NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:47pm On Feb 16, 2016 |
|
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:40pm On Feb 16, 2016 |
Cutehector: fraiser I like dat girl so much and I no dey take am play eh.. bros why u see shadow for ground nd u come dey chase am? I no fit just reason u again o as fraih don get husband, because of shammak I return d 10000 tubers of yam I collect from kbs468, u no go vex ni o |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:33pm On Feb 16, 2016 |
IghravweIG: I dey fine o Spixy dearie I don miss u nor be small o. As I Neva no my state of deployment, body nor just dey sweet me jare. My worry b say make dem nor troway me put for the northern states. just dey pray make dem carry u go kaduna, I don already secure 5 slots in NDA for PPA, I get one jagaban for dia d alowee na 30K per month apart from federal nd state government allowee. U no get anytin to fear about broda |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:25pm On Feb 16, 2016 |
Fraih: Fraiser, that was a bunch!!! You're indeed the best Twin  Abeg help me greet Rukkyola when you see her o. tanks alot my dearest, rukkyola dey send her greetings too |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:23pm On Feb 16, 2016 |
eaglevision: Fraiser I dae see ur handwork,I dn decide to lay low this night o,but u sha wan find my trouble,na me u wan use do bouncer ba? Ur case dae supreme court,just sit back,relax ur judgement is coming soon no tell me say u no won do bouncer o, shey u want make dat ur sexy 10packs dey waste? Hin go fit collect broken botu wella nw |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:18pm On Feb 16, 2016 |
jubrealguy: In other words, no carry your phone go kitchen and if nepa take light, anywhere u are......just gan pa for there cos me i no go like hear that tori say "my phone fall inside soup when nepa carry light"
Cc Fraiser abah kitchen ke? Wetin I won go do for dia, abi u don forget say na for iya kudira carteen I dey spend all my salary ontop amala, gbegiri soup nd ogufe meet |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:11pm On Feb 16, 2016 |
Shammak: Na so rukkyola talk the other time wey we no see her clutchlite  My prayer for you be say make den sha no do u as den do rukkyola cos this one wey I dey see no too click... abomination! Nobody fit do me lyk dat, me na elder stateman for dis city, enh enh I even forget make I tell u wetin I see wen I go chek rukkyola for dem village yesterday, I dey chok wen I see say our dear rukky don dey pregnant for one old juju man for dia village o, na wetin dey happen to anywoman wey too lyk juju b dat, I no know hw I go take tell sent4rina now, make my guy no go vex chop rat poison |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:03pm On Feb 16, 2016 |
IghravweIG: Hmm, Fraiser u nor go kill person o. As for ur ministerial appointment. We dey work round the clock. Cc Amodu. Pls what is the next line of action concerning the ministerial nominees? my senator sir, no b say I dey intentionally disturb u about d screening o, na d rumor wey I dey hear say some pple won protest because of d delay make me dey fear o |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 1:59pm On Feb 16, 2016 |
Shammak: You're blessed my son for that testimony... How ur body hope say sent no dey follow u again My inlaw my body don dey kampe, dat annointin palmwine wey u give me drink yesterday really work for my body, I don fit now to answer everybody wey don talk my talk for my back, hw is fraih my dearest twinnie, I hope u ar hearing from one nd only bolagabriella, d way I dey feel dis days if i don remember dat girl, no b here o, I go just dey feel lyk obama. E b lyk say ur annointin oil don expire for my body o, d juju don dey work again |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 8:52pm On Feb 15, 2016*. Modified: 9:09pm On Feb 15, 2016 |
Fraih: Me: Oh come in Dapaiks, I was really expecting you! Thanks Thanks #hugs #turns to Bae, dear this is Dapaiks from the Golden city, today is his birthday and he came to drop in some cake Bae : Wow, Thanks Bruv, happy birthday! You must be new in the city cos I don't really know you. But Thanks all the same. Sure you had a good day. Dapaik : Yea I did. Alright Fraih, we'll see later. Me: Thanks Thanks, Bye. I really appreciate. 
*** I can see the lovebirds in this city enjoyed their Vals day, we dint even get to see their brakelight.  My own pals, how're you now? Eaglevision, Justified10, IghravweIG, Terrymason, prindu, Abbeyunique2, DTOBS, Kbs468, LogoDWhiz.. Babes, SC31 (I dey look you o, be a good girl), JaneJoanJohn, spixytinxy, MissEvey. Everyone in the city, I greet you. Love you guys now and always. Fraiser and Shammak, I love you more 
Twinnie wotsup, I luv u so much too, hope say u neva vex sai I no show face for GC since, i travle go dem rukkyola village go chek am ni o. oya bring ur ear make i tell u somtin *whispering into her ear* na only u i miss for dis city wen i was away bur don let my sweet@ blizzydoDo, my crush spixytinxy, SC31, missevey, missoyin, shubs, mischubby, katrine7 nd all dos my future wifes bolagabriella, janejoanjohn, omolola1, cindy222, splendidmercy nd airstarkane hear dis tin wey i dey tell u. u know women can be very jealous dem no go understand say blood is thicker dan water. How is my inlaw shammak, shey hin dey take care of u wella. hope say nobody dey give pressy logoDwhiz wahala nd kbs468 d info minister. shey u dey hear from my friends sent4rina, justified10, abbeyunique2, DTOBS, crobboy nd oyehomie. Hope say dat guy called cutehector no dey disturb u again, d guy won turn my inlaw by force after d family don giv ur hand in marriage to shammak. Shey u don hear anytin from greatestman, kuchikau, amodu nd ighravweIG about my ministerial screening abi den no won do anytin until my pple start to dey cause wahala again. I hear say amynu, yanabasee, jubrealguy, olaSalo nd terrymason won shuk dem sef ontop one botu of alomo for inside d new paraga joint wey johndanny just open for dis city bur i no bliv am sha. enh eng shey u dey hear about this guys bobolil nd eaglevision i won open new club for dis city may b dem go fit help me do bouncer because e b lyk say dia chest wide welwel. if u help me see prindu, dominion92 nd somebodyMrs tell dem say i dey greet dem o infact God don show am to me for dream say na me b dat somebody. if u no see ur monicker no vex o may b u neva get residence permit for golden city. off I go*in rukkuola's voice* LOVE U ALL |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 5:10pm On Feb 15, 2016 |
Abbeyunique2: Good evening house, pls let's be patience with one another, no question is silly even if they ask us the meaning of lmao or nysc. pls to avoid wahala, if we felt the question being is too silly, let's scrol pass. i believe we are all matured individuals. namecalling, attacking eachother personality, character assasination was not and has never been the part of the basis of establishment of this thread. The why i joined this thread was that i saw a one big happy family of complete strangers comprising of diff ethnic grps, tribes, sch of thought, diff specialty, philosophies, and institution. i want this to remain like this. one love, one nation, one golden city. *special shout to my sweetheart beckytee pressy logodwhiz, kb468, fraih, fraiser, oluwafirefunmi, janejoanjohn, bobolil, amodu, jaylorm, chiefololade and all other monikers i forgot to mention. nb:ignore the typo baba I dey hail u bigtym, hw ur day? |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 5:08pm On Feb 15, 2016 |
bolagabriella: Ose jare...when i get alert i go dey think ur case wait o, did i said I wanted to giv u contract bfor, I no even know wetin I dey do wen I talk am, dat powder wey u use dat day wen I first saw u really worked o, na dchiefpriest do am for u? Na hin no make me know wetin I dey do again, tank God for d deliverance service wey my twin sis fraih carry me go for prophet shammak church o. I for just go giv u contract wey u no fit execute, efcc go come dey pursue me up nd down, Justified10 nd abbeyunique2 make una come make I award d contract giv una o, d juju wey bolagabriella use for me don clear comot my eyes |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 1:14pm On Feb 14, 2016 |
Abbeyunique2: you are welcome to our city sir, hope you find what you are looking for. in case u dey open bottle(ge igo). join me, fraiser and jaylorms at the downtown hotel tonight for some green bottles. Baba no wahala, we go meet for dia, na to drink forget house tonyt |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 1:06pm On Feb 14, 2016 |
bolagabriella: Lol I am not ooo Na Fraiser lurv for me make am one give me job wey i no qualify for,i'm a microbiologist na who tell u say u no qualify, dont worry even if u no fit do am, I go tell abbeyunique2 make hin come help u do am, u go just giv am small change, dis contract is for u |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 10:41pm On Feb 13, 2016 |
justified10: baby, I have been very busy... very stressed... e no easy fa.
************* erhm erhm....I want take dis opportunity appreciate everybody for golden city.I no wan talk much make i ni begin misyarn...
I don meet gud pple for here fa,(if naso una b for real life o), make I take tym mention few pple wey I fit mention.
kbs468 ( fun to b with,& always ready to help, bros I lyk u no b small...no homo o)
logoDwhiz (what I appreciate most about u is ur calmness, u mature die. .I lyk d way u handle issues...u are a born leader)
shammak( no much to say abt dis fake prophet, he is very funny. kontinu)
fraiser (dis one na anoda comedian, no tym wey I c ur name wey I no dey laff)
rukkyola( anoda A class comedian, 3 of una suppose collabo begin do show for tv..)
spinxytinxy ( fun to b with,..for real, dis babe na ma crush even tho I Neva take ma eyes c ha before...)
dominion92( very nice babe, don't ask me ow i found out)
IghravweIG (nice guy, u av just proven to me dat u don't forget ur pple...kontinu)
fraih( Dis babe no dey downgrade, i gbadun her gan)
amodu,(me no fit forget u fa, I b think say u b Hausa man before)
dtobs (dis one sef sabi help pple, bt I no sure. say he sabi tolerate lyk pressy)
katerine7, ma golden city iyawo.
I will love to meet all of u one on one...I really wish to.
***** I am officially moving to d "just created B16 thread"
God bless!!!!! Like seriously dis is the most emotional post I ever read in dis city. I must confess dat my heart is greatly captivated wit dis write up, I sincerely find it difficult to absorb d fact dat a friend and brother lyk u is leaving us for gud in dis city, I pray God will grant ur heart desire nd turn every form of delay nysc or d sku myt have caused u into resounding testimony. I look forward to welcoming u in d city of kaduna in few months tym. As a sign of respect nd loyalty to a very dear frirend lyk u, I will not post nor reply any mention for d rest of d nyt. may d grace of d lord b wit u bro |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 3:49pm On Feb 13, 2016 |
Walexz02: CAtching up with this thread self na war. See how man piking dey sweat.... I tink say na only me e dey hard to keep up o, I don already turn guest self wit d way d thread dey fly |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 3:10pm On Feb 13, 2016 |
Wao I opened a new page, dedicatin dis to all my kaduna peeps |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 3:08pm On Feb 13, 2016 |
Hotman0095 hw far? Hw ur syd nw? Longest tym, where dem post u? |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:55pm On Feb 13, 2016 |
Shammak: Oh..OK
Congrats! yes boss, thanks |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 2:22pm On Feb 13, 2016 |
boboLIL: Some people too like my name... Buh y I de vex be say dem nobi opposite sex...  you mean dis ur monicker? |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 1:59pm On Feb 13, 2016 |
Shammak: Fraiser ti gba kamu  mi o gba kamu o, na where my heart go dem put me o |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 1:57pm On Feb 13, 2016 |
Shammak: U sure say na 80k
Chill, make I prophesy Bornu for myself first so shall it be |
NYSC › Re: Prospective Kaduna Batch A16 by Fraiser(m): 1:46pm On Feb 13, 2016 |
I dont tink whatsapping is d next tin now, I suggest we should get to know oneanoder here more bfor going to whatsapp |
NYSC › Re: Prospective Kaduna Batch A16 by Fraiser(m): 1:41pm On Feb 13, 2016 |
KCTemi: Kaycee, uniben, biochemistry fear don catch me already, I tink say na only guys nysc send to kaduna |
NYSC › Re: Prospective Kaduna Batch A16 by Fraiser(m): 1:39pm On Feb 13, 2016 |
KCTemi: Kaycee, uniben, biochemistry |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 11:49am On Feb 13, 2016 |
DTOBS: Lol...city ti take over... i dey tell u |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 11:45am On Feb 13, 2016 |
Fraih:
girlfriend, you no nice  Sup with ya?
*** Omoalhaja7, wetin my twinnie do o? DTOBS, I see you! Morning IghravweIG, finally got to see you too , You fine o (@the other end)  Terrymason my guy, wassup? I havent seen Senator Kuchikau is he on sabbatical? Special good morning to my twin Fraiser and My Bae, Shammak.
Good morning everyone.
my cute twin sis, a very beautiful morni to u, I bliv u hav a blissful nyt. Dont mind Omoalhaja7 jare, I won help am bur hin no won gree |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 11:39am On Feb 13, 2016 |
justified10: fraiser, take time...
how u dey? u still Neva knw ur bearing for dis nysc stuff? padimi mo gentle o, hw ur syd be? I never no my bearing ke? Me wey don dey tidy up my load for my journey to kaduna |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 11:12am On Feb 13, 2016 |
DTOBS: A very good and bright morning to you all out here. How was our night and how has been our day? May the Lord see us through this service year we are about to enter oooo...
To the PCMs that are through with their registration, congratulations.
To the PCMs that have seeing the fake/unauthorized CUL, congrats.
To those yet to be through with registration, continue praying, God will see you through.
To those yet to register at all, well Bornu is still very much available for all of una.
In other news; A big congrat to my Oga, Kbs468 we re marching together.
BTW: Me don miss our political and romantical live style for this city oooo,NYSC don boil pipu sote..(make I shut up)
Moreover, who has seeing this OYO girl,Rukyola,e be like say her case don reach OYO true true oooo
Finally, greetings to all the jagaban in the house, greatestman, Sent4rina, crobboy, fraiser, Kbs468, bobolil, LogoDwhiz, Amodu, Armynu, yannabase etc.
Special greetings to all my queens in the house, Airstarkane (my Bae of life), bukish21, Missoyin, spixytnxy, dominion92, Fraih,sexysaphire who else?
MARCH TI GBE GBOGBO WA, E JE KA LO FI OKAN WA BALE... EMI NI TIYIN NI TOOTO... padimi I see u, u too gbaski, a very gud morni to u, no b only u miss dat our romantic nd political lifestyle o, all dis nysc repeated question nd answer matter don dey boring, som pple can even ask same question 50 times, we hav to take over our city back |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 10:02am On Feb 13, 2016 |
Happy weekend to all d citizens of golden city |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 9:52am On Feb 13, 2016 |
justified10: na u com sabi dat one o. lol... Ur work na very nice work o, I just dey play ni |
NYSC › Re: NYSC 2016 Batch A Corp Members House by Fraiser(m): 9:48am On Feb 13, 2016 |
SpencerM: all ds kaduna pple instead make una dey tink of how una go take end shiite patapata una dey hear dey talk i pirry una#wink...especially Fraiser.....#JustPassinBye....running to my Niger state jejeje.. abah why we go end shiite, na we start am? Dos shiite self dem b gud pple una just dey misinterpret dia intentions ni, either u lyk it or not na kaduna b d commercial capital of northan nigeria, d most social, d most ethnically diverse nd d state wit d most federal establishments, alot of opportunities await us dia. As for niger na nice place too, una go enjoy all dos Tapa people |