Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,747 members, 7,824,149 topics. Date: Saturday, 11 May 2024 at 12:47 AM

Na Wa For Teens - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Na Wa For Teens (2010 Views)

Na Wa For Men Ooooo / Missing Teens Ran From Home After Impregnating 13-year-old ─ Police (Pictured) / Na Wa O!!....meet The Grand Mothers Who Watch Porn And Sleep With Men(photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Na Wa For Teens by Nobody: 7:20am On Aug 22, 2014
E get one small gal,she be just 16yrs,with house cloth she dey look matured small, But with uniform she dey look like small girl,she just enter ss3 self,she dey yarn me dust.....say she no dey follow her mate,the least guy for her list dey 21,that be say the guy get car......na so afraid catch me......she even get dem reach six, and at 16 self she down fuckkkkk,first child and she get younger sis,Which kind example she dey set for her younger ones? , God.......weitin dey happen to our young girls.....everybody wan get maga, forget say the game get side effects



I no dey too blame all dis small girls,na we guys wey no dey use head think,but dey use dickkkkk think, How bros wey dey 22-26yrs go dey carry small pikin waka, con still dey climb her, and yet them want respect........the one wey pain me pass na I call one bros by him name without putting brother, na he begin shun me,one small girl just come they call am by him name direct,girl wey I senior, the guy no do anything...... I just dey shame for dudes wey dey do child abuse

There is God oh cry

4 Likes

Re: Na Wa For Teens by bastien: 7:28am On Aug 22, 2014
Hahahaha.... this ur pidgin strong..... u be confirm ghetto dude.........





Well I dey see many guys wey dey do that kinda thing,at 18+ is okay.....not 18- guys.....make we try help d future


If small gals open eyes dis kind age, na belle,or virus she fit get

3 Likes

Re: Na Wa For Teens by Randy100: 7:35am On Aug 22, 2014
bastien: Hahahaha.... this ur pidgin strong..... u be confirm ghetto dude.........





Well I dey see many guys wey dey do that kinda thing,at 18+ is okay.....not 18- guys.....make we try help d future


If small gals open eyes dis kind age, na belle,or virus she fit get
I beleive in the phrase thats says "catch them young"
Re: Na Wa For Teens by DaGC(m): 7:37am On Aug 22, 2014
Bros ehn, the mata tire me. I no gbadun am at all. I dey even provoke for people my age wey dey carry smallie come where I dey, talkless of say na me go come carry am. Some guymen no get shame sha. Dem dey follow all these small girls because they know say them no fit handle 18+, so na the one wey them go take feel like 'man' them dey go for.
Re: Na Wa For Teens by bastien: 8:11am On Aug 22, 2014
Randy100: I beleive in the phrase thats says "catch them young"
so u self follow with weitin d OP dey yarn..... chai deris God o grin
Re: Na Wa For Teens by Nobody: 8:23am On Aug 22, 2014
DaGC: Bros ehn, the mata tire me. I no gbadun am at all. I dey even provoke for people my age wey dey carry smallie come where I dey, talkless of say na me go come carry am. Some guymen no get shame sha. Dem dey follow all these small girls because they know say them no fit handle 18+, so na the one wey them go take feel like 'man' them dey go for.
I dey vex self......tear cloth enter road
Re: Na Wa For Teens by Tnot(m): 8:53am On Aug 22, 2014
ghetto44: I dey vex self......tear cloth enter road

ShOo! Abeg broz take am easy o. "Tear cloth enter road? because of dis small matter. Na madness be dat o.

Oloun maje.
Re: Na Wa For Teens by OohMpa: 9:48am On Aug 22, 2014
Bros eee, you dey talk like say you no do things that year...

Na teen life be that, the time of stupid decisions.....
If her p no fit knack am advice, wetin you wan do?
















Btw, you get her no? angry

1 Like

Re: Na Wa For Teens by Sunkyphil(m): 11:47am On Aug 22, 2014
abeg bros leave dem alone jare igba awon youth ni jor,je ki omo yen jaye ori e
Re: Na Wa For Teens by Mrniceguyjohn(m): 11:59am On Aug 22, 2014
smh

1 Like

Re: Na Wa For Teens by omololu2020(m): 12:03pm On Aug 22, 2014
Guys lik dat plenty for my area for ikorodu o,e don even turn to normal tin for hia sef
Re: Na Wa For Teens by Nobody: 12:15pm On Aug 22, 2014
...After reading dis ur write-up,afraid catch me too
Re: Na Wa For Teens by Dreyl(m): 12:59pm On Aug 22, 2014
temigracie: ...After reading dis ur write-up,afraid catch me too
huh?
Re: Na Wa For Teens by bastien: 8:15pm On Aug 22, 2014
temigracie: ...After reading dis ur write-up,afraid catch me too
make I drive am commot for ur body na
Re: Na Wa For Teens by chidekings(m): 9:47pm On Aug 22, 2014
Mrniceguyjohn: smh

seems am going blind
Re: Na Wa For Teens by tayoxx(m): 10:27pm On Aug 22, 2014
I no fit date 19- Cus my junior sister na 19 and e go con dey b me like say I dey carry my junior sis
Re: Na Wa For Teens by Omomehn: 10:48pm On Aug 22, 2014
omo e get as d matter be o. buh d thing be say those small gehz no dey dress like small pikin o. if u meet them them go say them don reach 20 years. abi u wan make d guy go confirm from her mama? buh sha child nacking na bad thing, e no jel sam sam
Re: Na Wa For Teens by Lagusta(m): 10:54pm On Aug 22, 2014
temigracie: ...After reading dis ur write-up,afraid catch me too

lololzzzz.... Chooooiii, kilode!!?!!?!?? grin grin grin grin
Re: Na Wa For Teens by mozele(m): 2:59pm On Feb 02, 2016
bastien:
make I drive am commot for ur body na

lol you still be learner. Try substitute the "afraid" and put "fear."

no dey fall guys hand again, shebi you dey hear me so?
Re: Na Wa For Teens by cruzita(f): 3:22pm On Feb 02, 2016
when you see those type behave like a big brother to them,direct them instead of spoiling them the more.even if they don't listen ,they will hold u in high esteem
Re: Na Wa For Teens by firstking01(m): 4:57pm On Feb 02, 2016
In plain english and summarization...the world it's never what it used to be....these thing have been happening since the time of noah and the people of anakims...so, na endtime things.
Re: Na Wa For Teens by bastien: 6:29pm On Feb 02, 2016
mozele:


lol you still be learner. Try substitute the "afraid" and put "fear."

no dey fall guys hand again, shebi you dey hear me so?
just whining

(1) (Reply)

He Doesn't Want Her Because She Is A Virgin. / For Guys: See 9 Reasons Why Curvy Women Are Best In B.e.d [must Read] / Blinded By Love? Boy Arrested For Doing This For His Girlfriend. See What He Did

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.