Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,155,896 members, 7,828,160 topics. Date: Wednesday, 15 May 2024 at 03:52 AM |
Nairaland Forum / SapeleWater's Profile / SapeleWater's Posts
(1) (2) (3) (4) (5) (of 5 pages)
Romance / Re: Asian Girl Looking For Black Men by SapeleWater(m): 6:48am On Apr 19, 2016 |
The person wey get those pictures name na Riho Sayashi, one Japanese celebrity like that. And na Moonraker dey use the Chinese girl account. Dominique, you need to ban am. Google Riho Sayashi if you doubt me. 2 Likes 2 Shares |
Romance / Re: Should He Forgive Her After She Threatened To Poison Him? by SapeleWater(m): 6:34am On Apr 19, 2016 |
Ha! God sef no go forgive me if I forgive her. |
Romance / Re: Guys Talk: What's Your Favourite Alcoholic Drink And Why? by SapeleWater(m): 2:16pm On Mar 02, 2016 |
sinaj:I dey use durex condom |
Romance / Re: Guys Talk: What's Your Favourite Alcoholic Drink And Why? by SapeleWater(m): 1:19pm On Mar 02, 2016 |
Soldier root or monkey tail, especially when I wan nyash Ejiro |
Career / Re: What Do You Tell Your Current Employer If You Want To Go For Interview Elsewhere by SapeleWater(m): 11:26am On Feb 23, 2016 |
ndujekwu:You no go tell am anything. Just go home but no come work the following morning. Then call am tell am say you no well and dem wan admit you for two days. But no give am any hospital name o. 1 Like |
Romance / Re: A Guy Just Told Me " I Virtually Threw Myself At Him" ( Pictures Attached) by SapeleWater(m): 10:29am On Feb 17, 2016 |
You throw yourself at him. Na wa o! You be stone? |
Family / Re: What Are The Weirdest Things You've Seen Your Kids Do? by SapeleWater(m): 12:27pm On Feb 06, 2016 |
Larablink:And the boy no lie o |
Family / Re: What Are The Weirdest Things You've Seen Your Kids Do? by SapeleWater(m): 12:19pm On Feb 06, 2016 |
I remember when we dey play ball (monkey post) for street and my mama come say make I dey look after my small sister wey dey about 1 year. As e come reach my set to play, naim I use one basket cover my sister come carry one big stone put on top so dat she no go fit escape. My mama come back begin cry 20 Likes 3 Shares |
Crime / Re: Uyo Weed Smoker Chained To A Chair (Photos) by SapeleWater(m): 3:53pm On Jan 19, 2016 |
E no go beta for the people wey tie this boy dey disgrace am like goat so! 1 Like |
Celebrities / Re: Rich Guy Iceprince's Girlfriend Cheated On Him With Shares Revealing Photos by SapeleWater(m): 9:33am On Jan 19, 2016 |
Na another guy, Obinna, and Ice Prince get the kasala from the start. See the real story here: Maima post this pinshure where she and Ice Prince dey inside car, Obinna come yab am say but she dey cheat with a married man (Akin). [img]http://1.bp..com/-0XZqel8YbPM/Vp3nSfCUduI/AAAAAAAIChY/p_Ip64bVJ7Y/s400/Capture.png[/img] He come post different pinshures wey de babe snap for de same area wey Akin snap pinshures too. And as I take look am, na Obinna dey snap these pictures. [img]http://4.bp..com/-mPO_JTmigRk/Vp3kb5pZpxI/AAAAAAAICfw/widv-2KpBO0/s1600/1.jpg[/img] [img]http://3.bp..com/-4sKyXHLpr_o/Vp3kdviUoyI/AAAAAAAICf4/UV7MZmMU6fM/s1600/2.jpg[/img] [img]http://3.bp..com/-TMp_sFtehQQ/Vp3kd2SPnEI/AAAAAAAICf8/2OxhqrCNziM/s1600/3.jpg[/img] Na wetin make Ice Prince make this comment: [img]http://4.bp..com/-tYeFLtV9ss8/Vp3l6tqZcDI/AAAAAAAICgk/R9uSMh6IlXk/s1600/3.png[/img] [img]http://1.bp..com/-ZK3yhd_cj1Y/Vp3l7N1qTAI/AAAAAAAICgo/OQW3Fpubo1c/s1600/4.png[/img] Obinna too come reply with pinshures of him and Akin to clear Ice Prince apollo [img]http://1.bp..com/-vL3fiVJZEzA/Vp3liLD5aUI/AAAAAAAICgY/jt1odxy_8sM/s320/Akin.jpg[/img] Ice Prince come begin act like werey as e don clear for him eyes [img]http://2.bp..com/-VulYOmSQKfM/Vp3l7vUQuuI/AAAAAAAICgw/wQMyTw5X58s/s1600/1.png[/img] [img]http://3.bp..com/-wq-6zqT5ZnQ/Vp3l8VViwBI/AAAAAAAICg4/ZfxY0pbbt8E/s1600/2.png[/img] [img]http://2.bp..com/-9vNZ4s6b1Eo/Vp3mvTax-jI/AAAAAAAIChQ/9DH5jO9ZQLc/s1600/9.png[/img] [img]http://4.bp..com/-aq1Bw3Qj0k8/Vp3mdHfTG9I/AAAAAAAIChI/TYG_smaL070/s1600/8.png[/img] My own understanding be say the babe, Obinna and Akin naim plan to kick Ice Prince out of the game 9 Likes 1 Share |
Family / Re: Dearest Nigerians, People Are Suffering.. Read This! by SapeleWater(m): 10:22am On Nov 07, 2015 |
EggovinMma:Babe, I gbadun u wella. God bless you 2 Likes |
Romance / Re: Men And Boobs by SapeleWater(m): 8:01pm On Oct 29, 2015 |
The kind topics wey I dey see for FP nowadays dey make me feel say dem dey do NL mods dem 1 Like |
Travel / Re: Some Funny Slangs Used In Warri by SapeleWater(m): 12:18pm On Oct 29, 2015 |
Lashing don expire na. Na "gbensh" dey on board now Fabu - lie Kawa or piam - run Kpro - calm down Kpakpa - smoke marijuana Shenkiz or curry - chic Shedas - money Odinga - babe wey carry belle 15 Likes 4 Shares |
Romance / Re: Married And Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 11:53am On Oct 22, 2015 |
hereiam:She been no dey yab when my bro's still dey date am |
Romance / Re: Married And Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 11:07am On Oct 22, 2015 |
hob:No be only u. But shey u go pursue her if na ur wife? |
Romance / Re: Married And Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 10:54am On Oct 22, 2015 |
Lalasticlala, how I wish say u fit help me move dis ministry to the appropriate site |
Family / Re: Married and Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 10:48am On Oct 22, 2015 |
armyofone:Hahahaha! Na my style be dat o, sis. English fit cause trouble |
Romance / Re: Married And Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 10:47am On Oct 22, 2015 |
hob:Bros, no be joke |
Romance / Married And Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 10:36am On Oct 22, 2015 |
Something happen between my elder brother and him wife and their inlaw last Sunday wey teach me correct lesson. Dem marry on the 3rd of dis month and just one week after their marriage, my brother run comot for house unto say the wife dey nag too much. Na so the wife begin cry dey call my people say her husband no gree show for house for the past 3 days. She talk say she know say na her mouth cause am but she ready to change if my brother come back. She call my momsy, call me, call their pastor. She say don call him number taya but my brother no dey gree pick. If she use another number call am, the moment he hear her voice the line go cut. I later find out say my brother dey go squat with one of him od time friend. Na from there he dey take go work too. When I ask am he tell me say no man fit follow him wife live for house one day without headache. I tell am say e no make sense, say another man fit go dey gbensh the wife for corner o, and na still rainy season we dey. He say e no concern am. So to cut the tory short, the father inlaw (dat is the girl papa) and him wife drive all the way from PH to Waff Town on Sunday because of this mata. Dem don already inform my bros say dem go show for him house. So after church na so all of us waka go my brother house to go judge mata. Na the mother inlaw first talk. After she don advise dem finish she come tell her daughter to apologize to my bros. The girl kneel down, begin apologize but my bros still dey frown. Na the father inlaw come handle the mata with one small but mighty drama. He just look my bros for face, tell am say. "My son, women wahala too much. Na dem be the devil wey we take eyes see. No be only my daughter get bad mouth, even my wife here naim worse pass." The papa never even talk finish when the wife begin rake. Her voice nearly tear ceiling sef, even my brother open mouth dey look. But as she still dey rake, na so the baba come stand up begin pamper her, dey tease her with sweet words. And na so the woman take calm down too. baba come begin hug him wife like baby for our present. Everything be like film. Then the baba come look my brother again say "I don talk finish. I don dey go. Bye bye." |
Family / Married and Unmaried Men Suppose Read Dis by SapeleWater(m): 10:28am On Oct 22, 2015 |
Something happen between my elder brother and him wife and their inlaw last Sunday wey teach me correct lesson. Dem marry on the 3rd of dis month and just one week after their marriage, my brother run comot for house unto say the wife dey nag too much. Na so the wife begin cry dey call my people say her husband no gree show for house for the past 3 days. She talk say she know say na her mouth cause am but she ready to change if my brother come back. She call my momsy, call me, call their pastor. She say don call him number taya but my brother no dey gree pick. If she use another number call am, the moment he hear her voice the line go cut. I later find out say my brother dey go squat with one of him od time friend. Na from there he dey take go work too. When I ask am he tell me say no man fit follow him wife live for house one day without headache. I tell am say e no make sense, say another man fit go dey gbensh the wife for corner o, and na still rainy season we dey. He say e no concern am. So to cut the tory short, the father inlaw (dat is the girl papa) and him wife drive all the way from PH to Waff Town on Sunday because of this mata. Dem don already inform my bros say dem go show for him house. So after church na so all of us waka go my brother house to go judge mata. Na the mother inlaw first talk. After she don advise dem finish she come tell her daughter to apologize to my bros. The girl kneel down, begin apologize but my bros still dey frown. Na the father inlaw come handle the mata with one small but mighty drama. He just look my bros for face, tell am say. "My son, women wahala too much. Na dem be the devil wey we take eyes see. No be only my daughter get bad mouth, even my wife here naim worse pass." The papa never even talk finish when the wife begin rake. Her voice nearly tear ceiling sef, even my brother open mouth dey look. But as she still dey rake, na so the baba come stand up begin pamper her, dey tease her with sweet words. And na so the woman take calm down too. baba come begin hug him wife like baby for our present. Everything be like film. Then the baba come look my brother again say "I don talk finish. I don dey go. Bye bye." 2 Likes 1 Share |
Celebrities / Re: Don Jazzy Shows Off His "Wifee" On Instagram, Funny Replies Followed The Post by SapeleWater(m): 11:57am On Sep 01, 2015 |
firstEVA:So which person level the babe go fit? |
Celebrities / Re: Don Jazzy Shows Off His "Wifee" On Instagram, Funny Replies Followed The Post by SapeleWater(m): 10:31am On Sep 01, 2015 |
firstEVA:So na because she be presenter make her level pass Don own? No way |
Celebrities / Re: Don Jazzy Shows Off His "Wifee" On Instagram, Funny Replies Followed The Post by SapeleWater(m): 10:13am On Sep 01, 2015 |
firstEVA:U no serious |
Romance / Re: Cutehector Is A Re.tard Nd Shouldn't Be On NL! by SapeleWater(m): 8:12am On Sep 01, 2015 |
Durent:U don already disgrace urself. Many pple here dey laff u 2 Likes |
Romance / Re: Cutehector Is A Re.tard Nd Shouldn't Be On NL! by SapeleWater(m): 8:07am On Sep 01, 2015 |
Durent:U need am. Go find work 2 Likes |
Romance / Re: Cutehector Is A Re.tard Nd Shouldn't Be On NL! by SapeleWater(m): 7:55am On Sep 01, 2015 |
Durent:I no know where u dey stay but e get one factory wey dem just open for PH. Dem dey pay 35k per month |
Romance / Re: Cutehector Is A Re.tard Nd Shouldn't Be On NL! by SapeleWater(m): 7:42am On Sep 01, 2015 |
Nairaland be like this world. If everybody dey normal, e no go sweet |
Celebrities / Re: Don Jazzy Shows Off His "Wifee" On Instagram, Funny Replies Followed The Post by SapeleWater(m): 7:36am On Sep 01, 2015 |
firstEVA:Say her level pass Don own or na her age? 2 Likes |
Romance / Re: Guys, Can You Marry A Taller Woman? by SapeleWater(m): 7:33am On Sep 01, 2015 |
cyprus000:Oga, na my choice. As me no be short man, I no fit marry woman wey go dey see on top my head. E no make sense to me. |
Romance / Re: Guys, Can You Marry A Taller Woman? by SapeleWater(m): 7:20am On Sep 01, 2015 |
Instead of man to bend down kiss him wife, na wife go bend down kiss husband. Wey I no be Aki and Pawpaw...God forbid |
Family / Re: How One Small Girl Take Play Me Yesterday Afternoon by SapeleWater(m): 7:16am On Sep 01, 2015 |
Joromi1:Thanks, boss |
Family / Re: How One Small Girl Take Play Me Yesterday Afternoon by SapeleWater(m): 3:13pm On Aug 31, 2015 |
naijathings:Na reality, no be Nollywood |
(1) (2) (3) (4) (5) (of 5 pages)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 58 |