Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,059 members, 7,956,952 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 11:46 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62629 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (36) (37) (38) (39) (40) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 4:23pm On Jan 03, 2011 |
I say make i drop my own new year qreetinq, as i b new born 4 dis piqin family meetinq, no b al d noise way nyash make b fartinq, abi na everytin way enter mouth b eatinq? We al qo njoy dis year wit joy,nu sonqsz n beatinq, beta qo plenty wit less hussul n sweatinq, make i stop 4 here b4 dem qo say i dn start d spittinq. Happy nu year |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 8:17am On Jan 04, 2011 |
Mak i drop one or two line before clock say quarter past nine. Na happy new tins tank baba God we mak am in styl no long tins to old n new comer in here i pour out my luv 4 u out there d thread na 4 every 1 of us e dey about i gat all of una bck,truss me,even as i sign out. Happy new 2 u all. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 8:17am On Jan 04, 2011 |
Mak i drop one or two line before clock say quarter past nine. Na happy new tins tank baba God we mak am in styl no long tins to old n new comer in here i pour out my luv 4 u out there d thread na 4 every 1 of us e dey about i gat all of una bck,truss me,even as i sign out. Happy new 2 u all. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 9:35am On Jan 04, 2011 |
Dis new year make we no fiqht,yab or cuss, as bordas n sistas,we supose help cari eachoda cross, i don plan 2 buy our family bus, make una just helep me pray 2 kind bad belle pple way qo wn stp me by force, we qo just dey move 4ward,no nid 2 luk left,riqht or even pause, buh una if just add anyfin 4rm una purse. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by bookworld(m): 9:46am On Jan 04, 2011 |
This creatively crazy. Keep it up. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 2:49am On Jan 06, 2011 |
Linqsz:as 4me i giv u my support, 4d bus my papa don work b4 4 port @ all mak we join hand cook d soup wey dey 4 pot diz thread lailai no fit abort, i dey sure say diz year na al of uz dey go "luv court'' me don dey already prepare my big 'hut' make we al cros our tz nd d iz mak we dot. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 2:51am On Jan 06, 2011 |
Linqsz:as 4me i giv u my support, 4d bus my papa don work b4 4 port @ all mak we join hand cook d soup wey dey 4 pot diz thread lailai no fit abort, i dey sure say diz year na al of uz dey go "luv court'' me don dey already prepare my big 'hut' make we al cros our tz nd d iz mak we dot. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:19pm On Jan 07, 2011 |
she say she lekpa & her name be Arita, wen i see d picsure i halla dis wan na confirm Mama Sita, i block am 4 facebook begin follow am 4 twitter, 4 my mind i don jam betta chica bonita, pesin wen go come make my life sweeter, broom 2 sweep all d dorty & make me neater, 2 God i miscalculate like NEPA meter, d levelz don become be leaf wen 2 bitter, matta don turn 2 work of factory fitter, no near dis wan if u sey u be wife-beater, cuz 2 carry am sef u gats 2 be weightlifter, d yam leg thick like 50 liter, see g-string get space like 14-seater, wafi boy no fit ever be repeater, so i sharpenly deny am 3 times like peter, come codedly pick race like cheetah nna men. . . .no be lie oh - if no be gold e no go glitter! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 2:41pm On Jan 08, 2011 |
RuuDie: dt's my guy. 2good,2hood, 2ruud! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 1:34pm On Jan 12, 2011 |
:p :p |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 3:10pm On Jan 15, 2011 |
E o ni duro! Te ba gbo rhyme ruudie, o strong hot nd sweet pax gudie-gudie, ko si bo sele ri te o ni drop 'kudie', ha change evrytin frm bad 2 gud mudie, e o ni duro! Tin ba yo ina lowo bi Zaki, e ma lanu sile bi taye,muri ati Rasaki, ko si bo sele tan lara mi ko ma kan dansaki, ni thread yi gbogbo wa la ni lowo mo fe ke gbabeski! E o ni duro! Coz we'r hot lyk faya, to ba to tyme kan ema wa hira, we are connectd 2geda lyk eletrik waya, o to ni mo so coz im nt a laya, e oni duro! So e fimi sile lorun, teba duro mo promise yin ema dorun! Ha ma jo dawo po gba yin lenu eyin bawo, e o ni duro to ri im omo Olorun! So ema duro! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:50am On Jan 17, 2011 |
RuuDie: hehehehehhe like say this rhyme na im wake me from sleep i come dey pray "the Lord my soul to keep" this one na good way to start the year 20eleven Make we all pray say na here go be our pidgin haven |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:39pm On Feb 19, 2011 |
i don see heaven i fly, wen u waka e do me like to die. . . baby na u i dey miss, e dey pain me pass i hol' piss. . . dat time i no even bother, eye don clear as u don find another. . . how i wan begin to beg, wen matta don kuku get k-leg. . . na wen i ready ben' down for u, e don too late for ur i do. . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:06pm On Feb 25, 2011 |
dis no be jus mai-mai chat, baby na yarnings straight from my heart, i don tire to dey dodge like rat, before na blindness dey do me like bat, head anything inside skirt like David Platt, those days wey dem dey call me "brat", some even say me i be "Arrow", e get pesin wey even call me "tat", run me down as dem dey use dirty foot-mat, but now ur boy don big-up liver don fat, so now i ready pay my dues plus even VAT, no more corner-corner i want d full 60-watt, we go comot ghetto go rent flat, becuz na with u i wan make my new life start! ***baby. . . . . .seriously i mean am*** |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:59pm On Feb 25, 2011 |
if u wan see ruudie orijo poems, enter HERE dem full like le'ms. no forget 4 lef' comment, u fit cut 7 past am like cement. jus yarn ya mind, no bother sey u wan dey kind. 4 pesin to fit do betta work, people must 2 see am b4 dem talk. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:46pm On Mar 23, 2011 |
no be sey i no dey able, but i wish sey things go quick stable, so dat i go follow una siddon for table, balance with una dey wa'sh cable, prove to u dat me still dey capable, & dis love wen i get na gidi'gba durable, e too constant e no fit ever variable, wetin i dey yarn so no be parable, wahala if na lie make i disable! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:18am On Mar 30, 2011 |
i no know where we dey now, & to explain i no jus sabi how wen we start d thin' na wow, d way d matta come be i dey bow, e don dey be like u dey see me as cow, sotey i don begin halla fa-fa-fa fa'ow. . . . as i dey so i blank, no difference between me & plank, as i still fit open mouth na God i dey thank, u jus dull me like wen money no dey bank, officer wen dem don comot im rank. . . . e bad becuz i no fit shout, even sef jus to small-small open mouth, if not u go dey think sey me be tout, but how i wan come take find out, understand wetin dis thing be all about, & begin to dey fit clear dis my doubt. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:31am On Apr 01, 2011 |
Wen i read ur rhymes guy im short of words, it completely took me in2 anoda world hw i wish i fit send am 2 her cord play d rhyme which i kno she go shout God! Walaitalai, u nid 2b taken 2 d board if possible change ur name 2 lord im sure al oda membas go give u nod it is more dan coconut pod wit ur words, u gud pass Stroud continue, no wahala, i dey ur back lyk rod . . . Unitd on top. . . RuuDie: |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:29pm On Apr 02, 2011 |
I no know wetin to talk, whether na please or sorry No be say I no get time abi na so so worry worry In any case, I no get excuse If I apologize abeg no refuse Accept my pele ontop of no vex E no too late, make we continue d flex |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 10:13am On Apr 04, 2011 |
Wasup na How una dey? Dis still dey simma No be sizzle. I hail o--- I hail To fall ma hand for dis salute wey I throway Abeg, fail. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 11:55am On Apr 04, 2011 |
[pre][/pre] No be lie o No be lie Na for me your features dey. From yua hair to toe. Na now I kuku know. Shey yu know bamboo? And dat palm tree wey get belle? Or dat werepe bean? I go show yu wetin I mean, Yua hair full reach ground like dat-- Yu cut am, e go still remain. Even sef for times wey e no rain. - Yu just dey sha-- Weda e green o, orange o or milky white, Yu feed me make I chop and drink wata-- Make I stand gidigba, Make I dey alright. - I hail because say, Yua wahala for ma sake-- E no get grade. And na babanla wahala yu get. Even me gan-an-- if I no undastand am, I go vex. And wen yu go vex, Hhen. If I see yua face and jasi, Na dat scarce palm oil, Na im I go get. I go pray for yu. Along with holy spirit. Cos if I try talk am like dat, Fuel go finish. ***Dedicated to my parents. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 9:18pm On Apr 17, 2011 |
U dey endowed from d crown of your head to d souls of your feet, u be d type wey everi bodi dey die to meet. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 6:50am On Apr 18, 2011 |
:d ;d |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:57pm On Jun 06, 2011 |
oya me sef wan rap, no jus sege becuz i fit stone u slap, lef disturbance make my rhymes begin drop like tap, i wan use pidgin put naija ontop d map, if uno sey no be beans oya begin dey clap, who'sai bar-tender sharpenly dey circulate d harp, u shine ya eye like sey i wan set u trap, open mouth waa'a, see pesin wey wan snap!? na okpats i dey yarn? oya jus dey zap, b4 i annoy, kolombi u squeeze & wrap. d kpali wey i dey hold na from a poly, so i no dey claim to dey too holy, but in those i dey draw like chukwunwike okolie, sotey oyibo see my handwork im shout "oh golly", my paddy dey here im name na fo'lly, i swear him shots hot like volley, im ragga smooth pass dat of baba wen be soul-e, no worry wen a' burst finish i go pass am d kpoli. u no like me cuz i dey ruud, but shenkes luv me die cuz i too good small thing remain i for be like food, cuz d way dem dey rush me,is yet understood, ur babe see me, instanta she don dey in d mood my name no be robin but i dey run thins' inside d hood, 2 hot i dey on fire even though i no be wood, hi'ajj dolapo & iya-charlie as if i dey export crude, so if e neva enta ya mind 2 bow, omo i think u should. bobz hope sey no be me u dey taa'asi, becuz ori e' ni ma la'si, if u no careful i go cantab u like hogan bassey, i no send ur gucci, me go rock my ben' down fasasi, chop for tastee, i go le'm tight 4 togo-embassy, inside surulere na me be father ja'si, wen a' voke my voice dey jam like revrend tansi, dey there dey form classy, say their chic dem 2 fresh, 2 sassy jor' leave am, all dat wan na 4 fancy. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:08pm On Jun 06, 2011 |
baby na ur kind i dey like to meet, d kind wen a' fit dor' ba'le greet, see eye & lips very sweet, as a' dey look u so, u dey gimme heat, wen u dey inside d room i no fit sit, talkless of sey to chop, piss even sh*t. u waka pass 4 my mind i go jus dey press repeat. before u fight me i don accept defeat, no need to drag i go just forfeit, who'sai mind dey to compete, cuz na only u get d power 2 press my delete, without u i no ever fit dey complete. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:17pm On Jun 20, 2011 |
how a' wish sey i no love u so, mai'be my heart no go dey do like e wan blow. . . . how a' wish sey i no love u so, mai'be me & u 4 fit dey shiddon flow. . . . how a' wish sey i no love u so, mai'be my blood no go dey run like sey e wan throw. . . how a' wish sey i no love u so, mai'be i no go dey do like pikin wey neva grow. . . how a' wish sey i no love u so, mai'be my arrow 4 still get bow. . . . how a' wish sey i no love u so, mai'be my eye dem go still dey shine like snow. . . . how a' wish sey i no love u so, mai'be all these things dem i 4 no know. . . . |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by emofine(f): 9:37am On Jul 01, 2011 |
I think say before we suppose formulate for valentine mata I sabi now course don change abi theme don scata shey! so na so my brethrens carry diverse talents sotey? no looooooong thing, literature na our forte chai Nigerians can narrate it must be the soil abi mek I conclude now before poem don spoil |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by IBEXY(m): 12:54pm On Jul 01, 2011 |
Uh, Uhh, Here we go: My love for you is like the tides of a raging Atlantic Tsunami Flowing from my heart like masticated tomato Deny me not my favourite food - Macaroni Lest I be forced to eat my worst food - Potato Uh, Uhh |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 9:13am On Jul 02, 2011 |
IBEXY: Na wa o. Na real wa! See as yu transfer: From Japan yu waka-->> To Italy yu jump reach--- Dat land of our kolonia master <<--Come Naija! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 11:17am On Jul 23, 2011 |
Cheyyyyy!!!! I don vex-xxxx! No-o! No hold me jor, Leave me Make I offload sand and gravel off ma chest. Yu no say ma kain yarns wey Concern yu ehn, Na yua face I talk am, Na direct. . . . . . . . . . Mo ti so temi Oya, so ti e, Ore. |
(1) (2) (3) ... (36) (37) (38) (39) (40) (Reply)
Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 61 |