PAPABOMBOY's Posts
Nairaland Forum › PAPABOMBOY's Profile › PAPABOMBOY's Posts
Egbon mi!!! e wa no jare. Since you neva sell this moto ----u put SOLD ontop topic. I go help you today---no worry because God don butta ya bread. Me get 600.000 naira wey i don dey save, make i come collect the moto tommorrow? |
[s]Shhh!!!!Cybercafe don close. Nahim be say our resident multiple personality senator dey sleep now. Una fit come out [/s] |
I smell egunje here!!!! Anything for the boys? Kuntash no mind viper dem, million, million. I remember when viper dey sell 300,000-450,000 moto. Then, i still get hope. E don see ajebuter nkc and foto,everything don change. Enough nah enough. |
See them------ flies!!! |
Nairaland's gang of thieves-even INSPIRED TOO? Na wah---dem say green snake no dey hide for grass for too long. E go surely shed im skin one day. Kola the International dupe, nah wetin inspire you to provide bad deal to nairaland customers? |
Student to student talk : Kai---this people again. Boniface, you hear say another Expo don leak? I hope I buy the right one sha. WAEC official to WAEC official : How much distribution did we make this year? I'm looking at a new car if we hit the mark. |
I go use vex buy 10 murano right now, nah wetin. no money oh ![]() |
:'-) . Nairaland Auto Section- the land of the good, the bad and the by-force millionaire. Tank God sey this confazation no happen 4 motorpark becos bolutito go don show u something wey be 5 million. ![]() |
@J-girl. Shey if dem give you genetic enigineering suya u go gree chop? ![]() |
For where----say job dey open for this Lagos and dem neva fill am? Go under bridge for Eko and see how volunteer agbero sef dey filled. Nah where d people dey avartize? |
Top 5 safe place to live for we poor people. 1. Ajegunle-Jungle city: Poor thif headquarters. This nah the area command of thieves. If you wan report a thif recruit, no go police station oh, go here . A recriut found thieving will lose his thieving priviledges and will never thif again. The ultimate price for thieving in this area is jungle justice by shouting OLE!!!!!. 2. Kirikiri: Come see how thif dey die for here nah. Becos of this, plenty thif for Kirikiri dey on reserve and retired status . This nah the only place you go find sey even police sef nah thif. 3. Oshodi: Thif wey no from Oshodi no dey thif from here. Whether nah Alaye oh, abi area father, you go find them in different shapes, tribes and specialities practising some form of thievery. Just show your membership badge (eyes like person wey smoke plenty gbana, severely contoured head, no front teeth, your jagudaness) and you fit tiff the whole oshodi safely all you want. 4. Okota: If you think only strong christains do night vigil, come to Okota after 7 and see wonders. A trial will convice you. . 5. Iyanoba: Awon University thieves. As many hold-ups you jam here, as many thieves dey dis place. This nah where the school for highway thievery dey. Iyanoba School of Thievery offers courses in Applied klept. studies, Mechanical break ins and Stealth robbery all at a no charge sign up fee. So where poor man go live for? |
Women to you are like fine wine------see your mouth. ![]() You don see Iyabo de rarest wine? Go apply nah. |
yahoozee----yahoozee. |
Nah which cain bres news be this---wey bres don carry gonorrhea. |
Chei,you don give me apatenshun oh! How much for the bress,I mean dress? |
---mouth drops honey. . ROFLMAO. Some dey yarn about how sweet thier hubby dey, in front of the hubby korokoro, nah shakara 24-7. |
Oga ToTochoper, just imagine this world with you as superhero---u really no well at all. ![]() @ Sister EFOSA VAL, abeg come back from dreamland Las Vegas, abi nah iyana ipaja. Caribbean ko, carrybeans ni, (as you no sabi spell carebian, make them no reject your visa fast before you even near der) ----Awa local Celestial Church of Christ get romantic beach wedding for bar beach. Everybody go wear white and white, with no slippers ----including mami water, u go see trip faint. @ Aunty Almondjoy. Nah woman like you we dey call, OGA MADAM----I no go surprise if you get calabar for your blood--- say Oga enter kitchen cook for you later. kai---why nah? |
Lovedoctor, Below nah love wey no go ever be. But wetin pali suppoz do to win Propecia heart. watch the video( )http://www.livesteez.com/videos/watch/BWyQJMm |
biodisc :d :d :d. dem don start. |
Make una follow me pray for Sista Gamine. Old woman wey no sabi sey lapa lapa dey chop man hair. Doh sista, make u wash the man hair with Izal three times a day, e go soon get oyibo hair reach im ankles sef. Abi nah you sef dey loose your hair. E be like say men-don pause your yonder. No worry sista, dem say if you can't beat them, make u join them. My own nah hot ororo or adiagbon to shine my bald spots. Once you fadon the thing, even fly go dey follow you up and down. Nahim i dey use shine for mamabomboy, u wan try. Bosha, we both dey pray for hairy mercies though. Make God deliver quick quick. |
Stay away from kpoff kpoff number 1. Eat plenty bitter leaf number 2. Drink agboo number 3. |
kekemaruwa nah my favourite. |
The moto and the price nah ejima------both nah correct. Chei-----if man, get money oh. |
Aunty mi, u no dey fear gbomo gbomo? |
My friend how much e be? You no know sey oil money never finish--not yet, . As the price for crude oil dey $103/ barrel, nahim be say nah profit season we dey. I go personally order 100 of this moto give am yello fever to control traffic or catch amu robber. |
Bomboy or Kpofkpofure,which one you go follow ?[I no sabi wetin im mama see for that name] [s][/s] |
Nahim be sey common sense no dey common----- . Oparisalt upon injury ![]() |
Me go school, for where? When nairaland get ogbologbo like this. See as grama full groud yakata. Abeg, make I copy am quick quick so I go fit tell Molue driver say the thing wey make me charge am 500 naira to patch im tire nah because the tire get ADIYE(fowul)batic compression from overload. |
:'-)