Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,054 members, 7,814,626 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 04:30 PM

Write the Bible In Pigin English! - Religion (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / Write the Bible In Pigin English! (13335 Views)

Summerise The Bible In One Sentence / Why Did God Need To Write The 10 Commandments / Did God Really Write The Bible? (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)

Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 8:11pm On Dec 04, 2012
greatdave: See,na me be d BOSS of evry evry; E get any gbègè,kasala,wahala,mata wey I nor fit arrange? Jeremiah 32:27
O boy e

2 Likes

Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 8:13pm On Dec 04, 2012
freechat: John 3:3
English version

Jesus answered and said unto him, verily, verily, I say unto thee, except a man be born again, he cannot see the kingdom of God.

Pidgin version
Jesus come answer say, wetin I dey yarn you so no be wash, if your parole no pure, you no go enter permanent site.
No be small thing o.
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 8:16pm On Dec 04, 2012
This thread is turning out better than I expected. Thanks guys for making it this entertaining. Keep them coming.
Re: Write the Bible In Pigin English! by AGgal(f): 8:18pm On Dec 04, 2012
O mumu Galatians,na who don charm una say make una no obey true talk,4 una before na it they crucify Jesus Christ among una?

2 Likes

Re: Write the Bible In Pigin English! by Peterpan1(m): 8:19pm On Dec 04, 2012
Romans 8:15-for baba God, no drop spirit of fear for us, may we dey act like pikin wey c snake, bt He dash us the ogbonge spirit of papa to son, se may we dey call am PAPA.

1 Like

Re: Write the Bible In Pigin English! by Peterpan1(m): 8:25pm On Dec 04, 2012
English version. Psalm 82:6-for you are gods, yet i say again you are gods, you sons of the most high God. Pigin version. For una be gods, oh boy i yan am again, una be gods, all the pikin of Baba God.

1 Like

Re: Write the Bible In Pigin English! by omenka(m): 8:26pm On Dec 04, 2012
advocate666: The bible is such a joke.
Seekin fame thru notoreity. Park well ojare..
Re: Write the Bible In Pigin English! by ijawkid(m): 8:26pm On Dec 04, 2012
Make ona hear LORDS PRAYER O....

Matthew 6:9-13

9..Ona must pray like this ""OUR Popsy wey dey for heaven your name too much JARE that is why we go dey call am,10 make your KINGdom come Àbeg,make your plans happen ,as e dey happen for heaven make na so e happen for this earth berekete. 11 continue to nak us our usual fufu,starch,ewagoin,afang soup,tuwo,kekefia,and eba everyday ;12 abeg forgive us for all the yeye/yamayama things wey we dey/don do as we sef dey forgive those wey don make us vex well well..13 BABA GOD abeg make sure say we no turn to satan scape Goat,instead make you continue to give us ODESHI wey go protect us from that "wiliwili" wey them dey call satan....
________________________________

1 Like

Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 8:29pm On Dec 04, 2012
Dem make party for laugh, wine for sake say make we jolliment: but ago, kudi, owo dey open every door. Ecclesiastes 10:19

If we go talk true, NEPA light sweet die, and na correct thing say make we use we eyes talk look the sun. Ecclesiastes 11:7
Re: Write the Bible In Pigin English! by buchibabe: 8:57pm On Dec 04, 2012
1 And thou, son of man, take thee a sharp knife, take thee a barber's razor, and cause it to pass upon thine head and upon thy beard: then take thee balances to weigh, and divide the hair.

Ezekiel 5:1....

And you,man pikin, carry knife wey sharp wella,collect razor blade,make you give yasef skin cut for ur head and make u level ya biabia: then carry am go measuring scale make u share d hair

2 Likes

Re: Write the Bible In Pigin English! by patostation(m): 9:13pm On Dec 04, 2012
As time come pass, na so Judah come marry wife for in firstborn pickin wey in name na Er and di wife wey e marry for am na Tamar. But Baba Godey no come like wetin Er de do, so tey e come kill am. As this thing come happen , na im Judah de yan Onan say make im de browse im brother wife website, make e be like say na brother-in-law marriage e wan do so, make im brother wey don die fit get pickin. The tori come happen say as Onan come know say no be im go get di pickin, na im make anytime wey im wan browse im brother wife website e go de troway di sperm for ground, make im late brother no get pickin. Na so this thing come vex Baba Godey so tey Baba Godey kill am. (Gen 38:6-10)
Re: Write the Bible In Pigin English! by Biggyd2: 9:14pm On Dec 04, 2012
Dis tread sweet die!
Re: Write the Bible In Pigin English! by buchibabe: 9:18pm On Dec 04, 2012
Acts 4:13...
13 Now when they saw the boldness of Peter and John, and perceived that they were unlearned and ignorant men, they marvelled; and they took knowledge of them, that they had been with Jesus.

Pidgin....
Now when dem see as peter and john tanda for ground,no shaking,come see say dem too sabi and dem be guys wey no send, afraid catch dem: dem com reason am say d two both of dem bin dey with Jesus
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 9:50pm On Dec 04, 2012
Matthew 7:23 Make I tell una say "Park Well joor"

1 Like

Re: Write the Bible In Pigin English! by dljbd1(m): 10:14pm On Dec 04, 2012
dadicvila: Amos 3:3>>two people go fit run package except them gree??

Hahahaha! Av been tryin 2translate ds since afternoon. U badest jare
Re: Write the Bible In Pigin English! by uche77zero(m): 10:14pm On Dec 04, 2012
take off from wetin be like bad thing
Re: Write the Bible In Pigin English! by dljbd1(m): 10:21pm On Dec 04, 2012
SniperInADiaper: Matthew 7:23 Make I tell una say "Park Well joor"

Hahahahahahaha

Mat 7:23
Then I will say to them, ‘I never knew you. Get away from me, you wicked people!’

Na 2tell dm, 'Park well joor!'.
Re: Write the Bible In Pigin English! by amy2882: 10:44pm On Dec 04, 2012
freechat: Luke Chapter 19:1-5
English version
1 Jesus entered Jericho and was passing through. 2 A man was there by the name of Zacchaeus; he was a chief tax collector and was wealthy. 3 He wanted to see who Jesus was, but because he was short he could not see over the crowd. 4 So he ran ahead and climbed a sycamore-fig tree to see him, since Jesus was coming that way. 5 When Jesus reached the spot, he looked up and said to him, “Zacchaeus, come down immediately. I must stay at your house today.”

Pidgin version
1 Jesus show for Jericho come dey pass enter another koro. 2 E come get this bros when dem dey call Zacchaeus, wey be tax collector come get pepper join. Zack try make im see Jesus, but im two short legs no let am because plenty people gather. 4 As a sharp guy, bros Zack come climb one tree when im see say Jesus don dey show that side. 5 When Jesus reach there come look up see where Zack anchor with im two short legs, na im Jesus halla: "Zacchaeus, oya show sharperly, na for your crib i wan crash today."



Now this got me laughing really hard. Hilarious! .."as a sharp guy"
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 10:59pm On Dec 04, 2012
I beg follow me check am o, one babe way dey d city, way dey run beta package, by the time she sabi say Jesus dey her corro, dey enjoy himself with nama for one oga Pharisee house, she come go commot one type oil way she don hide well well, them call am alabaster.

She no fear stand for him front o come begin form water for her eyes, and she come dey use the eyes water dey wash Jesus leg, dey clean am again with the hair way dey her head, she no stop there o, she come kiss him leg o, come pour oil untop join.

Na him the man way cook meat give Jesus, use one kind eyes look Jesus and the thing way d babe dey do am, the bros vex talk inside him mind say, if to say this bobo na correct prophet, him go sabi the kind person way this woman way dey touch am be: because she be correct ashi. Luke 7: 37-39

1 Like

Re: Write the Bible In Pigin English! by aixuehanyu: 4:02am On Dec 05, 2012
vote!
e-mail:
I taught some pupils of a school, (primary 1) on friday Bible study and on sunday while taking my bath to go to church, the thought occurred. 'What if the Bible was written or a version translated in pigin English', how interesting will it be?

I tried to use the normal KJV but I discovered reading a long passage will kill the spirit, so I opted to tell the stories the way I feel was ok and via the leading of the spirit.

In the light of this, can we put down our favorite portion of the Bible in pigin English with the verse as well? If yes,lets roll!
Re: Write the Bible In Pigin English! by nzeaji(m): 4:37am On Dec 05, 2012
Sense making thread... grin
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 7:08am On Dec 05, 2012
dl_jbd: Galatians 3:1
O YOU poor and silly and thoughtless and unreflecting and senseless Galatians! Who has fascinated or bewitched or cast a spell over you, unto whom--right before your very eyes--Jesus Christ (the Messiah) was openly and graphically set forth and portrayed as crucified?

(Condensed Nigeria Pigin Version CNPV)
Galatians! Una no get sense Ooo! Abi dm swear 4 una? No b 4 una korokoro eyes lyk ds dm carry Jesus Christ put 4 cross?

hilarious! grin
Re: Write the Bible In Pigin English! by Goshen360(m): 7:15am On Dec 05, 2012
I don't even know the bible verse to translate into pidgin....the laff wey I dey laff from this thread don empty my head so tay I no even fit remember any bible verse to translate...... grin grin grin
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 7:19am On Dec 05, 2012
Goshen360: I don't even know the bible verse to translate into pidgin....the laff wey I dey laff from this thread don empty my head so tay I no even fit remember any bible verse to translate...... grin grin grin
lol. Carry Bible and you go flow.
Re: Write the Bible In Pigin English! by Goshen360(m): 7:26am On Dec 05, 2012
^^^ Okay. I will try. When next I post, it will be bible verse pidgin translation..... cool
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 7:28am On Dec 05, 2012
Goshen360: ^^^ Okay. I will try. When next I post, it will be bible verse pidgin translation..... cool
That's the spirit.
Re: Write the Bible In Pigin English! by Enigma(m): 7:31am On Dec 05, 2012
From here https://www.nairaland.com/1032312/scandal-church#11991972

"Oga, dis one harrr o; dis thing wey you dey talk too hard!" then Jesus turned to the inner circle too (i.e. the apostles) and said "abi una too wan begin go - if de thing too hard for una?" And one of them reply ---- "Whosai we wan go? Na you when get the words of eternal life!"


John 6
66 From this time many of his disciples turned back and no longer followed him. 67 “You do not want to leave too, do you?” Jesus asked the Twelve. 68 Simon Peter answered him, “Lord, to whom shall we go? You have the words of eternal life. 69 We believe and know that you are the Holy One of God.”

smiley
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 7:44am On Dec 05, 2012
Luke 8:45

English version
45 And Jesus said, Who touched me? When all denied, Peter and they that were with him said, Master, the multitude throng thee and press thee, and sayest thou, Who touched me?


Pidgin version

45 Bros J come dey para ask them say, who connect my network? As all man bone, na im Piro with other guys wey dey run things together come say Brosie, you dey fall our hand o, see all this you fans wey dey follow you robe body since, na im you still dey ask who connect your network? Shuo!

4 Likes

Re: Write the Bible In Pigin English! by Enigma(m): 7:59am On Dec 05, 2012
Exodus 18:9 "And Jethro rejoiced . . . ."

Na im Jethro Belle come sweet like sugar --- jus like wen Rasaki bin buy Kawasaki.

smiley
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 8:59am On Dec 05, 2012
2 Samuel 11:2-5

English version
2 One evening David got up from his bed and walked around on the roof of the palace. From the roof he saw a woman bathing. The woman was very beautiful, 3 and David sent someone to find out about her. The man said, “She is Bathsheba, the daughter of Eliam and the wife of Uriah the Hittite.” 4 Then David sent messengers to get her. She came to him, and he slept with her. (Now she was purifying herself from her monthly uncleanness.) Then she went back home. 5 The woman conceived and sent word to David, saying, “I am pregnant.”

Pidgin version
2 As David don sleep tire one evening like dat, na im e climb go penthouse. As im dey look around, omo na im e see one otepu wey dey baff. Spiritual konji con hold am because the babe tap, 3 na im Dave send one runs guy to go arrange the parole. E come be say the babe name na Bathsheba and her palle name na Eliam. Na one bobo wey dem dey call Uriah from Hittite village, na im carry the babe wholesale." 4 Dave no dull himself at all, e ping the babe sotey she show, come collect banana, upon say she just dey finish her period. 5 E no tey before the otepu ping Dave back, come tell am say guy, you don package me o!

2 Likes

Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 8:59am On Dec 05, 2012
2 Samuel 11:2-5

English version
2 One evening David got up from his bed and walked around on the roof of the palace. From the roof he saw a woman bathing. The woman was very beautiful, 3 and David sent someone to find out about her. The man said, “She is Bathsheba, the daughter of Eliam and the wife of Uriah the Hittite.” 4 Then David sent messengers to get her. She came to him, and he slept with her. (Now she was purifying herself from her monthly uncleanness.) Then she went back home. 5 The woman conceived and sent word to David, saying, “I am pregnant.”

Pidgin version
2 As David don sleep tire one evening like dat, na im e climb go penthouse. As im dey look around, omo na im e see one otepu wey dey baff. Spiritual konji con hold am because the babe tap, 3 na im Dave send one runs guy to go arrange the parole. E come be say the babe name na Bathsheba and her palle name na Eliam. Na one bobo wey dem dey call Uriah from Hittite village, na im carry the babe wholesale." 4 Dave no dull himself at all, e ping the babe sotey she show, come collect banana, upon say she just dey finish her period. 5 E no tey before the otepu ping Dave back, come tell am say guy, you don package me o!
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 9:00am On Dec 05, 2012
freechat: Luke 8:45

English version
45 And Jesus said, Who touched me? When all denied, Peter and they that were with him said, Master, the multitude throng thee and press thee, and sayest thou, Who touched me?


Pidgin version

45 Bros J come dey para ask them say, who connect my network? As all man bone, na im Piro with other guys wey dey run things together come say Brosie, you dey fall our hand o, see all this you fans wey dey follow you robe body since, na im you still dey ask who connect your network? Shuo!
Imagine! Shuo. Lol

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)

The Dome Above The Earth Will Shatter Beliefs And Topple Nations-abachwezi / What's The Best Way Of Changing Your Church? / Psalm 109: Why Is It In The Bible?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.