Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,305 members, 7,957,780 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 08:05 PM

How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident (1872 Views)

OMG! Must See Big Yansh Of This IG Model (see Photos) / Why Do Guys Love Yansh/booty??? (picture) / See Naija Babes Doing Things With Their Yansh In Public [see Photo] (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident by Nobody: 3:34pm On Nov 24, 2011
I just receive phone call from one of my pally from hospital and all wetin im just dey yarn but me for phone na how baba God take save im live from the recent car accident wey he get.According to wetin dis my pally tell me for phone on a very hot afternoon he be enter im car with the intention to drive go one beer palour to cool off.As he just dey drive jeje dey mind im own business na im come pass one fine yellow sisi wey dey waka for sidewalk and this fine sisi get very big yansh and to make matters worse the babe even wear very tight jeans to empasize the thing.Ok my pally say as he pass the babe with im motor na im he come jus dey take style assess the yansh from side mirror he swear say na just for some few seconds na im he take comot eye for road and omo as he come put eye for road na im he just see one huge Julius Berger trailer dey come towards am at top speed.Ol boy my pally say na im just swerve comot from road go smash one electric pole with im car.As he yarn am he say na the safety belt for im car na im save im life and he dey very greatful to baba god for saving im life even though he get one broken leg and a broken shoulder blade from the accident.He come yarn me how lagos girls with their big yansh dey always dey use am distract motorist attention.He say if u no get strong blood na so u go stare and stare and b4 u know it na accident don happen.He tell me say come next sunday na thanksgiving he go do for im church together with im wife and family for god saving im life.Me sef dey jollicate with am but then i want make Oga Fashola do something ooo about all these wicked lagos girls with their big yansh wey dey use am distract motorists.I jus dey pray make dem no use distract any trailer driver because omo if dat one happen hmmmm we no go fit dey here talk ooo shocked shocked
Re: How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident by slimyem: 3:39pm On Nov 24, 2011
i don't need reading this before knowing its rubbish!!
Re: How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident by Nobody: 4:08pm On Nov 24, 2011
[size=14pt]***Yawns***

I'll be damned if i read this. . .[/size]
Re: How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident by Nobody: 4:17pm On Nov 24, 2011
Weeeeell. It was funny anyway. Dude shld be in the jokes section. This is funnier than all the jokes they have there.
Re: How Big Yansh Take Cause One Of My Pally To Get Accident by Kslib(m): 4:25pm On Nov 24, 2011
Very funny nyashy talk.Nyash dy him own una dy here dy judge am!

(1) (Reply)

Are Nigerian/west African Women Romantic? / What Tribe Makes The Best Wife? / Top 10 Traits Of A Real Man

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.