ClassCaptain's Posts
Nairaland Forum › ClassCaptain's Profile › ClassCaptain's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 86 87 88 89 90 91 92 93 94 (of 100 pages)
Episode 18 ( The Prophecy ) Ok calm down sir..am just playing with u .seeing dat u are so moody.We are suppose to be happy in d house of d lord "" hehe hehe .. " He said. I just day look d man.. When he turn Basketmouth or Bovi wey dey crack jokes .. No be your fault. Na wetin carry me come here. You can now see d pastor... in his office.. .. He said as he beckoned o At last...I standa slowly and Walked into the pastor Seun office. . I enter meet book for everywhere, i greet am ..The man no greet me.. He just use hand show me chair.. He was a new pastor..No be d one way day church be this during d sex scandal. . Well done sir ... Yes how may i help u " I am boo " Osin ..yes av heard about u ..Like i said earlier how may i help u.... ..?? Hmmn Sir i have a deep probelm i will like to share with u sir. Na so i start i start my formulated tori . I tell am about my life . How i take dey knack babes and everything and how i day live a sinful life . I narrated amidst tears how i met God and received Christ.. and how i am now a new being in Christ. I jump enter how i still single and how getting a life partner be don day cause me wahala for me all dese days and how Av been praying to God for my own wife. and life partner. The man just day look me.he no say a single word..me sef day look ,hope say dis man day chop my lies sha. |
MrsAnyanwu:Thanks |
Episodes loading |
flaky66:am doing my best ma. |
giftalways:your baby is pretty !!! |
ogalee04:Sorry sir.Expectations are high ...and I had to consider my initial ending.. ..I had to restructure some things..I can't please everybody but I will do my best sir. Am trying as much as I can sir.Thank u |
Tolupage:Putting finishing touches sir..Trying to cut out some things and minimize d bulk and also trying to add some things into it.Thanks for your attention sir |
There something people ain't getting..Am not going to just come and put anything or rubbish just because I want to end d Story or conclude it so that some people can be satisfied and move on. Please like I said earlier, I have 3 alternate endings to this story... Surely I know some people have no idea how tough it is to try manoeuvre the best story to choose.. please. if anyone is bored or sick of d story, pls U can kindly Stop and don't even come back to d thread but if you still want to follow, then a little patience is required for me to edit and try and see d best option possible.. |
evegran:Good day ma.I am more than dissapointed that u can't comprehend that this story is not about the me.It is Fiction and is not about me in anyway. and U called d shoes a second hand ?? yet nobody forced u to go to my profile nd check my picture out..Sincerely,I don't reply things like this but u need to work on yiurself and d way u speak ma.Thank you ma |
Episode 17 People day enter day look me day shook head, me sef look dem back they shook head. " What's that thing on your face",Did u injure yourself " the backo trouser guy ask me.. " Nothing to concern yourself with ," i responded. The backo bag trouser guy dey look me sef day look am. .Look me i look you.Man no go wetin ------------- ( Fill in d gap ). The concontion rice day make stomach sing Tonto dikeh songs since morning .My guys be day call me for lectures ,i no pick infact he reach one stage way i just switch phone off . The hunger wey day gbab me plus d Kind eye people take dey look me reach make i vex comot d Church but no. Am here for a reason. Na on top d chair i be don sleep day dream of how i go take spend my 40k winning when i just waka comot from d sleep enter reality.. Haa 2 hrs don nak..30 minutes join am sef. I look around for the Backo trousers guy i no see am ..Haha..I bin don day fear untill i bin see d Guy day come inside with small small pikin speedy biscuit and purewater,they crack d thing chop.. " U mind "..he said offering the speedy biscuit to me.. Dis one day craze..Na speedy biscuit day do me naw " Pls where is d pastor " he should be through by now " i said as calmly as i could.. " haa brother...sorry ..dont u think u shld come back d next day...I think he will He will be kini?? See i cant come back d next day oo..I must see d man of God today.. Lai lai.. Even the people wey day read this tori wan sabi wetin i wan go do for d man of God syd.. U con say make i come back the next day.. Next day kor. days of d future past ni. oga i no day come back kan kan. |
Episode 16 Brother boo " The guy abi na man wey i meet for church greeted me.I look am from head to toe as he be like Stick man sweet inside hin Oversized shirt and Backo bag trousers.. " Am not a brother pls ".. i responded " But brother.. sorry ..we are one body in... " ( Cuts in ) pls is pastor Seun around... " Pastor Seun ?? " No pastor lalasticlala..is he around jare " i said getting impatient ' Haa hope there is no probelm " he said ..he was Smiling all the time clearly ignorant of his delapitated brown dentition. ' Will u get me d man of God or will u keep me waiting.. Isthat what d book of the lord taught u ?? No sorry sir.i will get him now....He said..He beckoned to one sister in the blue shirt and red Skirt uniform and asked her to check the pastor in his office... Omo dat sister get yansh no be small ..on top all d wahala wey carry me come.i couldnt help but check out dat sister basia as she walk enter pastor office.. " Haa brother boo ..i have a message " Oga pls i dont want any message... Haa ok..The sister soon came back and gave a report that d pastor bin day pray for inside room and say he fit take like 2 hrs because na Special Week prayer he day pray today .Haa which kind thing be this. 2 hours ?? Him day pray for the whole school ?? Wich kind level be this naw... Ehn today na today .I go wait.. |
Episode 15 As i dey waka go the syd. Na different things day come my mind..me me?? .Angel..Na me con turn person wey day waka about .day struggle on top one babe ?? OK.. no probelm. If no be something way make crayfish bend .Me to dat kind ichinbong . God sabi when last i don step my leg for inside dis church.The last time wey i con scout for babes. Na d first female usher i meet for door discourage. ..How usher go wear blue top on top red skirt join am with yellow socks con finish any form of Attractiveness she suppose get with her pink beret ?? Later dem go full vigil say dem no see husband .. "" How u go see husband when your dressing be like person wey no sabi house to support for interhouse sports .... Yeye dey smell The person i meet for church nearly tear race comot on sighting me.. Me i just bone face enter. Me i no see d guy blame because i don sabi d atrocities wey i commit .. As i day talk say the babes for d church no fine reach. i still manage tear deir three of their choir members including the much loved holy mary ,choir mistress. Sis blessing Ojai. How d news take spread i no sabi till date ..The matter almost tear d church into two.But dat one na tori for another day. |
Episode 14 ( Going The Spiritual way.. scoping the man of God ) Na the Fourth day be this ooo.My guys don day ask me how far with the package ...dem sabi say he no day take me long like this before parole go click. Rokiatu no take me pass 2 days even almighty Ishilove na d first day we meet i chop am,na only tantalizers meat pie and Cold Fayrouz he cost me .why dis inchinbong own wan con different. Na ??. I sha dey whine dem sey work is in progress ,then show dem our previous chats .dey sef dey nod day await result. Me wey i no get myself..Na different foolish ideas just day come my brain.. Make i try my luck with this one. The next day, I chop the concontion rice wey i cook yesternight...I no finish am as salt too much.. i sharply do rub and shine,Wear my nigerian super eagles Jersey ,jeans and timbaland. Spray my aboki perfume,rub damatol full my hair and set out to ichinbong's fellowship center.. |
Make we sharply drop some episodes before we go out various places of worship.. |
The story* Continues Tomorrow ** .. Thanks ... God bless |
INTROVERT: |
michade:OK Sir ..noted |
Ogadtop:choi.Oga Mi .. Go iron am come back |
hammedonisade:I don't know you Sir. Thank you Sir |
choi see as mosquitoes and alasunbere dey bite me For under this iroko tree as I dey type .day try rearrange ,reedit.reinfuse and reorganize d tori.. Chooi people day read d tori with popcorn,na Cheese balls and mosquitoes I dey read am with. God dey |
Jadonaldson:oga mi I hail Oo.Abi u go wire like 100k come my account so I go see Mb buy upload d stuff. " Lol..Nice one and God bless u |
charlie009:Sorry sir.. I apologise for your probelms but I have finished the Story since last week sef.. I have Three endings to this story and am trying to see d best one to choose .. Thank u sir..Have a happy night rest Sir. |
More episodes Loading. Meanwhile U fit read " The Day MTN taught me d lesson of my life ". ... www.nairaland.com/2638248/day-mtn-taught-me-lesson And How 2go relationship landed me in Psychiatric home www.nairaland.com/2645445/how-2go-relationship-landed-me I take God beg u..if u dey chop pepper ,no read am a beg .. |
lizh:Oga Mi.Use Style Read this one small .. www.nairaland.com/2638248/day-mtn-taught-me-lesson |
ki02020:See as u use Koni koni like Tortoise advertise shoe ..choi |
turnup05:Isnt it a man"s greatest prayer to bring smile to his fellow man"s face ?? God bless u Sir |
Estrada:Say God ![]() |
Sunkyphil:I am a Comedian sir..I do stand up comedy |
Episode 13 Luckily it was only me and her that day.Na wetin just save am be that,if to say another person witness am..No be wetin we day talk we go dey talk now . "". She Left and warned me never ,ever,again in my entire life,approach her and Tell her such dirty thing again. He don finish ,how dare this chick... Abi make i arrange guys go beat her make dem deflate that yansh she day use yanga about ?? Despite all these her behaviour ,it just made me more interested in her.What is it this girl really wants ?? Its the Fourth day already ..I never do parol wey pass a day or 2 days at worst.. Wetin other girls dey see wey d girls no day see for my body ?? Even if i no think of the sex again as i go get that one from my many other chicks,how about the 40k bet wey remain 3 days to expire ?? Something had to be done. .. Na so one silly but workable idea just enter my mind.. Ehn where this kind idea day wey i con day suffer myself. since. .Inchinbong, whether u like am or not ,by fire by force. i must chop u.. |
ryd3:thanks..oga Pm me now lol. |
Episode 12 Slap wey my mama never slap me before ?? The kind slap wey dem dey call destiny reset..The kind slap wey dey make everything for your Front turn double..The kind slap wey your ear go day hear " ooiooooooooiooo". " You slapped me ?? I no sabi wetin make me comot that kind stupid thing for mouth. Person slap me i still day ask am .. ..no oh ..no .No be slap ,na handjob . Yes and if u dont stop harrasing me,i will slap u again..I felt like holding and cutting open her intestines that moment ,then machete her boobs and slice her stomach,roast her yansh and Feed her remainder to the dogs while i severe her head and hang it a stick .. ..Many stupid and silly things just started popping up in my mind..Sincerely,i felt the urge of slapping and harassing her but it took a kind of Grace wey i never see before to restrain myself. This was the First time i was Slapped by a Lady.. Tho Halfrica and Farano had attempted to try it with me before but Dey calm down when dem see say my eyes don red and doing that fit land them for Gbogbi. This inchinbong,na sudden,sharp.accurate, well placed and direct all five fingers slap without any warning. she give me so. |
.. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 86 87 88 89 90 91 92 93 94 (of 100 pages)
dude... I was actually thinking u are damn creative n funny but ur last 3 posts reeks of epic boredom n desperation laced with a failing effort at creating suspense. save urself some credit n wrap ds up.