Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,488 members, 7,819,769 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 10:51 PM

Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) (1160 Views)

That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. / Ekene And Judith, A True Life Sexual Story In Pidgin English (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by Iceking1(m): 5:26pm On Feb 01, 2015
FACTS OF LIFE Sometimes, when you look the way some men dey treat their ladies, you go dey wonder how and why dem dey act like that.

When you also see how some ladies dey do their men, you go almost cry.

These na some questions wey I want make we chew befor we drink wetin I wan right.


1. Why bad girls dey always get good men?

2. Why bad men dey always get good ladies?

3. Why e dey common say person wey you dey die for most times nor dey get your time?


4. Why e dey common say women nor dey quick dey love men wey ready to die for them?


5. And why e be say men nor know wetin women really want? All these questions be like strong kpomo wey dem nor cook well.

No matter how you chew am, e nor go fit soft finish. Instead, you either spit am throway or you close eye swallow am like who dey shit strong shit.
When I reason the way hearts take dey love, these na wetin I deduce from life wey make me tag am"FACTS OF LIFE"

1. Dem nor dey fit buy woman love. No matter the cars you buy for her. Take her to Dubai. And give her CBN as her birthday gift, if she nor love you for nothing, she nor go love you for something. Money fit influence woman attitude towards you but she nor go ever give you her heart if she nor love you. So, when you dey date woman with your money, she nor go fit stay in love with you. Na so so fight unu go dey fight cos she go dey do side kick.


2. Faithfulness to your partner nor mean love for your partner. If man love he wife well well, e nor stop am from cheating on her. Lolz. Think. Nor be becos say man love e wife nai make am nor dey cheat on her o. The lady fit sabi cook, sabi make love, good character and the man fit die for her becos she dey good, but when the man see lady wey carry 'something' e go still fit run follow am.


The love wey the man get for that e lady na for am to always put am for heart say, e love e wife and nor go let any affair affect he love. For a man to not cheat on e woman na if the man get the fear of God for heart, and not the love of e wife. Wetin fit hold man prick to order na God's fear.


Some men nor like sex. But the ones wey nor fit do without sex must find a woman to stay with. Wise men pray for the feqr of God in them so that dem fit lead a good wife. Stay faithful through the grace of God.


3. Men can never be satisfied by one woman when it comes to sex. Mistake must dey. Show me a man wey marry as a virgin and remain faithful to that woman till e die, and I go show you a perfect child of God. No doubt say, even though man marry the most well mannered woman, get a lady wey fine pass and dey blow am steady, e mind dey always dey flick to taste another woman. Sometimes when he like to taste another lady, the God fearing man go contain am, while the others go fall.


After the deed, e go come back and plead for mercy. Men! They always have one thing more to get. Look at their ambition. Men nor dey satisfy unlike women. Woman fit stay with her hussy alone without sex with another man. I nor say women nor dey involve in adultery o. But the cases of adultery dey higher with men than women.


4. Nor try am say you wan die for love, die for God. Na Jesus Christ God give the assignment to come die for mankind. Nor let love make you enter hell. Which kain love man wan give you wey your mama and papa norva show you? So, use your brain.


When you marry or dey date someone, know your tolerance level. E good to endure and get patience cos if you marry, you marry for life. But when that relationship dey threaten your life; Your spouse dey molest you, Beat you to the point of death, Or even use charms to control your heart, Please, find solution.


E nor dey anywhere say woman go die for her husband hand. If you die for man hand like that, you nor die a matyr but you die by mistake. So, wen your life is being threatened by your partner, make move: Report to constituted authority.


6. Being nice to someone nor mean say that someone must love you. Forget those miracles. When you wan plant flower, you go look the roots whether e fresh. Whether dem dey alive befor you plant am cos you know say e go surely grow. Na so our hearts be.

When someone heart nor get a drop of love for you, forget, river of joy nor go fit come from that person. So, never assume say you go get somebody love by being nice to the person. No. You fit dey good to the person. Train am go school and do everything for am hoping say the person go grow in love with you. No way. When love dey somewhere befor nai e dey grow. so, no matter how nice pipo are to someone, it can never amount to love.

Nor mistake being nice with love. Na common error in practical loveology.


7. Pipo hardly pretend. Many go say; Nor be so e dey behave befor I meet am o. When we dey date, he use to be nice. See, with or without dating, every human get wetin dem nor go fit hide. Character be like smoke. How you wan take lock am for room? When you dey roll with someone, nor dey carried away by laughter and smiles alone.

Concentrate on the other aspect of the person life, When he offend you, how e take dey beg you? When he wan give you gift, how e take dey give you? With arrogance or pride?. How e dey do when unu dey public places? Which kain pipo dey salute am for road if unu dey roll? How e dey do if you dey beg am for forgiveness?


How e dey do if e see someone in need? How e dey talk about the old? Etc. My pipo, nor dey carried away by smiles, listen to sighs and write out of it, a good line nai go be your guide.

2 Likes

Re: Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by datguru: 5:35pm On Feb 01, 2015
I love your command for pigin english. grin nice one
Re: Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by DeeBoiyy: 6:00pm On Feb 01, 2015
datguru:
I love your command for pigin english. grin nice one
he still dey learn work for where i dey.


Listen to wazobia fm abuja for two weeks and your vocab in pidgin will triple that of Queens English grin grin
Re: Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by ifex370(m): 6:42pm On Feb 01, 2015
nice
Re: Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by cutieberie1(f): 8:07pm On Feb 01, 2015
nyc post..
Re: Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by wizard007(m): 7:24pm On Feb 02, 2015
Iceking!!! Agba awo nie ( you be chief initiate)
Re: Some True Facts About Love That Many Still Don't Know About ( In Pidgin) by Iceking1(m): 5:41pm On Feb 15, 2015
cutieberie1:
nyc post..


tnx, u cn go 2 my profile 4 more

(1) (Reply)

Why Do Nigerian Girls Love To Hang Out With Peoples Boyfriend More? / But Seriously What Do Men Want? / Guys I Need Ur Help

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.