

If it was me, the minute she'd refused to get jiggy, would have been the minute I would have packed her stuff and thrown her stoopid aaassss out the place. Nonsense ungrateful beggars that think they can make rules in another man's house!

3 Likes

Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by MrsChima1(f): 1:34pm On Oct 01, 2012
SMH at the comments.

1 Like

Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by mumumugu(m): 2:39pm On Oct 01, 2012
Lefulefu can manufature stories.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 3:18pm On Oct 01, 2012
Lefool Lefool and him imaginary pallies sha...Abeg I dey feel u jare. But that ur pally na mumu ooo...shey he no fit tell the babe say he no be her papa ni. Guys of nowadays sef. Mscheww...Na so later the girl go cme dey cry like fowl say she no love her husband anymore after she marry am becos of material things finish com dey sleep with all these small small boys.. Help me SLAP ur pally back to his senses
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by slimchi2k2(m): 9:43pm On Oct 01, 2012
lefulefu na one pally u get,or them many
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by saintneo(m): 10:08pm On Oct 01, 2012
Why don't your pally engage the services of a professional proostitute? It's cheaper and it's pay as you go.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 10:39pm On Oct 01, 2012
shocked shocked.... cheesy cheesy grin..... lipsrsealed... cool
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by ikekings(m): 10:52pm On Oct 01, 2012
Lefool lefool which one be okirika pant nawa ooo... The guy no try at all... Him for buy her ”designers pant“ nw... The girl sef no try why she no wan open her wide gate for the guy nw? Because him no give am 90k...
Emmm... Lefool lefool wetin come happen with the girl wen she came to your house now?
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Ariyke: 11:29pm On Oct 01, 2012
If u ask me na who i go ask
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Mynd44: 4:25am On Oct 02, 2012
Personally, me I no understand why that your paddy dey pay school fees of person we no be im pikin or sister. The girl no he parents or she no fit work.
But as e don happen like that, e good as he pursue her commot. Make the babe no come turn landlord for house wey she no build
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 5:08am On Oct 02, 2012
Ariyke: If u ask me na who i go ask
as in...the things wey i dey see, wey i dey hear, i no go lie e pass me.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by ghettodreamz(m): 5:32am On Oct 02, 2012
Lol.. Guy you sure say both your bafoya and the shawdy de reason you confirmento sha? 90k no too much na for d guy as long as d love between dem tanda but if hin no get am e get level hin suppose put d babe so she go fit reason wit am na say hin no get d bar. D tori sound like say d guy na ashee, why she go dey deny hin guy d thing at ransom na? If na true true say na yor padi rent d house giv am, no be new level things you do for love no ni, but if na so, d girl no suppose behave like dat na cos na ur guy de pay hin rent and even sch fees. Both ur padi n d babe wrong here and 2 wrong no de make one right, make both see down reason wella togeda, if true love de, d babe suppose understand if hin tell am say hin pocket no shaka, but if d babe no wan hear or beliv hin fit allow d girl waka 4wd, be like say d girl don de eye dos hin friends' boyfriends sef so she wan measure and follow dem enter league as big girls dat na why she need dat kain bar for d birthday. I de sure say if ur guy pay am d bar sef, hin no go sabi wey d girl go do d birthday cos enuff oppression go de, when your guy carry leg waka go dere and hin friends' boyfriends enta d place with different cawara with Ilefo toh badt(serious temptation) cos d babe no go wan make ur guy fall hin hand na. Nokia torch lite, I even think say na BB torch you wan mention sef, Porsche or iPhone, tell am say make hin de prepare pocket ready small time d girl friends go de use iPhone 5, she too go wan join body enter league wit dem so make e ready go biri biri for months to fit afford d fone for am. My own no pass like dis, if you need me talk more u fit ask more questions sha, I de hear tanda, no de waka go n wia for nw
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Mynd44: 6:53am On Oct 02, 2012
^^
Abeg guy, lock up jorh. The girl wan turn the guy to maga na. If na unto love, she suppose understand say man we dey pay im school fees come pay rent join and dey feed am no selfish.
The money no dey and im suppose manage
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by ghettodreamz(m): 11:06am On Oct 02, 2012
Mynd_44: ^^
Abeg guy, lock up jorh. The girl wan turn the guy to maga na. If na unto love, she suppose understand say man we dey pay im school fees come pay rent join and dey feed am no selfish.
The money no dey and im suppose manage

nA same thing we de yarn na... It depends on the levels dem de na.. If na Loving you or Friends With Benefit, levels de street full ground...
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 2:33pm On Oct 02, 2012
ikekings: Lefool lefool which one be okirika pant nawa ooo... The guy no try at all... Him for buy her ”designers pant“ nw... The girl sef no try why she no wan open her wide gate for the guy nw? Because him no give am 90k...
Emmm... Lefool lefool wetin come happen with the girl wen she came to your house now?
seee the way ur mind dey work grin.u dey ask me wetin happen wen the girl come my house.u think say i chop the babe?.i no fit do such thing to my pally ooo cheesy
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 2:38pm On Oct 02, 2012
joeydozzy: o boy that guy stingy true true torchlight phone? grin Why hin come tell the girl make she pack comot. He no try at all. Make him try support the girl, na him babe no be him sister. even if he no hold 90 ton, hin suppose give am money wey make sense, come explain palava wey dey hin side. she be babe, she suppose grab cos this thing na small wahala.
for some places in naija na even big levels if u get torchlight phone.abeg my pally still try say he buy phone for her
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 2:41pm On Oct 02, 2012
ghettodreamz: Lol.. Guy you sure say both your bafoya and the shawdy de reason you confirmento sha? 90k no too much na for d guy as long as d love between dem tanda but if hin no get am e get level hin suppose put d babe so she go fit reason wit am na say hin no get d bar. D tori sound like say d guy na ashee, why she go dey deny hin guy d thing at ransom na? If na true true say na yor padi rent d house giv am, no be new level things you do for love no ni, but if na so, d girl no suppose behave like dat na cos na ur guy de pay hin rent and even sch fees. Both ur padi n d babe wrong here and 2 wrong no de make one right, make both see down reason wella togeda, if true love de, d babe suppose understand if hin tell am say hin pocket no shaka, but if d babe no wan hear or beliv hin fit allow d girl waka 4wd, be like say d girl don de eye dos hin friends' boyfriends sef so she wan measure and follow dem enter league as big girls dat na why she need dat kain bar for d birthday. I de sure say if ur guy pay am d bar sef, hin no go sabi wey d girl go do d birthday cos enuff oppression go de, when your guy carry leg waka go dere and hin friends' boyfriends enta d place with different cawara with Ilefo toh badt(serious temptation) cos d babe no go wan make ur guy fall hin hand na. Nokia torch lite, I even think say na BB torch you wan mention sef, Porsche or iPhone, tell am say make hin de prepare pocket ready small time d girl friends go de use iPhone 5, she too go wan join body enter league wit dem so make e ready go biri biri for months to fit afford d fone for am. My own no pass like dis, if you need me talk more u fit ask more questions sha, I de hear tanda, no de waka go n wia for nw
bros me dey suspect say na one rich Alhaji wey near their area na im this babe don dey eye.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by tellwsdom: 3:00pm On Oct 02, 2012
Thats one thing about these girls…they request like this money in question is like pure water u get anywhere…Shame on u bytches embarassed embarassed
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by ikekings(m): 3:22pm On Oct 02, 2012
lefulefu:
seee the way ur mind dey work grin.u dey ask me wetin happen wen the girl come my house.u think say i chop the babe?.i no fit do such thing to my pally ooo cheesy
I just wan know nw.... You be badt guy nw... grin grin grin
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 3:40pm On Oct 02, 2012
lefulefu:
for some places in naija na even big levels if u get torchlight phone.abeg my pally still try say he buy phone for her

grin
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 5:29am On Oct 05, 2012
LEFOOL LEFOOL, abeg make you confess. You chop the babe. cheesy
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Mynd44: 6:54am On Oct 05, 2012
ghettodreamz:

nA same thing we de yarn na... It depends on the levels dem de na.. If na Loving you or Friends With Benefit, levels de street full ground...
Na im I dey yarn you too
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by deshclones(m): 11:25am On Oct 05, 2012
Hv always had a policy since ma school days..never date a gal that ma dad is richer than hers...never..I don't even date poor gals..dem no born u well..even if d gal na agbani..I no go date..I no just dey ready for extra responsibility..I never even pay for hair or school fees..all dem chics from poor home are so damn selfish..asking a guy to buy things their fathers can never afford..rubbish..tell ur guy to bounce jor..u nd ur guys no even try..why in fccks name will someone date a student or corper in dis age?
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by deshclones(m): 11:26am On Oct 05, 2012
Hv always had a policy since ma school days..never date a gal that ma dad is richer than hers...never..I don't even date poor gals..dem no born u well..even if d gal na agbani..I no go date..I no just dey ready for extra responsibility..I never even pay for hair or school fees..all dem chics from poor home are so damn selfish..asking a guy to buy things their fathers can never afford..rubbish..tell ur guy to bounce jor..u nd ur guys no even try..why in fccks name will someone date a student or corper in dis age...imagine as lagos hard reach person go use him hand go carry extra responsibilty say na galfriend.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Nobody: 5:35pm On Oct 06, 2012
pDude: LEFOOL LEFOOL, abeg make you confess. You chop the babe. cheesy
guy abeg ooo no go put me into wahala with my pally ooo.i touch im babe ooo shocked shocked shocked
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Rossikk(m): 10:42pm On Oct 06, 2012
That guy left it too late. He should have kicked her dirty, ignorant, greedy assss out long before it got to this stage.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by ghettodreamz(m): 6:05am On Oct 08, 2012
lefulefu:
bros me dey suspect say na one rich Alhaji wey near their area na im this babe don dey eye.

grin grin grin No mind am jare.. Most of the Nigerians girls de very cunny at the same time, gullible.
Re: She Wants Him To Give Her Ninety Thousand Naira For Her Birthday by Mynd44: 6:34am On Oct 08, 2012
Rossikk: That guy left it too late. He should have kicked her dirty, ignorant, greedy assss out long before it got to this stage.
Nice

(1) (Reply)

Girls and SLMs: Seeing This In A Restaurant / 137 Reasons Why You Should Stay Single!!!!!!! / Why Do Guys Like "Girl Fights"?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 185
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.