PAPABOMBOY's Posts
Nairaland Forum › PAPABOMBOY's Profile › PAPABOMBOY's Posts
BABIE ME. O GA OH . MORE GREASE TO YOUR ELBOW. E WA NO JARE, E DON DEY REACH TO CHANGE MY MOLUE. HOW MUCH YOU GO SELL MOLUE FOR ME---STRAIGHT FROM YANKEE |
We know the name nah ARMADA, but nah AMANDA we dey call am for yard because the moto fine like woman. . |
INSPIRED !!! INSPIRED !!! INSPIRED!!! ![]() HMMM!!!!!!!NAH HOW MANY TIMES I CALL YOUR NAME? |
Fly wey no dey hear word, dey follow dead body enter grave. I remember that guy (Abalaka) wey come on T.V say him get vaccine for AIDS----well nobody dey hear of am again. As im dey inject the virus LIVE inside im body--- just to prove say him vaccine dey work---maybe im too don find out say AIDS no be joke. |
Oga wia the VIN for this moto wey all the light dey show for dash. |
@Drekid SWAMP KE!!!! EVEN INSIDE SWAMP SEF, THE MOLUE NAH CHIC MAGNET - -----GO GUARANTEE PLENTY FINE FINE GIRLS - BETTER PEPPER SELLER, BOLI SELLER, EWEDU SELLER, EVEN WORM-MEDECINE SELLER PASS ANY MOTO WEY DEY HERE FOR NAIRALAND. THE MOTO IS TRIED AND TESTED. DEY DIA DEY TALK. MAKE YOU HIDE YOUR BABE WHEN I COME YOUR YONDER, NAH ONE CHANCE STRAIGHT OH ![]() |
Anything to sell moto----whether nah Cayman Island, dealership on Western Avenue abi fake degree. Omo, haba--shame no dey catch you, u dey even fake as whiteee callin your own people baboon. I don hands up oh!! This one too much |
This same Otay guy wey dey sell camry 2007 for 5.4million.https://www.nairaland.com/nigeria?topic=113910.msg1971051#msg1971051 This is almost laughable. Infact your vote of confidence on Inspired rather proves all of una be the same. Inspired please help me sell my molue for 7 million naira https://www.nairaland.com/nigeria/topic-155145.0.html |
Hot air -----(abeg make I go sleep jare). Another case of Lawyer and police forces wantin in on the deal-------abi no be naija we dey. Oga Ikeyman, them say a tiger does not need to declare his tigritude. If you be Super man, show your Super "actions" first without all these undue entertainment on nairaland. |
Inspired, wait make i hear you well well. Nah which one u be----fuk n run dealer, or auto dealer---- ? This cain thing wey make this babe (babe is me) open ya yansh wide open, breeze dey enter am ----nah wa oh. Me I throwe salute to you ----I no say e no easy----person wey fit talk woman out of her money---- come talk romance out of am at the same time----that nah love-vendor be that. Make i see you near my daughter---you fast talker, fast seller and fast fucker------you go hear nwiii!!! |
All this allegations over for one man-----(abi one business name---INSPIRED). MIDAS you sef no do well oh (but I see why you choose Abimbola over yahoo------very humble---- 97 deep n still sleeping in a bedroom with no palour-----but I'm sure other perks dey). Me----even the name yahoo sef, let me know sey the bobo shouldn't be trusted. Yahoo go yahoo yahoo the whole business . ;DLOL!!!But nothing do you jare MIDAS (INSPIRED). We still like your business drive, be it accidented, flood or clean title . KEEP THE FLAG FLYING, remembering that the road is never easy. |
Camry 07 too, nah bad belle jare. |
Dem no born the amu robber well. Nah mad im wan mad!!! Come carry moto nah, matter of fact, come Ajangbadi come steal MOLUE wey dem write PAPABOMBOY on top. Ask for me, I don dey live for area for 37years. Becos e carry jazz for body con hold gun liver don plenty, Kai, see me o!!!!Papa Ijebu, e mi. E no go better for that person wey go remove somethin for my moto, not to talk of remove the WHOLE MOTO where i pack am. I hear say nah only one person don survive death after 3 days. Hope una carry bible too, OLOSHI! |
Oga Foto, me I go hate to see Oga Seun comot you from nairaland. As I no sabi wetin happen, i go say the thing be one cain. Like: Passenger to driver: Nah where u dey drive go driver, why you go see bus stop come pass am? Abi you never see me for my moto? Tenant to Landlord: Oga u don come again with your wahala, which wan be rent? Toilet still dey full after 2years, u never fix am. Abeg make u dress go jare, go disturb the tenant for near your domot. Student to Lecturer: Teacher you wucked oh, why everytime u dey send me go front of class? Anywaay, me I go follow this thread see wetin dey shele, meanwhile any bets? |
lol ;d . |
Una don ready? Go bring koboko come nah nah nah nah. Bring pepper too, plenty pepper, bring cement, with water for side, rope, tire, etc. Oya, OOOOOLLLLLLEEEEE!!!!!!!! |
Oya over to you funkybaby----make i siddon look |
una thank u for the mails, still available |
Nah naija-used space bus be dis? |
"Gorimapa" nah like GPS receiver. Once u shine am well, GPS signal go clear. |
@ Bennygee TRACKING KE, OYIBO WAYO. ![]() NAH WETIN BABALAWO DEY FOR NAH, NO WORK O!!! TRUST ME, THIS BABY WORTH EVERY BIT OF MONEY You SPEND ON AM. @Freshmoney WARRANTY FULL GROUND AGAINST GUNSHOTS, MOPO, YELLOW FEVER, HIGHWAY ROBBERS, -- WHEN You COME I YARN You THE REST. ![]() @Okija. THE MOTO COMOT BEFORE IM TIME. NAH NAIJA-AMERICAN SPECS WITH AUTHENTIC ABA LEATHER AND BIG 28 INCH WHEELS. YOU GO BOW. |
I don join, i don join abeg follow me thank Nairaland dealers wey dey sell moto for triple or fourple the price. Dem do well, elect me as official Nairaland car dealer.OYA, WHERE UNA WEY DEY BUY MOTO? THIS NAH VINTAGE MOLUE, TRIED AND TESTED. YEAR UNKNOWN BRAKE NAH HELELE, TROTTLE - E NO GET TOMMORROW. WHICH ONE BE ALL THIS MOTO WEY I DEY SEE DEY CARRY COMPUTER NAVIGATION-----ABEG KNOCK CONDUCTOR FOR HEAD, E GO SHOW You WHERE ROAD DEY. AC NO DEY, BUT HEAT NO GO CATCH You- AS WINDOW WEY DEY PLENTY WELL WELL. YOU CAN SEE. NAH FOUR OF THESE MOLUE I START TO SELL, ONLY ONE REMAIN. SO IF You DEY SEROIUS, MAKE You HURRY UP MAKE DECISION. ASKING PRICE 7,000,000 NAIRA. ANY QUESTIONS? COME AND SEE THIS BEAUTY FOR YOURSELF. THE MOTO DEY AJANGBADI AND VIN/ CARFAX WILL BE SHOWN AT SIGHT.
|
Fine girl, nahim be say nah good choice u make becos eventually u fit sell CRV for naija fast. I know some Hajia wey dey die for dis moto. Which one be rogue again? Kai madam, u no be rogue so no let Amu robber claim sey u buy moto for them. |
I hear oh, na so moto dey sell. Anyway, me i go drink shine shine bobo! |
700,000 naira for a 1992 USED honda with fabric? Baba o, o ga o! |
Why I go take leg waka rather than buy this cain moto ![]() 1994: Almost 15 years old. Nahim be say moto no be small pickin any more. Eye don open small, so demands go increase for your pocket. Stick shift: For where, nah molue u dey drive? 2 door: Which cain jeep dey carry 2 door? Portable: Pencil nah portable, biro nah portable----this moto, abeg e no even near portable. Description: green --picture nah blue---nah the camera light no worry (psyche). Price: 700,000 naira. Even if nah medi sef e no go work. |
Oga foto, me I go buy the okada now now now now (for where, na credit?----na who dash obioma monkey suit). ![]() Bosha, the wey u dey get accident, e be like sey carfax be option. |
Cold kunu nko? Remember sey nah cold water dey enter fish mouth oh ![]() |
@Oga ono m8k u dey here dey throwe spit 4 ur computer----say blow effry tin. Easy 4 u nairaland blogger since army neva blast ur akpeteshi/ogogoro drinking mouth with shakabula. No go nak Mama Plaintain to release pressure. For me I no say I no be militant----but man wey wan nak my wife, kidnap my pickin con blow my house join, that person go see rambo and Bus Lee sharp sharp in me. So as una dey hide inside water abeg blow effrythin 4 ur papa house, blow ur mama and papa join too for all i care. But the dey una go near Lagos nah the day una go know sey if nah kidnap toddler, we don do am (gbomo gbomo), if nah fuk toto, nah awa expat be dat----whether nah to kill amurobber abi militant sef ---shouting OLE here go show u how jungle justice for Lag dey different from niger delta. |
Oga, you dey yankee u dey holla, come back naija come see die nah. lol. |
I wan buy aeroplane nah who dey sell? |
Pure water!!!! ![]() |
.