PAPABOMBOY's Posts
Nairaland Forum › PAPABOMBOY's Profile › PAPABOMBOY's Posts
Forget all these legal proceedings, amnesty bull$shit and arrest. I know the likes of Asari &co and its only one language they understand, KILL!!! That he is brazen enough to threaten MY OWN SECURITY AS A CITIZEN AND THE SECURITY OF MILLIONS OF NIGERIANS after growing slobby from the proceeds of the amnesty programme is enough grounds to shoot his mouth off his two-faced head. Next to line to follow is any lazy cow, retired military men and elite who support these groups with firepower and money----fu5ck all the wasted ethnic sentiments and KILL ALL OF THEM cos at the end of the day, they are just in it for themselves not the masses. |
Una say nah wetin him carry for body? No be him padi (Henry Okah) mosquito dey bite for nyash for SA jail for 24years? I disagree, he got it coming soon-Dokubo's days are surely numbered and then una go realize that not even the biggest most die-hard thief(militant)can hold any country at stand still; bunch of coward,jobless crooks [size=10pt][/size] |
@Poster If you sef dey wire am and the thing dey sweet you, she come ask you " do you love it daddy?" I sure say you know the answer to dat. ![]() |
Oh boy wait oh make I hear you well. You mean say if I see this guy dey cruise this moto for road like BIG BOY make I carry my leg waka enter nearest police station go yarn dem? For wetin nah ------"handsome reward" for nairaland. Nah who you think go be the monkey and who go be the banana, me or police? |
Inspire u don begin sell spare parts too , --------abeg make you no go over do oh. Selling fake parts is very lucrative business venture |
Pali, mobile X-ray machines come in different specifications and "tokunbo" is not a detailed and compelling way to describe what exactly you want. For all it's worth, how much are you willing to commit? |
Nah which one u be--------- pastor abi car seller? ![]() Oga I dey wait for the pics oh |
Mutallab don spoil market for drug traffickers |
So nah 20K/day you dey "CHOP" for patrick45:. oh boy, dis ya 25 mins drive for 20k na wa ![]() |
Even if nah one naira, you no go still price am? ![]() Oga Mearsk no mind dem jare. 1.5M for naija used Honda nah serious AWOOF. |
All these trips to the East are telltale signs of unfinished business. Oya @ Platinumk. When be the marriage date jare? Begin talk tru o. Make you no invite us for "mmiri ogwu" before traditional marriage. |
nwachi2:Lol @ hotcake comment . Abi na chop dem dey chop white people there or nah kidnap for ransome? |
Abi the seller enter your domot, knock 4 your door . . . . say you must buy this moto 2day for 1.9m? Ol boy no be by force O ![]() |
N100 still get hope o. If me I get N100 I go buy: 1. 8-10 sticks kokoroh, kulikuli, or donkwa 2. Boli and groundnut (no guguru. . . . e don cost) 3. Rice with ewa agonyi. . . no meat o. . . . . . infact ask for the bones. 4. Akara with hot dundun (fried yam) 5. 5 bags of condense or kunu 6. 2 spoon rice with stew The list goes on. . . |
@ post. What you can eat with N100, . . . mean wetin man fit chop for N100 . . . . e no include belleful. |
Some dog dey detect egbo. . . . . some dey see vision. . . . some nah SHITIVOROUS animal. Oga Oblo wetin be dis ya dog special talent? |
How much last? |
Oga ToTo, I get person wey wan buy dis moto for 1.4, shey you gree? |
Oga ToTo ![]() You no try o, abeg come down small nah make we sef dey see ToTo chop---lol |
Answer: To protect business dis awa hard time. Una know sey awa Maradona General (IBB) get mega oil business for Sao Tome------follow the money ![]() |
Even if swine flu enter naija, the amount of kpomo person dey chop sef---man suppose don build immunity. |
"Corruption flu" . Wetin be the strain? |
Beauty product ke. For wetin nah, say nah hamattan catch you? Abeg dress go jare, hungry never catch you!!! Make una dey there dey ajebotize una post. Ponds ko, eye lotion ni. |
This cain thin dey taya me. See as we dey discredit awa self sha, becos nah whitey nahim be say e betta. Open your eyes people All these oyinbo ass-lickers !!!! Scenario: White man speak Pidgin English (Gets a whole thread on nairaland) Response: The boy try sha! Awa own naija man with thick African accent speak American English. Response: The bobo nah American-wanna-be, fool, olodo buruku,etc *shakes head and walks out* |
Oh boy we go wash am o and ogogoro too no too small. Meanwhile,me go soon send mamabomboy sef go her village. This recession wey evrybody dey hala, begin waya us since i marry am put for house. |
Man must wak ![]() |
Realizing the market here, branches to sell guguru and ekpa to onlookers. ![]() |
You say wetin? Make im add fuel additive to moto wey engine light dey show. Fuel additive wey fit spoil oxygen sensor or blow catalytic converter!!!!! Oga Poster, if you like your moto at all, abeg carry am go mechanic make dem read the computer. No jump from frying pan enter fire oh. |
Me I no know too many things (nah only primary 6 I get-----so man no dey yarn grammar up and down) but I know say: 1. Seller dey Calabar dey operate----meanin say seller neva see moto korokoro imself (check history for other threads) 2. Seller only contact nah cell phone (which fit to change). 3. Moto no get VIN (nah wia dat Monitor Lizard dey sef?) ![]() 4. Price of moto $2900 too too overgood-------especially now all naija dealer eye dey show red like fire 5. MAJOR DEALER for Japan no get contact, no get website, no get name-----nothing. Only account number known only by seller. Abeg ooooo I no fit shout . |
$2900 for Honda 2002 Nah thief !!!! |
Begin talk tru o.