Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,382 members, 7,819,391 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 03:27 PM

Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! (1089 Views)

I Don't Know If This Married Woman Wants To Fûck Me Or Not...see Wahala / See Wahala O! / Ladies With Tattoos Ummmm Omo Make Una See Nauuu (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by megastarjec(m): 7:12am On Jan 26, 2018
See me See wahala o!
this boyfriend and girlfriend pipo wan break my left big finger for me o! My dear na serious mata o!

I jus enta taxi dey go were i wan go finis one book work i dey do, na so dis girl enta moto tell driver to move. next tin i see, one boy jus enta d moto o! Hmmm! As the girl see the boy she com say she ney dey go again. Oya com down na, No, commot for d moto na No, na so driver jus dey shout, mek una commot, mek una go down for my moto abeg.

d boy jus dey claim sey di girl chop him money wan run. di girl dey say na lie o! di boy na my boyfriend bifor, since 6 months now, i don tell am say i no want again o! na so him come dey trace me nywhere wey I go. Since 6 months now I never meet am or see am sef.

My dear no bi small tin I see for them o. Na so driver dey shout, mek una commot o! I no dey carry again, far far far fowl. Dem no gree. befor i no o the girl dey shout driver carry me go mile 3 police station. Chio! as di boy hear am, him blodu start to dey vibrate, him dey blow di girl o!
See me see wahala o. I jus dey dere like fowl wey water pour. Mek i hole di girl wey dey fall for my body or mek I for wan hold di boy wey even dey fin way mek him com down as moto dey move, my dear i no no o! Mi phone sef com dey mi hand, if i no open my eye, aboy hin go disappear. Choi! See problem o.

Driver jus dey fire speed dey go UST police station, di boy jus dey blow di girl. As i sey mek for put hand to tell sey mek him no blow with mistake o! Na so i hear gpom for mi hand, mi phone run commot for mi hand, di boy unco? com use fear sey driver dey go UST police station come down o even as di moto dey move o!

But thank shaa, mi phone no loss, di boy carry di girl phone run, di girl go police sey she go go carry di boy moda and fada put for cell.

Since dem mi big finger jus dey pain me o! Na wa for boyfriend and girlfriend mata o inside dis new year. Hmmm. I fear but I no run...

1 Like

Re: Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by braimeddy: 7:23am On Jan 26, 2018
So u wan tell me say na only u b dey inside d moto? Wetin oda passengers kon dey do? And which road una pass go ust police station? Na through agip una for dey come abi na from ikoku side?

1 Like

Re: Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by Epositive(m): 7:23am On Jan 26, 2018
this tori worwor small o op undecided
Re: Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by AnodaIT(m): 7:37am On Jan 26, 2018
No video?
Re: Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by megastarjec(m): 9:42am On Jan 26, 2018
braimeddy:
So u wan tell me say na only u b dey inside d moto? Wetin oda passengers kon dey do? And which road una pass go ust police station? Na through agip una for dey come abi na from ikoku side?

Mi dear na from Ikoku o! Around 10 o'clock for night o! na me first enta sef mek i for go reach wey i dey go o! Na mile 3 sef di bobo come down run enta bishop okoye o! I no fit laugh, i no fit shout sef... e no funny at all
Re: Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by megastarjec(m): 9:44am On Jan 26, 2018
Epositive:
this tori worwor small o op undecided

No bi small tin o. Wazobia abi naija fm for hear am o.
Re: Mek Una See Me See Wahala O! For Girlfrind N Boyfriend Mata O! by megastarjec(m): 9:47am On Jan 26, 2018
AnodaIT:
No video?
Na wa for u o! video for backseat wey every tin dey happen. abi u neva enta taxi bfor? n di tin jus happen quick quick wey me nd driver jus dey surprise sef for di mata

(1) (Reply)

. / Charge Your Woman Up From This Position If She Can Allow You / Is This True About Ladies (or Young People) ?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.