Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 81 pages)
See slim fine boy ..: the other one just dey chop dey fat anyhow. |
Money na honey, human beings na flies, flies dey always follow honey. |
This woman fine ooooo, I wonder why that man been dey beat am, how person go think say na only am go dey nack this kind woman... She fine pass her teenage daughter. |
Na when person get good health he go dey do shakara true true... Baba God thank you ooooo.... Get well soon sister Halima. |
Mr man dem say dem don hold you tight, you don enter trouble ooooooo. Na inside burger you chop wetin hold you tight abi na inside vegetable soup?... Hmmmmmmmm!!!! You don enter am!!! |
Their foreheads , na plasma TV. Shining!!!! |
Wehdone girl, na person way no get money dem dey do shakara for... Fat guy for that matter, him thing go don enter inside, small finish.... He no no say you just wan show him sisters say you fit get their brother na him make you born for am. Yeye show off family. |
"when i get better thing,i dey hold am tight,i no dey use am play lie lie" she don take style tell us say person way been Marry the man way she collect dey use the man play... She don hold am tight, na with juju, abi wetin? I fear you Stella ... Continue, you hear, people dey watch. |
Ani this your laugh way no reach belle don dey too much oooooooo!! |
This guy no mad oooo, him no wetin him dey yan, 2baba thief him song true true., but the evidence to take charge 2baba go hard, na him make 2baba no wan gree say na this guy get that song.... Africans no dey acknowledge person way write song for them unlike oyinbo people dem. |
Who she follow go there,this kind people dey fear to shine Congo for Nija now. Na hide hide things dem dey now. |
They are not at all, all they are after is MONEY.. How person go open mouth call another person Mosquito... Hmmmmmmm!!! |
Papa get swag pass son, son just stand anyhow...the resemblance dey sha!!! |
She don tell them wetin father of all nation like, more baby mama loading.... Weldone ma. |
FIRST PICTURE Pikin: papa and mama make una leave me ooooo,i no understand una oooooo, una don separate abi una still dey? What is the koko? |
Na showkey you jab, a whole showkey, na him you call mosquitoes,children of these days self,,dem fit do anything because of money.... Showkey baba, forgive am, Ejooooo!!!!!! |
People go just open mouth dey talk anyhow, come dey say dem sorry at last.... Showkey baba, no mind am!!! |
Empress niece welcome to the world, your stay shall be glorious. Congratulations to the family . |
This girl too fine, i no blame am if she face her book, so that she go take that one shine..... Hmmmmmm!!!! Congratulations ooooooo... |
Don't mind them hushpupi, won fe mo idi abajo. |
Why did those that gave him a befitting burial let him roam the streets without caring for him... Medicine after death na him people dey always do. |
My friend,relax, cool down with one woman ooooo, see as your children no dey one place now.... Relax ooooo!!!! |
Something way she for relax do with church, na him she go dey do for movie... Church too fall hand, he no even show sign of getting her back at all, and he no say women like shakara and begging.. |
Mr man,go marry the one way you rich pass,GO AND MARRY, Adein?? |
This man see Ikebe forget him first wife and children... Ikebe get power oooooo.... Wetin be that man name way been sing Ikebe song self, the man really think before he sing that song... |
After raggea, no be blues?after wedding no be belle suppose follow am, which one be lekpa belle way she dey show ... |
Who talk say dem find dem, their mama still dey Look for them ooooo...find dem for where!!!! |
Dem been say she get belle, way the belle? Madam, do born boy or boys way go fight for your daughters,because war dey for polygamous house if you no no..... Hmmmmmmm!!! |
Must they always bring up the professional role she played with zack.... Na wa oooooo....na true you talk jare my sister.....Church matter don dey turn Hmmmmmmmm!!!!!! |
Na this yeye hair be $87 dollars... If mama sikira way dey do my hair for mushin see this one now,i don enter gbege be that... Hmmmmm!! |
Davido is becoming bald.. He fit be too much money cause am. |
what if na man dem catch, hope say na the same thing dem go do am... The granddaughter has brought shame not upon her grandma but to the entire family... Think before you act is the lesson to learn. |