Franvincoop's Posts
Nairaland Forum › Franvincoop's Profile › Franvincoop's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 41 42 43 44 45 46 47 48 49 (of 61 pages)
Targeted operation, escalated offensive, coordinated military strikes, narrowly, nearly, escaped by whiskers, escaped with bullet wounds, abeg dis music dey on repeat since 1900. Dis music no get 2nd verse? Make una kpai dat beast asap or una wan confirm for us say Turji get insider 4 una midst wey dey give am updates. We go know when this same Turji go ambush una. I go dey here dey count scores, if una like make una no kpai am, im go kpai una. Na the innocent soldiers wey dem go ambush I dey pity but no RIP for dem till Bello Turji is killed and his carcass paraded on tiktok. |
@ the bolded. Righteousness has an IQ of a church rat. SultanOfAbia: |
Are you alright? I mean it literally. Abi u read the news b4 u post am? Or u just rush create post and be the ftc while disparaging news brought by you to this forum? Who do you dis kind thing? Na ur village people? What damages!!!!!! It's unbelievable seriously. Nairalanders, any topic u see on front page with the OP as TimeManager, pls don't waste ur data to even open the topic. Some of the OP's bolts are loose and he is on a long long thing. - Kiss the truth my black a$$ TimeManager: |
Why una no put our nairaland resident artist Dbull for this list? Una wicked ohh... |
Who tell u say FRSC or Police dey aware of this judgement? If u like print the article and the judgement join. Make God no punish u say u meet the ones wey no sabi read. U go read am urself and u go explain tire. When u finish, dem go tell u to call the writer of the article or the judge make e come meet una for that roadblock enforce the judgement? Na so EFCC chairman be give audio ban on raiding people's house at night. Wetin happen? No be one EFCC just collect free bullets recently for around 2a.m? What of IG wey announce audio ban on checking of phones? Wetin happen? When ekelebe stop u, say dem wan see your phone, tell dem say IG said that....... when u finish explain, dem go tell u to call IG make e come meet dem for roadblock. If ur numberplate don fade, egunje go your way or go buy new numberplate. Dalohad: |
Get your facts right bro. Gaurdialo and his wife have been separated since 2019, even b4 dey won the treble. She returned to Spain since 2019, the news of recent is about a confirmed divorce and settlement. There is no link between his recent finalised divorce and man city woes from November. Softmirror: |
Another "it's confusing me". This one na minor case, Edo State get governor wey no sabi count. Nollywood need to act movie titled "Coming 2 Nigeria" |
Mr Cover kudos to you, if bad news no happen, how u wan take complete your building project. My people say goat di chop na for the place wey dem tie am. Bros epp me, since 1st January I dey follow u count scores and I know say na you be scorekeeper. That award wey Anambra and Ogun dey drag, who u feel go win am by December 2025? Who get endurance pass? I see Delta state too fast coming up. MrCover: |
That's not all. If dey devalue the Naira again as they have already done twice since 2023, crude @ 80 dollars per barrel can be 2000 Naira per litre and even crude @ 40 dollars per barrel can be 2000 Naira. Kapisch? nedu666: |
All dat egunje wey him don collect for 40 years plus interest adjusted for inflation, e go vomit am now. 99 days for the thief, 1 day for the owner. Make dem bill am 30 billion asap 2morrow morning. |
Great shot doc. I wish many more such shots to the EFCC and Police who raid houses in the dead of night. Abi una dey read wetin I dey read? Doc, shoot ekelebe, dem rush ekelebe go hospital but doc to treat am no dey hospital meanwhile na doc shoot am. Abeg, who fit epp me calculate the probability say that doc wey shoot ekelebe na the same doc wey suppose treat am for hospital? |
Of course there are as per EFCC. Have u 4gotten those gods of men with private jets and airstrips? Have u 4gotten the APC ordained Bishops and Archbishops of 2023 campaign ? Dey play. PSmurf: |
Just invite your Muslim neighbors to a meal and tell them its Halal and after dem chop finish, tell dem say na pork wey dem chop. B4 u go wan talksay na joke u dey joke, your blood gon don dey short. Try am for 9ja for Islamabad, UK or US, the result na the same. Even you, things dey happen daily for ya life wey u dey damn the consequences. The other day, someone dropped this wise words into my whatsapp.. Death or prison no be obstacle for person wey wan achieve im objectives. Na to achieve am first, if heaven wan fall after make im fall. These words na after im 44 year old brother don collect 102 year prison sentence for China. After im die dem go still chain the corpse cuz im no fit live for 146 years. nairalanda1: |
Normally, dem suppose sentence to death person wey dey lie about im gender. Na so e suppose be. If u knowingly cause me to commit that kind abomination, I must knowingly kill you with passion, emotions and the belief that I am justified before God and man. Na why you hearsay dem stab am 14+ times cuz of the passion and emotion of betrayal. How dare u knowingly cause me to betray myself, my religion/spirituality and my principles? This same case now, if na Iran, those judges wey dem assassinate recently go gift dat trans death penalty with immediate effect for "corruption on earth" and free those dat stabbed him. How dare you cause me to betray myself? Na here bible dey talksay the wages of sin is death. Murder here is justified. If na USA, I trust Trump for pardon them on day 1. |
OP, I no know why that woman husband no knockout ya 2 front teeth sef. Dat way u for lack the ability to be expecting forgiveness from Amanda after u caught her cheating. |
Its fabricated. Go to court, go to court, dem go show video evidence where Egbetokun poison the cassava and threw it to the cows. Cows grazing outside his farm? Another fabricated statement. Infact, Egbetokun go pay for the 3 cows and herders go pay for 500 tons of cassava wey those cows don dey chop for that particular farm and others nearby since 2015. JuanDeDios: |
Egbetokun don drop format against herdsmen. Benue/Jos people take special note. Tried and tested. If u no wan cows for ya farm, just spray otapiapia and let dem feed. If herdsmen know say pple don dey spray otapiapia for farm, dem go dey avoid people farms self consciously. Na to just spray otapiapia for ya farm, then put u signboard say "Nyaamdu naindi alaa koyoɓi". Simple. Egbetokun is a genius. A very bright idea dat I wonder why nobody ever thought about it before. Abeg make VDM enter dis matter make we crowdfund pay Egbetokun e bail and damages. Im theory don work for practical. |
Abeg, take your sexual enhancement herbs very faraway from any place wey dem dey talk abt "knacking of nyash" na beg i dey beg. Talkisneeded: |
Na u go tire. Nobody hates igbos, it's just that igbos are paying for the sins of their past. It was an igbo coup. If u like write from Genesis to Revelation. All ur writeup just proves it was an Igbo coup cuz Igbo politicians were spared whether by luck or by collusion. The direct beneficiaries of the coup were igbos and the igbo perpetrators were not executed. 1+1=2 not 11 Igbos living in the North were very reckless and were insulting and taunting Northerners after the coup. You also mentioned Archbishop of Canterbury and not wanting to involve the British. Nice one. Do you think the Archbishop of Canterbury is more important that Sir Ahmadu Bello? Do you really know who Sir Ahmadu Bello is? Killing Sir Ahmadu Bello is like killing the grandson of prophet Muhammed. But Christians and especially igbos will never learn. You decided not to involve the British, but you involved the whole of Muslim africa and Saudi Arabia. Do you think Sir Ahmadu Bello concerns only Nigeria? Think again. Either you are a poor history student or you've forgotten. Who do you think brought Islam to West and Central Africa? A few years ago, the biggest mosque was inaugurated in Cameroon and who do you think was invited to come and do the honours - Emir Sanusi Lamido and even at that time he was still banished and not the Emir of Kano. Do you know how many Muslim countries in West and Central Africa look to Northern Nigeria for directives on fasting and appointment of Lamido and Emirs? Boko haram which started in Nigeria, now affects how many countries? Do you know why there was kwashiokor in Biafra? Ojukwu was planning to pass food and weapons from France and co. through Cameroon but the Cameroon President Ahmadu Ahidjo who is a distant relation to Modibo Adama who was the Cameroon Islam envoy of Uthman Dan Fodio (Sir Ahmadu Bello grandfather) received those weapons and aid and instead handed it over to Gowon. Due to this France replaced Ahidjo with Biya but Ahidjo knew that no matter the cost, the igbos must pay a very heavy price for the killing of Sir Ahmadu Bello. Let me not talk about the riots in Chad, Mauritania and Niger once they woke up in the morning to the news that Sir Ahmadu had been killed. What about the fatwas that were issued calling on Jihad and massacre of the igbos after every Friday prayers in these same countries? I am just trying to give you the international dimension to what Sir Ahmadu Bello represented vis a vis the Archbishop of Canterbury whom I don't think you personally can take a bullet for? The worst crime the igbo tribe ever committed was to kill Sir Ahmadu Bello and the Muslims have never and probably will never ever forgive them till thy kingdom come. The consequences of killing Sir Ahmadu Bello still haunt the igbos till date. Let me inform you the consequences. 1. Anger in the igbo pogroms and massacres in the North. 2. The brutal countercoup 3. Biafra civil war and the impoverishment of the igbos. 4. The continuous Northern coups till 1999. 5. The refusal to let the igbos ever enter Aso Rock. 6. The refusal to let the igbos ever secede and to always subjugate them. You can see even in APC and PDP, they have gone round twice North and South but no igbo man even as VP. Pls don't mention Goodluck Jonathan as an Ibo man, if he was an Ibo man they would never have allowed him to be even VP. None of these parties are ready to hand over their ticket to an Igbo man because Northerners will never accept it. Imagine Kwankwaso telling Obi to be his VP? What read you from that? That's the only way Obi can be VP because if Kwankwaso becomes Obi VP, then the ticket is useless as NNPP Kano people will refuse to vote Obi as President but will accept his as VP eventhough we know Obi will be bringing more votes to the table. What was the use of Baba Datti Ahmed as VP to Obi ticket? minus zero. I am not insulting igbos but merely stating the facts as you can never solve a problem that you have not diagnosed yet. All insults are welcome but know that I am half Ibo and my maternal village is Ekwulobia, Anambra State but truth first before emotion/tribe/religion or nationality. franchasofficia: |
I believe these things keep happening cuz we allow dem to happen. I mean we allow dem to happen be say, we no dey apply jungle justice immediately say we dey wait for police. Which police? Justice must not only be done but must be seen to been done. We get to show dis kind man say concerning wickedness na kindergarten im dey. His genitals must be burnt to a crisp to serve as a deterrent to others. When dem burn like 10 person prick, nobody go try am again. |
Bros, no vex. That money too small. Better reason one business dey do wey go double/triple that money for you within 2-3 years. 7m na Big money for 9ja for business. While u dey run the business, dey play US lottery, e fit show for you. 7M to travel out na frustration u wan enter and no try middle east. After flight, visa, accommodation and B4 u go settle down then start work that 7M go don finish except u get somebody for there u go go meet. My own 2 kopeck. g17prinz: |
I believe dis wahala na for person wey marry one wife ohh. Me wey get 2 no get dis kind problem. I believe my seniors wey get 3 and above no dey face dis kind dilemma. |
In 2015, a bag of rice 50 kg was 26,000 xaf which was 9000 naira. In 2025, a bag of rice 50 kg is 30,000 xaf which is 74,000 naira. How u wan take explain am? If not that naira has been devalued. In 2015, 1 naira was about 3 xaf, in 2025 1 xaf is 2.4 naira. How e sound for ya ear? Na facts I dey give you so, b4 u go wan ask me what is my source, I dey import rice from Thailand and supply to Chad, CAR and Nigeria via Cameroon. Belel, Mubi, Jamtari, Jimeta na my naija border crossings be that, use road or water. All CEMAC countries, Cameroon, Chad, - even Central Africa, Gabon and Congo with no land border to Nigeria dey benefit from Tpain government pass Nigerians, no cap. Their purchasing power don pass Nigerians own far far. Na for nairaland here I hearsay 9ja border dey lock, I just dey laugh in fulfulde. helinues: |
Lakurawa 5 0 NA As dem loss 5 soldiers, dem just wan cover up say dem kill 6, make we think say dem dey work. The P in APC stands for Propaganda. |
Dat otapiapia and red pen don dey work. |
Ask them where the audio 200 million dollars wey dem get from IJGB in Detty December? The P in APC is for propaganda. Know this and know peace. Na why minister wan spend 8 billion for sensitisation on electricity for people wey no get light plus those wey get generator and solar. MatrixCircle: |
Am Israel chai aka Botragelad. How far my brother? Since Gaza has a ceasefire and Hezbollah is down and out especially due to HTS in Syria what are the future plans? Face off with the ayatollah or invading Yemen? But the Houthis will surely stop firing due to this ceasefire. Trump too will surely negotiate Ukraine-Russia. The way dis ceasefire dey vex me ehh cuz I no go dey feel u and your insults again and to dey give u wotowoto. But surely the world can never be at peace, something is cooking. As u said it will be unveiled soon. I see China invading Taiwan as soon as Russia-Ukraine ceasefire. Just knowsay any side wey u support, I be steady opposition. Good morning. Botragelad: |
Russia no be your mate. Some of una just hear Russia una feel say na one small place. Russia is the biggest country in this world. Russia has borders with more than 14 different countries including China, USA, Japan, Korea etc. Russia is in 3 continents alone. Na Russia sell Alaska to USA. Russia get 11 timezones only inside Russia, I hope u know the meaning cuz even the whole Africa no get even upto 6 timezones. Russia dey even inside EU territory. So ask yourself who is a Russian? If I tell u to show me a Russian face, u go fit show me? No be Russian face Zelensky carry so? If u see Chinese face e tell u say im be Russian, y u go wan dey doubt am wey dem share border and intermarry for centuries. U no hear Far East Republic for the write up? No be train Kim Jung Un dey take visit Russia? U feel say that train dey fly for air? Putin no be any kind man. U know how many Republics dey inside Russia? With their own President? I no mean regions or states, I mean Republic. Remember say abt 25 years ago na Yeltsin call Putin handover Russia to am go house, just imagine am. Imagine am say Tpain just wake one day, handover to Shitman. U sef knowsay e no fit happen. But e happen for Russia. U know how many US Presidents wey Putin don see? Even after Trump and the person after Trump, Putin still gallant. IMPARTIAL: |
Bros abeg u go fit epp me? U know where those saner climes crew dey hangout? I b wan ask if dem go prefer death by dogs or death by herdsmen. Looking4Trouble: |
A word of advice, dogs dey fear me, shepherd/bulldog/ekuke u name it. I mean all dogs, e dey like dem dey smell/see the dogmeat wey I dey chop all ma life. If u thinksay I dey lie, ask that guy man or Calabar girl for your area about 404. RIP Patricia. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 41 42 43 44 45 46 47 48 49 (of 61 pages)
