Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,762 members, 7,817,106 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 05:53 AM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (37) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61153 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (34) (35) (36) (37) (38) (39) (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Hussain555(m): 12:38pm On Oct 20, 2010
Ohh boy,
I hail all of una 4 dis thread.
U dey mak me wan learn how to mk rhymes.
I go dey happi if any1 fit teach me,
I hail una
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 4:31pm On Oct 21, 2010
Adebaba, i dey feel ur pain
dis election fit cause scatterbrain
i wish say i get mouth to complain
but 2much talk no get gain
mi i don ready 4dem with my cane
i go tongue flog anybody wey com do wayo campaign
with my village long sugar cane
god go helep me flog craze off dia brain
al my guys we just dey train
prayin say our trainin go b invain
but if d baggers refuse to maintain
d tears of dia family members go pour like rain
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Hussain555(m): 11:33am On Oct 22, 2010
Madean, rotimy,
U guyz shud b artists walai u go hammer pass p.diddy or fiddy
make u no jst dey talk for hia,
make am real,
Man and wife, frends, best singers,
u'll take over the world in minutes with your first album,
Dbanj, tu face, dagrin sef go seek collabo wit u,
U guyz dont kno au much i feel u.
I'm supposed to b on unilorin admissions thread but u guyz jst kip pulling me back.

Abeg, connect and make a musical album, please, ejor,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 6:03pm On Oct 22, 2010
Hussain five five five
guy i dey feel ur dive
on how say u read dat love rhyme series
by our two greatest love strawberries
guy na now we welcome u to our home
feel free and roam
for here we b family
we treat al man n woman equally
we like and so we talk abt loff matter
somtimes we do off topic like dat of adebaba
bt the d koko matter na anyfin 4d heart
so boss, welcome to d finest pidgin chat
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:02pm On Oct 22, 2010
Hussain555:

Madean, rotimy,
U guyz shud b artists walai u go hammer pass p.diddy or fiddy
make u no jst dey talk for hia,
make am real,
Man and wife, frends, best singers,
u'll take over the world in minutes with your first album,
Dbanj, tu face, dagrin sef go seek collabo wit u,
U guyz dont kno au much i feel u.
I'm supposed to b on unilorin admissions thread but u guyz jst kip pulling me back.

Abeg, connect and make a musical album, please, ejor,


Thanks Hussain555 as u say u enjoy our groove
We sef we no get too much to prove
As joecool talk, love na our main subject matter
Just feel free to check in anytime to read our pidgin chatter wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Hussain555(m): 12:58am On Oct 23, 2010
when i see pple drop real
poems,
me sef dey aspire mak i be
poet
i get dis babe wey dey my
villa,
she dey make me melt like
vanillla
i dey give nice treats to the
babe,
but she dey do lik say i be man u`s
Bebe
one day she tell me say she dey
broke,
na so me sef go hustle dough 4rm
coke
wen i come give her tangible
money,
na so she wan start to treat me lik
honey
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Hussain555(m): 1:26am On Oct 23, 2010
na so d babe go buy me
boxers,
my brain come dey run lyk
Boxers
na im come dey make me
wonder,
maybe she sef don dey grow
fonder
love doctors, abeg wetin you
think,
cos me sef 4 dis tym no dey
sync

i hail una 4 dis thread as flows dey
difficult,
like say i wan start to make
african cuts
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 10:46am On Oct 23, 2010
I troway salute
una too much
even as i siddon 4 fence dey jejely play my flute
i dey use my eyes dey watch una lik vulture
coz una stil de kip real lik culture.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:14pm On Oct 23, 2010
Hussain555:


     when i see pple drop real
     poems,
     me sef dey aspire mak i be
     poet
     i get dis babe wey dey my
     villa,
     she dey make me melt like
     vanillla
     i dey give nice treats to the
     babe,
     but she dey do lik say i be man u`s
     Bebe
     one day she tell me say she dey
     broke,
     na so me sef go hustle dough 4rm
     coke
     wen i come give her tangible
     money,
     na so she wan start to treat me lik
     honey     

Hussain555:

    na so d babe go buy me   
    boxers,
    my brain come dey run lyk
    Boxers
    na im come dey make me
    wonder,
    maybe she sef don dey grow
    fonder
    love doctors, abeg wetin you
    think,
    cos me sef 4 dis tym no dey
    sync

     i hail una 4 dis thread as flows dey
     difficult,
     like say i wan start to make
     african cuts


Lol, thanks Hussain555, say u give us some insight
Into this your relationship/love plight
Be like say d babe get classic case of money-hunger
I for advise say make u run even as u shout, "Cowabunga" cheesy
OK seriously, maybe she just need to know say u care
So she too fit reciprocate with her own "I love u too" stare tongue
Well me sef I no go claim to be expert
But make u open your two eyes down so u go know what to expect cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:28pm On Oct 23, 2010
hmmm una don leave me go,
see me dey back dey slow,
i no show since cuz i been dey heavy struggle,
as i no get jay-jay skills of ball juggle,
e hard me well-well to stay for up,
hol' my liver make e no comot drop,
una go hear all the 'tori,
how wan baby jus turn me to o'kori,
the matta jus' get as e be,
anyhow i look am na different levelz i dey see,
sometimes e dey be like she play me su'mbu,
and bodi dey do me tu'mbu,
nah she dey je'je with her man,
while me dey hi'a like empty frying pan.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 10:04pm On Oct 23, 2010
If no be sites like dis, wen persin wan over craze;

I no know how e go be.

Like the place wey I dey ehn, na only God go helep me.

Dey pray for me jor and for my paddy,

Na so-so beg I dey beg so dat she fit eat.

Na lie oooo!

She no wan 'gree!

She don cry warta comot,

Me sef, join am sotayyyy,

Ah, I don tire but I no go give up,

I don vex for am now

Make she sit up!

So na prayer I dey o,

Make she heed.

Na me be im paddy

As she dey in need.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:15pm On Oct 23, 2010
na here i jus ka'k dey cry,
sotey my eye don over-dry,
my mind jus dey boil follow join fry,
in fact wetin remain na jus to die,
to hol' mysef na gri'gai i jus dey try,
i no even wan think am sey u been dey lie,
becuz now u don ready to fly,
& e dey pain me sey i no fit ask u why,
if i remember everythin wen i buy,
how everybodi dey think sey na me be ur guy,
e reash me to hang with tie,
lock-up bone every & jus close eye!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:26pm On Oct 23, 2010
i think sey i don see my wife,
ten years of my life,
na im she cut comot so with knife.
how i no go do like who craze,
as if dem gimme la-la blaze,
wen till now i neva so'ji her wayz.
d matta jus dey make me vex,
even wen men show with lex,
heavy headache do me to follow flex.
wether na cruize,
e no matta cuz na me still lose,
wetin dey hol' my head now na booze.
she way'le me like man wey thief,
hang put for up with ele'run beef,
inside my mind now na bitter leaf.
my guys don yarn me to bone,
make i jus maintain on my own
but her picshure full my head plus even fone.
me know sey i no fit force u to stay,
wetin remain na to follow u pray,
with all my provoke i still luv u & no be today!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Vavavoom(m): 10:05am On Oct 24, 2010
Ah Rude boi! Luv suppose be jeje and tender
nothing sleek, only something to make una fonder
I feel your pain cos like u my gal always dey on my mind
e no easy to leave those u luv behind
cos the picture dem impress stay there like print
but for dis life me and u come no be sprint
and when d time come u go find dat correct rib
until dem dey kampke till i flash anoda luv beep
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 7:18pm On Oct 25, 2010
Chei. Tru tru d way fins go mak me dull
i weak sotey, i no even c ground fall
sha, shits happen, but we gas go on
no time, i dey here for strictly fun
i com surprise hw al my guys com dey complain
how dem babes just dey cause em pain
e com b like say dis babes plan am
to take dis mber period cause bobos harm
mak i try treat una mata one by wan
mi no be loff doctor bt mak i try as i can
my guy hussain
ur case na al bobos pain
say baby want money
before en cal u honey
na general wahala
inshot na natural palava
my mumsy tel me say romance
without finance dey cause annoyance
so my guy try sow wit ur material available
and u fit work harder to kip ur desirable
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 8:29pm On Oct 25, 2010
@RUDDIE

Guy dis ur tori fit mak person cry
i read am finish com sigh
e no easy 4tears 2comot guy eye
talk mor say en brain com fry
en com dey even wish to die
chai, kai, oh gawd why
why al dis dey happen 2my guy
na smal fin dey mak brothers go high
why gals dey quick wan say goodbye
tru loff dey no dey fully supply
chai my brother ruddie
just take am easy
mi believ say oneday fins go dey rosy
and al dis jagajaga loff story
go turn romantic testimony
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 8:48pm On Oct 25, 2010
@FIRESTAR

hmm firestar, if she b ur wife abeg no vex

just play along as she flex

if u vex 2much, she fit remember her ex

nd dat wan min say 4u no xex

just as u talk pray for her

show her say na u be firestar

mi go dey pray 4 both of una

wif time, una go b like bread n butter
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 9:09pm On Oct 25, 2010
@maedan n vavavoom

my ladies how una dey
hope una stil dey okay
my dues 2una i no go stop to pay
even dou my angel tel me say
e be like sey una chuz 2play away
gawd dey sha, 4una i stil dey pray
e go beta 4una every breakin day
una advice 2my guys dey like dat of loff doctor
or beta, if fit b dat of loff professor
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Dkaz(m): 9:14pm On Oct 25, 2010
Hmmm, Really hot
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:26pm On Oct 27, 2010
i thank una 4 d commentary,
in short e do 2 make ogbo'nge documentary,
na true talk sey luv matter no be 1, 2, ti'hree,
and no be all mouth go talk wetin dem see,
d reason d matter pepper me so,
if i begin look how far i don waka go,
plenty energy wen be like e don waste,
4 d end na dis kain bitter taste,
e dey do me not to look anoda woman face,
not'o go do again & receive yawa + disgrace,
no doubt love sweet,
& wen man jam solid woman e dey make am stand fit,
but d level wey i dey now na zo'bo eye,
skele wen go come change my mind gats correct die!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 3:48pm On Oct 28, 2010
Tant u ruudie for d complemento
no be beans na oringo ringo
no too close ur door for where women dey
na understandin u go know dem 2 sabi play
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 10:21am On Oct 30, 2010
grin truely 9ja love rhyme
al na to get tyme
just dey waka pass lyke diouf maime
hope say doz girlz de do dier tin 4 armstadame
i wish 2 av my honeymun 4 kanji dame
oh god! Battery low. What a dame!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:30pm On Oct 30, 2010
no need to dey tell lie,
e no get how time wan take fly,
but last thin' wey dey my head,
na to open up my shed,
una fit yarn sey i be f.cuk up,
but nna ga'i i don lock up,
i no even wan hear any advice,
becuz 4 4 my brain e don turn to lice,
even dem sort me i no advertize,
ol' boy i don 2 over wize,
if na 4 life make i remain d single,
walahi i no jus ready to begin dey mingle!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 3:47pm On Nov 01, 2010
Jooooor~ ooo

I no be guy!
And pali-paddy, no be ma wife!

Which side!

Na ma sista from anoda mister.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 11:21pm On Nov 01, 2010
Firestar,firestar baby
i no mean nt to treat u like lady
ur yarn dey like dat of mi guy
i just do am 2fit mi style
abeg no vex
make we stil dey flex
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 10:21am On Nov 02, 2010
<Sighs>
. . .
Bros, next time make una rhyme right. . .
. . .
And no sacrifice am to rhyme tight. . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Dkaz(m): 7:59pm On Nov 04, 2010
Cool musik
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 3:16pm On Nov 09, 2010
na now i jus wake,
after she don remove 10yrs take,
plus everything wey i give 4 luv sake,
yakata my heart don fall throwey break,
she chop her own finish join with my own cake.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 3:36pm On Nov 09, 2010
Hmmm. . .I don dey rusty like old nail
But to show face and not drop na big fail
So make I just drop one or two rhyme
Make e nor be se I just come here waste time

Una welldone o!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 6:06pm On Nov 10, 2010
RuuD Broda dat na REAL WaA~
.
Ten years no be small matta.
.
And yu yarn say na now yu just wake?
.
My broda, I go pray for yu o, make yu tranda wella and weld dat heart wey don break.
.
No gree bend down like say yu be palm tree!
.
Me, I don waka dat road o, no be today.
.
Dat advice wey helep me, I go replay,
.
Say:
.
Yua powa go scant die, if yu dey dull yua sef for wahala,
.
So no shakin',
God sef dey,
You know nau, Im no dey play.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:54pm On Nov 12, 2010
sista fire babe wen come join put star,
i cut cap 4 u like sports car,
only u jus hol' groun' gidi'gba like solid koro' tar,
d way u yarn am na 1-hand e no go over d bar,
but i don betta wound don dey dry only remain scar,
me sef no be pikin e don tey & i don waka far,
so make e no be like i jus dey do gra. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:24pm On Nov 12, 2010
now no be d time,
like sey love na crime,
omo make i turn snail,
becuz i no dey gree go jail.

my parolz now na siddon look,
small time sef i go comot facebook,
i say, i say e no go ever happen again,
na solo ontop my own lane.

dis omo boy no dey smile,
d boning gan fit seperate river nile,
u no get anything wen i want,
so no even dey yarn sey i dey front.

e don do me 2 cry,
so now e don reash make i fly,
jus dey jolly with awon paddy mi,
till love torch-lite dat okpe'ke wen my heart wan see.

(1) (2) (3) ... (34) (35) (36) (37) (38) (39) (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.