₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,926 members, 8,447,785 topics. Date: Sunday, 19 July 2026 at 12:42 AM

Toggle theme

OLDESTWARRIBOY's Posts

Nairaland ForumOLDESTWARRIBOY's ProfileOLDESTWARRIBOY's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 22 23 24 25 26 27 28 29 30 (of 37 pages)

PoliticsRe: Osinbajo Presides Over National Single Window Trading Platform Committee by OLDESTWARRIBOY: 9:12pm On Jun 23, 2020
Osinbajo still dey alive? We no know o. Buhari dn turn this Afonja pastor to gateman o im own go worse pass Ebele Jonathan wey Yar'Adua & im wife turn to houseboy.

One Window o, 2 window o, 100 window...9ja na still cast. Obaseki, Oshiomhole and our policticians go still they useless themselves

GrammarNazi1 I sight you, Hope say you go translate my own to Queens English. Make dem do lift lockdown on schools so that you fill go back to that private school & start to they collect your monthly 20k salary, make you fil get busy and stop to they do work wey nobody send you
PoliticsRe: Abia APC Elects Orji Kalu As New Caucus Chairman by OLDESTWARRIBOY:
Ikpeazu no come abi im never still recover?

This thief wey Tanko free..So EFCC no go follow up the case again abi dem dn bribe dem too?
Which faction of APC this one even dey
Giadom
Ajimobi

God go punish all these thiefs
PoliticsRe: Edo: PDP Drags Justice Obile Before NJC by OLDESTWARRIBOY:
Emperor Wike dn see the future o, he really talk say APC own madness go be like child's play compare to wen PDP wan start dem own

Make this Ihama & Judge Obile calm down jor, why he blood dey hot? Na for Obaseki to share the money reach everybody hand den he loot am back from Edo state treasury when im win

For all the people wey PDP wan write letter give na Tanko dem cor go give? That APC judge wey dn spoil Imo state.
CelebritiesRe: Davido And Chioma Are Still Together – Adewale Adeleke by OLDESTWARRIBOY: 8:08pm On Jun 23, 2020
Maliqcious:
yeye warri boy is Davido your Father? Abi the political matters where dey ground you fit run am foreign.. Typical Old warriboy no go yen swe swe for O.B.O matters..
.
Na the political matters na concern me, frog voice davido mata no be problem yeye Afonja boy
PoliticsRe: Imo State Pensioners Protest On The Streets Over Non-Payment Of Pension by OLDESTWARRIBOY: 7:52pm On Jun 23, 2020
Oghene see people papa & mama for inside hot sun dey protest, make dem careful o make some trigger happy policegoats no go shoot dem o

God go punish Father Mbaka, Tanko, Mumumadu Buhari, Baba Osho & supreme court for bringing that Igbo to rule this great state. By now Ihedioha for dn destroy all Okorohausa statues and im for dn recover all the female okadas etc wey okorohausa and im pikin hide for garage by now.

The idiot Uzodinma dey Edo state dey form lion with Ize Iyamu & Oshiomole self when e never pay pensions...make e no worry Obaseki go put them to shame

Foreign AffairsRe: 7.4 Magnitude Earthquake In Southern Mexico by OLDESTWARRIBOY: 7:45pm On Jun 23, 2020

Foreign AffairsRe: 7.4 Magnitude Earthquake In Southern Mexico by OLDESTWARRIBOY: 7:43pm On Jun 23, 2020
LadyExcellency:
Says who?
Says Ogun & Amadioha

PoliticsRe: PDP Ticket: Groups Threaten N2b Lawsuit Against Imansuagbon If He Steps Down by OLDESTWARRIBOY: 7:38pm On Jun 23, 2020
Creeza:
If you don't know anything about Apc primary elections conducted yesterday just keep quiet and stop making a fool of yourself.

EPM is not APC and APC is not EPM
No be me do you but take this chilled bottle below tey step down...I know say the country hard

PoliticsRe: Wike: Some Members Of The PDP NWC Are Tax Collectors by OLDESTWARRIBOY: 7:29pm On Jun 23, 2020
Emperor calm down o, no go use this that your big mouth start wetin u no fil finish

Wen you dey fight Amaechi & APC for Rivers State, nobody talk anything about tax collectors or NWC o. Dem leave you make you fight. Now abeg allow Obaseki make im fight Baba Osho, Tinubu etc e own way.

Go destroy more hotels and threaten people papa with cutlass, na dat one you sabi. Edo state no be Obio-Akpor

PoliticsRe: Martins Idakpini: Lance Corporal Blasts Buratai Over Incessant Killings by OLDESTWARRIBOY: 7:28pm On Jun 23, 2020
famulan:
He is from Middle Belt (Benue). Did you even bother to watch the video before showing your stupidity and tribalistic mentality? Yoruba this, Amotekun that!

Even the guy in the video praised Femi Falana as the only lawyer who stood for soldiers when they were being tried.
If my mata pain you well well abeg go drink sniper, no be me dey do you
Wait you say Benue, the other guy say kogi. Who cor right now?
PoliticsRe: Martins Idakpini: Lance Corporal Blasts Buratai Over Incessant Killings by OLDESTWARRIBOY: 7:25pm On Jun 23, 2020
extol1:
he is an Igala guy from kogi state
Thanks
PoliticsRe: Wike Pulls Out Of Edo Governorship Project by OLDESTWARRIBOY: 7:23pm On Jun 23, 2020
Kemistri4:
U have started again today. If I engage u now, you'll start running to the mods

Cry cry baby cheesy
Dem never still ban you? Mods ona dey play Ojoro o, this small boy dey insult me that day. Make I catch you first

PoliticsRe: Martins Idakpini: Lance Corporal Blasts Buratai Over Incessant Killings by OLDESTWARRIBOY: 6:41pm On Jun 23, 2020
zeusdgrt:
Nonsense post

PoliticsRe: Martins Idakpini: Lance Corporal Blasts Buratai Over Incessant Killings by OLDESTWARRIBOY: 6:21pm On Jun 23, 2020
Idakpini?? Which tribe be that? Hope no be Afonja?

Brave Idakpini, small small o make dem no go set you up like dem do that one wey dey transfer money from Sokoto to Kaduna...Ojikri abi wetin be im name.

Buratai and im soldier ants dn try, we need new guys to fight insurgency...make them try use IPOBs or Amotekun. Or dem use Dokubo Asari & im boys
PoliticsRe: PDP Ticket: Groups Threaten N2b Lawsuit Against Imansuagbon If He Steps Down by OLDESTWARRIBOY: 6:11pm On Jun 23, 2020
Make Obaseki share this ones dem money, make dem allow am contest

Make this guy jejely step down make he no go disgrace im linage go lose im own LGA like Odubu & Obazee yesterday wey no fil win no own LGA for primary election
Foreign AffairsRe: 7.4 Magnitude Earthquake In Southern Mexico by OLDESTWARRIBOY: 6:06pm On Jun 23, 2020
All the sins wey all those dem drug cartels dey do na den dey get the payback so

Or

E fil be that Orange goat for white house handwork since the wall wey he use make mouth for 2016 no cor work again
PoliticsRe: Wike Pulls Out Of Edo Governorship Project by OLDESTWARRIBOY: 5:50pm On Jun 23, 2020
Fuckalldmods:
Developer hammer you dia, you better go pick your brain where you drop am.

CelebritiesRe: Davido And Chioma Are Still Together – Adewale Adeleke by OLDESTWARRIBOY: 5:40pm On Jun 23, 2020
Who gives a flying shi.t?

Abeg make ona carry this Afonja frog voice and im Erosion yam legged mgbeke babe comut here

We are dealing with Important issues right now, Father christmas Aketi don finally show im true colors sack people papa dem wey no do am anything
Wike dn cumot hand for Edo matter
Ajayi dn employ people wey dem be sack before
Giadom mata still dey court
Ajimobi still dey coma
Buhari is still shocked

And you dey here dey bring this noisemaker tori come here...abeg stop nonsense na Davido dey feed me?

PoliticsRe: Agboola Ajayi Appoints Sacked Aides As Personal Aides by OLDESTWARRIBOY: 5:40pm On Jun 23, 2020
dongodav:
Guy you don smoke weed abi? Na my state dey Bush road abi

PoliticsRe: Wike Pulls Out Of Edo Governorship Project by OLDESTWARRIBOY: 5:33pm On Jun 23, 2020
Emperor Wike

You think say Edo state na Rivers wey you dey do anyhow dey destroy people hotels way ashawo/runs babe & Yahoo boys tey dey hustle. Come form boss for here now, e go clear for your eye

BTW why Wike & Uzodinma wan resemble somehow. Dem get the same Developers head
PoliticsRe: Police Denies Sealing APC National Secretariat by OLDESTWARRIBOY:
Damage control
Baba Osho, Obaseki, Asiawaju Jagaban, Giadom, Eta and that other one wey dey coma dn finish this dem useless party

BTW this one wey Amaechi & el-Rufai quiet since, problem is lurking o
Buhari is shocked

PoliticsRe: Agboola Ajayi Appoints Sacked Aides As Personal Aides by OLDESTWARRIBOY:

The Fall of APC part 1 & 2
Starring
Baba Osho
Obaseki
Ize Iyamu
Giadom
Ajimobi (Voiced by Eta)
Produced by Edo state Gubernational films production company, No 16 Airport road, Benin city.
Directed by Hope Uzodinma

Coming soon!!
The return of the Fall of APC part 3 & 4
Starring
Father Christmas Aketi
Agboola
Secondus & more TBA
To be produced by Ondo state Gubernational films production company, no 40 skull Mining bush road, Akure
Directed by TBA
More details TBA!!

FashionRe: Alexreports, 10 Others Appointed Board Members Of West African Fashion Council by OLDESTWARRIBOY:
According to validated reports

Why the Validated reports?

Abeg congrats o for your appointment for WAEC hope say na miracle center? If I get who wan write, I go hala you


Modified: Wait o dem say na fashion council, which one be fashion council again.

That's Mr Alex go dey disturb us now o no be only Nigerian beauty queens again, na the full west africa beauty queens na we go dey see for Nairaland Front page. Something like



With the arrays of impacts created by iconic beauty queens and women across West Africa, a young beauty queen and upcoming Model, Queen Joy kaffour Mensah has kept the fire of success burning, as she continues to make and take remarkable steps at advancing her modelling career and humanitarian projects in communities across Sierra Leone cheesy cheesy
FamilyRe: Osun: Wife Damages Husband’s Genitals Over Infidelity by OLDESTWARRIBOY:
Na dem

SportsRe: Pogba Set To Be Benched For Man Utd's Premier League Return Against Tottenham by OLDESTWARRIBOY: 4:44pm On Jun 16, 2020
cheesy
CrimeRe: Suspected Thief Burnt To Death In Ogoja, Cross River (Graphic Photos) by OLDESTWARRIBOY: 4:37pm On Jun 16, 2020
Cross River again?? It's like it's every week na dem dey burn back to back o

Dem just dey parade pastor just now. Now dem dn burn thief. Why can't we do this to politicians? If we bring this energy to them polthiefcains, we go dey corrupt free o

Besides, e be like this cross river people no dey fear o. Make Nnmadi Coonu hire dem na make dem go fight for Biafra
Christianity EtcRe: Prophet Paul Abam Caught Burying Charms In Someone's House In Cross River (Pics) by OLDESTWARRIBOY: 4:11pm On Jun 16, 2020
Why are Nigerians so backward..who cares if e buy charms. We care about the wrong things

When dem go parade Gov. Ben Ayade and all the useless politicians wey don loot their children future, those idiots house of rep members wey no give that Judge im post cuz she be from Akwa-Ibom

Abi Dem no see Brownroof & Erosion people, you don see them parade TB Joshua, Indabooski or Father Mbaka wey see vision dey tell Ihedioha say make e pack say Uzodinma wan enter but e no see vision for Corona?


This Calabar people dey craze sha o, only dem burn Thief, parade pastor if only dem fil carry this energy go Aso Rock go parade/burn the people wey dey there
CrimeRe: Police In Lagos Prevent Frustrated Man From Jumping Into The Lagoon (Photos) by OLDESTWARRIBOY: 4:05pm On Jun 16, 2020
Enoch07:
yes o nobody dey go anywhere, we go suffer am together. check well em follow vote buhari
Exactly bros, you sabi the mata well
SportsRe: Chelsea Preparing To Offer Juventus €120m For Ronaldo This Summer by OLDESTWARRIBOY: 3:51pm On Jun 16, 2020
Dem no go buy defenders, abi na Azpilicueta wey im time dn pass, Zouma, Christensen, rudiger, marcos Alonso, dem tomori and that idiot Emerson na dem wan use stay top four?
PoliticsRe: Oshiomole: APC Can’t Bend Rules In Favour Of Obaseki by OLDESTWARRIBOY: 3:14pm On Jun 16, 2020
But E dey seat for four years with all that documents, if only Nigerians know their right all the bullsh..it for no dey happen o

What about Ganduje wey dem catch they collect bribe...abi to collect bribe dey among APC rules?

PoliticsRe: Protests Rock Kaduna Over Killings (Photos, Video) by OLDESTWARRIBOY:
Where Alexreports and all those im beauty queens dem, where Bukola & her houseboy Timi, where all those nollywood ok.pos dem, where Ladycewhy and all those nairaland galz dem.

You no go see dem protest this one o, but if na alleged rape case wey happen before dem born me or that other girl wey im nd pastor dey run things dem go see them o

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 22 23 24 25 26 27 28 29 30 (of 37 pages)