Maedan's Posts
Nairaland Forum › Maedan's Profile › Maedan's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 98 99 100 101 102 103 104 105 106 (of 120 pages)
@semid4lyfe hey chill out , this can never be over . So the TV series has finished running, so what? Some people still haven't seen the series or it's ending, and they may need a place to discuss it when they do. And in any case, Prison Break will always be worth talking about. In fact, if u are not careful, a SEASON FIVE will begin in some months, starring Michael's "whiz-kd" son, who inherited his late father's genius and may end up taking over the Company and turn it into a family business ----- (okay, now u know I have PB officially on the brain . Can't help it, it was the best TV Series EVERRRRRR.) ![]() |
as for you, RuuDie make u no get too moody ![]() with these ur good wordings, u go get d victory over this your love of 5-year history ![]() woman like sweet-talk pass food & money keep up ur rhymes wey dey flow like honey ![]() finally finally, we go package dem to ur babi-boo u go see say she go gree b4 u fit say "yahoo!!!" ![]() |
@ rotylovy i hapi say u come quick-quick to my defence as a good e-hubby with prudence and patience ![]() make we take this RuuDie case as our own pet project e no easy to send love make the receiver come reject u feel im pain, that one na good of you and we go devise sometin for him to do to take him mind from this heart matter make d girl no make him head come scatter ![]() |
Hmmn. I've had an utter crush on Lawrence Fishburne for ever . I think some serious auditioning of everyone and anyone who's interested in the role should be undertaken. ![]() |
the following in bold na my favorite lines from this ur post wey pass love letter 4 valentine . . . [b]maedan abeg no laff dis no be okpata, dis thing do me sotey i tire, if na to pay with with rice and cassava, i fit try small becuz me i be common farmer, . . . or small boy casanova, or d man wey call imsef mr lova lova, i no get liver to put asunder, better wey people jackee tey'lee to discover. . . . . e be like dem baff me hot water rain, na one edu wey jus dey carry me train, in fact, she don carry my heart waka like aeroplane, wen i hear her voice d happy no fit jus contain, d sweetness pass sugar cane, instead to lose her my make my market no gain my small money make agbero obtain, if ee'ke like make dem detain, for her love i fit climb mountain, shuo, warri river sef na fountain, for where she dey, no long thing like plantain, i fit waka from abule-egba to costain, all for her to dey sustain. . . . . . d chic'alla don finish scatter my head, wetin dey hol me now na jus needle and thread, ![]() i don write luv letter "a" to zed, so she go dey reminded, how mush she dey needed, abi make i run enter market square naked? ![]() i no even mind to go join MEND, if na to borrow people plenty wey go lend, i no sey her toasters plenty and i no fine reash to contend, d kain place she dey enter i no fit attend, but nothing wey she do dey make me offend, if any pesin try her i go gree'dai to defend, as day dey go d more my heart dey bend, dis my sick na only she get the power to amend, e don reash five years and na make we jus be friend, how she no dey see sey my for luv her no go ever end!? [/b] @ RuuDie dis ur post long almost reach like chronicle but I see say u be guy wey get good principle as u take d time explain ur situation i come see say no be ordinary infatuation fost of all, make i raise elbow to respect and commend this paragon of womanhood wey dey make ur head bend ![]() i wish to say she fit read this your post u no go need me again to help u to toast be that as it may, i no get much to say ![]() inside love mata, third party no fit play d only thing be say i go dey helep u to dey pray make u win d love of dis ur dreamgirl b4 e too tey. ![]() no be until ur hair don turn full grey by then, e go too late for u to have ur way!! ![]() |
RuuDie: RuuDie: ![]() ur rhymes dey make me go ha ha ha me i no want my roty wahala ![]() if na any oda thing i know I go fit assist but if na to overtake d show, make u no persist ![]() shark & crayfish get plenty difference make u take the others as point of reference i no go mention any of their name but dem all back down even b4 dem finish d game in any case, u come bring some fresh air to the cobweb wey for gather for this naija rhyme fair ![]() |
na now i understand, why my roty say make we always dey prudent ![]() becos when suffer go come, e go teach u lesson like jamb student ![]() now wey d economy dey bite with im credit crunch and person no fit buy one whole plantain bunch I happy say we remember to pinch and manage Or else, after d big society wedding, nothing for remain for us to salvage! ![]() |
RuuDie:na wow abi na wa, i no know which one i go talk see as ur poem long an' sweet pass jack & im beanstalk ![]() i dey wonder dey ponder where u dey all dis while u for don dey on top of the pidgin rhyming pile 2nd to my roty of course ![]() u know with him na beta 4 worse as d rhymes don dey mature from the love zone come enter into a more serious life tone in fact, i too much appreciate how d economy don depreciate people dey waka around with a big frown and blood pressure dey rise all over d town but as u talk say, for here u find comfort, i happy say u dey recommend our effort to put a little smile for the face of the masses and crack d ribs of both the low and high classes ![]() i mean dem dem wey think say we dey too local to dey rhyme for this naija pidgin vocal as always i go say, make we always dey real b4 our beautiful identity, westernisation no steal ![]() |
Playing For Pizza----John Grisham since it doesn't seem to be about law/lawyers this time (so far), I guess I'm in for a good read. |
RuuDie:how we no go like am as u too come join d naija luv jam but how u come call am swine flu ![]() e be like say u no get d clue how this thread come be an inspiration and last last, a nairaland pidgin sensation! ![]() u fit be last, but not d least congrats as u enjoy the rhyming love feast ![]() |
semid4lyfe:No be only Michael Scofield, na Dominic Purcell. ![]() aieromon:now, that's a thought. Trust Americans to always leave an opening, just in case. You never know . . . ![]() |
chrisical:Ask the person who put Sunny Neji on the list. ![]() baslone:I'm talking waaay before that, when all three Remedies were together. They showed the way for what others are doing today. IMO. |
rotimy:palmwine na for drunkard ![]() u wan make our pastor ban us for d churchyard instead we go share plenty new naira wey CBN governor dash us for Zaria ![]() i try now, e don tey u know ![]() |
How could anyone forget to mention the Remedies, remember their album with "Shakomo?" To me they deserve to be on that list 'cos they changed the scene at that time, and were considered the best when they first started. In short, they made an impact that is still showing today in the current scene. |
^^^^ sez who?? I've watched three whole movies already: Coraline, Star Trek, Night at the Museum 2 - I'm now on Angels & Demons. I'm just saying, your topic title is really misleading - it says : All Free! Latest Movies etc. ![]() |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 98 99 100 101 102 103 104 105 106 (of 120 pages)
, this can never be over
. So the TV series has finished running, so what? Some people still haven't seen the series or it's ending, and they may need a place to discuss it when they do. And in any case, Prison Break will always be worth talking about. In fact, if u are not careful, a SEASON FIVE will begin in some months, starring Michael's "whiz-kd" son, who inherited his late father's genius and may end up taking over the Company and turn it into a family business ----- (okay, now u know I have PB officially on the brain
. Can't help it, it was the best TV Series EVERRRRRR.) 
