PAPABOMBOY's Posts
Nairaland Forum › PAPABOMBOY's Profile › PAPABOMBOY's Posts
Nah small picken dey really worry you my dear (no worry--- I no go insult you back)When you carry your own for 9mths, put am thru school, give am chop, clothe am, carry am see dokinta when im no well, etc-------all for 15years. Make you come back then, come correct yourself. Dis life we dey live no get duplicate! May his soul rest in peace. |
WHAT ![]() If nah your brother nko? My prayer nah make im too no die like dis b4 you see wetin we dey talk |
Oga Kabloomee, make I be the first to hail you. Welcome to nairaland autos. The land "where all man must wak" or as one professor don talk am nah "survival of the fittest".We get people everywhere so no worry--- the thing go sell, nothin do you. People hia dey for jandon, some Gestapo, some 9ja hia, even some dey vacation right now for Carribean Island ----dey soak awa Ijebu garri with coconut water Not to forget awa dignitaries and local C(t)hiefs. You go soon see dier boi yo yo------siddon small. Oga K, e get one nairalander wey dey answer Keyremotes for hia-----dey stay for Gbagada area. This thing u dey sell now, the guy dey sell am (replacement transponder/coded key) for 20K last -------with delivery for 1K-2K extra. Nah very good guy. But I trust say as you come to "cut down the price", urs go dey extra "gooder". So how e go be sir------because as I dey here now, nah oshuka I carry for one hand---go soon begin sell key. |
Excuse say file too large nah yeye excuse abeg------and you wan make million eh? . You don hear of free online picture resizer? No need to download nothin, just select your picture from your computer to resize am free for internet, finish!!! Bring am down to nairaland standard. These nah only 4 (four) reasons out of plenti wey dey out there. 1. http://www.picresize.com 2. http://www.shrinkpictures.com 3. http://www.resize2mail.com/ 4. http://www.resizr.com/ |
on behalf of all wey no fit call----how much you dey charge? |
Call am well -------power okada ![]() |
Ewu Kambia!!! Make you begin practice meeeeehhhhhh!!! |
Money Laundering ![]() Na today? Just as some dey koro koro sell salvage death traps for high price under guise as clean old papa, virtuous name or big grammar. Nah the nature of the game jare. BOTTOMLINE, MAN MUST WAK!!! |
A whole Etim Essien nahim dem do like small boy like this----- chie!!!! One yeye N100K I-phone dey miss for party ------so now, make dem come sampam my wife nyash well well for I-phone because possibility dey say the way her bakassi look something really must dey inside . Thunder fire dat person!! Sha thank God say me I no get power----- because I for wire three hot slap for the person face wey dem send eh---GBOSA GBOSA GBOSA!!! before I go even tell dem to call Okocha out make I look am well----- tell am say next time im wan disrespect me or my family, make im no invite us come him house at all. This nah disgrace. |
You go tell say she be JJC for checkpoint. ![]() Imagine say nah trailer dey her front------haba, money like this no good oh. Funny thing nah say even if dem raise their salary dem go stay dey harass people for more 20 naira. |
Oga Totochoper, e be like say u don over-qualify for this cain position. People like you go dey marry 3 or 4 wives put for house, still dey find more outside. ![]() |
No die yet o. I know somebody wey dey find fresh male body parts. |
Geesh wan faw you megida. Geesh go karri am faw fluenti fluenti yarinya. I go sell am fah sheven miyyion.
|
Bottomline, VIN nah must ---no yawa. But this nairaland don get feri feri useless pickin sha. Igwe abeg make you tell your Oga make im cover im nyash well well O. We no wan catch asthma attack hia. Eyin peoples, relax. |
----so you wan show ur craw craw nyash? . |
Larez nwoke, All this ya fine fine houses u dey design, e good oh. At least to see awa brotha dey represent us well well. Wetin I wan know nah if you also dey design house for poor people too. Yes oh, we sef wan betta house like your own with big garage to park two or three bicycles and one okada Chimney included ----make smoke no go kill person wey dey roast corn for fire. See awa yard for village need plenty help like the first picture. You sabi work with clay? Anyway, anythin you can do to make us happy, we surely thank God.
|
Cherry Jeep ke. Shey nah Datsun Cherry? |
@ bodieb2005 Oga, u do well o!!! Three gbosa for you. |
Abeg mak una helep old man with highlife 1. The Late Cardinal Rex Lawson: Sawale 2. Rex lawson: Pay me my money now 3. Fatai Rollin Dollar : She go run away 4. Victor Olaiya: Trumpet highlife 5. Nelly Uchendu: Mamausa 6. Stan Plange & The Uhuru Dance Band: Grazing In The Grass 7. Dan Satch & His Atomic 8 of Aba: Baby pay my money 8. Sir Victor Uwaifo: Joromi 9. Eddie Okonta: Kuru kere 10. Rex Lawson: Love Adure |
This awa administrator get Ibo man blood o ---i swear. |
I need one molue too |
Today nah 30 December. Me I think say you go don mark SOLD SOLD SOLD for 1.65m. Abi ya deadline no be 29th December? |
Mak u n ya bruva dey run from monee. |
The moto fine o but my uncle dey hol me monee. I go stop for I'm house, then i go come see the moto. Abeg hol am for me because nah 300k be my widows mite. Help the poor like Saint Vincent. |
Even 19 boys dey fear dat time |
Soundin just like a politician--lol. Question again--mention "one" person wey go after awa corrupt leaders with RESULTS like Ribadu and you go see why them hurry comot am from office. |
Maybe dat nah the reason why some of the people wey dey support Ribadu dismissal only get a few post on nairaland. OLOSHI DEM. ![]() |
Abeg dress go, Ribadu no stupid. You know wetin u dey talk? Stupidity nah person wey think say im fit come fool us for nairaland. Everybody know wetin dey happen. Ribadu nah "stumbling block" to both past politicians wey thief awa money and even aspiring poli"thief"ians. Under Ribadu, even among politicians sef, if you be government official wey chop serious pepper while in office, nah just matter of time you go come answer and dem wey thief know-----body go dey hot in the meantime---hypertension (we all know some of them), no fit sleep for night(lol), worry o ---up and down whether your name dey list. Ribadu try abeg. Question now nah--mention "one" person wey go after our corrupt leaders with RESULTS like am and you go see why dem hurry comot am from office. |
Egbon, I neva see Toyota Xetra before o. Show picture abeg |
8million naira How much be that in DERIKA OF RICE? ![]() |
(shakes head) The more you look the less you see nairaland's TRUSTED AUTODEALERS. |
USA 94 team jare. Una remember when George Finidi score goal, come run go corner begin act like sey im dey piss like dog---- . where that WERE dey sef? |

