ClassCaptain's Posts
Nairaland Forum › ClassCaptain's Profile › ClassCaptain's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 85 86 87 88 89 90 91 92 93 (of 100 pages)
Episode 37 I was almost through with d cleaning when my phone ring. ..Na Mrs Akorowem day call. Na one of the Rich mamas wey i bin tear one tym be that..She be business woman and na even part of d money way she give me i use take rent d house i day live now sef. Tho she seldoms come to town,na Sexchat we day usually do most times and na her mone wey she day send i day everly use maintain body for school. She tell me say she be done text me ,i reply say i no see am... Well ,she tell me say she was in town as usual for business and needed some " COMPANIONSHIP. Choi.. this woman day always spoil me silly anytime she come and at d same time a mad woman on bed.Wetin all dese small girls no fit do for sex.she go do am " Ma,u know its not a easy thing am doing ... " Yes boo . I know naa...See this time..the Business I came for went well.. with enough profit " But ma " haha pls dont call me ma..we ve bin over this now.. " Ok..Mrs Akorowem " ( sighs ) " See am sorry..i have " No no ..Dont say dat now.. Am already in d mood now.. " But ma . Am kinda " Haa.pls dont give me a No pls...Am full already and no one here in this town. rocks my engine like u do.. " ma ,try and understand ..its not that " Ok..u want an increase abi....i will pay You 150 thousand cash ,if u come today.... |
Episode 36 I con start d cleaning proper.Comot bed.comot carpet ,dust everywhere. comot cow webs, comot all dirty dirty tins and everything.. Clean d whole house proper.. The kind sweeping and cleaning wey i never clean since i packed in 3 years ago,na hin i give the room dat day. I sharply wash d two Cottons ,hang am for outside.. As per say my bed don tear tear and d thing don soft. as usual i borrow foam from MrCork ,put am under for more thickness.. Con spray perfume for d bed sheet put am for there.. Ehnn i think all is set now. All dese while i never see a single thing put for mouth. Everything don set..I don pack Spartacus.game of thrones and all dis erotic movies full lapi incase she wan watch film..dat one go ginger her up. |
The tori day end today.Less than 9 episodes left |
Episode 35 The guy come back and hin give me d Gen..i no pay am anything at all..i prayed for d guy....Tho d Gen don old gan and oil just day gooze from the body.i carry am like that from pastor djeezy syd reach my side.. The distance reach 3 kilometers.. i day drop am day rest for road.Day drop am day rest for road. People just day look me for road.me sef dey look dem. " My guy ,ur gen spoil" na wetin guys dey ask me be that " yes" i no get strength to day talk long tori again..By d time wey i don almost reach House, i don be like mechanic as na all my cloth don dirty but me i no send,ichinbong na hin be my inspiration. Next thing as i reach house,i buy card call Emusmith make hin con repair d spoilt fan and Wristbangle to con repair d toilet, way no day gree flush well. I no fit day kpansh inside heat ooo.. " Oga we no fit repair am today,na inner wiring spoil" Haa..no be today dat one go happen.i paid his transport fare from there go there market and come back.wetin dem day sell for 1k d guy call am 2500 for me.As i no fit go buy am myself,i give emusmith. The toilet guy no give me probelm,he just come do hin own work comot as we gather dey make jest...He knew i was quite happy....Fan fix .Toilet fixed .everything getting in shape.. I think am ready to receive ichinbong |
Episode 34 i carry the banner wey i buy. Plaster am for wall in a position wey be say na d first thing wey she go see be that..Hehehe half naked women in bikini.that will send her d signal say look " You are here for business". But wait,Gen nko. .in case light no day i go TechsNg house. dem say he don go school.lock hin gen inside room.Oh wetin be this one naw. I sharply go one of the holy holy guys wey day hood, djeezy. ...The guy na very cool guy,he no day smoke.drink or fornicate and na pastor hin be. I sharpaly formulate one lie give am and he agree give d The Gen with d Assurance that i return d thing d next day. While the guy day go sort out d Gen for me.i see say na pastor Chris oyakilome day preach for hin phone and d topic na " Sexual prosmicuity ". Dont sleep with that girl.. The Bible says in d book of something something something ..that ...The woman lures the man.. ..the kini kan do d man.. Mtcheww..Everything wey d man just day talk be like jargons to me..This message is not meant for me..No be me get am..If God no want make i kpansh inchinbong.he no go allow her change her mind and come my side.. Abeg pastor Chris abi ludacris ni,Swerve go one side abeg.i just use Vex comot d man video comot.Shey dog wey go lost. No go hear hunter whistle. |
Episode 33 As i dey come,i branch Eleniyan15 electrical shop.buy this disco light bulbs wey no day white, wey day usually day club. i buy one red bulb and i buy one blue bulb.. . I no forget also branch Dj abiambo Syd. Na there I buy two collection of blues and romantic Foreign songs.At least person no fit day play Terry G nack apako for insyd dat kind parol naw.. .how body go even move ?? Choi.i no get music player naa ?? How i wan take do am.i sharply rush go Trishguy house go, borrow him sound system.2 k na him d guy request for.. 2k too much naw ?? " Take it or leave it ?? He said.. No be today i sabi say d bastard stingy with money. Shebi na just 2k...Na 40k i go win if i tear dis girl oo.I pay d guy carry d speaker go ?? " he no day spoil oo,na my papa hand i inherit am oo " " Your father yansh, if he spoil shey i no pay u... .. |
Episode 32 After i reach house, i go Mama Peter Store, buy Viagra and two bottles of alomo..con use one leg branch iya shakira alagbo ,na there i con buy 200 naira worth aleto,opa eyin.jedi jedi and Ato pa. After i buy all this.i go Abigurl and Prettyjo pharmaceutical store and supermarket , go buy condom..Make she no day dey reason me cheap or local ,i buy Original Durex condom..... He be like set everything don day set small small... What of the rice wey she wan chop ?? I hustle go market back ..Be like say I get rice for house,I just go buy fish.small meat.tomato.Maggi. ponmo and the rest wey i go use sama d girl better jollof rice. i just day sweat day pespire as i bin day jump from one okada to another. ... Na dere i meet one of my old padis,Edgyslim. . We greet. talk small and he talk say make he con sabi my house ,say he get one big business way he wan involve me. ..Today ?? oloshi..He no con fix better time,na,around 6 and 7 the bastard go fix again. Destiny destroyer, by d time wey my guy go talk say make he carry wetin hin buy and comot phone collect my number,i don tear comot. |
Episode 31 I shaved all the hair wey dey my body comot ,both upper and lower region, ..Anything fit shele anytime, wey she go feel like licking the Stick sweet . She fit go vex comot if na Mangroove Forest she go meet for there,i make sure say everything,clear like Sahara desert... Na Reflex action . Time no day today ..i get plenty things i must get sharpaly .as soon as possible.. I sharply go bank atm...i go withdraw the last 7 thousand 500 naira wey remain for d account.. One guy wey day beg for transport fare go hin village,though nobody give am any money.i comot 500 wey day top.give d guy. From there,i comot go market. The First thing wey i bin buy na flowers..I buy flowers.. I buy this poster abi na banner wey dem day put for wall for inside house .I specifically make sure say na d one wey dem day kiss and romance and half naked ladies in bikinis day na hin i buy.i buy 3 of that one. I buy air freshner and better perfume,i buy hanger to arrange all my clothes wey i be no arrange and i buy Foot mat wey i go put for door as i bin no get any before.. |
Episode ( Check where we stop naa no vex just go check am )... THE " D " DAY "!" As next day reach like this,na around 5am i don wake up.. i no kukuma see d sleep sleep like that sef .I see say he be like say morning never reach well,make i chill small.i go sleep back. By d time wey 8 go knack,i don wake up. I wan use the Close up tooth paste .I see say he don finish .I use knife cut am into two.use d one wey remain inside brush mouth well.All d inner and all those corner corner teeth na hin i wash well as i no pity d Tongue sef.. I scrape d thing wella make i no con wan day kiss ,make mouth day smell..After i finish The small close up, i con use the other Oral B toothpaste wey i get,use am brush mouth again.. If one toothpaste no work ,d other go work. After i brush finish.i used sponge and Dudu osun to scrub away every impunity and dirty dirty wey day for my body. Na almost 1 hour spend for bathroom..Any place wey i fit Scrub na hin i scrub..As i day scrub,dey baff ,na hin i day sing Reminisce Tesojue laleyi.,wafe Ku laleyi Infact na d kind baff wey person wey day baff am go sabi say d baff wey hin day baff pass oda baff wey hin don dey baff before . |
swedge218:lol I swear DAT girl case tire guys. |
lantessy:Oga ...This your White man language too powerful.. Are u related to obiagbon ?? |
tjfulloption:make I give u spoiler..I knack d babe gan...Lol. Tomorrow na my boss |
Richie0974:lol .2morow |
The Story ends Tomorrow ..D story finish pata pata tomorrow |
Episode 29 She ask me if any girl don embarass me like the way she embarass me before .i talk no .. She narrate how joke134 take spoil me for her face.. Me sef narrate how useless d babe day and we laughed over it. she ask about my Gf which i tactically evade ( i for talk wetin i tell am but Some guys go day use am cruise babe about.i no go drop am..Oobi ) . We kept on talking and talking..she no even give space before she day reply my message.i send now. 2 seconds she don reply. ..I described my address to her and she told me she wants me to cook rice down for her oo and buy her shawarma. Shawarma ??. Ichinbong. sharwama ?? Haa. Sharwama no go fit do u oo.Why u want shawarma,when i get better banana for here.. By 11 30 pm,i had to end d chat and wish her a good night rest..And she replied with Kiss and love smileys .Choi. This girl never sabi anything.She never sabi wetin go befall her... Kiss and love...Green light toh bad ...I slept heartily with Synord Otubante playing in d background and my manhood kept nodding with REFLEX ACTION in preparation for tomorrow 's LA liga match versus ichinbong. Throughout that night i no balance, i just day change boxers anyhow.. I no fit wait make tomorrow come. I get some many things i must to put in place before the babe come to ensure an unforgettable experience with Inchinbong babe I just Cant wait for Tomorrow to CUM.I just cant wait.Tomorrow,the day inchinbong finally visits me. Make tomorrow do sharpaly abeg. To be Continued |
Episode 28 Through out d class that day,i was just cracking jokes and i was so full of energy.. I heard people saying " wetin do this guy today".The energy was just in me. I bought things for people. i pay People's T fare, i was just feeling Fly. Super excited...That kind feeling wey merlin get wen he first kissed Freya , na hin i get dat day. I bin feel say make i go thank pastor Seun for hin contribution to the matter but i just later free d idea.No be man power jare,na Lord prayer. Na God do am,no man deserves credit for this miracle. I got home happy and vibrant..I chatted ichinbong up till midnight..The Bitch ass girl was actually cool and friendly.. Tho i make sure say i no talk anything wey near sex chat at all but dis girl actually got some naughty things up her sleeve. |
Episode 27 I really could not understand what was really happening All i sha knew was that Ichinbong was coming to visit me and my hopes of Tearing d babe and winning the 40k just gained weight. By the time wey i reach school unfortunately i no see d babe contact.. My guys wey we gather bet don day use me day laugh,day crack jokes ...Kingsley sef dey tell me say how far with their money,sey i don ready am. Hehe see Idiots..I just day look dem i just day smile..They no understand why i dey smile Choi..I just day pity their silly girlfriends wey day expect outing for saturday..Make this guys better day prepare for break up from their babes...Hehehe |
Abigurl:na Yoruba proverb , |
Episode 26 " Sincerely i just dont know what came over me.But my pastor called me and brought me to order and i realised my mistakes. Pastor Pastor nke..Your pastor ?? I asked very surprised " yes ..pastor Seun.He called me and told me what i did was bad and adviced me to reach out to you. ..Will u be at home tomorrow ?? Did i just hear " Will u be around tomorrow " ?? " What " i asked as if i didn't hear what she said d First time. " I said will u be around tomorrow. preferably around 6 30 pm .7pm time ?? Haa.6 30pm .7pm ...who born me make i turn down wetin i don day have sleepless nights for..This is all av been striving for. offered to me on a platter of Gold.. " Ok" " aww ,thanks dear"" . Will u whatapp me tonight so we can talk more dear " Na me ichinbong just day call dear dear so ?? Choi. My own don better" " ok " i replied " till then dear,once more am sorry " " No problem.. and i ended the call. Everything dat just happened was still like a Dream..What could be d reason for this sudden change in Ichinbong..Maybe she just sat down and thought of her mistakes.. or maybe one of her friends talked to her.. No ..not a Friend..She said her pastor spoke to her and asked her to forgive me..Haha..What is not D Same pastor that disgraced me out of his office ?? pastor seun ?? Could he possibly have called Ichinbong to apologize to me after giving me such a bad treatment. ?? me I no undestand oo . Everything just seem to be falling into place without stress .. .Little did i know that i was counting down to my doomsday... shebi ignorant me no sabi say The thing wey day back of six, pass seven . |
Episode 25 After like 1hr pass and some minutes, the message finally delivered and almost immediately it delivered. i saw my phone ring .It was inchinbong 40k bet calling.. Make he go be say na dat her friend or her younger sister dem.i go finish deir Life with abuse ,con cut am.Wu get tym for rubbish ?? Lo and behold ,it was Ichinbong. I instantly recognised her sweet ,baby like and soul soothing voice. It was like ecstasy.. A feeling i never felt before.. " Hello boo " My mouth bin day shake...I no even sabi wetin i go take reply am..Any little mistake or Bleep up now,fit end chances pata pata. " Hello" " yes " So u didn't want to answer me abi " she said jokingly " No no..its not dat... ' Ok " " yea " An awful silence enveloped d atmosphere for like 3 seconds "I just called to apologise to u..I know i did wrong by all those treatment i melted to you.. It was not like i hated u but i just dont know what came over me during that period." .I was dumbfounded. was dis Inchinbong really speaking /? Abi she dialled wrong number ni ?? |
Episode 24 "".. Hi " I rubbed my eyes very well..Maybe na d effect of Yesterday origin still day shark me for body ...I " Ichinbong messaged me " Hi."Haha .i day dream ....I go inside, carry knife use am tear my body small .no be dream oo.. Abi na previous chat.wey just day deliver .. ..I saved her number with " ichinbong 40k bet "..it was clearly Her. What could be the reason for this sudden change in her attitude .Abi na another Person she wan message wey d thing go mistakenly enter my phone ??.Make he no be like say i too rush answer the babe make she no con day feel like say i miss am.i intentionally delay like 30 mins before i reply. ..To form boss small . I just reply am back in form of a question "" Yes . The message no quick deliver ?? 15 mins go.30 mins .1 hour pass.This girl must be mad.Abi na dat her 2nd friend carry her phone take day message me.!!.Which kind rubbish be this. ..Shey dis girl wan day taunt me ni ?? |
evegran:Lol.Seriously the temptation to engage u is overwhelming but e be like Say your Problem na from the Gods. .... .. Visiting my my profile picture after my post na Reflex Action..Lmao. Why u no use DAT reflex action stop for Episode 1 .comot the thread .. " Dem no go use reflex action pass book,find husband na profile pics of person way dem no know dem go use reflex action Look... |
sirxbit:lol |
mtn 100 naira card !!! |
nobosaba:on point . |
Boyooosa:lol. What am saying is that once they bet the money, it automatically means to my own available knowledge.that if I fail to fulfill d terms why day made d bet,I will of course have to pay naw.Anyways thanks |
Boyooosa:choi...I actually said bet !!! check again sir |
Episode 23 ( The Beginning of the End ) The call from one of d guys wey we bet, Profojah. Con further discourage me sef..The guy just be day use me laugh say i be fool. He kept telling me he knew i could never get d babe to visit me not to talk of tear am. Say people wey strong pass me ,even lecturers don try am,d babe no gree " Choi ..guy u better day use style gather 40k down before Saturday come oo.Shebi we tell u u no hear.. Better start selling your clothes small small or call your mama for house.. Guys go obtain u if u no get dat money cos kingsley1000 and richommie don plan say na d money dem go use carry their babe go outing this saturday oo. He admonished seriously to start sourcing for d money..and sincerely i knew i had to start doing that..Friends matter no reach this one cos When i suppose free dem dat time too.i chop d bet money without remembering Friendship . Well.This has taught me that it is not everything a man will always get. F or d first time in a long while, i knelt down and prayed to God.. i just told him to take control. That was one of my deepest and most sincere prayer i ever prayed in my life. Really i felt I needed God more than anything now especially after what the Pastor said to me yesterday. Tomorrow i go see if i fit wyne ma parents send me some money and whine some of my other babes dem. Collect money take pay my debt.. I drank the 6th bottle of origin,cooked some indomie and egg and watched the only Christian film on my system ' Gods not dead as i slept off So u can imagine my surprise,when Ichinbong messaged on whatsapp the next day ". " HI".. |
Episode 22 ( Not a Laughing matter ) I called two of the most matured girls wey i don tear and ask dem wetin dem think say be my weak point and how i fit see any girl no matter how stubborn get.. Both of them surprise for my question but all d advice way dem give me na hin i don try on top ichinbong..haha Dat same day,i called one of my big Bros .Tosyne2much wey be like my mentor for all dis woman matter and package ,na still same same he give me again. Same,old method wey i don try.. I was so tired and frustrated ..I went to Mama Peter store,bought 5 canned origins and one don simon. maybe if i drink am.. wey i con high small ,something go pop up... .I drink am reach 3rd origin bottle.Nothing came up oo..No idea whatsover.. Everything for Charles nneji. All dese "10 things to toast a lady.. how to be a gentlrman.. Shior , Na all of dem i don try for this babe. E no work Shebi na even babe wey give u listening ear all dat one go work for..Ichinbong no even wan see me around her not to talk of See chance speak to am sef. |
Episode 21 By the 5th day, I started reading up..I waka go buy MTN 50 naira card repay my former debt. con borrow MTN 100 naira join.use am buy 10 mb. I was indoors all through as i had cancelled all form of visits from anyone that day.Not even Missnora way talk say she day come visit me fit make me change my mind..I had to brain storm..I only have two days left. .And i am too sure these guys would not Extend the time wey dem give me..Because me sef don follow two of them bet this kind thing before and i no give them any time extension as i chop their money, clean mouth. So we no need go near weda dem go extend time or not. I was in my room.. Researching " How to meet a girl and make her visit you withnin two days ". Na yeye and unhelpful results Google just day give me. . i login enter nairaland. Day read charlesnneji bang rules .all him posts and topics from A to Z na hin i read.. I even go create topic "How to make a girl visit you at home..The insult wey i get i no fit forget till date..Shey na d yabbing from friedplantain,vizkiz .or all dese ladies i wan talk. Person wey yab my papa.person wey call me fool ..infact i later regret bringing up dat kind topic sef. |
Episode 20 I walked out in Shame from the church and Rather than go to class for lectures ,i went back home.. I have never been more disturbed in my life. Church wey she day go wey we think say we fit use enter d parole, dat one no click. My guy, Methylblack later called me that Two lecturers wey dey take two of our core courses fixed emergency tests that morning and threatened that anybody that was not around would carry over the course..Shior.. i was least bothered about d Tests and the yeye lecturers. after all,one of dem na female lecturer wey i day tear at will...she go help me resolve dat one abeg. Ichinbong was on my mind throughout the night.. I kept rolling up and down looking for ways to make this babe come and get my " Gbolaga". I couldnt sleep peacefully. |
Episode 19 ( prophecy) Amid tears * ( so after all my troubles and travail Sir, i went for serious prayer) .I narrate how on the 7th day of prayer, An angel in a white gown appeared to me.how i fell into a trance and d angel showed me a particular member of d church.. I was in a black blazers and had a ring in my hands. The angel of d lord showed me a member of d church and lo and behold.before God and man .it was. inchinbong,dressed in a flowing white wedding gown. I now look d angel and ask him " Angel of God. angel of God. what shall your son do with the lady before me verily. ..What did d angel say " The pastor finally spoke for d first time since i entered the office.showing his interest...His face was strong and Bold... Sir,he told my she was going to be my wife... He told me we are destined to be together. And i caught d blessing. it was So vivid and clear. Pastor, With a great deal of faith.i approached her to Tell her this but she didnt even give me chance to explain instead she slapped me ...... Is it only slap she slapped u ?? The man of God asked " haa she insulted me too and warned me never to approach her again. " She should have done worst... Haha " yes Mr boo .do u really think u can fool the lord's annointed. i shock small ,but still managed to pull an answer "No sir..i dare not lie.. It was shown crystal clear..What God has joined together... " Get out of my office " Sir ... " i said Get out..Why you are really ready to turn new being..Come back for repentance and restitution. " But sir what happened to the revelation of ...Get out now before i open the gates of hell on you.. ..You agent of the devil.. We heard of your acts here and unless you trurly repent of your act .And what ever plan you have for the girl.Nemesis will catch up with u. And indeed as he prophesied, nemesis did catch up with me.. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 85 86 87 88 89 90 91 92 93 (of 100 pages)
i go TechsNg house. dem say he don go school.lock hin gen inside room.
no vex just go check am )
. Well, he try sha for the courage. Next tym dont use 4 months to submit ur Ministerial list, u ll end up submitting Amaechi, Audu & co. 