Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,362 members, 7,826,425 topics. Date: Monday, 13 May 2024 at 02:08 PM

A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard (2505 Views)

My New Girlfriend, She Slapped Me During Her Period / 3 Things To Avoid When Toasting A Girl / Help! Chima Slapped Me! (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by OmoUSH(m): 9:52pm On Sep 07, 2013
Abeg make una help me o. E get one FINE babe wey don dey eye me for over a year now, with serious green light. She wan fine lyk Beyounce. So last week i kon approach her with great shyness naim she happy greet me with blush. We talk that day so tey, body chemistry kon dey. I met her yesterday again. When our face just jam each other, naim she run jump on me with speed and one kind tight hug, for public o, i mean people dey look us like movie. I felt awkward and stupid. Man lost confidence patapata as e be like say make i disappear. Infact, e kon be lyk say i develop hatred for d girl at dat spot, and i be very timid and egoistical guy for girlz matter. I bone sha.Me and her no see each other for 4 days after that event. But yesterday night, when we meet in the night, i con scope her. D next thing be say d chik just scream and left me. In shock, i ran after her and grabbed her hand. The next thing wey happen na *GBOSA*. One kind heavy slap land for my face. O boy, kon c confusion and stagger. People kon come dey ask me wetin happen as the girl comot.
Abeg wetin cause make the girl start to dey misbehave to me all of a sudden. The thing now kon b say is like i don totally dey love d chik o, cos i sick no be small. Now, i dey struggle to see her. She don scarce baje baje.
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Enegod(m): 9:56pm On Sep 07, 2013
she gave you holy slap...atleast e reset your brain
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by ceosville(m): 10:01pm On Sep 07, 2013
So wetin you want make we talk?
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by sunday478(m): 10:03pm On Sep 07, 2013
May be she dream say u give her belle.

1 Like

Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by EejaNla01(m): 10:05pm On Sep 07, 2013
Op, sorry uh cry

1 Like

Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by wasak(m): 10:11pm On Sep 07, 2013
woman slap u? tchaii... wetin dem kill for ur naming day?

http:///15KQiAX
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by OmoUSH(m): 10:31pm On Sep 07, 2013
ceosville: So wetin you want make we talk?
Na type of u no get pity for your fellow man.

Okay, okay, maybe u think say i dey joke. Na until i show u my face u go understand. As in, the girl really hit me. C me naoo.

A beg get pity.

Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Adufaye(m): 10:36pm On Sep 07, 2013
Now wey u don talk evrytin finish weitin make we con talk again...........@OP
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by bionicdude(m): 11:13pm On Sep 07, 2013
OmoUSH:
Na type of u no get pity for your fellow man.

Okay, okay, maybe u think say i dey joke. Na until i show u my face u go understand. As in, the girl really hit me. C me naoo.

A beg get pity.
na ur face be dat.hehe @op u for tell me say u wan date mike tyson,i for know wetin to talk.
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Sunnytexco: 11:15pm On Sep 07, 2013
I hope say d hand wey she used slap u na ordinary hand make e no come b say na jaz she come jaz oo grin
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Nobody: 10:44am On Sep 12, 2013
@op... hope say d slap neva affect ur brain hard drive coz e b lyk say na iron hand she take slap u o
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Heineken(m): 11:19am On Sep 12, 2013
If any gurl try am 2 slap me ehn,I swear 2 God the gurl go fit die. Imagine...is it not a NO or YES something? Guy u be mum.u sef. U know tell us wetin u do d gurl as she slap u o
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Arosa(m): 11:44am On Sep 12, 2013
@op what does this mean?
when we meet in the night, i con scope her
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Nobody: 12:45pm On Sep 12, 2013
Pics or it didnt happen :-/
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by OmoUSH(m): 2:23pm On Sep 12, 2013
Segeggs: Pics or it didnt happen :-/
Haba! Nawao. So u mean i will be snapping myself as i dey toast the girl, or as her terrific slap dey come. How some people even dey think sef
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by 25omega(m): 2:58pm On Sep 12, 2013
Bamzy_don: @op... hope say d slap neva affect ur brain hard drive coz e b lyk say na iron hand she take slap u o
grin grin

poster your story seems to be missing some points but here is what i get from it so correct me if i'm wrong ...... Anyway she saw you and hugged you but you acted like a D-bag and then you ignored her for 4 days then, you saw her somewhere and tried to go claim her but she wasn't having it. Then instead of letting her go and cool off you grabbed her. Then she rebooted your hard drive with a slap.

is this about correct?

1 Like

Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by OmoUSH(m): 4:22pm On Sep 12, 2013
25omega: grin grin

poster your story seems to be missing some points but here is what i get from it so correct me if i'm wrong ...... Anyway she saw you and hugged you but you acted like a D-bag and then you ignored her for 4 days then, you saw her somewhere and tried to go claim her but she wasn't having it. Then instead of letting her go and cool off you grabbed her. Then she rebooted your hard drive with a slap.

is this about correct?
Men, almost correct sad
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Godson201333(m): 5:54pm On Sep 12, 2013
Okay did you return the slap...If you didnt then you are nothing but fooolz grin
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by MrCork: 6:07pm On Sep 12, 2013
OmoUSH: Abeg make una help me o. E get one FINE babe wey don dey eye me for over a year now, with serious green light. She wan fine lyk Beyounce. So last week i kon approach her with great shyness naim she happy greet me with blush. We talk that day so tey, body chemistry kon dey. I met her yesterday again. When our face just jam each other, naim she run jump on me with speed and one kind tight hug, for public o, i mean people dey look us like movie. I felt awkward and stupid. Man lost confidence patapata as e be like say make i disappear. Infact, e kon be lyk say i develop hatred for d girl at dat spot, and i be very timid and egoistical guy for girlz matter. I bone sha.Me and her no see each other for 4 days after that event. But yesterday night, when we meet in the night, i con scope her. D next thing be say d chik just scream and left me. In shock, i ran after her and grabbed her hand. The next thing wey happen na *GBOSA*. One kind heavy slap land for my face. O boy, kon c confusion and stagger. People kon come dey ask me wetin happen as the girl comot.
Abeg wetin cause make the girl start to dey misbehave to me all of a sudden. The thing now kon b say is like i don totally dey love d chik o, cos i sick no be small. Now, i dey struggle to see her. She don scarce baje baje.
..is she fat? angry
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by flolancracker: 6:11pm On Sep 12, 2013
gringringringrin nice one.
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by TrojanEdu: 6:48pm On Sep 12, 2013
Enegod: she gave you holy slap...atleast e reset your brain


Hommie,this is some funny shiit!!!! Couldn't hold myself...
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Jovanna(f): 7:04pm On Sep 12, 2013
Na slap of love dem dey call dat kian slap, u sef acept ur fate
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by addictiv(m): 9:45pm On Sep 12, 2013
op it was reflex in action....if you didnt try to stop her , she might have calmed down and had a mature conversation with you as to if she would accept or reject your proposal.....she was probably overwhelmed and just acted out.....kpelle. smiley
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by mashnino(m): 10:28pm On Sep 12, 2013
hahahahaha...

dat is how hard reset is been done on HUMANS..

next time watch out
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by funkyjms: 10:55pm On Sep 12, 2013
mashnino: hahahahaha...

dat is how hard reset is been done on HUMANS..

next time watch out

lmao grin
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by OmoUSH(m): 10:34am On Sep 13, 2013
Jovanna: Na slap of love dem dey call dat kian slap, u sef acept ur fate
@Jovanna. So slap of love dey swell person face. If i kon die nko?

As for u there wey u dey say make i revenge. Me wey i confuse patapata. As if say if na u u fit revenge
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by Jovanna(f): 2:12pm On Sep 13, 2013
[quote author=OmoUSH]
@Jovanna. So slap of love dey swell person face. If i kon die nko?

U knw fit die nw, nd if d gal con agree nw u go promise heaven nd earth say u fit do anytiny 4 her, nd u no fit chop common slap nawa 4 u jor
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by obami007(m): 2:22pm On Sep 13, 2013
Sorry OP,,,,u don chop slap b say u don slap,,,notin wey u go fit do 2 rewind d slap,,,just take hear,,,,God is in control,,,,,,,next time u go wise
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by okeke2: 8:04pm On Sep 13, 2013
@OP Congratulations dis girl luves u
like dat girl for "my heart beats for lola"
shey naa Lola Vulcan?
sha Congrats Disturb dis girl wella cuz dats wt she wants u to do!!
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by OmoUSH(m): 8:07pm On Sep 13, 2013
[quote author=Jovanna][/quote]
@Jovan. Na wa for u o. I no blame u sha, as na ur fellow girlity how u no go talk. So be4 she love me slap must come. If na so make we bone joor
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by UyiIredia(m): 8:39pm On Sep 13, 2013
I dey laff grin I sorries 4 you.
Re: A Girl I Was Toasting Slapped Me Hard by DONKINGS10(m): 4:14pm On Jun 23, 2019
broda foget the girl love you die , na shakara she wan begin do for you so dat u go fasten ur sit belt begin chase her.. ;Dbroda foget the girl love you die , na shakara she wan begin do for you so dat u go fasten ur sit belt begin chase her..

(1) (2) (Reply)

Your Boo Or 15 Million Naira? / What Is The Difference Between Flirting And Seduction / Open Letter To MzNelly

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 33
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.