₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,329,406 members, 8,440,449 topics. Date: Tuesday, 07 July 2026 at 04:19 AM

Toggle theme

Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl - Romance - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralRomanceYour Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl (5576 Views)

1 2 3 4 Reply (Go Down)

Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Geminita1(op): 6:11pm On Jul 01, 2022
Why your mama no go fine but you wan marry fine girl? Your mama get fine face? She get flat tummy? She get hips and soft skin? Her voice cute? Her hair long? She neat? Her breast still stand? Her legs nko?

But you wan make your girl correct from top to bottom? You wan the finest face, the biggest backside, the best curve?

You want aje when your mama na Iya Tafika with two left legs and zero waste line cheesy

Abeg make everybody no demand pass wetin their parents be. Abi I lie?

Thank God say my papa hold, fine girls like us na confam oyoyo dey pursue us. grin

I repeat if your mama no fine, you no get right to any standard, go find your type.

If I vex you, abeg rest!
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Shalommy(f): 6:15pm On Jul 01, 2022
If person mama no fine, na to marry person wey fine so as to correct the worwor error. Chaii.. cheesy cheesy
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 6:19pm On Jul 01, 2022
Small play o, u change am to vawulence..

Team inner beauty BTW
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 6:20pm On Jul 01, 2022
Correct cheesy cheesy
Them want babe way get big nyash, but their mama nyash flat like plasma. cheesy

Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Ritzybeauty(f): 6:29pm On Jul 01, 2022
You this girls, una wan put person pikin for deep thinking.. Lol
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Itzurboi(m): 6:31pm On Jul 01, 2022
Call for backup, over.
Zonefree over (aerial attack)
Kollins11 over (ground support)
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by 9182736455O1999(m): 6:35pm On Jul 01, 2022
Make i tanda for this thread wait for the Vawulence.

Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 6:40pm On Jul 01, 2022
Even if the man mama is ugly, let the wife to be a virgin, loyal and virtuous as the mama. No be only beauty most men dey find. My submission is for men that believe in marriage, not for me because I don't give a fucck about it.
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Prettygirl200(f): 7:21pm On Jul 01, 2022
Chai this girl see vawulence LOL u made me laugh honestly grin grin grin all these broke as redpillers now go avoid this thread!!!! Lol
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Silentgroper(m): 7:38pm On Jul 01, 2022
Beebah2000:
Correct cheesy cheesy
Them want babe way get big nyash, but their mama nyash flat like plasma. cheesy
tah! Forget that side. Mum c carry for back wella, ask my p.man..

But y u dey jealous big nyash women like this..

Shey i no go carry u go do BBL like this, mke u dey alright tongue
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by newdawnlive: 7:50pm On Jul 01, 2022
your baba no get weelbarow but u want to marry a guy that's using Benz
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Sukkyy2010: 7:53pm On Jul 01, 2022
This wan dey try justify her worwor predicament. E be like sey guys don show her shege angry
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Hamzaaaaaaaa(m): 7:56pm On Jul 01, 2022
Your papa na tenant for your uncle house,but you dey look for husband wey don build mansion
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Jeon(f): 8:09pm On Jul 01, 2022
lolz.

And one was crying when I stated my desires. He said that's a double standard grin

Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by KyberTHEGREAT(m): 8:22pm On Jul 01, 2022
Geminita1:
Why your mama no go fine but you wan marry fine girl? Your mama get fine face? She get flat tummy? She get hips and soft skin? Her voice cute? Her hair long? She neat? Her breast still stand? Her legs nko?

But you wan make your girl correct from top to bottom? You wan the finest face, the biggest backside, the best curve?

You want aje when your mama na Iya Tafika with two left legs and zero waste line cheesy

Abeg make everybody no demand pass wetin their parents be. Abi I lie?

Thank God say my papa hold, fine girls like us na confam oyoyo dey pursue us. grin

I repeat if your mama no fine, you no get right to any standard, go find your type.

If I vex you, abeg rest!
Your papa no get money buh you dey find man wey get money
Your papa na pot belly but you dey find man with 6packs
Your papa no get beards and pink lips with broad chest
But you dey find man we get those attributes and more

You be ozuor (spits)
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 8:38pm On Jul 01, 2022
Silentgroper:
tah! Forget that side. Mum c carry for back wella, ask my p.man..

But y u dey jealous big nyash women like this..

Shey i no go carry u go do BBL like this, mke u dey alright tongue
so, u dey look your mama nyash?
Blood of fowl....!! shocked shocked
Jeez, you deserve to be flogged. angry

Who tell u tell u say I dey jealous girl way get big nyash? Abeg, no talk wetin I no dey do ooo.
No need for BBL, I love my natural butt. tongue

Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by helinues: 9:51pm On Jul 01, 2022
Hahahahaha

Werin be this now

cheesy
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Streetmovement(m): 9:53pm On Jul 01, 2022
Wotoporiously cool speaking

Mumu cappings, na you go tell me wetin I suppose dey find ? Bleep out of here
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 9:54pm On Jul 01, 2022
What manner of savagery is this?

Rivers of tears on this thread already grin grin . I'm loving it smiley

Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 10:02pm On Jul 01, 2022
newdawnlive:
your baba no get weelbarow but u want to marry a guy that's using Benz
cheesy

Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Geminita1(op): 10:12pm On Jul 01, 2022
Prettygirl200:
Chai this girl see vawulence LOL u made me laugh honestly grin grin grin all these broke as redpillers now go avoid this thread!!!! Lol
My girl grin
Those redsufferhead people Don cast, na una still dey give dem level
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by blinking001(m): 10:13pm On Jul 01, 2022
Beebah2000:
so, u dey look your mama nyash?
Blood of fowl....!! shocked shocked
Jeez, you deserve to be flogged. angry

Who tell u tell u say I dey jealous girl way get big nyash? Abeg, no talk wetin I no dey do ooo.
No need for BBL, I love my natural butt. tongue
Now i get why you're always bitter grin. All this small yansh people.
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by blinking001(m): 10:15pm On Jul 01, 2022
Hamzaaaaaaaa:
Your papa na tenant for your uncle house,but you dey look for husband wey don build mansion
This got me rolling on the floor. grin
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Geminita1(op): 10:15pm On Jul 01, 2022
Hamzaaaaaaaa:
Your papa na tenant for your uncle house,but you dey look for husband wey don build mansion
See mumu o cheesy
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Prettygirl200(f): 10:15pm On Jul 01, 2022
Geminita1:
My girl grin
Those redsufferhead people Don cast, na una still dey give dem level
Exactly sweetie I love that vawulence!!
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 10:35pm On Jul 01, 2022
blinking001:
Now i get why you're always bitter grin. All this small yansh people.
see your long teeth. U get big nyash? huh
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by blinking001(m): 10:42pm On Jul 01, 2022
Beebah2000:
see your long teeth. U get big nyash? huh
A girl with an a.ss like yours have no right to ask me questions. Hell no...
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Silentgroper(m): 10:46pm On Jul 01, 2022
Beebah2000:
so, u dey look your mama nyash?
Blood of fowl....!! shocked shocked
Jeez, you deserve to be flogged. angry

Who tell u tell u say I dey jealous girl way get big nyash? Abeg, no talk wetin I no dey do ooo.
No need for BBL, I love my natural butt. tongue
Lol. E no get way wey u no go notice big nyash na. Na u dey reason am like that.

na lie.. Y u no drag men wey dey like big breast abi na only nyash men dey like.. U dey jealous, admit am..

Good for u. Is that ur butt though?
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Silentgroper(m): 10:50pm On Jul 01, 2022
blinking001:
A girl with an a.ss like yours have no right to ask me questions. Hell no...
Leave her.. I like that ass like that. Though i'll persuade her to eventually do a BBL
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 11:15pm On Jul 01, 2022
Silentgroper:
Lol. E no get way wey u no go notice big nyash na. Na u dey reason am like that.

na lie.. Y u no drag men wey dey like big breast abi na only nyash men dey like.. U dey jealous, admit am..

Good for u. Is that ur butt though?
no ooo, no be my ass ooo.
80% of Nigerian men dey like big nyash. tongue

Jeez wetin be your problem?? undecided
I tell u say I no dey jealous. undecided
Believe me
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Nobody: 11:25pm On Jul 01, 2022
blinking001:
A girl with an a.ss like yours have no right to ask me questions. Hell no...
u don dey shame to answer my question because u get flat nyash grin
Re: Your Mama No Fine But You Wan Marry Fine Girl by Silentgroper(m): 11:32pm On Jul 01, 2022
Beebah2000:
no ooo, no be my ass ooo. 80% of Nigerian men dey like big nyash. tongue
Jeez wetin be your problem?? undecided I tell u say I no dey jealous. undecided Believe me
80% hahahaha grin .. Na u do d census tongue ... Na u kuku sabi..
Lol. I believe u tongue .. oya when u want mke i carry u go do BBL tongue
1 2 3 4 Reply

I'm A Fine Girl, I'll Get Married To A Fine Man So My Kids Will Be Fine - LadyMention One Tin Wey No Fine, But E Dey Sweet.Check If Your Mama Dey Among The Girls This Man Go Bonk That Night (PHOTO)234

Lady Shares Very Scary Encounter With Her Dead Friend Who Visited Her (pic/vid)Big Mama, Big TroubleNon-Igbo Guys: Do You Avoid Marrying Igbo Girls?