Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,793 members, 7,956,028 topics. Date: Sunday, 22 September 2024 at 09:45 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English (1564 Views)
Recession Bawo! Check This Out!!! / That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. / Ekene And Judith, A True Life Sexual Story In Pidgin English (2) (3) (4)
Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by Nobody: 4:50pm On Aug 31, 2015 |
BAWO AND TOSAN
(True life Story)
Tosan and Bawo dey date when dem dey
SS 2. When dem finish school, dem cum write Jamb after WAEC.
By the time results come out, Bawo make
am but mathematics cum cut Tosan.
During when Bawo dey process e
admission nai e papa die. And e mama
nor too get. Little money wey Tosan dey get from her
parents, she dey use am support Bawo
education.
Na when Bawo graduate nai Tosan for
cum make e mathematics.
Bawo cum get job for one construction company.
He rent house, gather money nai e marry
Tosan.
Though dem both don agree say Tosan go
do part time.
The following year nai she get belle. God cum bless dem with a son.
Becos say their mouths don increase,
Tosan cum say make she wait small cos
money nor too dey for her school.
And to avoid being idle, she cum dey go
market go buy corn dey roast for front of their compound.
One day wey she dey her stand dey peel
corn, nai one jeep park for her front.
The driver cum tell her say nor be corn e
wan buy.
But na the first time e dey see her so. And e like to make her e friend.
Tosan cum tell am say she nor go fit be e
friend cos she don marry whether the
man nor dey see ring for her finger and
baby for her back?
The man cum laff say make she nor worry.
Say e ready to buy her car if she ready to
be e lady.
E cum tell Tosan say e name na Dr
Kenneth and na him get Emacok Drilling
Line. She know the company but she norva see
the owner.
The man cum give her e complimentary
card say if she make up her mind, make
she call am.
Na so e take drive go. When she reach house, she nor fit tell her
husband. But in the night when Bawo
wake up say e dey go piss, e see her
sidon for the bed, put hand for jaw dey
think.
When e persuade her to talk, she cum tell am everything wey happen between she
and Dr Kenneth.
The husband cum say make she nor
worry say make she just forget.
Two weeks later, Bawo cum dey get
problem for e working place. E come house one day nai e ask Tosan
whether Dr Kenneth still dey come meet
her?
She say yes.
Nai e cum tell her say make she beg am
to give him work. The following day nai she really beg am
but Dr Kenneth say na under the
condition say e go sleep with her but e
nor go date her cos e know say she love
her husband wella.
Tosan nor fit tell her husband. Na when Bawo don disturb her taya nai
she open up.
Na that day Bawo for nor talk again.
The next month nai dem kidnap the man
wey get the company where Bawo for
dey work. By the time dem release the man, e
money don less.
The company cum dey owe workers.
Bawo don find work for other places but
no hope.
Things cum dey very rough by the time their second child come.
One night nai Bawo for wake Tosan.
Kneel down for her front begin dey beg
her
"My wife, I know say I marry you as a
virgin. I know say you norva know any other
man since you know me.
You know wetin we dey go through for
this house.
I beg, just do it for our love.
Our family. Our kids.
And do it for us."
By now, her eyes don dey open to hear
wetin Bawo wan talk.
"Just let am sleep with you make e for
give me job for e company" As e talk the words, na so e drop e head
begin cry.
"When frustration don hit man, e ready to
do anything to get money"
She nor fit talk.
She just fold her hands across her chest. Water just dey pour....
The next day, Tosan dey front of Dr
Kenneth office dey wait make the door
open.
The secretary cum take her enter the
office. Na there she dey till everybody go break.
Dr Kenneth cum take her enter e office,
lock door. He cum dey remove the button
from e suit.
Tosan cum drop the CV for table, she cum
dey pull her wedding ring. Where she for dey pull am, nai she burst
cry.
She turn back towards the door.
Dr Kenneth cum rush stop her.
She just dey cry.
"I nor wan do this. I love my husband.
I can't do this..."
Sympathetically, Dr Kenneth cum calm
her down nai e tell her say make she go.
Say e go give her husband work when e
don go through the CV. E cum even give her some money for
transport.
When she reach house, she cum tell her
husband everything.
Both of dem cum dey happy.
Na that week Bawo start work. In 16 months time, dem cum build house
buy cars and get enough money.
Tosan cum say if she born her 3rd child
nai she go ready to go school.
Where trouble dey sleep, yanga dey go
wake am. Bawo cum dey friend one of their
cleaners for office.
The news cum blow enter Tosan ear.
One evening, as e just dey drive enter e
compound, nai pregnant Tosan for stop
am start to attack am with question. The thing cum lead to serious quarrel.
Bawo dey say e be man and e get right to
sleep with anybody wey e like.
Abi when e own oga dey sleep with her,
e talk?
Tosan clean her ears asking, "Who dey sleep with me?
Your oga sleep with me?"
Na there she for grab Bawo shirt dey
push am dey cry say why e go talk like
that?
Whether she nor tell am the truth? Say Dr Kenneth nor touch her"
But Bawo still dey shout dey call her
ashewo.
Say e just quiet but e nor fit tolerate am
again" so, make she leave am make e
Bleep who e like. Na there dem cum dey fight. Bawo cum
dey beat her till their tenant rush cum
separate dem carry Tosan go hospital.
Na doctor confirm say she lost the belle.
From hospital nai Bawo carry Tosan with
the two children go Tosan family compound say e nor marry again.
Like play, dem cum separate.
Bawo cum carry the babe wey e dey
friend cum dey stay with am.
Tosan with her two children cum dey
stay with her mum cos by then, her dad don die.
One day when Tosan go market go buy
foodstuffs, rain come meet her.
As she dey co |
Re: Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by Nobody: 4:51pm On Aug 31, 2015 |
rain come meet her. As she dey come back, rain cum dey fall heavily. She nor carry umbrella. Where she for dey rush to comot from road enter shade, nai be motor horn wey dey blar for her front. The Camry cum park. She notice say na she the person park for. When she enter the motor, na Dr Kenneth. E cum tell her say why she nor carry motor and she know say na rainy season we dey? She breath reach ground. Na there Dr Kenneth for ask her say wetin dey happen. Nai she judge full ground. Where pain the man pass na say, e feel say e sleep with her whereas e nor sleep with her. E cum carry her go drop for house nai e give her 10k. The next day for work nai e send for Bawo. Bawo sidon dey wait make e finish call wey e dey make. Dr Kenneth clear e throat, nai e tell Bawo say "As a man, e easy for you to tell woman say make she chop grass than for you to tell your wife say make she sleep with another man. Becos of work, you tell your wife make she sleep with me. But becos I see the love wey she get for you, I nor doam. She loved you so much. And she wanted the best in your marriage. But you betrayed her. I don talk with Hannah. She confirm to me say she dey date you. Mr Bawo" E cum stretch envelop for am. "Meet the finance director as you dey go. You are fired." All the tears wey Bawo cry nor touch Dr Kenneth. Na so e still sack Hannah join. Bawo dey house for two months, no job. E cum dey drink. Na so thoughts cum dey trouble am. In the end, stroke cum doam. Na that one nai sink all e money. Dr Kenneth lost e wife 6 months back. And e get two children wey dey school abroad. E cum dey ask Tosan hand in marriage. Now, if na you be Tosan, wetin you go do? *Go settle with your husband Bawo. *Marry Dr Kenneth. *Stay like that. And if na you be Bawo, wetin you go do? *Go beg Tosan back. *Go beg your boss. *Stay like that. Lesson to married women! Whatever you dey go through for marriage, God dey see you. Nor let your husband ask or convince or deceive you to go sleep with somebody for any favour. The mouth wey you take agree, nai e go take judge you. Even if you nor doam, e go put am for mind say you doam. And to our youths, who unu blame for the break down of this marriage? Bawo. Tosan. Dr Kenneth. We pray make bad situation nor meet us for life. Amen. 1 Like |
Re: Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by kolatobs(m): 4:53pm On Aug 31, 2015 |
ok |
Re: Bawo And Tosan, A True Life Story In Pidgin English by afolwalex20(m): 5:12pm On Aug 31, 2015 |
Would have love dis story better of u wrote it in English.. Anyway, tosan should marry Dr kenneth.. |
(1) (Reply)
Funny Sallah Hilarious Pictures(photo) / Photo: Meet The Woman Who Sells Breast Milk / When Your Girl Tells You To Pack Your Things And Get Out.
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 58 |