Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,265 members, 7,818,917 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 08:02 AM

30 DAYS OF POETRY,DAY2 "If You Hear Say I Dey Prison" Pics Inside - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / 30 DAYS OF POETRY,DAY2 "If You Hear Say I Dey Prison" Pics Inside (1646 Views)

Wole Soyinka Escorted To Prison In 1967 (Throwback Photo) / AUGUST BREAK; Dairy Of A Married Barchelor- Day2- Before The Last August / As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

30 DAYS OF POETRY,DAY2 "If You Hear Say I Dey Prison" Pics Inside by lyricalpontiff(m): 11:42am On Jun 02, 2015
If you hear say I dey prison
No reason say I thief
No think say I kill
Na small question wey I ask

Oya make I ask
Why e be say after elections politicians dey comot mask
Abeg wetin graduates commit
Wey companies dey treat us like vomit
Why new roads node last like nepa
Why bail na free for only paper

If you hear say I dey sanko
No think say I steal
No think say I kill
Na only question wey I ask

Why we go go school, read book, graduate with nothing to carry hold hand
I still no understand why people wey shoot gun, burst pipe, kidnap oyibo, go enjoy government settlement
Why our soldiers dey score A for foreign peace mission but for book haram na carry over

If you hear say I dey prison
No reason say I thief
No think say I kill
Na small question wey I ask

Why our leaders’ node take oath of office for amadioha shrine make dem serious
Why fire service motor dey suffer from dehydration
Why the price of petrol dey sky rocket
Why black market people dey empty our pocket
Why everyday police dey catch armed robbers for newspaper
While armed robbers still dey thief with pen and paper
If you hear say I dey prison
No reason say I thief
No think say I kill
Na small question wey I ask

Why lecturers still dey measure dia grades by shots of sperm or marks based on sorting
Abeg how much be security vote
Wetin happen to excess crude account
Why police men dey always high for checkpoint
Why pastors like to preach about tithe from Malachi 3 and not Deuteronomy 14
Dem say person wey ask question node miss road.

Hook from Humphrey Ogu

4 Likes 1 Share

Re: 30 DAYS OF POETRY,DAY2 "If You Hear Say I Dey Prison" Pics Inside by Enoquin(f): 11:55am On Jun 02, 2015
Dem de disiv demsef
Wai a no go hala

Your first was pretty long I enjoyed it though but if you hia say I dey prizin was it.

Following
Re: 30 DAYS OF POETRY,DAY2 "If You Hear Say I Dey Prison" Pics Inside by lyricalpontiff(m): 4:57pm On Jun 02, 2015
Please keep following, tomorrow's poem will be nice.

(1) (Reply)

The Nemesis Of Ezra Season One:beginning Of Karma. / Destiny / Boomerang

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.