PAPABOMBOY's Posts
Nairaland Forum › PAPABOMBOY's Profile › PAPABOMBOY's Posts
Oga proo u welcome o, but abeg make this tory get end of discussion. |
I surprise say Proo, Sultan and Siena never show up, @ Midas02 and Ivvie (nairaland auto internet professors) plus anybody wey dey flash their respective certification. All this una gra gra, una still no fit build una own moto. Una dey here dey slaughter una sef with SAE, ACE, this law, that law sotay person wey dey ask question sef don run, leave una comot. First, I fit tell say una know book well well. Me, nah ordinary vulcanizer i be, but wetin different with me and professor wey go plenty school yet dey stammer up and down nairaland like person wey chop slap from Yellow fever, or the one wey fit nak engine block tory ooooh only to use am sell second hand moto from America. Abeg make una perch. That's why me i like yahoo boys------no long talk. leaves-----rolling tire to the bus stop. |
See oh---Wetin concern amu robbery with blocos again, abi e wound you . Nah young man be that-----You don see how babes dey line up after im show to see am, (all wan become im AFRICAN QUEEN, kai) Abegi, let the bobo live im life jare. Nah the same ones wey dey talk SHOOT BLOCOS nahim dey vex because dem don crase for the bobo finish. Tuface, enjoy your life jo. Next time carry convoy with you wey get seroius shakabula. Armed robbers go know sey nah you -----nothing dey happen. |
Oga Jide, I dey sell used radio/CD player for apongbon and fit sell better BOSE to you at cheap price since your moto no get radio. |
You no sabi the koko? ---------oh boy, nah the motorpark name jare. ![]() Wait nah make u hear Calabar man pronounce am. |
Ashewo bananaaaaaaa. kai, Oga Siena don do am again. Me sef be professional -------professional vulcanizer and e remain small i go soon upload my work for here. I dey specialize in molue, kekemaruwa, okada, wheel barrow, danfo, combi, luxurious, ati be be lo. More to come, no shaking. Again, nice work Oga Siena. |
Whatever happened to baba dudu? |
Oga Viper, me I like this moto no be lie and I sure sey e go be bring better money as kabu kabu. As I dey close to seme border, all my customers go be important people wey get money yanfu yanfu. If i drive this moto eh, Lastma no near me, fear go catch OPC--- dem no go seize my mirror. Yellow fever wan cough? As the moto black so, even dem go think sey na be be Oga kpata kpata for RRS. My Oga, I don save 1,000 naira but I promise to bring the remaining by the end of the year. Abeg help me. |
You dey fine mamiwater for club? Dem plenty for barbeach. |
More fine moto oo! |
Awon internet butta wey neva see biscuit bone abi kpomo chop---- pussy bow-----Ed Hardy.Hahaha. |
;Dsomebody fine your trouble? Haba |
Naija!!!! Where una dey go? This long tory wey una dey call "due process" wey that Ole himself Aondoakaa use to let ex-poli-thie-cians waka, nah una wan use let this chick waka. Again I ask, where una dey go? Hmmm, nah everybody sabi play sense man o. |
Abeg, this una luv wan tintin for nairaland don pass me O---- sotay I no fit tell who be the chaser or the chasee. I recommend Oga Seun to headlight for the main page "Toothless BIG B1 weds im MAMA". ;Yeye people-- Doh |
(As im come out say im be CAPITALIST) I no go surprise sey Oga Seun wan make you settle ground - collect egunje on top money you don see from selling moto on nairaland. . On another note, u sure sey nah yoruba boy be this? |
Una too much book sef, sotay engineer wey neva qualify dey halla for bragging rights too. . Chei----book ohhhh!!!Me kwanu, professional vulcanizer------Ajangbandi no go see beta tire without me. Abeg helep the bobo if u sabi, if u no sabi make we hear word jare. |
Awon Aladura ![]() |
No spoil the man hussle, na vintage be that . |
Oga Oje, ah ah, make we wash the moto nah, which one be your own ? I check one website for the engine number the thing say, ------------The serial number is stamped on a cast pad on the cylinder block. Look on the left side of the engine between the two center exhaust ports (numbers 3 and 5). There you will find the engine serial number. The engine compression ratio is also stamped above the serial number------------------the air flow meter may be in the way, obstructing your view of the serial number. The air flow meter may need to be disconnected and/or removed. However, if you have a flashlight and the right angle, you should be able to find the engine serial number. http://www.motorcarsltd.com/technician-tips/landroverengine.asp Basically Oga you go need to take some parts out to find the engine number. The thing go dey close to the back of the engine. |
Shey nah new parts eh? Oga, wetin be the vital part una change? |
For where, last I see Oga Viper nah for ceme border when we go bring moto come. E tell me sey e get one nairalander wey dey find cheap moto. If I recall, the person live for yakudima and im want Honda bulldog. this one wey im mama die nah news o. |
I swear money really dey disgrace person for we yonder. Chei, see moto, see whitie. Man don die for this world o. I go cry o. Omo nna (Oga okeyjazz, no vex), make you show us the latest Okada too nah. You don forget sey this nah luxury too? |
My brother, if you wan save owo/raw cash I go suggest you get the paint code yourself for your moto, unless you wan paint the whole car another color. Through this code you fit buy the correct paint wey the panelbeater go use for your door. Abeg, no let them open office for your head o. |
Oga Ivvie, your grammer no get to be continued I swear. Abeg, make you suffry suffry my oga, which one you talk say moto nah mecha gini? I don lost since yesterday. Obodo oyinbo wey you dey, take enter school dey begin dey scatter grammer beyond scatterable you don forget sey hunger dey tear awa belle 4 naija? The bobo ask question because im wan fix am for cheap. My Oga, for Ajangbadi wey man dey, I go tell you sey almost all the mechanic for area nah drop-out like me. Nah condition make Sikira get belle, make Kalu enter Gabon begin answer head of state. But 9 out out 10, them no really go school unlike you. Although them sabi work but by trial by error. Oga give us this terminal program make we know wetin mechanic go fix abeg. |
Viper,Bomboy go wash inside and outside your moto u no go know which one be which.I trust my son,professional. @Yanga rat my brother long time, this one you follow me enter internet I know say that your okada don dey act up again. My Oga everly, nah yesterday I go see dokinta wey tell me say the tusa tusa inside your pami nahim give me typhoid. I go bring bill wey him give me tomorrow. |
Mr Viperman, how are you sir? How is madam, she let you sleep lastnite? Pickin nko? Ehem, my Oga, e get one other thing wey i wan yarn with you. I no tell you say my pickin BomBoy don reach age to work and I wan send am to you to learn sell moto. Nah very good pickin and all im teeth never fall. So that one let me know say im no dey fight when i no dey house. Oga I don tire Area rough and the wey i dey look e be like say im go spend christmas for your place the wey you dey sell motor Pls, Bomboy nah professional vulcunizer, una fit need am Abeg help |
Baba monivator! We go wash am oh. Nah who talk say good thing no dey happen for person wey dey wait? Your own good jare, enjoy. Me sef wish I no dropout from primary 6. I for use grammer too dey opress for nairaland. I sure say you dey single. All that time you don spend for Nairaland SEXUALITY/ROMANCE/ DATING section. Anyway, you deserve am. |
Wetin me wan know nah who take this cain picture in this first place? Im for edit the pic with photoshop. Na so the omo turn around for picture like alangba wey dem wan stone. From her back, any ass connoisseur go fit tell say dat nyash don chop slap tire sotay e don loose im supple. (Hint, Jayon) And this nah private picture, wey man suppose look from time to time dey tell im omo say she fine regardless. Make I yarn you. With her mismatch bra and panties set (Ist & 3rd pics: bra nah black, pant nah brown, 2nd pic top nah pink, pant nah red), face deluged with pimples, back unsightly with love handles, hair wey I no know whether she wan fry am or roast am, against all these odds, guy man go still nak am, nak fine into her brains. Nah why you think say she dey call herself model? She is being disillusioned by the wood. But in all sincerity, what really matters the most out of all is her HEART. |
Pls,i'm professional mayguard from Maiduguri,lookin for vacancy in your boysquarters. All these million naira houses I will keep eyes wide with my trained dog bingo.Pls hire. Thank you. |