9free's Posts
Nairaland Forum › 9free's Profile › 9free's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 49 50 51 52 53 54 55 56 57 (of 93 pages)
Elai147: So una dey code the ticket make we for no see buy? At least we must see buy for black market.I fit sell 1000units out of the 2000units I have for N25/share. |
feelamong: bros leave that story,... many of us wey been dey wait for the Cop deal don already squeeze ourselve enter this OANDO bus...Ok. I don see you. I dey for back row. Seat no. 56 ![]() |
texaco1: I am bringing some products today.thanks for the concern.Waiting......... |
feelamong: Bros .. i no sabi PH o! you know say too much oyel money dey that una side!Haba Oga feelamong, why you dey put fear for prince body nah ![]() ![]() Prince dey find where him go put him oyel/militant loot and you wan make am begin fear, why? Oga Prince, abeg visit any FCMB Bank closet to you and ask the right questions. Am sure you get satisfying answer. Goodluck. |
princeuk21: please where is the branch? First bank branch close to me says the minimum abount is 500k, GTbank says there minimum is 1million. Somebody should please tell me which branch i can get the NTB for 100k in portharcourt. Feelamong come help your man o.My kobomart Oga, you too wan join do TBills? |
jposuagwu: @FeelalongChei....... See metamorphosis |
Xtfield: Hello Fellow importers, I stumbled on this thread a few weeks back. I have patiently gone through Season 1 and 137 pages of season 2. Kudos to all who started this thread and delivered us from e-book sellers. Today I took delivery of 2 items I ordered from Amazon.com and cowboom.com. I bought a microscope from Amazon and an HP laptop from cowboom. You need to see how my colleagues' eyes almost popped out when the goods were delivered to my place of work. I immediately got an offer for the microscope which will net me 150% profit! The laptop is for personal use. Its so beautiful. Lest I forget, I used OandO gadgets[color=#990000][/color] to ship the items in. The goods were delivered promptly. Will post pix later.Bros, which one be OandO gadgets ![]() |
feelamong: Phew!!!!No worrry urself, I go put you for my prayer points...... |
Born 2be Rich: This situation get as im be...Me i never see this kind thing before...Abi na showers of blessing from unity we go call am.Afraid dey fear me oooo...... Na just yesterday I offload the tesere units wey I been get since April. Who dem pay my undeclared dividend into his account ? |
janykute: Very very sure of that.What i saw on my phone was Neft transfer-Unity Bank plc/final Div.bros, abeg check again. If you no mind wear magnifying glass check am again. |
feelamong: Bros... i go dey shadow you now going forward!!hahahaha......LOL ![]() |
Elai147: Where the source of the news na... Body dey hot here o... According to fxisreal post, the deal has not gone through yetMy Oga, no vex oooo.... Oga fxisreal post na dey correct one. These yeye Nigerian Journalists no kill person. Couple with the fact say me Nokia 3310 dey only show headlines without the body/content. Abeg make una no vex oooo.... I hope say I never make some people for here to wrongly compose BUY Mandate text or foward online buy mandate against tommorror. |
Elai147: Yes, they extended it till Nov 30th. But what if Oando is unable to meet up with this new deadline? I hope there is room for more extension in such case. Because any attempt for Oando to terminate the deal the way dem terminate Brass LNG agreement with COP, the tin go rofo rofo o.. Anyway, vigilante mode activated on COP deal.The deal don scale through oooooooo....... |
Born 2be Rich: I read somewhere that the dead line for the conoco deal will expire on 30th of novBros, CoP deal has been consumated. I just read the news on broadstreetlagos but I can't post the link cos am post with Nokia 3310. I just hope Oando go enter fast lane tommorror ooooooo.... Dancing Azonto. |
kolidave: u sharp gan ooo. Fast fast? Me I just dey fold my hands dey observe oooo. If I see any clue or tiny hint, na to sell am off ooooMake sure say you dey the conductor side of this train oh just as Oga feelamong cos if dem blow offloading whistle, you fit no see chance offload your own as an observer.... |
kolidave: I bought transcorp 2wks ago and its really increasing. Do u think it can reach N5 before December? U know say Xmas dey come and man gats flex naBros, if Transcorp continue accelerating at this break-neck velocity, I see it getting to its 2008 listing price. I may be wrong sha and this is not a recommendation for anyone to buy. NB: I don't have a single unit of this coy. |
kolidave: Chai I don die. Na here this thread dey hide all along. I don miss and jonze big time.Where you dey since ?Welcome ooo |
Elai147: E don tey wey NEM dey linger around the car park but this time nothing fit stop am from reaching there... I no call oga 9free name o..I dey watch you in 3D. Oga Migiets, abeg borrow me that your mace for 30minutes only.... |
qizick: thank God for tramscorp is it a good time I sell I just wanna make. my capital back n trade wit d interestI am ready to buy all your holdings @ N1.5/share Don we have a deal? |
amustsuccess: I heard Unity Bank is merging with Ecobank. Will this downgrade the price of UnityBank? Whats the advantage for UnityBank?Oga's abeg make una confirm this rumour.... Make I know wether to stop my sell mandate of Unity bank I sent this morning. Biko ooooo |
qizick: stock bull born to be rich and co ebi. like. say una dey select ppl una dey talk to abeg do I sale my transcorp ? again what is d current name of African petroleum. reply now pleaseehmmmm..... madam, when you dey buy Transcorp why you no tell us make we join you that time buy our own? We no dey select who to answer here o. All animals are equal on this thread but some get power pass some sha.... ![]() African Petroleum = Forte Oil |
jamace: My bros, I dey inside dis bus o. My belle dey sweet me well well.You go wash am for us for mama Ejiro buka oooooo No chop alone and die alone ooo... |
Who dey move Transcorp?? Oga Elai and ma'am Mercy, I dey see una handwork here ooooo...... |
Berylmoi: pls, which university is still selling master's form? Who knows?ABU Zaria.... Closes November 28, 2013 |
Canme4u: am still waiting for serious minded people from Oyo state.Bros, all of them don join kobomart. I no dey sure say you go anybody here wey go leave kobomart join you oooo |
dav8id: [b][/b]add me on whatsappOK |
surveycash: Interested marketers for kobomart, start dusting off your shoes. The race is about to begin. Don't be left out.What products have Kobomart got in those containers? Wholesaler tins...... |
mayorall: Abi nah Gold Iphone from ChinaThe thing fear me oooohhh. I don dey think whether na diamond phone.... |
mercylicious: At times, brokers do make mistake. The may have sell order from another customer and while inputing the order, they make mistake with one digit and another customer's stock is sold or bought.You no dey sleep ![]() |
Oga david and mayorall, so na here una two hide dey runs things abi ![]() I will never leave you, unless you properly put me through!!!! |
presiade: I think this is the opportunity to deal with my broker that I've been waiting for all this while.Bros, you don hammer!!!! Run sharp sharp go tell SEC. Claim that the stock your broker sold is one of your longest term stocks. That you intend to hold it for 15years or more and your targeted exit price is N100/share. I say you don hammer!!!!!! |
petaling: Sell everything you and put in OandO. This stock will be bullish at no distant time. My girl friend working in stockbrooking firm told me to do exactly that. But me I dey fear small small.Bros, I too young now to start dey battle High BP. BTW: I get 2,000 units of OandO sha ooo... |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 49 50 51 52 53 54 55 56 57 (of 93 pages)

