₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,404 members, 8,450,177 topics. Date: Wednesday, 22 July 2026 at 09:53 PM

Toggle theme

Hungryboy's Posts

Nairaland ForumHungryboy's ProfileHungryboy's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 23 24 25 26 27 28 29 30 31 (of 119 pages)

TravelRe: The Bad Image Of Nigeria Abroad. Kenyans Blast Nigerians by hungryboy(m): 10:57pm On Feb 21, 2017
Some ediots here will be bashing a particular tribe forgetting that when e happen for dia
Dem no wan sabi whether you be igbo or yoruba or Efik
Na only Nigerians dem sabi



Majority of drugs entering the United States na from Mexico
But Americans never rise up burn down Legitimate Mexican businesses or beat up Mexicans going about their legitimate businesses



Black South Africans are the most pathetic set of people in this continent




First the were attacking Zimbabweans for taking their jobs



Next it was Somalis for taking over the roadside kiosk business




Now is Nigerians for dealing drugs




Those guys are just frustrated human beings
Make dem no go fight the white South Africans were corner all their riches


Make dem continue dey blame their fellow Africans for their problems



Mumu people
FamilyRe: Beautiful Pre-wedding Photos Of A Lady With Her Albino Man by hungryboy(m): 9:52pm On Feb 21, 2017
Xcelinteriors:
This is true definition of unconditional love. Best of luck oyinbo and iyawo oyinbo
Sister which unconditional love you dey talk about

That albino were dey up dia look like all those albinos for streets were dey suffer for sun

You don see ajebutter albino finish were sell him blackness collect riches

you come dey talk of unconditional love
TV/MoviesRe: Gifty At The Airport, On Her Way Back To Nigeria (Photo) by hungryboy(m): 9:46pm On Feb 21, 2017
Sweetest Gifty



Welcome back
FamilyRe: Lady Gifts Her Mum A Car After Jokingly Making Promise 4 Years Ago by hungryboy(m): 9:40pm On Feb 21, 2017
[quote author=Ahmed0336 post=53934155][/quote]If you want am come buy nah

Phone were the touchpad dey work only for night



And I no dey fit type any symbol or question mark again



Even the Speaker dey sound like frog were dey cry
BusinessRe: 24 Hours After New Policy, CBN Injects $371m Into Forex Market by hungryboy(m): 9:35pm On Feb 21, 2017
This Buhari Government mumu no be small

Even me were no go school sabi say

Selling of dollars to banks no go help

Cos bank managers go still hoard the dollars were dem buy 360 naira

Carry am go sell give their Bureau de change friends at 500 naira




Make cool millions in profit




The best thing is for the Cbn to sell dollars directly to importers and companies who are about to purchase things abroad
CelebritiesRe: Sheriff Ilori "Big Sheff" With His Kids (Photos) by hungryboy(m): 9:26pm On Feb 21, 2017
Nwaoma198:
I love big things
I hope say the big things include

Big poor Men
CelebritiesRe: Sheriff Ilori "Big Sheff" With His Kids (Photos) by hungryboy(m): 9:24pm On Feb 21, 2017
dominique:
He needs to work on that weight gosh!!! sad
aunty are we in a military regime

Pesin no fit fat in peace again
FamilyRe: Lady Gifts Her Mum A Car After Jokingly Making Promise 4 Years Ago by hungryboy(m): 9:15pm On Feb 21, 2017
I just dey shake my head for this life

Me I dey here dey think how I go take give my landlord this month rent of 3k

Woman dey somewhere dia buy car worth millions give him Mama

Dem swear for me
Abi others get two head
PoliticsRe: Jonathan’s Camp Reveals What Ex-president Told Sheriff by hungryboy(m): 9:09pm On Feb 21, 2017
Gurumaharaji:
Nawa ooh....Una think sey we give a Bleep??
see pesin were no give a bleep

Spend him time click on reply topic button
Come siddon type sentence

Come click on submit


Bros If you wan learn how not to give a bleep

Come make I teach you
Car TalkRe: Shame As Fire Burns Chrysler Car In Awka,FRSC Officials Have No Extinguisher(pi by hungryboy(m): 9:06pm On Feb 21, 2017
No be Naija again


The same Frsc officer were dey worry you to put seatbelt
No go ever put seatbelt when him dey drive him own motor
CelebritiesRe: Video:married Man With 4 Children Set Himself On Fire In His House In Edo State by hungryboy(m): 8:20pm On Feb 21, 2017
But the man sef no try oh
Even If you wan commit suicide

Rope full market
Rat poison cheap pass garri now



Why you go come set fire burn down the only inheritance (the house) were you go leave for your children
CelebritiesRe: Video:married Man With 4 Children Set Himself On Fire In His House In Edo State by hungryboy(m): 8:17pm On Feb 21, 2017
We are in a
country people are afraid of opening up and talking about their problems with their neighbors





Co workers and even relatives for fear of being judged or avoided






I dey pity struggling to married men now sha




Young bachelors like us dey even go through so much hardship right now








How dia own go come be
PoliticsRe: Presidency Budgets N60m Again For Grass Cutting by hungryboy(m): 8:00pm On Feb 21, 2017
Every day I lose hope in this country




The most annoying thing Is that


the are ediots on here




who are paid to defend daylight robberies like this on our treasury by the "incorruptible Bubu" Government
FamilyRe: Imo Chief Plaiting Wife’s Hair (Photos) by hungryboy(m): 6:51pm On Feb 21, 2017
BleSSedMee:
Look at those finger nails. Jeez.
you been wan make she fix long claws



like una dey do
RomanceRe: . by hungryboy(m):
Finalboss you don shun your boy sotey e come dey like say na swear I swear







I sabi you already sef






I already get your number but I no wan disturb you






If you think say I dey lie
CelebritiesRe: "Use Smaller Gods To Swear-in African Leaders" - Pete Edochie by hungryboy(m): 6:40am On Feb 21, 2017
Abeg leave matter

No be money we dey talk about again
I swear finish with Amadioha





Still go back go meet the herbalist with






Ghana must go bag of money make him clear the oath comot for my head


If him no gree


I travel go India go do am
TV/MoviesRe: See Photos Of Big Brother Naija Kemen's Very Pretty Girlfriend, Abasiono by hungryboy(m): 6:26am On Feb 21, 2017
I don see why him no gree Tboss rest for BBN house


Na fair and pretty women him dey like
TV/MoviesRe: See Photos Of Big Brother Naija Kemen's Very Pretty Girlfriend, Abasiono by hungryboy(m): 6:24am On Feb 21, 2017
poshestmina:
Mrs \Miss lipsy is cute
abeg e don do with yabbing his lips nah
No be him create himself
PoliticsRe: London Police Called To Arrest The Guardian’s Reporter Over Buhari by hungryboy(m): 6:09am On Feb 20, 2017
MaziOmenuko:
What else do you think investigative journalism is? Should he have stayed back in his house and write a report about the whereabouts of the president without making efforts to find out things for himself? He is trying to do his job professionally and you are crying foul, what if he stays inbthe comfort of his house and writes that the president is dead or has cancer or is down with stroke? Would that be better?

Someone is making effort to get the details of what is really going on, the trip must have been sponsored by his employees, the dude must have spent hours waiting to be attended to and that is not investigative journalism. Tomorrow if he publishes a report based on speculation, you start shouting fake reporter.
Bros leave that man


Na Buhari media centre employee him be
CrimeRe: Recession Pangs forces Man To Slaughter Wife For Rituals In Lagos by hungryboy(m): 11:16pm On Feb 19, 2017
Make we leave hunger out of this matter
That man na ritualist


And am very sure that
No be him first victim be him wife so Make dem interrogate am wella

So that him go tell us how many people him don kill before now
CelebritiesRe: Actor IK Ogbonna Shares Racy Topless Photos With Wife, Sonia [PICS] by hungryboy(m): 10:50pm On Feb 19, 2017
Make Thunder fire poverty wherever him dey
Love dey sweet when money full your bank account

My Papa and Mama no get time for this kind romance,
I no even catch dem dey kiss before


Na to dey hustle dey find wetin we go chop,


Which bed sef dem for take snap this kind picture for one room apartment were all of us dey sleep together



Na him make I promise myself say

If i no make money


I no go marry
CelebritiesRe: Nigerian Singer, B Red And His Bed Full Of Dollar Bills [PICS] by hungryboy(m): 10:17pm On Feb 19, 2017
See dis poor B red oh


Na just 1000 dollars with small 300k were dey make am feel like Boss



Guys like me were our money long sotey we come dey loan bank money no dey even make noise like this
TV/MoviesRe: Big Brother Naija 2017: Live Thread by hungryboy(m): 10:06pm On Feb 19, 2017
I'll miss Gifty


Her accents

Her trysts with Bally


She made the BBN house fun


She looks like a good person in real life too


Didn't hold a grudge or talk ill of others




People hated her for being fake,

Forgetting that almost every one in that house are faking it


Bye Gifty


I pray you become a star
I'll always remain a fan
PoliticsRe: Ffk Secret Revealed ( Shocking Stories) by hungryboy(m): 3:16pm On Feb 19, 2017
sarrki:
Ffk is a serial lier
lol

Na so pot been take call kettle black
HealthRe: Lady Runs Mad Inside Osogbo Popular Market, Causes Traffic Gridlock (pic) by hungryboy(m): 3:12pm On Feb 19, 2017
I dey Pity Mad Men/women this days oh
Cos people no dey troway food for dustbin again
PoliticsRe: Is The Buhari Regime Really Fighting Corruption? by hungryboy(m): 3:06pm On Feb 19, 2017
Buhari is fighting corruption

Though the fight is mainly targeted at Jonathan's Men

But money is being recovered

No thanks to corruption
today ,

Some ex governors are richer than their States

There is hardship in the land right now and many of us are barely surviving,



But I don't think there is much the Government can do about it
If you think you are some genius




Tell us how we can make the naira exchange for 160naira or even 200naira again
HealthRe: Severely Disabled 8month-old Girl Born Blind And Without A Skull (photos). by hungryboy(m): 2:53pm On Feb 19, 2017
Things like this make me sad

Why should this baby have to suffer like this
.

This life is not fair
PoliticsRe: Buratai Attends Munich Security Conference, 2017 (Photos) by hungryboy(m): 2:46pm On Feb 19, 2017
Abeg where the Youthful swag dey
Abi na microscope I go use before I see am
CrimeRe: Woman Kills Pregnant Co-tenant In Ebonyi (photo) by hungryboy(m): 2:35pm On Feb 19, 2017
Na dis kind thing were dey make people talk say "No allow devil use you "
Devil don use this woman head play guitar



Now she go relocate permanently to Prison yard
PoliticsRe: Die-hard Supporter Of Pres. Buhari Spotted In Abuja (Pic) by hungryboy(m): 2:30pm On Feb 19, 2017
At the end of the day


That Man
Buhari
Osibanjo
And even Me too


Go die one day
RomanceRe: I Need New Friends In This Part Of The Country by hungryboy(m): 2:25pm On Feb 19, 2017
Be specific bro




Na ashawo you dey find Abi na girlfriend
RomanceRe: . by hungryboy(m): 2:22pm On Feb 19, 2017
slimzypink:
se you boys are not crazy like dis, she is just there , not fine angry

na becos of am you guys started ignoring me se,no more likes,no more messages ... no wahala cry
Madam na so you dey


you no even hide your bad belle sef

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 23 24 25 26 27 28 29 30 31 (of 119 pages)