₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,276 members, 8,449,532 topics. Date: Tuesday, 21 July 2026 at 11:14 PM

Toggle theme

Sinistami's Posts

Nairaland ForumSinistami's ProfileSinistami's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 19 20 21 22 23 (of 23 pages)

CultureRe: Whats The Difference Between Warri Pidgin And The Standard Nigerian Pidgin by Sinistami(m):
Warri pidgin na only Lagos people de feel se e hard
Untop say dem own weight no touch half levuls weh wafi deh. Buh we we nigerdeltans no say e no hard laidat. Minus play ehn wafi pidgin wetin deh make im Hans sound like dat na bi seh e still de use somekain old word dem fo pidgin weh other city dem no deh use plus accent and slang dem weh e deh bring every day. Note Porthacourt Benin and yenagoa people fit hear am wella.
CultureRe: Whats The Difference Between Warri Pidgin And The Standard Nigerian Pidgin by Sinistami(m): 9:07pm On Mar 02, 2018
[quote author=Efewestern post=65505242]lol.. okay interpret the following.

1. "Okon today en, everywhere burst, na so boys just dey root kala from all angle b4 kpokpo show men don chokin"

2. "Oshare d opko I sight 2day en bam die, base on say I no feet shoot bird mama fly, I nack am. "

Warri pidgin is also influencing All pidgin in NEeria, due to it's influence and popularity. [/
quote]
Easy but I'll translate it in my yeniz pidgin (yenagoa pidgin).
1 Okon todey ehn kasala bolo nai men-dem burstat alagba (Kala) fo all angle b4 Ojo lap men don gbaga.
2 Aboby d Ozed weh ai sait tude ehn make die se'ko'se (sake of say ) kpai kpai GATS jump na ah loot am.
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 8:01pm On Mar 01, 2018
Cameroon pidgin is like a different but related language to naija pidgin they both share the same mother language English. I Iiking it to the relationship of urhobo and Isoko to Edo their mother language and Spanish and Portuguese to their mother language Latin.
LiteratureRe: Why Baba Polina No Dey Do Hunta Again. by Sinistami(m): 9:12pm On Feb 28, 2018
Jakumo:
Sinistami you no lie. Yernagoa and Warri broken, na dem be king. We all when remain dey follow ona for back. Na Edo broken dey easy for we.
No-oh Edo own sef folo join weigh wella like jinin tin-dem fo jinin place. Di one weh wi de look say easy die na lagos own.
CultureRe: Whats The Difference Between Warri Pidgin And The Standard Nigerian Pidgin by Sinistami(m): 6:04pm On Feb 25, 2018
yes from yenagoa bayelsa
CultureRe: Whats The Difference Between Warri Pidgin And The Standard Nigerian Pidgin by Sinistami(m): 8:04am On Feb 24, 2018
Rexia:
I don't think the question I'm asking is silly.I'm a Cameroonian but I think I can really understand warri pidgin.But I dare not speak mine cause if I do, everyone here will get confused trying to understand what I just wrote.
Warri pidgin isn't as hard as they all say
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 8:02am On Feb 24, 2018
Rexia:
A say eh ma paddy man you dey na how? You monch na weti do mornin time?
WUS kain news na
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 1:31pm On Feb 22, 2018
Rexia:
It's not really like another version.It's just different.We usually call it mboko pidgin.Because it is mixed with words from mboko and pidgin.This is why most Nigerians wouldn't understand it.
Try me they were many of my relatives in Cameron and they came back during the bakasi crises they brought back what my dad called Bad pidgin grin and I picked it up somehow. So Abegi yan us small Mboko pidgin make dis Bayelsa boy hear.
CultureRe: Whats The Difference Between Warri Pidgin And The Standard Nigerian Pidgin by Sinistami(m): 7:39pm On Feb 18, 2018
To me warri pidgin isn't qs hard as others say it is. To me the only thing great about it is the Accent and some of their slangs Iam from yenagoa and there is nothing a warri person will say that a yenagoa person won't understand.
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 5:08pm On Feb 18, 2018
Yenagoa pidgin slangs
Wida: somewhat of an insultive way of greeting depends on the context means whatsup or whats wrong with you be careful some people dont take it lightly when you say to them Wida you
Banny, CHinkins, bitchise kpass, Ageli A'be(bae): girl
Aboy, Aboby Ogopi: boy
how e de be: whats up
Robs, List:money
Ozed: Prostitute
Okpolor: Phone
Oguaja: odd job
Gba: work
Gba/Gbaga: run
Injeke: Untrue Story
Wet,Oil,Press,Loot:sex
Fall: kill/die
Ofiolor: backdoor
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 9:12am On Feb 18, 2018
[quote author=Nicheey post=65147900]pidgin varies in different forms and dialect, nice yenagoa has thiers,buh seriously i'd stick to warri dialect,e too good[/qwas Yenagoa is a little near Warri so we have lots of influence from Wafi pidgi. We too speak a lot of pidgin yenagoa was even Listed five on most pidgin speaking cities in Naija. But we still cut cap for Warri pidgin shaa.
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 9:00am On Feb 18, 2018
Nicheey:
tfhuh its beautiful
Too beautiful
CultureRe: The Origin Of Ìyàwó by Sinistami(m): 8:55am On Feb 18, 2018
Good to know
TravelRe: The Ten Most Notorious Neighbourhoods In Lagos by Sinistami(m): 12:17pm On Feb 17, 2018
johnoris:
Bros.... Calm down.... Shey warri boy fit come ajegunle com dey form strong head niii.... Everyone of them is at their best... When they are in there hood and with there homies
no bi dem warri boys dem make Ajegunle hot. Na dia Nigerdelta peepsdem boku Yakata. Abobi Wida na.
TravelRe: The Ten Most Notorious Neighbourhoods In Lagos by Sinistami(m): 12:13pm On Feb 17, 2018
This is every day life in Yenagoa Portharcourt and warri.
TravelRe: 10 Cities In Nigeria Where Pidgin English Is Most Spoken by Sinistami(m): 12:01pm On Feb 17, 2018
Well for facts I know bayelsa isn't as homogeneous as people think it is its my home state and in yenagoa they are many people who speak nothing other than pidgin I used to be one of dem. cheesy grin grin
CultureRe: Nigerian Pidgin English And Their Meanings by Sinistami(m): 11:55am On Feb 17, 2018
Nicheey:
To begin with ,there are different dialect of pidgin(warri pidgin ,ekpoma pidgin etc)

But generally we could say "I heart you" the heart there simplifies the "love" .or luff ,loff ,heart. All simplifies "love.

How to say when you're in a relation in pidgin could be hard though ,remember there's different dialect of pidgin.so assuming I'm using warri dialect I'll say "me and dha girl get parol"."parol" there simplifies the relationship.

Bobo for you to learn nigerian pidgin you gotta be precised on the dialect ,or else your brain go jam .

Sha happy new year brodha
In Yeniz or Yenagoa pidgin we say Dread for love Eg i dred yu die means I love yu to the fullest.
Then to be in a relation you say: Me and dat Banny(girl) don de run tinz. Or mi and her get compass or parol.
LiteratureRe: Why Baba Polina No Dey Do Hunta Again. by Sinistami(m): 11:41am On Feb 17, 2018
Jakumo:
I been know one man when hin name na Baba Polina, and before-before, that man no get any anoda work pass to enter bush dey do hunter, for afternoon, and for night sef. Whether na antelope o, abi na monkey o, abi na grasscutter, or big snake together witi Mami Wata sef, no one when Baba no dey see kill for bush, as hin sabi do hunta reach.

One day be one day, wey Baba say make him go take style lay ambush for monkey dem, for inside deeeeeep Igbo-Oro forest, near one big river so, before daybreak. Baba plan say hin go hide hinsef, and wait the time when the monkey all go wake up, begin dey play, dey jump, dey find chop for on top one big Agbalumo stick there.

As Baba don wakka reach where the monkey dey sleep, and day never break, Baba say make him do sofry tanda on top one dry timber wood when dey ground, to get chance count the monkey for up, before the time when day wan break, an den take eye look the place when the monkey dem biya-biya Chairman kak seat for up.

As Baba Polina mash that dry timber wood when dey ground to get chance see up well, na so the wood just bust GBOSAAA, and carry Baba fall down for potto-potto Gbiii. Baba say make him do quick and stand up to see road, but na that time he come begin dey hear how honey-bee dem justo start for dey halla wuuuu-wuuuuu-wuuuuu for inside that wood when him don take leg match am by mistake and kukuma broke am, open BIG hole when the honey-bee all go take look outside and confam who be the mumu when scatter dem house, korro-korro eye. E get as e be that day.

Before Baba get chance to look wusai him go fiti run pass, na so the honey-bee dem just bost out yakataaaaa, begin dey bite Baba for head, bite am for belle, bite am for back, bite am for yansh, sotaaaay Baba look down and justo see say hin leg don pick race already, make am dey run like mad pesin, gbidi-gbidi, gbidi-gbidi, witi full speed when pass the one when meat sef fiti run after when hunta bullet don meet am.

E remain small when Baba for don forget all the honey-bee dem for back, but na that time the cutlass when him use rope tight for trouser come go hook one bush rope, carry Baba fall down again Gburu-gudu, gbiiiiiii. Na Papa God say make Baba Polina no die that day, because na small like this remain wey the honey-bee all for kukuma finish am one-time for there, if no be say Baba fight sotay hin trouser kuku commot, fiyamm, together witi him cutlass, come allow Baba to throway hin gun and use only hin pant to begin run another new run for inside bush that day.

As the man come see say wata don dey pass garri, because of how the honey-bee don dey bite Baba more-more, na him make am forget say him no sabi swim, before hin go jump for inside river Juwaaaaaa. God so kind, na that time all the honey bee turn back and leave Baba for where hin dey fight for inside wata, dey cry, dey shout say if Papa God let am commot for today wahala, hin nogo do hunter for bush again lai-lai, forever-aneva.

So, if you mistake jam Baba Polina for beer parlor, just salute well-well am for me, but no go ask am anyting concern hunter matter again o, if you no wan see the man vex.
dis yo pidgin different from di won weh we de yan for Yenagoa oh na WUS type bi dis

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 19 20 21 22 23 (of 23 pages)