Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,081 members, 7,821,715 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 05:09 PM

Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached (9436 Views)

"Our Mumu Don Do" Group Visit Family Of 10yr Boy Killed During Market Demolition / Why We Dispersed Charly Boy's "Our Mumu Don Do" Protest - Police / Lai Mohammed, Fashola And Fayemi At FEC Meeting Today (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)

Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by progress69: 9:18pm On Oct 14, 2016
Dear Nairalanders,

For months now i have been suffering no be small. To remove fish, meat for freezer na wahala.

I be dey send 10k for prepaid card to my younger ones for house wey dey with my parents every month, now dem dey manange 15k every month with plenty minimizing, like nor on ACs over night (thank God for better weather wey dey Lagos)

To remove anything for freezer u go need gym for 1 week, then buy cutlass, stick, After u don wait 3 days make the block vex reduce.

Uncle Fashola which kian wahala be this.

Some people say na rain, Abeg the rain wey dey fall for the past 16 years different from this one??

I never suffer like this for long time.

The first time i be suffer, na when Buhari first enter with body language before some terrorists begin dey blow banger for gas line

To go Church or work sef na wahala now, Light go just dey shine for your eyes.

Uncle Fashola, please e don do, u don show your self reach. We know say u sabi work.

U don even dey do road anyhow now, people go soon dey do need for speed 10 and asphalt 100 when dem dey trvavel go village after dem don "develop" Lagos finish. Meanwhile na 2 days dem take dey reach village before, cos dem go press brake for porthole so tey break go dey press en sef.

Uncle Fashola, e don do ooooooo

*MODIFIED*

Reporting from Gowon Egbeda Lagos.

30 Likes 2 Shares

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by HungerBAD: 9:21pm On Oct 14, 2016
LOL.

God bless Buhari.

Genesis 1:3 And God said, "Let there be light," and there was light.

26 Likes 2 Shares

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by progress69: 9:23pm On Oct 14, 2016
HungerBAD:
LOL

My brother u dey laugh me. Make una beg Uncle Fashola o. Na wetin Yoruba dey call Gbese re oooo!!!

11 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by madridguy(m): 9:24pm On Oct 14, 2016
Make I relax for here small since morning. Wailer don bombard my mentions ontop mere joke from Sai Baba.

Meanwhile, @ OP, Fashola deserves 3 Gbosa.

14 Likes 2 Shares

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Justiceleague1: 9:28pm On Oct 14, 2016
progress69:
Dear Nairalanders,

For months now i have been suffering no be small. To remove fish, meat for freezer na wahala.

I be dey send 10k for prepaid card to my younger ones for house wey dey with my parents every month, now dem dey manange 15k every month with plenty minimizing, like nor on ACs over night (thank God for better weather wey dey Lagos)

To remove anything for freezer u go need gym for 1 week, then buy cutlass, stick, After u don wait 3 days make the block vex reduce.

Uncle Fashola which kian wahala be this.

Some people say na rain, Abeg the rain wey dey fall for the past 16 years different from this one??

I never suffer like this for long time.

The first time i be suffer, na when Buhari first enter with body language before some terrorists begin dey blow banger for gas line

To go Church sef na wahala now, Light go just dey shine for your eyes.

Uncle Fashole, please e don do, u don show your self reach. We know say u sabi work.

U don even dey do road anyhow now, people go soon dey do need for speed 10 and asphalt 100 when dem dey trvavel go village after dem don "develop" Lagos finish. Meanwhile na 2 days dem take dry reach village before, cos dem go press brake for porthole so tey break go dey press en sef.

Uncle Fashola, e don do ooooooo
mental...grin wetin dey dat fridge sef,only 2 items?! grin

11 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Lamzee(m): 9:28pm On Oct 14, 2016
Uncle lala wetin we go fit put inside this freezer?
Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by progress69: 9:29pm On Oct 14, 2016
Justiceleague1:

mental...grin wetin dey dat fridge sef,only 2 items?! grin


How u wan see am. When block don cover Everything. The only visible items na fresh items for small kids wey con play with me. Make e for quick cold small. Abi na uncle wan drink sachet hollandia and that tiny Happy hour. Big freezer stil dey sef, but i don off that one for 3 days. E din defrost small.

19 Likes 2 Shares

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Nobody: 9:30pm On Oct 14, 2016
Una no serious o... When light no dey, una go dey swear... Now light dey u no con want again. Oga wetin na... grin

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by finalboss1(m): 9:32pm On Oct 14, 2016
disaster
Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Justiceleague1: 9:33pm On Oct 14, 2016
progress69:



How u wan see am. When block don cover Everything. The only visible items na fresh item for small kids wey con play with me. Make e for quick cold small.
thou shall not lie with kids o...na 50naira drink be dat,i know am,na u wan shack am..grin

13 Likes 1 Share

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by EWAagoyin(m): 9:36pm On Oct 14, 2016
hahahahahahahhahahaha im proud to be an APC (Tinubu branch) supporter.

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by GoodofNaija: 9:37pm On Oct 14, 2016
Well....good for you!

Its commendable and I sincerely hope it can be sustained, because there are saboteurs all around.

Light in my area is still poor though.

But I believe with time, everyone will feel the improvement.

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Nateben(m): 9:40pm On Oct 14, 2016
So you no get switch?

22 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by NOC1(m): 9:44pm On Oct 14, 2016
Last week friday till Monday early morning what I enjoyed is what oyibo man called uninterrupted power supply.
For the past one month my Gen has not been on, if it continue like this till the end of this month, I will packup the gen.

14 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Cadamlk: 9:44pm On Oct 14, 2016
Lamzee:
Uncle lala wetin we go fit put inside this freezer?
snake meal grin

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by progress69: 10:14pm On Oct 14, 2016
Justiceleague1:

thou shall not lie with kids o...na 50naira drink be dat,i know am,na u wan shack am..grin

Oga se u dey whine ni. See the freezer still dey off and open....wahala dey dey ground patapata...e gaz defreeze well b4 u fit comot wetin dey there. See the small frezer wey i just on yesterday morning. See Normal fridge. Na wein uncle dey take be that.

4 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Nobody: 11:03pm On Oct 14, 2016
lol

1 Like

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by potbelly(m): 11:06pm On Oct 14, 2016
Op, Be careful what you wish for bro...
Enjoy while it lasts...

P.s which area in Nigeria is that exactly...

7 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Freegift75: 11:07pm On Oct 14, 2016
This one na gbese. Prepaid meter dey consume unit o. I don tire

4 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Ajibel(m): 11:17pm On Oct 14, 2016
Light has greatly improved in my area. Unfortunately, it has made me lazy. I don't go out like before. Just spending all day with my PC.

11 Likes 1 Share

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Yuneehk(f): 11:29pm On Oct 14, 2016
Nigerians can complain sha.. Sometime ago, I was complaining about the unsteady power supply in my area but now ehh, I'm tired too.

It's cool having light all the time but I'm always tempted to take extremely cold stuffs and end up with cold,cough and catarrh most of the time.

As for the bill eh, they aren't being merciful with that one. The steady light is one positive change I'm seeing.

9 Likes 2 Shares

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Oliviaxx(f): 11:29pm On Oct 14, 2016
Is this Nigeria?
Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Aquariann: 11:56pm On Oct 14, 2016
Oga Op, Abeg switch off, defrost and clean your freezers...

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by jiinxed: 12:03am On Oct 15, 2016
Dirty refrigerator

6 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by PaulIdu: 12:05am On Oct 15, 2016
Still not noticed the improved light ..Infact I have not used light all day

9 Likes 1 Share

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by ihimiray(m): 1:09am On Oct 15, 2016
Oliviaxx:
Is this Nigeria?
yes it is.... The power supply has greatly improved...

1 Like

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by DelGardo: 1:30am On Oct 15, 2016
I agree. Power supply has increased. Never felt it this way.

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Nobody: 3:34am On Oct 15, 2016
And people like us who work online 24/7 are struggling to get it for like 5 minutes for the past 3days

5 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by opiaoku: 3:43am On Oct 15, 2016
MrLouisVanGaal:
And people like us who work online 24/7 are struggling to get it for like 5 minutes for the past 3days
Fact is that there are some places you get light more than the other even during obj era
and the OP may just be fortunate one living there.

But to be honest fashola is the only minister working hard to meet the expectations placed on him. Others are just bunch of vagabonds especially that dunce kemi adeosun

3 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by babdap: 4:08am On Oct 15, 2016
See what long years of darkness had caused. Thank God op hasn't travelled aboard he could have disgrace her fatherland.

4 Likes

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Kingsley10000: 4:41am On Oct 15, 2016
God Bless apc.......wailers how market

1 Like

Re: Uncle Fashola, Please Come And Carry Your Light oooo! E Don Do....(pics attached by Tundeiab(m): 4:47am On Oct 15, 2016
progress69:


My brother u dey laugh me. Make una beg Uncle Fashola o. Na wetin Yoruba dey call Gbese re oooo!!!
Is that a Frigde/freezer or a DUSTBIN?

6 Likes

(1) (2) (3) (4) (Reply)

Ibrahim Odumboni: Backlog Of Waste In Lagos To Disappear Soon / Bauchi First Lady Attends Exhibition To Honour Victims Of Terrorism Attack, Band / Over 20 Journalists Attacked During Presidential Election

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 35
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.