Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,109 members, 7,835,745 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 02:13 PM

Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. (517 Views)

If I Get Money Eehn... (Check Out This Stuff From Nairalander "Kuttie StylebOi") / Check Out This Stuff I Just Rounded off. / Lady Flaunts Her Boobs On Instagram And Got This Funny Reply (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by dayvid0bedz: 1:45pm On Aug 10, 2016
SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
09/08/2016.
WOMEN!
When we say somebody na virgin, we mean say the person norva indulge in any form of sexual intercourse.
For woman, e get one membrane wey dey as gate to the vaginal.
This membrane nai dem dey call hymen.
Na this hyman dey break wey blood dey flow if man penetrate woman for the first time when she dey involve in sex.
Na good thing and na pride for woman to marry as a virgin.
E still dey give woman family pride say dem train her well.
Many men love to marry virgin becos dem believe say women wey be virgins norva spoil and norva too go deep into immorality.
But let us evaluate this matter.
Teddy dey plan marriage with Ejiro wey e meet for almost 6 months now.
Teddy know Ejiro ex but e nor ask to confirm wetin make dem break up.
Few days to their wedding nai Teddy tell Ejiro say e must test wetin e wan pay for.
E must know how the place be cos e nor dey say shoot bird mama fly.
Ejiro don start again say make Teddy just endure. Say e don already endure till now.
But Teddy nor gree. E say e wan do.
Where dem for dey argue the issue, nai Ejiro for tell Teddy say na this same issue nai make her break up with her ex.
Teddy cum tell her say e know her ex. And that her ex na player. Say e nor believe say e nor sleep with her for almost one year wey dem date.
So, why Ejiro dey lie for am say she be virgin?
Ejiro begin cry say make Teddy believe her.
She cum dey swear with her life.
That evening, Teddy cum tell her to go say e go find out.
Only for Teddy to go meet Ejiro ex begin ask am questions about Ejiro.
Talk cum lead to talk wey Ejiro ex for cum tell Teddy say actually, Ejiro na still virgin.
All through, she nor gree make e penetrate her. But na through she nai e himself take like anal sex. Na she intorduce am to doking through yansh.
She say she wan reserve her virginity for the man wey go marry her.
But she fit give anybody her anus.
So, na through anus nai she dey for dey make love since.
As Teddy hear this, e just lost affection for Ejiro.
E call Ejiro nai e ask her whether she don naked romance somebody once?
Ejiro say yes.
Whether she don suck person once and also whether dem don suck her once?
She say yes.
All this while, she don dey cry o cos she know say things are going wrong.
And she dey fear make Teddy nor go say e nor go marry again when dem get just 3 days to their marriage ceremony.
After so many questions, nai Teddy ask Ejiro whether she don make love through yansh befor?
Hardly nai she take say yes.
Finally, Teddy cum ask her, if you don do all these, so, are you still a virgin?
Ejiro just dey look am kpeeeeeeyyyyyyyy!
My pipo, if na you be Teddy, will you still marry Ejiro say na virgin?
And if na you be Ejiro, are you still a virgin?
Make I sidon dey drink my akamu with straw as I dey wait answer.
Fear God! Fear Woman!
God Bless Sapele.
I LOVE SAPELE.
SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Re: Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by DRISKLEF(m): 1:48pm On Aug 10, 2016
Bad keyboarding.
Re: Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by ehizzybaba(m): 1:55pm On Aug 10, 2016
No b only virgin.......






U nor green gve person Ur knife take cut dog meat jxt bcox
Nah abomination for to eat dog meat
But u choose to offer Ur teeth........



WETIN B D DIFFERENCE BETWEEN SIX (6) & HALF A DOZEN
Re: Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by adewumiopeyemi(m): 2:14pm On Aug 10, 2016
cool cool cool cool cool
Re: Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by oglalasioux(m): 2:30pm On Aug 10, 2016
A thousand and one girls brandishing virginity have done what Ejiro did.
Re: Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by Nobody: 2:56pm On Aug 10, 2016
This is very funny
Re: Got This Stuff From Facebook,share Your Thoughts.. by ClassCaptain(m): 3:02pm On Aug 10, 2016
Funny shii

(1) (Reply)

Bride Attaches Newborn Baby To Train Of Her Wedding Dress / Sleeping Position / Future 9ja Celebrity That Are Nairalanders.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 28
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.