Sunisonflex39's Posts
Nairaland Forum › Sunisonflex39's Profile › Sunisonflex39's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 66 67 68 69 70 71 72 73 74 (of 88 pages)
the way this post take reach FP what. lala dem dey do partial partial |
hope it's not his football age? happy birthday to Germany beatee |
[quote author=ElonMosque post=89447645][/quote]manny |
YorubaHero12:they lied to him to gain favor..so they will keep operating inhindered... |
Abeg,my Port Harcourt brothers and sisters here. una good evening seun good evening lala good evening mynd44 good evening all of una good evening o make una help una guy,una guy na young guy, una guy na guy wey dey hustle as per photographer,una guy na upcoming one for that matter.. Una know as wike keep us now and na daily bread I dey see chop that time. I know things hard for everybody here, I know as e dey be,make una pardon my manners. Na beg I dey beg. Abeg I know say God fit use one of una touch me between today and Wednesday as per say wike lift lockdown for two days say make we go restock and the lockdown go start on Thursday.. as I dey talk now, I no get shishi.palliative or waiting den dey call am, them no One gree share. abeg Aunties and uncles, help me to get a cartoon of Noodles.. abeg for my PH brothers, I stay along TANK road near rumukwrushi market. abeg, you fit call me out to give me even garri, it's highly welcome. my bank detail dey my signature. make una no vex. abeg no be "Like" I go chop na.. abeg. person should use church mind and bless me..in due time, God will use me and bless you back.amen |
nonsense thread..if not for those collective trophies from the Chelsea guys, I for say who be Mikel? |
Pat081:motu mogbe modaran... she never start to appear to u for dream? |
malaria patient... |
we never see picture of the people for isolation center.. shingbia we never see since. we never see how our own isolation center be like when them dey treat patients.. corona in Nigeria is a conduit pipe to siphon money. Na because of 10b Naira wike one kill us here. if bubu call wike to send account number now, wike will just go on air and call off lockdown.. mean I dey hungry but we dey see pic and video from them Italy, Spain, Brazil etc them dey treat malaria. even for GEJ era wee see picture and fideo of Ebola patient na this livescore Kinda update Don tire me |
this Matter pass me.. |
Pat081:did u later move? or u stayed back? my brother move o, if u still dey Dia. make we no come hear for nairaland say "Help, the spirit of my late landlady is pursuing me" |
captainking:Boss,u fit send me small something make I use by a carton of indomie tomorrow, as tomorrow and Wednesday be lockdown free days as govt just talk. abeg. .reply pls.. I dey starve |
small small football dey come back.. soon we go see Messi and Ronaldo thread for fp.i miss sitting on the fence and reading messi>Ronaldo , Ronaldo< Messi comments |
GOFRONT:brother u forget LOCKDOWN... |
Under 3.5 sure for this turkey league..... Bundesliga do start o.. I Don ready for una and over 2.5 |
pDudd:were u dey |
davillian:imagine having indabosky as the president now. as he just hear this case he will be like.. on national Tv who China? who born China to maltreat children of the lion himself we smile, but the smile of nigelia is very gengelous, China should beware.. we citizen go dey feel our president. bubu take note.. these are what makes us miss abacha sometimes |
pDudd:my dunce or our dunce? nobi only me get bubu |
omohlexy:since morning I dey use mic dey shout for nairaland..nobody Don come to my rescue I swear.. if person just help me, u no-go see this post for another thread... mehn |
who want go there before.. oya time to do deportation and counter deportation of Chinese in Africa. Africa, if after this corona period and we no still get sense. then I go know say Africa case na spiritual |
Abeg,my Port Harcourt brothers and sisters here. una good morning first. everybody good afternoon Seun good afternoon la-la good afternoon Mynd44 good afternoon make una help una guy,una guy na young guy wey dey hustle as per photographer. upcoming one for that matter.. Una know as wike keep us now and na daily bread I dey see chop that time. I know things hard for everybody here, I know as e dey be,make una pardon my manners. Na beg I dey beg. Abeg I know say God fit use one of una touch me between today and Wednesday as per say wike lift lockdown for two days say make we go restock and the lockdown go start on Thursday.. as I dey talk now, I no get shishi.palliative or waiting den dey call am, them no One gree share. abeg Aunties and uncles, help me to get a cartoon of Noodles.. abeg for my PH brothers, I stay along TANK road near rumukwrushi market. abeg, you fit call me out to give me even garri, it's highly welcome. my bank detail dey my signature. make una no vex. abeg a cartoon of noodles abeg.. someone should touch me today na |
if say na US ship that thing hit.. OMO e no-go funny o iran and mistakes, na so them go do mistake start WW111 this is another reason why IRAN should never be allowed to have a nuke |
Siki355:na waiting I fess think.. 80k for that matter.. and him one japa. |
Melezenawii:even pharmacy too.. someone should come and help us over here in ph o.. palliative them no share no to dey put us under house arrest |
onyxo76:i was having headache yesterday, went to check on the 4 pharmacies along my street, all closed.. the feeling no be here in the night o.. wike, open this lock down once n for all and implement mask policy.. |
Guliver:80k you one sell person moto? waiting do the car wey u one sell am that price |
doggedfighter:Shame dey catch me for my governor and the way governors in Nigeria be shouting restock... is like person will just walk into a shop and say.. "I one restock" he begin pack all he want dey go. people wey no get money dey restock.. our leaders think like imbeciles |
See wike Your Own Don too much.. waiting u dey feel like? Who be this man adviser self.. and our yeye rubber stamp house of assembly people wey dey follow wike with him pot belle.. oh how I miss the times of chidi Lloyd. when our house of assembly were not anywhere belle face assembly like this one we have now. we don't even know who our speaker is. teuh for my state. . were is that Evans bipialaka and co.. my state has gone to the dogs.. |
kingkakaone:me I no follow sing shingbia o.. nobe everybody for ph support wike for this o...bros I swear, me wey no dey reason politicians matter. na survive I one survive o..Thank God u say some people..abeg help me. .abeg bro |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 66 67 68 69 70 71 72 73 74 (of 88 pages)



