Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 (of 81 pages)
So na this man make this girl forget her country... You try my man. |
This one don do fashion forget say she need to born another pikin for her husband. This fashion way dem carry you enter no dey let person born or even chop better food self, na leave leave you go dey chop like goat. |
Hahahahahaha... Nothing way women no go use do their fashion, toothbrush follow too... Hmmmmm!!!! |
I sure say na that church way people dey touch their forehead, touch their chest, come touch their shoulders too... Very boring place, but doesn't justify the act of reading newspaper or taking picture during service. |
This Desmond too fine sha!!! |
She don finally get wetin she dey find. Yeye dey smell. |
Uche is proud of her husband, no be that Nadia Buhari way dey hide her husband abi na her baby daddy, she even hide her children face join am.. Yeye. |
Toto no be bad girl as people dey talk, she just get small bad temper when person do am nonsense . |
Those way their papa dey do yeye dey provide for them, go appreciate their papa, if dem hear wetin Evans do take provide for him own family.... Evans is a disgrace to fatherhood. Making people cry, and thinking that he will get always with it. |
That real thing way you dey do way dey make you spend money like this go soon show .. |
Some so called fathers go just leave their fatherly responsibilities to the woman alone... Yeye fathers. |
Make women way no say dem marry hot tempered men and men way no send them keep their mouth quiet ooooooo, make dem no go talk wetin go make them punching bag for their boxer husband them. |
She for no run, she for wait make you kill am with beating.. Yeye dey smell. You took her quietness for mumu, abi. |
My friend, you better consider your children before tagging their mother whatever... Talking too much no good oooooo.. Person don leave you waka, you still dey talk for justification ... Is it not disgraceful enough that you could not keep your family together ? |
This church needs to visit a church for deliverance from unstable marriage.. I suggest scoan .... TB Joshua go help you, you hear.... |
Madam, make sure say all this show body way you dey show finally get you husband to marry ooooo, so that you go leave people husband, and people matter way you dey carry for head like brazillian hair. |
Nothing concern this man with gym way people dey go at all... He just dey let himself go just like that. |
All wetin she dey talk paint toto black .. Madam, na like this una go take settle the matter? Make una leave toto ooooo, sha na because her mama no dey abi wetin? Na only una get mama way dem dey abuse. |
The father is not putting any effort to be with the boy..he just dey write grammar for social network. Na the secrete way he hide from toto pain toto. Why him no tell am say him get children before he marry am. |
Wetin bring this kind talk now, na abortion matter dem ask you... Na you give am money to abort the baby, because this your regret get as he be oooooo.... |
Looks like by force marriage . |
He be like say na D'banj head dem put for the body, which day he fat like this? Hmmmmmm!!!! |
I thank God my parents profession was not a disgrace... Kudos to my parent. |
Hahahahaha.... Nothing way person no go see.. |
Why dem dey overrate this headmaster nah. |
This boy way Femi born yesterday don grow like this ... Hmmmmm!!! |
Nothing way people no go use make money .na wa ooooo....Hmmmmmm.... |
I wonder why toto no marry from the east,men from the east always go with their family to their wives family to settle querrel if any arises, before it gets to messy level. |
I will say church is very nonchalant , what strong move did he make to see his son this Father's Day? I don't blame him, na because he get children for plenty place as dem talk... Toto na really actor.... I laugh ehhhhh...... |
Of what use is all your deeds now, Evans? What will it profit a man to gain the world and lose his dignity,respect, and heaven at last?.... Hmmmmmm!!!!!! |
Make una no blame am ooooo, where she from dem dey born for 12years, and baby daddy no be big deal for there, no be Africa way dem go say you must marry before you born, way make girls dey do plenty abortion to cover up. |