Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 24 25 26 27 28 29 30 31 32 (of 119 pages)
Before i been dey think say i be mumu
Na as i come join Nl
Were i meet people were make me feel like say i be Albert Einstein |
Malaria too does not exist Na people dey wan use am as excuse give mosquito bad name |
Na Airforce1 way of telling us say him don buy new shirt yesterday be dis oh |
I'll feel sad if Gifty gets evicted tonight People say she's fake Who isn't faking it in that house The only girl that was being her real self was cocoice Who had the guts to smoke not caring if people will hate her because of that And you guys didn't vote to keep her in the house Because she talk say she no know Banky and Falz no mean anything Cos i sabi many people were no know 'em too Abi na crime now not to know a celebrity Una go get shock tonight Cos Our sympathy votes go keep Gifty for that house |
edoboy33:women don realise say no be fine boy dem go chop Go back go make millions Then come create topic here say am this rich yet no girlfriend You go receive pm from almost all girls for this section Telling you that The wan be your girlfriend |
Lol Make we turn this thread to Buhari remix thread Leg Over remix by Mr Eazi ft Buhari Buhari dey confuse me oh with him Government Him tell us e get doctor were dey cure am Headache for London Him dey see us like a Johnny just come When Nigerians dey work eh The Dullard go just dey chop We go chop all the suffering As long as him give us our portion Bubu make you no dey kill us Abeg just dey treat us with caution eh eh eh Leg over Bubu don trow us leg over ah ha More suffer Bubu don make us to suffer |
Na my Papa Mate be dis oh |
All this fake Pastors sha Him don see people wife toto sotey him title come change from General Overseer to General Over See Her After those army men go finish with am, Him no go dey like see Pesin wife unclothedness again |
Pennyways:you were been get sound education wan make "put some senses into you empty skull" Bros no come here disgrace yourself nah We know say Akpabio and his boy Udom Emmanuel get paid laptops full Internet Stick to defending 'em and attacking their critics on Facebook abeg Wetin Akpabio use 3 trillion allocation do for 8yrs you no fit talk, Na to throw insult around you sabi |
High thief Akpabio been loot my State sha but many ediots in my State will tell you that at least he tried in using some of the funds in building roads and a Stadium and stealing some My advice for Mr Inibehe Effiong is, no go die for people were no go acknowledge or appreciate your sacrifice , Akwaibomites and many Nigerians have normalised corruption |
Diezani na Commander in Thief of the Looting Forces sha So much greed in one mind Abeg make we follow start Hold the Saint Buhari Government to account too Na security post(gatehouse) for Osibanjo were dem wan use 250million build Money were I go use build 100 two bedroom flats and change go still remain |
Whether my village people go gree you notice me today Finalboss1 i know say hunger no be disease And hardship no be sickness I have no sob story to tell you Am just a young guy going through a rough patch right now Abeg nothing is too small . |
redgem:Sister i have seen him help some popular accounts too Though my badluck no gree am notice me Dude Is for real I'm just amazed that this kind Philanthropist dey dis Naija |
I agree with some of the points the guy made But dude sounds more like a guy working at the Buhari Media Centre in Abuja than a guy who just wants what's best for this country I like that Buhari is fighting corruption and recovering looted funds But he is still comfortable working with a Secretary to the State Government who gave his company a 200million naira contract to clear grass If we want to succeed in stamping out corruption, they should be no sacred cows, All men who steal government funds be him an Apc or PDP man should be jailed |
E dey vex me too why people go dey loot billions from Government treasury go stash for their house while many poor Nigerians dey die of hunger The only way we can stamp out corruption is by sentencing to death any Politician or Civil Servant caught with Government funds even if na 100naira e be But those thieves for National Assembly no go allow that kind bill pass first reading |
Abeg make una help me beg Port Disco say we no dey dance to dis kind disco oh For Nepa time were disco sef no been dey we been dey get light pass now oh |
E dey vex me too why people go dey loot billions from Government treasury go stash for their house while many poor Nigerians dey die of hunger The only way we can stamp out corruption is by sentencing to death any Politician or Civil Servant caught with Government funds even if na 100naira e be But those thieves for National Assembly no go allow that kind bill pass first reading |
Sweet Beyonce I go marry pretty and rich wife for this life |
highrise07:If na your plan be dat You go blow the whistle tire |
Vivly:smh I already know what you are insinuating So I'll skim through a thread of hundreds of pages looking for posts about Kemen to convince you that I do watch the Show |
Vivly:Did I tell you that I don't watch the show Please tell me how the behaviour of Kemen is peculiar to Akwaibomites What has he done in the house that Men from other ethnic groups don't do too Is it gossiping (With TTT and Efe) Insinuating raping a drunk girl (Gifty) Trying to make Tboss fall in love with him Trying to make a Girl kiss him (Gifty) Being Jealous that Tboss was with another guy (Miyonse) etc Abeg which attitude were him don exhibit were no Man from another tribe no dey do Abi you just dey feel like being Tribalistic today |
Vivly:How did you come by this statistics Woman You schooled in Cross River and met a few ediot Akwa Ibom boys and now came to the conclusion that that's how majority of Akwa Ibom guys behave Imagine accusing a tribe of millions of people of being rapists just because of the words of a stupid Reality show contestant |
Na poverty i blame for all this A rich old woman will never be accused of being a witch na only poor woman Poverty makes you so paranoid that you will even blame your own kids for locking your riches in the witch world and keeping you in Penury |
We Mr Eazi fans are not ignoring his mixtape I'm still jamming to Leg over here |
It's tragic that this handsome guy with a beautiful family had to pay the ultimate price for the failure of our Government to regulate the selling of drugs in this country The drugs we take are a matter of live and death It's not something to be toyed with |
finalboss:finalboss look into hungryboy matter too now E don tey were I receive credit alert for this my phone The account number again na 0058509716 diamond bank God bless you as you click on the transfer to hungryboy button |
Where the many gifts dey now
Cos na only one small carton were I see dia oh |
This is tragic
I won't pretend to cry more than the bereaved family I just hope God gives his family the fortitude to bear this loss |
Am happy that Yakubu was caught and some of his loot was recovered But let's not pretend as if this guy will even make the top twenty looters of Government funds in this country |
One thief caught Am happy But truth be told There are many out there who have stolen more but are so untouchable that Efcc will not even dare to try to investigate 'em We will only stamp out corruption in this country when the are no sacred cows Do to Saraki Akpabio Tinubu Amaechi what you just did to Yakubu |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 24 25 26 27 28 29 30 31 32 (of 119 pages)