Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,661 members, 7,809,500 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 10:36 AM

Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) - Forum Games - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Forum Games / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) (57845 Views)

Finish Off The Sentence With A Rhyming Word / ╚►start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 3 ◄╝ / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 2 (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (100) (Go Down)

Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by KennyG6(m): 7:07pm On Jan 28, 2010
[center]as we no wan cheat people wey no sabi english i don start pidgin version of the game so make una start[/center]

wey una dey?

1 Like

Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Godmother(f): 7:14pm On Jan 28, 2010
dey for where? we dey come
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by KennyG6(m): 7:18pm On Jan 28, 2010
come siddon make we chop kola
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 9:30pm On Jan 28, 2010
Kola bearer na life bringer
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by KennyG6(m): 1:12am On Jan 29, 2010
bringer abeg wey your egunje?
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 1:29am On Jan 29, 2010
Egunje na im Ascari dey collect
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by KennyG6(m): 11:21am On Jan 29, 2010
collect wetin? na wich yamayama talk be dat
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by kokonets(m): 4:11pm On Jan 29, 2010
Dat kola way una bring don cos kasala
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 5:09pm On Jan 29, 2010
Kasala no fit bust for here
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by DeepSoul(f): 7:46pm On Jan 29, 2010
Anyborri wey make kasala burst go pay fine
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 7:56pm On Jan 29, 2010
Fine na im u go pay cos dey talk say make u start wit last word
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by DeepSoul(f): 8:16pm On Jan 29, 2010
Word wey my eye no see well
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by nellaluv(f): 9:21pm On Jan 29, 2010
Welli done o una. But make una wellicome nella da vanilla grin grin grin
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Qiana(f): 9:23pm On Jan 29, 2010
vanilla . me i know how 2 begin sentence again oooh grin
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 9:52pm On Jan 29, 2010
Ooooh u no even sabi yarn d pidgin sef
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Qiana(f): 10:11pm On Jan 29, 2010
i don see u wey fit yarn am, oya teach me.
i gbadun dis ur name ,
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 10:19pm On Jan 29, 2010
Name na small tin. As u con gbadun am sha we go dey yarn well well.
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by nellaluv(f): 10:20pm On Jan 29, 2010
Well sha, make una yarn dey go, i go dey do siddon look
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Qiana(f): 10:26pm On Jan 29, 2010
word dey hard 2 start.
d game hard 2 play no be everytym last word dey make sense angry
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 10:27pm On Jan 29, 2010
Sense na wetin pesin fit take style dey learn
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Qiana(f): 10:30pm On Jan 29, 2010
learning no dey easy
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 10:48pm On Jan 29, 2010
Easy tin dey good sha
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by KennyG6(m): 1:18am On Jan 30, 2010
sha make we no tay
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 2:31am On Jan 30, 2010
Tay for where?
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by kokonets(m): 9:35am On Jan 30, 2010
Where we go collide dis weekend
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by nellaluv(f): 10:01am On Jan 30, 2010
Weekend jolly i dey gbadun am, where i go meet una.
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by LordReed(m): 10:28am On Jan 30, 2010
Una done start weekend abi, make una no leave me o!
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by lysaa(f): 5:01pm On Jan 30, 2010
o kenny ur head korrect wella. tongue
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by goodass(m): 6:12pm On Jan 30, 2010
wella wella me sef see am so. hw una dey naw
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Amigoz(f): 6:13pm On Jan 30, 2010
Naw, na U I 4 ask ow u dey? As e don tay!
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by goodass(m): 6:15pm On Jan 30, 2010
tey like long tin. i hapi 2 see yu o
Re: Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) by Amigoz(f): 6:16pm On Jan 30, 2010
ooooo na me happi pass, u no see as i dey shine ma grin grin grin

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (100)

3words Per Post: Part 2a / 1. . . . . .999,998 999,999 1,000,000. Who Will Write 1? / If You Were Stuck On An Island With

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.