Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 81 pages)
Mr puppy, this watch way this mr fear fear wear so na fake abi na original.... Tell us ooooo! |
Na the love of money dey make some people dey do anything to make money...you chose the Kind of life you want to live,there is no excuse about it. |
I wonder wetin dey make harrysong dey look old everyday.... Hmmmmmm!!! The 3 men have one thing in common.... THICK SKIN!!!! |
Why dem come dey far from each other for pic, dem for hug well well ooooo..... |
He be like say jzeee, don nack that Kim before ... |
As fear comot for your body,you come start to dey give women belle anyhow. Yeye dey smell. |
This woman really try for her late daughter,, sickle cell sickness no be am at all.... R.I.P. to the dead.... Mama, take heart, your late daughter will not be happy if you continue grieving....Hmmmmmmm!!! |
Wetin Ani first daughter dey chop way she dey grow like this ... 2baba no like as he born scatter for many places, he show for him face..I hope say Ani go follow am go abroad for graduation of his children way dey their too... This pastor try no be small...., Na correct man of God he be.... Hmmmmmmm!!!! |
Why she wear show breast go small pikin dem graduation... Well, she get good heart sha . |
All the things way this guy dey take pose na someone else achievement. You fit buy those things dey pose, wetin make people way get those things way you dey take pose come do... Cool down man.. |
This girl small body dey deceive am, she no wan marry, for her mind she is still young... Ok oooooo!!!!! |
. |
Dem suppose give Omotola husband award of THE MOST UNDERSTANDING HUSBAND IN THE WORLD... The sex scene dey bad!!!!! .... Hmmmmmm!!!! |
The pastor way marry this sumbo na really good pastor he be. He go dey see 2baba face everytime he looks at his step sons, only that one self fit spoil person heart.... More power to his elbow, na really good pastor. Hmmmmmm!!!! |
Na her papa blood full her body, na so her papa dey give women belle up and down, dey change women anyhow, dey born pikins with different women. The mama self na street woman.... The girl just take rich guys dey survive, na Rob pass him boundary go meet am. |
Why she come go model for dirty place for Ghana... The dirty place spoil the beautiful pictures. |
See her head like olomo rock way she carry give her son. Yeye dey smell. |
The mama let am get access to the boy anytime, that is good .... Wetin this man do this boy mama way make am leave am go serious ooooo,i like as the woman no talk wetin cause separation like some parrots them. |
That her ex husband really help am , because na that bleaching way she say she bleach because of the ex husband upgrade am... I pardon her bleaching because her before before picture no be am at all. |
This girl way dey always cut her belle comot her baby make she for no born with her toto, make her olosho work for continue ... Na Rob pass him boundary. She go soon tell the world how took pick Rob John Thomas dey if rob continue to dey beef am... |
She stopped breathing. Na so she take die. R.I.P. to the dead. |
Omotola husband too dey understanding, I comot cap for the man... If una see Omotola new movie ehhh, una go no say the husband na very understanding man way make their marriage never spoil. |
Na him girlfriend hair net he wear go thief abi wetin...Haahahhaahah . |
Rob don sell this girl market the more,for him mind he think say him dey do am bad... Yeye fat rob. |
Controversy pikins dey resemble their papa ehhhhh... Hmmmmm!! |
This silicon breast go fit endure serious sucking like this... Person fit see say na fake from far.Yeye. |
Make she continue to dey be your own personal Angelina ooooo, I no wan hear one thing one thing... Hmmmmm!!!! |
Na advert she dey do as her husband don die abi wetin... I no even see any flesh self.. |
Wetin bring all these talk talk from this Orobo man,person way him dey talk about no send am self.Yeye dey smell. |
Madam, na your slay pregnant body we dey wait for because this lanky self of yours don dey common. |
Na beating been no let her beauty come out finish before ... Beautiful woman. |
Some men no fit cook Indomie chop self, dem even come social nextwork come dey talk am .... Some men don turn their wives to their slaves .Yeye . |