Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,885 members, 7,956,335 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 10:11 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62622 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)
Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:06pm On Feb 11, 2009 |
You be de correct sugar for my garri, And I love you pass all girls for Warri. You be de apple for my own eyes, If no be you I go die frozen like ice. You dey homely like ofada rice, We no go fight again like cat & mice. You be my ogbenga orishirishi for egusi soup, Soon I go buy for you a mercedes coupe. You be the only Christmas clothe for my wardrope, If you leave me,walai, I go hang myself with a rope. My endless love & African angel with you I no fit sleep, Even my own people say you don turn me to a sheep. At this season of Valen-wetin and always, My bodi,heart, & pocket na for you always. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by abdulone(m): 1:05pm On Feb 12, 2009 |
thats great and really lovely guy[b], i like it[/b] here is mine i write yuor name on the sand and the breeze blew it away when i write on water it got washed away when i write it in the sky, the night covered it when i write it on my heart i got heart attack |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:57pm On Feb 12, 2009 |
abdulone:LOL True love surely do give lovers heart attack. Take heart. Love is pain. Love is life and death |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:36am On Feb 13, 2009 |
rotimy: bros, abeg u try if i be ur babe i for dyyee 'cos dis kain love fit kill e sweet pass jack n jill dis one dem say u turn to sheep hope say for night u dey sleep? no worry, if she no want u dis valentine i get one small sister wey too fyyynnnee . . . . u go like? no mind me o, all na psyche!!! i dig ur poem no be small sha . . . make i tiff am for my val na . . . ? |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:03pm On Feb 13, 2009 |
maedan:I trip for your poem poem. I like am pass suya & isi ewu! Why your small Sista when we go be Vals? A beg, use me as a stand by generator in case your powe holding hold the power! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:28pm On Feb 13, 2009 |
No need for generator lai lai my own na solar power!! no more fine sista for u again u no rhyme well at all 2day!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 5:50pm On Feb 13, 2009 |
maedan: lol omoge , fine sista, go easy on d brother, no b everytime he go fit rhyme tight, no even rhyme right, d tin no easy like that, abi, u get 9 lives like cat? give am ur sista, and she go love no other, everybody deserves a 2nd chance, d guy can't afford to not eat dat yam |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:15pm On Feb 13, 2009 |
maedan: How you come say you no need a generator? When some men love dey quench like terminator. At noon the love go over-load with solar power, But for night, e go blackout like NEPA power. Your fine sista I for true true like to take, But now her hand I must try to forsake. Bride price high well well for Auchi, Make I manage Aisha wey dey Bauchi! You fit apply, And I go reply. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:19pm On Feb 13, 2009 |
olulu:Thanks o jare. Man know man. I go dey rhyme all the time? I be Wole Soyinka or Achebe? For your defence and effort, I go dash that her fine sista. Ebi like say you sabi eat yam. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:28pm On Feb 13, 2009 |
rotimy: ehen, na now u dey talk beta u sure say ur lv na all weatha? anyway, na ur scope i like u sef, u no fit know psyche? i dey play na, how i go give u my precious sista u fit be one serious playa mister!!! olulu: na my sister u dey call "yam?" bros, make u stop am!! luv is more than dat no be game of mouse n cat!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:49pm On Feb 14, 2009 |
maedan:I must tell you say I no be playa I just dey Church dey holla my prayer. I dey ask Baba make E butter my tea And bless me always in land,air and sea. For true,I go prefer you to your little sista, Make two adults tango go dey better. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:02pm On Feb 14, 2009 |
lolxxx u be longthroat no be small u no wan hear word at all at all how i go fall 4 brand new toaster no be say u be d main kokomaster i tiff ur poem give my boo, no vex i also send am to all mypals by text hope say e no get copyright bc dat 1st poem dey v. tight . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 8:31am On Feb 16, 2009 |
maedan: since d guy flow tight and rhyme right, u come trip and u let ur guard slip kuku enter d place, run d race make we see fit u no go carry belly two, but, hope would not make u after two ? rotimy: i've got ur back u will feel no lack maedan: i no call ur sista yam so keep calm but tell me, is she really dat fine? abi u just cook up dat line? |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:58pm On Feb 16, 2009 |
maedan: Walai talai, I no get am for big longthroat, Only say I dey over-honest as if I swear oath. I no be kokomaster but correct lover- master, And I day stick to friends like I be plaster. I no vex you send my poem without copyright, Don't forget say love dey like onions at 1st bite, E go make you sneeze or cry, But with me, we go just fly! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:13am On Feb 17, 2009 |
@ rotimy my guy dis is getting curious i no believe say u dey serious valentine don go since now its high tym we take a bow but since u say u be gud friend make we stick dat way till d end. . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:28am On Feb 17, 2009 |
@ olulu na true i talk from day one my sis dey fine n bright like sun e be like say u like 2yab but me too get quick upper jab anyway i no wan fight u sef u dey rhyme tight (even tho' u get serious bad mouth . . . ) |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 8:32am On Feb 17, 2009 |
maedan: i no fit fight woman, afterall, u dey in dis world to serve man, u think i like to yab? and u can shut me up with ur jab? hey, go easy, don't lets get messy. u even say i get bad mouth well, by dis end of month na dat same mouth u go dey kiss on top couch |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:08pm On Feb 17, 2009 |
maedan: Who come dey talk say Valentine don pass? Every day na for true lovers wey get class. I no be Police or soja wey go take a bow My love dey plenty like[b] fura[/b]for Fulani cow. My heart dey jolly as U say we go be good friends till end, But I dey fear say like Naija babes ur word go soon bend. Asssure me you no go try break my heart, Na only then I go truly throw in my hat. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:26pm On Feb 17, 2009 |
olulu: OLULU OLULU OLULU How many times I call you name? True true I no sabi your game!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:29pm On Feb 17, 2009 |
@ rotimy i know say u be beta person wey we fit trust for any season even if na e-love, nothing spoil at least e good to ease d toil na true say whether na valentine or wintertime correct couples need to flow n rhyme so make we jolly dey go with this our pidjin love show . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:39pm On Feb 17, 2009 |
@olulu see me see palaver i think say u come enter as observer i even manage to swallow ur yabs i come dey hail u for your vocabs now u don show ur true colour kiss 4 couch ni, kiss 4 couch ko. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 9:45am On Feb 18, 2009 |
maedan: well, if i kiss u, u suppose happy, u think say na like kiss of those small boys still wearing nappy? i only wanted to help ur condition, b4 u enter frustration. but no yawa, as u don talk like a typical mama tawa, i withdraw my offer, but no come beg me after |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 9:49am On Feb 18, 2009 |
rotimy: coolu temper, i no dey tamper, olulu na my name, being a playa na d game, but i no dey collect ur woman, after all, for dis forum u b d main man |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:23am On Feb 18, 2009 |
chei, for nairaland i don suffer dis bros O wan make i run 4 cover i come for peace, na him start war dis forum of love e don make am curve bend go a wrong slide well, we go meet for d dark side u think say u be player wen u only sound like hater dis valen-wetin no dey 4 u rara as u come call me mama tawa i talk am say ur mouth no good look as u dey yarn like boy from 'hood na u gangan get d frustration i don make u lose concentration if u beg well well i fit pity u turn u into my next mumu but as u no get taste, my time i no go waste just leave me and my rotimy matter b4 my luv-stylee make ur head scatter |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sIceees(f): 11:31am On Feb 18, 2009 |
DANG!!!!!!!!! d flows' craziiiiiiiii y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii keep d rymz ryt dis thang's soooooooooo tyt |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:28pm On Feb 18, 2009 |
$Iceee$: nice 2 c another ryhming sista dnt mind the Olulu mista turnin' me to a fighter when i'm truly a peacemaker! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:37pm On Feb 18, 2009 |
maedan:One fine female singer wey get big bobby, Talk say love wey be true no be for puppy. She say love dey flow and float like butterfly, Which mean say na patience one go apply. Weather e-love,v-love or even sef 365-love, I go tanda like rock and dey gentle like dove. E dey do me for heart say you go dey always talk true, Dat's why I wan flow and see this love show through! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:47pm On Feb 18, 2009 |
$Iceee$:Eninem no rhyme pass our own Tuface, Naija get talents wey dey set de pace!! You talk say your username na Iceee, If u be rapper or rhymer we go soon seee. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 12:51pm On Feb 18, 2009 |
maedan: pity me? when na u dey beg to b with me. i b d original player, and i know say u go like b my bed partner, i for help ur matter, and do u well well for ur under, but u fit go mess up my quarters since u still b bed wetter. and ur kind sister, no sabi love matters, na when u c money, u go come try b d person honey. so go away with ur wahala, but i vex cause kasala. $Iceee$: i feel u girlfriend maedan: lol oya i no fight again, since my love u no fit gain, and if i don cause u pain, no seek me to slain, so go deal with ur love matters, but abeg, no do love for corner corner |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Moyola(f): 12:54pm On Feb 18, 2009 |
hehe! weldun yu lot! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:09pm On Feb 18, 2009 |
Moyola:Ah, thank you Moyola!! Here we no get wahala |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:09pm On Feb 19, 2009 |
rotimy: yes o, true true wahala we no get na only one troublemaker make us forget d real purpose of this sweet thread but devil is a liar, 'im go regret d day e try disturb true vals who don dey turn into real pals so rotimy, how u dey hope u still tanda as u say abi d love don dry or u wan make i cry well, friend in need na friend indeed remember say u don plant d seed make u no slack make e turn to weed . . . |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)
Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 91 |