Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,863 members, 7,817,557 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 02:18 PM

This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me (1475 Views)

Would You Serve Jail Term For Your Babe To Be Released? (photo) / Disadvantages Of Dating A Fat Woman(orobo) / South African Girls Have The Real Orobo: Bums Like No Other-- (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 12:28pm On Oct 29, 2012
There is this Orobo babe wey don move into my area.I dey suspect say this orobo babe dey trip for me.Every morning wey i dey pass her area and i greet her na so she go jus smile this sweet smile and halla back at me.Sometimes if i dey my room dey watch film she go join me too dey watch film with me.Sometimes sef she go even cook food bring come my room and at times sef wen hunger don waya my belle na so i go just finish lick plate.Now she dey ask me if i get girlfriend but as a sharp guy i tell her say i dey single for now.Anytime one of my babes from Jalingo dey phone me and if the orobo dey there and she wan know who call i go tell her say na my sister for village dey call.Me sure say if i wan do with this orobo she go agree but the thing be say i no dey attracted to orobos.But then if i tell this babe say i no like her then e mean say those free food wey she dey bring go stop, the small money wey i dey borrow her wey i no dey pay back go stop also and the bush meat wey she dey bring come for me wen she travel go stop.So omo wetin una want make i do?
Make i tell the babe say i no wan do or make i go ahead dey post the babe?
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 12:34pm On Oct 29, 2012
he be like say you be one jobless no lifer. go and get a job.

3 Likes

Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 12:39pm On Oct 29, 2012
rafhell: he be like say you be one jobless no lifer. go and get a job.
dem don baff u wit cement b4? sad
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 5:44am On Nov 12, 2012
Guy, close eye chop the babe. Because if you nor shine ur eye, no more free food for you o
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Mynd44: 7:29am On Nov 12, 2012
Chop the babe jorh
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 9:26am On Nov 12, 2012
Lwkmd! This guy na Antelope! I thought 190 was d only clown here...damn.lmao!
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Mynd44: 9:40am On Nov 12, 2012
binger: Lwkmd! This guy na Antelope! I thought 190 was d only clown here...damn.lmao!
you never jam
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by KINGwax(m): 9:50am On Nov 12, 2012
Mynd_44: Chop the babe jorh
on the contrary, the fat thing will chop her. If a fat girl is eyeing him he shld be sacred cos fat people, i learnt, eat a lot.
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 9:51am On Nov 12, 2012
Lefulefu!!!
Chop the kpomo, clean mouth!
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 10:10am On Nov 12, 2012
grin grin dude run for your life
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by jodam: 10:37am On Nov 12, 2012
lefulefu no go kill person for this NL o.
LOL!

BTW, Pls, where is born2fuck?

Lefulefu, Pdude (the guy with Adamawa experience) and mynd (Onile sweetest heart) don answer u.
Chop and belleful
LOL
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by jodam: 10:39am On Nov 12, 2012
rafhell: he be like say you be one jobless no lifer. go and get a job.

wetin be ur own?
Who called you for this matter.
Cant u just move on to the next thread (Im sure you have unfollowed this thread as Im typing now)
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Mynd44: 10:50am On Nov 12, 2012
KINGwax: on the contrary, the fat thing will chop her. If a fat girl is eyeing him he shld be sacred cos fat people, i learnt, eat a lot.
Hmmm. That's a thought
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Teejayphillip(m): 11:45am On Nov 12, 2012
@poster, wat r u waitin for now? U wan make anoda man com take am away frm u shey? i Hope u wont b jealous wen u see her wif anoda man,jus dnt bother 2 holla @ her... grin grin
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 11:20am On Nov 14, 2012
jodam:

wetin be ur own?
Who called you for this matter.
Cant u just move on to the next thread (Im sure you have unfollowed this thread as Im typing now)
u mind dat yeye village headmaster sad
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Nobody: 11:21am On Nov 14, 2012
Teejayphillip: @poster, wat r u waitin for now? U wan make anoda man com take am away frm u shey? i Hope u wont b jealous wen u see her wif anoda man,jus dnt bother 2 holla @ her... grin grin
me i dey still think wether make i plug the babe or not.i no wan go enter mysef inside wahala oooo.u8 know say na free congo meat na dem dey dangerious pass pass the ones wey u pay money do grin
Re: This Orobo Babe For My Area Dey Eye Me by Mynd44: 11:43am On Nov 14, 2012
[quote author=lefulefu]
me i dey still think wether make i plug the babe or not.i no wan go enter mysef inside wahala oooo.u8 know say na free congo meat na dem dey dangerious pass pass the ones wey u pay money do grin[/quote
WEREY

(1) (Reply)

Advice..am Going Crazy / Guy friend gets mad after I told him that I Will Paid For Dinner / Ladies And Their Attitude

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.