BAZ001's Posts
Nairaland Forum › BAZ001's Profile › BAZ001's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 101 102 103 104 105 106 107 108 109 (of 135 pages)
chillex8:As in ehen I just gentle for here dey read how bolt (bonus) dey cause commotion. Who could ever imagine dt a time will come when I will be avoiding surge request on bolt Small destination trip wey I wan set gbam 1st request - 5mins Trip - 1000 (d babe change an for me na gateman rescue me) 1* sure 100% 2nd request - 9mins - 1100 ( cool but I no sure for her mind) 3rd request- 57mins - 10,300 (yellow babe face turn red) 1* confirm I don off app dey read nairaland. Na to begin do inDriver and Uber before dem go chup my ratings finish. If not for bonus I no dey near bolt at all, but no how wey I go on app for my house wey no go be surge. |
SokizzRaven:Bolt get Nigerian version be that. Before ur paper expires on Uber u go don dey get warning. And dts why police will never ask Uber/bolt drivers for papers. Bolt Nigerian version, once you upload for the first time nothing concern them again. But this your case and @peeps4u might be COVID-19 new developments or App don porous. |
SokizzRaven:Baba I think something is not adding up here m, can you share your bolt app dashboard? If you are an old driver, I understand dt all ur papers could have expired and u still be active. But for new driver no physical inspection How Well anything can happen But wait ohh, why you no want mama Radu ![]() U don go mess up for there or na Jamaican rice dey scare you ? |
Pearl1910:God bless you In the whole of March I no do reach 60 trips yet my ratings dropped 3 times Last one was 4.65 last friday and I started smiling and playing with riders to get better ratings I did 12trips on Saturday and 3 trips dis evening (make you and Kanu no go clear all d trips finish come start to dey chup bonus and make me look lazy) Ratings dropped to 4.62.. I no just talk to last rider after good evening, hello/hi. My ratings has never ever been dis low... maybe I will send them a chat too ‘for peace to reign ) |
kanuisagoat:Bros, how many trips u don do today ? E be like say u don complete all ur 40trips today and bonus starts from tomorrow |
deedee44:This same thing happened last week, Suddenly I realized that 3 request came on inDriver from my location and trust fast fingers people rushing them, after 5mins I noticed d request of 3,400 still pending nobody touch am. I offer price 4,200 rider rejected. Na so I offer 3,800 let me close eye since it’s going to yaba from Ajah rider reject, I offer 3,600. Na so Baba accept. Na so I say make I even check google map. Na so I see 2hrs 15mins, say who die? 21mins delay another 13mins delay and on fastest route. Fortunately for me I no off bolt app na so 1.9x surge enter to ijesha/Surulere. I just switch go bolt beg guy say I no fit come cos time to PU inDriver and bolt na 12mins and 7mins respectively. Bolt 7mins later turn 15mins cos of dt Ajah/addo traffic. Since then I compare price on bolt before doing fast finger inDriver. Fear no go gree me tell rider about offline, I will rather dey suggest it to me. Trip ended 6,200 Though all dis fit be part of my ratings dropping |
Gentlelife50:No leave no transfer ![]()
|
Felicity001:Juicy offer from juicy ovens. Abeg how town be today ? Both apps just red soji everywhere but to drive no dey hungry me. I no wan come out now begin pack mushin children from one Shoprite to another.
|
Speedoo221:They say na slowmor mod dey
|
How can u remove Cavani and bring in Van da beek
|
prinsam30:
|
prinsam30:Na Baba go slow ?
|
Make somebody updat scores for here naah. He come be like say dem disallowed Man U goal ? |
Stanleyucee:Where u see d 1-1 ?
|
Felicity001:Na waoo I no fit, you know more expensive item have been forgotten in my car and I returned, I could have denied it because d lady wasn’t sure, she just called to ask if it dropped or I should look around d car. When I saw it, I could have said no not my car. But my conscience no go gree me. I want legit and pure money, if not I for no dey do Uber join hustle. Yboys wey no go school or graduate dey chup money steady. Na to join dem easily but I no fit. |
Deigofortune:Lol, I didn’t even check immediately and she wasn’t sure if they will reverse it or not. I got one alert while driving home. Woke up next morning to see 2nd alert and her chat plus account numbers. She said pls I got debited thrice, incase you get d money 3times kindly transfer back to me. I replied dt I got two alerts not 3 ooh. We were cool and chatting, only dt I couldn’t do transfer immediately. When I saw it online I told her too. How will she post it online? That she was high and mistakenly transfer money three times, that people should beg me to return it or What ? After I transferred self we chatted for like two days, na me quick stop before I turn to Pope & tojahh. Na money I dey find not oven to light
|
peeps4u:Lol, I paid her back immediately. Trip end 1500 She Did first transfer, na she use her mouth tell me not successful. She did 2nd time and said successful and she didn’t go out of the car; saying she wants me to get alert, I told her not to worry dt I will call her if I don’t get alert. It was late and I was trying to get home before 12, but did girl just relax dey sluggish for car. I didn’t get alert and wasn’t interested at dt time. Early morning she don text her account no. dt she got debited 3times and I checked found out it was twice. But later realized from account balance dt it entered 3 times. I transferred later in d night when I was free and remembered but from morning till evening na call and chat |
Ghost1994:They will not hear, One person will soon come asking if HP of 3m is good with 30k weekly. Some go to extent of getting loan from micro finance banks to buy car, I don tire to dey talk. Cos you will pay loan back through ur nose in 3yrs . And I can tell u for free dt after driving in Lagos for 3yrs you and your car no fit normal, u go don lean and u car self go don hear am. |
Ghost1994:You said it all, only cooperate or people getting married or occasions will keep u on stand by. But u see olosho geng , na to dey do Snapchat or video in ur car still abuse u for driving slow. You need to see d way some bridal train girls load my booth with bags and shoes from hotel. Dey no send u at all. Expensive/big cars are not so good for the job. I wonder how dem @Pope191 dey do 400k offline |
ncnerio:Next time you don’t rush to take an item back, u negotiate offline things naah. Took 4guys from lakowe to landmark beach (destination trip) cos it was 10:15pm. Definitely dey were runs guys from their talk and dressing ( tattoos and blink blink) Long story short trip ended 5,100. Na so dem begin rush comot, d guy dt ordered was begging dem to see how dey go settle. One of them come meet me for front how manage d fare reach 5k now. (For my mind na me say make una request during surge ?) Asked for my account no. 3 seconds he mentioned my name and showed me transaction successful and was walking away. Me : Bros I never get alert Rider: don’t worry you will get it Rider 2: if u no get call my number Me: (na to cos scene for here or go pick another surge rider going to my destination) Okay I will call u incase I no get alert. R: okay As I dey go I know say I don enter one chance but I can’t stay out there for police to take me chup. D rider I rushed to pick na another story (she was high/drunk or na smoke ) Shaa on my way na him one of d guys called dt he forgot his small phone (work phone ) dt I should bring it back now now and he will give me something. Me: I’m with a rider I can’t turn back R: pls come I will pay u Me: not this night pls ( wey I never see alert, na dis phone I go sell) Next day rider kept calling per seconds Me: bros I’m not working dis week till next week and also I never get my alert oh (Within 2secs alert enter, I shock) Make I no bore u with story I returned d phone after 3days and collected 4K cash. Next time dem no go try scam any driver again. Nonsense. ... Drunk lady transferred money to me 3times. Na next day her eye clear, my phone no rest dt period... both of dem just Dey call. |
donfortune48:Ovens dey like sweet mouth
|
kanuisagoat:Na you dey ginger me, cos ur dashboard makes me look so lazy and spoilt. No be men dey hit millions everywhere ![]() 300k is achievable but not sustainable, if not u no go drop keys for December. |
Gentlelife50:I’ve never begged for ratings , I don’t even have to look at my ratings 4.87/4.89 I no know d kind witch wey I meet dis few days, dem no try at all. I won’t beg at all Na to buy chocolate / gum inside car Buy mask too and avoid jazebel looking olosho Na drivers wey go allow olosho knowvsay their ratings count |
Felicity001:This na d real net of all bets; though some people no dey eat while working. Is it that partners don’t want you to make your own money ? With dis ur post some people mouth go don dey water not knowing how u make ur profit.[b][/b] D way u don change partners, you be real veteran for this hustle. Plenty riders Plenty partners Plenty enemies Plenty ovens |
[quote author=deedee44 post=100411462]As for me, I use 3 terms to define my earnings 1. Gross income - Total money made 2. Net income - Total money minus app commissions 3. Profit - Total money minus commission and fuel[ /quote] Number 3 is d true reflection of your earnings and that’s what I term net. Those days I to say I must net 15k on dashboard, I will burn nothing less than 7k/5k fuel. So d 15k net I see on dashboard is no where close to my pocket. Thank God I wise up |
Pearl1910:No wonder, now I get ur point. If it’s dashboard net then all of us na rich men be dat. That’s why people are rushing into d hustle, even govt wants there share of it. |
Some riders don’t understand ratings at all. My last rating was 4.72star on Saturday. Started driving by 6pm today, unfortunately or fortunately two surge trips enter and all trips were back to back, so I remembered my ratings and was asking all of them not to forget to rate me. I couldn’t check my ratings during pickup or drop off cos it was back to back. So I dropped dis young guy (teenager) and told him to rate me. And he said okay picked is phone before I could say jack. D guy don drop 1star and thought he was doing me well. My eye don red, And speechless. So I knew I was in soup. I picked dis tall fresh yellow girl and I started sweet talking her from start, cos end result na 5star. She was just laughing and gisting. Na so I end trip oya rate me now. R: sure I will rate you when I get inside Me: no do it now u might forget R: no I won’t. okay, but see ur app has hanged. not showing self, will do it later. ( na so bolt app hang, me just dey stammer) Me: praying app loads ... As ratings just show, na so dis pretty lady (but no brain), carry hand tap 1 star. Me : nooooo noooo no now R: why (looking for comment to add) Me: noooo ahhh R: (started laughing) why are you shouting now Me: 5 star is all d star must be 5 and green R: ohh so sorry (she now gave 5star) She continued laughing. Guess my rating now = 4.65* I just close dey go house, before dem send me to 4.4star geng |
FantasticJ:I was going to say dis, both I say make I no too talk. Even London used iPhone 8 price done drop |
Felicity001:
|
kanuisagoat: net no be wetin u take home or net na wetin u see on your dashboard after app deduction?Pls house what’s the definition of net with 5k fuel ? 1. Is it App Net (Net showing on Dashboard after App deduction ) or 2. Money in your pocket (after you minus fuel money from dashboard net ) Like I ve been saying what I see on dashboard is never in my account. It’s better for me to know how much I’m taking home as profit, rather than dashboard
|
chucsmoore:Thank you sir, I’m sure that with 5k fuel I will take minimum of 15k home. But all this hyping of figures dey always trip me, and it’s this figures people see and rush into the hustle. I already felt there is something wrong with my car o |
Pearl1910:My weekend is fri - sat, I don’t drive on sundays How many hours do you drive same as Nnamdi Kanuisagoat ? I will confirm next weekend maybe I’m down playing the car fuel consumption. Though Once I net 15k I’m off for the day. Net: is deducting 5k from net earnings on dashboard after app deduction. What should I check in my car biko ? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 101 102 103 104 105 106 107 108 109 (of 135 pages)

) it’s pretty urgent ( I think my car lower arm has gone bad ).
How 
