Celebrities › Re: Ehi Ogbebor Finally Dumps MC Oluomo After He Allegedly Got Popular Yoruba Actres by MMempire(m): 10:43am On Sep 20, 2021 |
Kasala don burst. Oga blogger, be careful make dem no come for you o. |
Romance › Re: I Spent 3millionaira In A Night Club (my Yahoo Story) by MMempire(m): 12:17pm On Sep 16, 2021 |
Enigma1510: My story na same thing as the Op, imagine being a spammer coz me no like to dey chat and i no like to dey show off or club...but i fit carry babes for myself and friends and I won’t touch am and still pay am more than normal because if i later switch on my light when i get home, and you aren’t my taste, i would just sleep off, if the lady don smoke and i dey smell am, i no go sleep that room, I don’t like alcohol but i sabi sey most runs girls drink alcohol because if the way guys Bleep them. Imagine olosho falling in love with you coz of the way you treat them and wouldn’t wanna Bleep your friends no matter what. I’d just be like ama increase your money, its you my pal want. I wouldn’t say because you are a prostitute, i must treat you like one but if you cross your boundary, when i shout, u go think sey i dey possessed. I think am attracted to smart women, worst part be sey other olosho i carry for my friends fit see me again another day and go wan follow me!!! And me no dey carry same girl again. Lmao, most times you go give your niggas the money to give the girls so it won’t look like you are the one spending the cash and you niggas go Bleep the girl tire and still give am change. Their gfs go wan date you, go dey complain sey dem broke and if you transfer just 20k, dem go start to dey chat you up and dey badmouth your padi and how stingy he is...blah blah blah,
Mama talk sey buy land, me prefer gold, and i know how to bribe alot to avoid stress anywhere. the only thing was i never did anything illegal till i finish university and that was why i was able to still hit 4.11/5.00 GP in one if the toughest department in engineering.
Na that time all this SEO dey hot and I remember leapviral...lol, i was using a script then and i no buy car though i had the cash but i no sabi tell people no if dem ask for money. And i used to believe 5k was too small to give someone then...coz my brain go convert am to USD!!! Lol... When i con finish NYSC, it was easier to become a spammer because i used to create landing pages and all and doing affiliate marketing, i sabi how much go dey my account. If i dey broke e mean sey i get like 5M for acct, my brain go dey work on how to make more coz i dey lazy. Wetin be my own with CV!!! Had already said i would never ever work under anybody. Bought my first car and i no dey post anything, na friends cast me. Bought second one for transport business a month later, bought the third for my friend whose car we were using when i had none few weeks later. All in less than 3 months, told him to pay back anytime he makes the money, i no dey comot during the day, na night, i no like people seeing me. But the noise of generator 24/7 made people wonder how i dey make money without leaving home. And i dey buy 50litres of petrol!!! Started business with my so-called friend and was the money man but nobody knew, I wouldn’t talk to any olosho unless na my taste, dem go dey ask que who dem wan follow, you go see me wearing bathroom slipass, but anyone i choose go follow me reluctantly until we reach house and dem see sey na me be the owner of everything including the house and i always see the look in their eyes sey, so the guy in bathroom slipass na the joker. I just love wearing anything comfortable. I won’t buy clothes but would give people money to do shopping. Na when no update dey, spent the money in my main account and started touching my savings i knew something dey happen, car developed fault, instead make i manage, i said make dem remove the whole shit under the bonnet and put another one...spent around 800k to repair a car wey no worth 3M. I just love disguising, i no dey shout but money no dey enter, na xo i start dey borrow niggas money sey when money enter, we go sort am out, na one by one niggas comot. The one wey be face of the business and i made sure the biz acct na either to sign incase i travel, him dey spend money i dey use run salary for the two of us as i dey plan to comot, na the day he withdrew 120k i talked....this guy no tell me wetin he dey use money do. Lmao...the guy go buy land with my money. Later got to know...na the same guy i buy car for, even phone wey pass mine.
Na when you dey see too much debit alert you go sabi sey something dey sup!!! Me wey go dey use one useless phone go buy better one for friends and families because i am always happy anytime i surprise anybody. But when nothing dey again, fake friends dey follow another person comot, family members sef dey shout...go find work, even if na 50k, you are too lazy. But i no lazy when i dey give everyone monthly allowance...lol or give dem money to pay salary for their workers.
Bro, my account entered red!!! I never knew i was just being lucky and people dey pretend to be my friend coz of what they were collecting and they were keeping their own...a week turned into a month and a month turned into a year and didn’t make that big money, was only making money to survive...i still believe everything was a big lesson but i fit borrow to make others happy. The day it dawned on me was the day i was calling everyone i needed 200k and was gonna return it thesame day and nobody gave me 1 naira i knew I made a fucking big mistake despite all the humility and everything. Didnt know how to spend. My own is make money enter and make e comot!!! Sey big money is coming. We all budget for money we never see, like saying once i see 20M, dear remind me to do this...
Me wey no fit do job wey less than $5k con dey do job of $1k, $200 just to sha work and continue trying. Nobody told me to close my laptop and start afresh...thats my plan...i know my big moment is still coming but i gotta wakeup and know sey i no dey yankee but Naija and make my brain no dey convert!!! You go just hear me talk sey ordinary 50,000naira wey be $100btc. Lmao. I don’t get intimidated so when i see guys using a ride of 17M, because i would just convert the 17M to dollars and laugh it off...na dubai made me realize cars are not expensive at all!!! Na naira no get value...who wouldn’t wanna earn in dollars and change it to naira. I would still laugh and think lets see whats gonna happen in 5 years. At least i got my certificate which i earned without doing any runs. I read like my life depended on it and i earned it but certificate i never sabi who i gave to help me keep sef. I just have the scanned copy of everything.
Now i don get CV but i no sabi how dem dey look for work. I no get any shirt, tie or those shoes you go wear go interview. Not even one!!! It’s depressing like mad coz u go dey reason sey u wey dey spend 50k daily without leaving house con dey look for 10k. Na music dey help atimes!!! And na mood go determine the genre if music to listen to. So Op, we all gotta retrace our steps and start from the scratch because game money will always go back into the game if not well spent!!! I always tell people I didn’t spend lavishly because thats what people would say but na lie, if you give someone 10k, they would think you must have up to 500k, not knowing you even gave them outta the money you borrowed.
I realized i started seeing money at a young age(19years) affected my thinking till now. When i was importing but wasn’t good at marketing so i partnered with a friend then too and the biz got bleeped up, got broke and later started making money again, still dropped all the cash for another business but they were big money to us then, 200l student wey get 500k for acct, and dey collect 6k for pocket money every month. So i no sabi spend, but i sabi borrow ppl money dem no go return. And i sabi drop money for biz but people must not know na me drop the money. I no like overhyping. Thesame way i was hiding my result and was always sitting at the back of the class and missed series of tests until my stupid department pasted our result even with our names on it. That was when people no teach me anything again. It took me years to realize never to borrow ppl money again but just give them what you can or borrow them and forget the money because it would never come back!!!
Saying all these tonight made me feel good. Sold all my gold, sold lotta stuffs just to satisfy ppl, na when i called my mum i wanted to sell the only car left and my wife started crying i realized I need to act like a man and not wait for the money to come...man must have a constant source of income. My next move is in my mind. I just dey call everybody i dey look for work, dem no believe...
Sorry for all the typo errors, I don’t have time to be correcting anything. Dem say na who wear shoe know where e dey pain am. Me no follow you wear your shoe, but I feel your pain bro. God go rise you up again. The world dey only recognize people when money dey dem hands. You go bounce back better and stronger. Just believe in yourself. Peace ✌✌✌ |
Car Talk › Re: My Experience With A Roadside Mechanic by MMempire(m): 6:51am On Sep 16, 2021 |
hope4nigeria: he hasn't done anything wrong infact the mechanic is the best for you. Viscosity of used oil in the engine is equal to new power steering oil. Because it's now lighter oil.
My own experience was a terrible one, I studied mechanic engineering and I'm very good in automobile, I fix most of my car trouble shootings myself. But last week, I was very busy with a contract job in maiduguri, I traveled with my Peugeot 407 from Abuja to maiduguri and return to Abuja. The engine gave a very good paformance with great speed, no issue on the road. When I return to Abuja, I noticed engine cover was liking oil, I becon on this disaster mechanic. Just to open the cover I place gum to stop the lickages. Bro he knocked my engine, he went and open timing compactment just for no reason and and fixed the timing wrongly. Imidiately I start the engine. The engine hook. Now I need 300k to fix the car. I only cease his tools and his phone.
|
Crime › Re: Bob Marley Death : Confession Of A Cia Hitman by MMempire(m): 10:53pm On Sep 15, 2021 |
Bastard CIA. |
Properties › Re: The New Fraud Done By Developers In Lagos (serviced Estate) by MMempire(m): 10:36pm On Sep 15, 2021 |
Scam real estate/property managers and agents. |
Properties › Re: The New Fraud Done By Developers In Lagos (serviced Estate) by MMempire(m): 10:33pm On Sep 15, 2021 |
[quote author=MMempire post=105856887][/quote]Fact! |
Properties › Re: The New Fraud Done By Developers In Lagos (serviced Estate) by MMempire(m): 10:32pm On Sep 15, 2021 |
dipset01: How can i be paying 500k for maintenance fees, is that not almost another house rent in disguise. After paying 40m to buy the house. |
Crime › Re: Have You Been Accosted For Wearing Army Camouflage. Share Your Experiences. by MMempire(m): 2:35am On Sep 14, 2021 |
Wore a snow camouflage trouser a friend gifted me inside my school (higher institution) as per say I stay on-campus. Na so one bastard sojo wey barrack send come do music for my school see me, come tell him friend wey dem dey inside motor dey drive, say make him friend pull over. Na so him come down come dey say make i identify myself. I just tell the otondo say I be NMS graduate, even say I never near Zaria for my life. The idiot come dey yan say were my I.d? I come tell am say I no carry my I.d come campus. The mumu come say him for like make i pull the trouser for there, but him go free me make I no ever wear the trouser again even inside campus. I just they imagine if I no arrange my niggas knack the bastard after if him embarrass me finish. Imagine the fool carry sojo work enter campus. The mumu no know say barrack different from campus. Though, I stop to dey wear the trouser to avoid unnecessary confrontation with the bastard.
PS: snow camouflage no be part of African military wear. Only jungle and desert camouflage. The bastard just wan use me shine. |
Jobs/Vacancies › Re: Hello I Have A New Appk That Will Pay You N50 X 100 Per Day= 5,000 With Free by MMempire(m): 1:06am On Sep 14, 2021 |
Register at your own peril. Why will common app require NIN when not a loan app? |
Agriculture › Re: Do You Desire To Make More Profits In Catfish Farming ? by MMempire(m): 6:20pm On Sep 13, 2021 |
How much? |
Sports › Re: Home Gym Fitness Complete Bench And 50kg Weight Set by MMempire(m): 6:17pm On Sep 13, 2021 |
How much? |
Education › Re: Secondary School Boarding House List For Boys & Girls (Photo) by MMempire(m): 6:12pm On Sep 13, 2021 |
Don't think it's a school in any of our African countries. |
Sports › Re: Recommend Android Streaming App For Live Football... by MMempire(m): 6:06pm On Sep 13, 2021 |
Me too need a good streaming app. I sometimes view live match through SporyBet or 1Xbet app. |
Pets › Re: How To Avoid The Costly Mistakes Experience Dog Breeders Make When Buying A Pup by MMempire(m): 3:38pm On Sep 07, 2021 |
Waiting for my Ekuke. |
Education › Re: Are Beans Carbohydrates Or Protein by MMempire(m): 1:12pm On Sep 02, 2021 |
wealthgoddess: In one of my posts about genetics on this forum I argued that elementary biology or science in general has only been structured to introduce the unlearned mind to the basics in a way that they find it interesting without loosing interest. Realistically, some of what we have learned in elementary science do not always conform with what is present in nature. Not that they are wrong but truth is always complex. Note that. . Back to your question. The simple answer us that beans is a carbohydrate food. Combined with fibers there are about 60℅ - 75% of carbohydrates in beans and just about 25% of proteins. . This is why the choice of textbooks for elementary science is equally as important. "Beans is a source if protein" would be very correct because even at 25%, beans is relatively very high in protein content. . However "beans is a protein" might not be so much on the right lane. . In comparison soya bean which has one of the highest amount of proteins in the 'beans family' has up to 36% protein and 35% carbohydrate. . However when you look at nature, it is very hard for any plant or food to not contain carbohydrates which are like the major components of all organic matter. This is why a percentage composition of other nutrients in sufficient quantity (relatively) regardless of their percentage composition in direct relation to that of carbohydrates, in any food is sufficient enough to say that food is rich in that nutrient. . The logic here is that carbohydrates are present in almost every food, so except they take over 90% percentage composition of that food, we can as well overlook them. . Did you know? Meat is 75% water, 19% protein and 1.2% carbohydrates.... I have learnt new thing today from you. Thanks for the info. All my years as an engineering student, I have never come across such information. Thank you once more. |
Car Talk › Re: VREG: No To Re-Registration Of Vehicles - Daily Trust Editorial by MMempire(m): 8:58am On Sep 02, 2021 |
Tinubu don dey teach Bubu how to generate income like e dey do for Lasgidi. |
Food › Re: What Is Your Favorite Food ? by MMempire(m): 11:43pm On Sep 01, 2021 |
Yam and Egg. |
Crime › Re: Nosa Uhumwangho: Abba Kyari Asked Me To Pay Proceed Of Hotel Into My Account by MMempire(m): 11:37pm On Sep 01, 2021 |
adefitim: Breeze don blow Fowl yansh don open. |
Travel › Re: What’s The Worst And Weirdest Experience You’ve Had At A Hotel? by MMempire(m): 2:29pm On Aug 31, 2021 |
Had a after wedding party at Eleko beach around the Lekki free trade zone. Checked into one of the hotel very close to the beach with a ridiculous high priced rooms (25k per night), only to enter the room and see the mattress being placed on a grave-like structure. On sighting this, many of us said we'll prefer to sleep on the bare floor instead. I personally went to look for the manager and made our observation know, but he told me the ocean breeze do make their bedding structure to corrode, and thats why they now use the tiles structure. Another annoying things was that most of the bathroom lights were not working, the rooms are also not properly litted, worst of it was that we have to wait till around 12am to put on the room A/C. The place looks like a packaged shrine. Fears was all over the place. PS: checked into the hotel at around 9:30pm, so no way we could have seen or notice much of the hotel errors before hand. |
Education › Re: Memes And Facts To Ease Your Stress [photos]♠️ by MMempire(m): 12:26pm On Aug 31, 2021*. Modified: 7:48pm On Sep 01, 2021 |
Cracked me up I must confess. Keep it up bro! |
TV/Movies › Re: What's That Movie You Can't Get Tired To Watch? (Pictures) by MMempire(m): 1:16pm On Aug 30, 2021 |
naturefellow: yes. Impressive. Seeing on YouTube again.
Have you seen Tom Clancy's Ghost Recon? Seen Tom Clancy's Division. Same short action filled movie. |
Celebrities › Re: Top ten World's Longest Bridges In The World by MMempire(m): 12:55pm On Aug 30, 2021 |
China to the world. |
Pets › Re: My Dog Kept Barking At Me Don't Know Until I Goggled This by MMempire(m): 9:44am On Aug 30, 2021 |
dynicks: Instead of mine to do same, it's be staring at me in a manner I don't seem to understand.....
Abeg who knows why this dog is giving me this angry look? Your dog even try. My own dog no even send me again.
|
TV/Movies › Re: What's That Movie You Can't Get Tired To Watch? (Pictures) by MMempire(m): 2:16pm On Aug 29, 2021 |
Best for me.
|
Politics › Re: Tears For Abia State! Efcc Traced N551 Billion To Former Governor Son's Account by MMempire(m): 5:11pm On Aug 22, 2021 |
Werey leaders. |
Career › Re: The Privileged #nairalife Of An Investment Banker With Multiple Side Businesses by MMempire(m): 1:55pm On Aug 17, 2021 |
Oil dey this boy head. Imagine at just 23 years of age. |
Sports › Re: Sure 2odd Can Make You Become Something In Life by MMempire(m): 8:54am On Aug 10, 2021 |
Create a telegram channel and post the link. |
Politics › Re: BUSTED: Buhari Claimed He Couldn't Afford Nomination Form While Paying Millions by MMempire(m): 2:23am On Jul 31, 2021 |
Bubu na bloody liar right from time. Always lying about everything. |
Business › Re: Please How Can I Send Money To Someone In Canada? by MMempire(m): 6:46pm On Jul 26, 2021*. Modified: 7:06pm On Jul 26, 2021 |
Use "Airtm" |
Phones › Re: Xiaomi Mi 11 5G 8GB 256GB Pre-order SOLD!!! by MMempire(m): 9:56am On Jul 24, 2021 |
What about Xiaomi Poco F3? Not the Poco F3 GT. |
|
Crime › Re: *the Largest Bank Robbery In History – About To Happen In Nigeria* by MMempire(m): 7:30pm On Jul 15, 2021 |
This post is one of 10 Best Articles/Writeups on Nairaland that I have come across. Kudos to OP for coming across it and posting it there. |