₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,854 members, 8,447,383 topics. Date: Saturday, 18 July 2026 at 08:44 AM

Toggle theme

Maedan's Posts

Nairaland ForumMaedan's ProfileMaedan's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 95 96 97 98 99 100 101 102 103 (of 120 pages)

LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:38am On Jul 11, 2009
RuuDie, thank u for dat ur commendable eulogy
u show say ur own no be just grammarcology
u speak am straight from de heart
but make we no let d bag out of d cat grin
bc dis one u call am Angel Michael, some haters go vex
i hear some pple walk out during d minute of silence
which dey hold for am for U.S. Senate
their mind no just fit relate
say MJ no need their label of "American Legend"
Which them come refuse give am for d end
For us, he go always be a shining Star
Wey we go always dey see from the skies afar wink
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:29pm On Jul 09, 2009
semid4lyfe, wetin u talk na d essence
even tho' na only one man, d world go miss im presence
how a single person go make such an impact
and cause so many hearts to just dey contract
see as Usher just dey cry, even Bros Jermaine eye no dry
i no think say we go forget MJ in a hurry, make we no even try
we go only fit hope say tings go better by and by! wink
TV/MoviesRe: Dbanj's Nu Reality Show Tagged "koko Mansion" by maedan(f): 9:42pm On Jul 09, 2009
hahahahahahhhahHAH! our own home-based Susan Boyle situation - losing in a reality show = losing ur mind! tongue. Shame about Mary Mama woteva. Is she d girl dat is like 3times bigger than everyone else, stays the longest at the dining table(she actually fell off her chair once and had to be helped back in during her 3hour meal) Lawd, she finished off some eba, and when some other girls made pounded yam for themselves, she had some of that too. She was gross! No sign of self-control. Getting fat in Koko mansion. Good thing she left. At least the Koko pantry won't be out of stock so quickly. embarassed
Jobs/VacanciesRe: The Witch Job That Pays £50,000 by maedan(f): 1:14pm On Jul 09, 2009
Sick stuff. ;DCan't believe I looked in the thread with such a topic. Witchless my *** grin
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:43am On Jul 09, 2009
yes oh, semid4lyfe, i dey feel ur pain
dis season just dey bring showers of rain
Stevie Wonder come ask say, why MJ come die for summer
when we supposed all dey happy, oh what a bummer cry
oh well, I hope im dey for a happier place
but meanwhile, no1 go ever fit take im space
and BTW, dem say make we no call am King of Pop
Na the Greatest Entertainer im be- he go always dey on top!! wink
TV/MoviesRe: ~ Big Brother 10 UK ~ by maedan(f): 3:05am On Jul 09, 2009
Wow, been staying up all night watching Norin tear into Siavash and in fact, everyone about who called her a group-hopping bunny. She shd really stop the drama queen act, it's BBH, pple will think, and say mean things behind ur back. She should learn to ignore some things or she will lose everyone's friendship.

And BTW, Half-wit doesn't look half-bad now that he's gone skinhead. Hawt, but still too skinny for my robust tastes. Now Siavash---yum yum. tongue
TV/MoviesRe: Nollywood Not Better Than Ghollywood — Yvonne Nelson by maedan(f): 2:46am On Jul 09, 2009
Ghollywood, Tollywood, follywood---geez! It took years for pple to get used to the Nollywood concept, now this! But for real, the Nigerian movie industry is tops in Africa for its actors, production, and popularity. So Ghanawood or wotever shd get a grip. grin
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:56pm On Jul 08, 2009
TOYOSI20 lovey, I feel u on d MJ issue
when Usher sing Gone2Soon, i go grab tissue
the memorial service dey v. emotional
no be say everything na just promotional
the feelings and tears of all dey quite real
and the words of im pickin come put d final seal
well,well,well, no need to dwell on sadness
na d message, not d mess, go bring us gladness grin
na so Rev. Sharpton talk, and i concur
for all we blacks, MJ help 2 open d door wink
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:48pm On Jul 07, 2009
Hey guys, hope una no take offence
as I analyse una style, i hope e make sense
semid4lyfe, u be great thinker, ur pen na sword
and RuuDie na wise man of many words
and TOYOSI20 na babe true true
with rhymes wey always dey fresh like dew
ay yo, sista-girl, happy b-day in advance
shey u kno July na d month of romance grin
come rain, come shine, make u always stay blest
and make u get plenty presents from east to west!! wink
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:07pm On Jul 05, 2009
i just say make i go take a stroll
e come be like say i dey on a roll
even tho' i no be storyteller like RuuDie
i go stay cool like i dey wear hoodie grin
semid4lyfe get im philosophical style
i no fit compete as im be top-of-d-pile
and to newcomer TOYOSI20, na she trip me pass
she dey rhyme like a true naija pidgin lass wink
may we always to dey continue the show
where great minds dey, good rhymes must to flow smiley cool
Music/RadioRe: Jim Iyke Ft 2face - Who Am I by maedan(f): 10:59am On Jul 05, 2009
The track was ok abeg, is it bc its Jim Iyke? Tuface is not a fool, he saw the guy's potential that's why he risked his rep to rap with J.I. The video is cool too, so u haters should cut the J.I some slack.
TV/MoviesRe: Dbanj's Nu Reality Show Tagged "koko Mansion" by maedan(f): 10:22am On Jul 05, 2009
Yesterday was ok, Julius Agwu came, and even with all the bad jokes, talked some sense into them. Also, we all found out that the girls can, at least, dance. Good for the entertainment level of the show, but whether dancing and acting(which they do v.well too, going by the two drama sketches they put up), will do anything to show for womanly qualities is another issue.

The calibre of girls aside, the show would have been great if the organisers/producers did their research and planning well. You put a bunch of girls in one house, what can u do to bring out their qualities/shortcomings to the public so the viewers can enjoy the show and also, know who should go or stay. Reality shows are for creative thinkers who know how to make it work. The producers of the show should hire some brains who will turn the thing around abeg.
PoliticsRe: Thins Fall Apart Is 14th Best Book In The World-the Only One From Africa by maedan(f): 7:16am On Jul 05, 2009
TFA in the top 20? The only African novel? I really have to go and read that book(again). Hope I can find a modern edition with larger print, unlike the original. It must be really good. Chinua Achebe, well done, you. wink
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:02am On Jul 05, 2009
^^^^my dear, i neva go too far
na im i come see ur shining star cheesy
i say make i rush back and join d flow
make dem no come say i don dey slow tongue
as u don join, d girlpower don increase
i pray say ur elbow go always get more grease wink
sometimes e dey lonely 4 hia with only d boys
but now my naija sis don come to share d joys
make we always dey on hand to heat up d fire
so dat our fans no go ever blame us say we don tire tongue
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:02pm On Jul 03, 2009
thank u semid4lyfe, for giving honor where e dey due
to this wonderful thread, we go always stay true
no be say dem dey pay us, or say we dey get gain
but at least we dey have fun and build up our brain
anyone wey get anything meaningful to say
make e always use dis pidgin medium (no need to pay) wink
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:36pm On Jul 03, 2009
if na one thing i learn for dis life
na dat love no be long story, stress or strife
u no fit plan am, e go just happen
e no dey ur hand to mould or shapen
some go force demself into relationship
only to find am full of hardship
if only dem fit exercise patient
hope and pray without relent cheesy
d love of dem life go fall for their lap
and the joy go gush out like say na from tap tongue grin
TV/MoviesRe: Dbanj's Nu Reality Show Tagged "koko Mansion" by maedan(f): 12:28am On Jul 03, 2009
yes indeed, the cringe-factor level is HIGH. I mean, none of the girls seem to have one polished tongue in their heads. The one in the dyed low-cut was so loud all day Wednesday. In fact, they were all lousy till the "governess" told them that "people" were asking for a new set of girls. Now that was a wake-up call. It's a pity because this is a good idea for a show but the caliber of participants----shudder. All they really care about is making up and outdoing eachother in what they put on. Sad really, but I think Dbanj deserves what ever he gets from this lot. tongue
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:16pm On Jul 02, 2009
semid4life, i like as u talk sense
u be real poster of excellence
for dis NL person go meet all sorts
some go become long-standing cohorts
while some go dey form say dem be foe
start to dey blast eachother from high and low tongue
in essence, wetin i mean be say
for here everyone dey flow&play
we don form a pidgin-rhyme brotherhood
wey go be d envy of all wey for join if dey could wink cheesy
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:17pm On Jul 02, 2009
TOYOSI20,
ur post dey always get the lol factor grin
u just dey level all issues like tractor
i don guage now say u be love guru
and u sabi play-play pass francis duru cheesy
main squeeze for here, i no get
but my rotylovy i no go forget
we dance the pidgin rhumba for many pages
til the romance reach im final stages
in any case, i dey watch ur back
make no NL playa come give u heart[i]crack [/i] wink
TravelRe: Nigerians In Sweden, How Is The Economy And Life Generally by maedan(f): 1:16am On Jul 02, 2009
@nethacker,
thanx for the gem of advice, I will get on it. Nice one!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:07am On Jul 02, 2009
RuuDie, i like as u respond to my teasing
true true ur ways dey very pleasing
of course, for here love na d mission
and we dey use Nairaland as our television tongue
to take spread the gospel of live & let live
whether u be ibo, yoruba, hausa or tiv wink
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:04pm On Jul 01, 2009
shebi i talk am?
RuuDie, u don jam! grin
i know say u dey get easily carried away
u don forget say all na play
u come write 4000-word dissertation
like say na final-year presentation
u come make love come tire person cheesy
i think say u for don learn ur lesson
but i don see say, u get a long way to go
i hope say in d end, alarm no go blow!

na becos you be my person i dey yarn so
i only wish u d best as we dey rhyme dey flow
hope all dis ur composition no be for anyone in particular
make u no scatter our head for dis pidgin perpendicular tongue
TravelRe: Nigerians In Sweden, How Is The Economy And Life Generally by maedan(f): 5:45pm On Jun 30, 2009
embarassedoh, shoot! Thanks for that. I guessed as much, just had to be sure. do I have to go home and apply, or from here in UK?

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 95 96 97 98 99 100 101 102 103 (of 120 pages)