OLDESTWARRIBOY's Posts
Nairaland Forum › OLDESTWARRIBOY's Profile › OLDESTWARRIBOY's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 26 27 28 29 30 31 32 33 34 (of 37 pages)
Goal Goal Goal Goal Goal Goal Goal Goal Goal unbelievable Goal Dat annoying commentator for winning eleven, PS 1 chai i dn old o VCD one loader - Contra Terminator - 200 meter race, 100 meter race, Javeline, long jump, high jump, contra, That gun to shoot bird, super mario etc Sega - Sonic 1,2,3, Golden Axe 1,2,3, Teenage mutant ninja turtles, Mortal Kombat 3, road rash 1,2,3, sunset riders, bare knuckle 1,2,3, Tiny toon, super mario, super shinobi, contra hard cops etc PS1 was bae - Fighting force 1& 2, Road Rash: Jailbreak, Tekken, Xena, Gran Turismo 2, ninja assassin, smackdown 2, marvel vs capcom, Duke Nukem (All of dem) etc PS 2 - God hand, MK: Shaolin monks, Pes 2008, God of War 1 & 2, King Arthur, GTA: Vice city & San Andreas etc Na only football I play for PS 3 PS4 - The last of us... hands down |
[quote author=Altimatic27 post=90567704][/quote] I dey vex na, no be my fault |
I no do....if I wan read, I know were dem dey sell novel. Abeg make somebody help me summarize |
Galactico4ever:lol you no see that guy wey quote me dey say call am derogatory term |
the way dem tey serious for this rape mata make dem still serious for other more pressing issues too |
pasol4real:bros no follow play that play, you no knw delta state reach me |
Crayfish09:Aboki means my friend sir |
All this rubbish never tire ona when all this edo girls dey carry cardboard dey protest against rape some few weeks what was the outcome? No be FG dn make rape mata state of emergency? Oya we need that same energy let's protest against poverty, insecurity, looting etc so that FG go get sense do something so dat we no go dey see news like that this again Most guys are into scam, girls okpo..we need to set our priorities right for this our country o...shebi ona see that university of Ghana thread? I dn talk my own. Na ona knw |
When dem go declare state of emergency for looting, corruption and thieving of politicians...wrong priorities. Hope dem know say 70% of rape accusations are false Dat porn guy dey below me....my guy how ironic on a rape thread too, you still dey post porn...Guy who dey do you? Racoon:Exactly...spot on |
The programme is to last for a period of five consecutive years and the essence is to produce sufficient indigenous engineers who will continue to build and sustain railway infrastructure in Nigeria and beyond. Haha I laugh in fulfulde...build? Railway Infrastructure kini? last last na bank these ones go work no be Nigeria again Rotimi Amaechi fil just employ dem sha nothing still spoil |
Abba dey, Aba dey too why this people dey confuse us na R.I.P. sir |
Audio punish Na 2day?? 2moro Buratai go come tell us say dem wan surrender. Den senator Ibrahim Gaidam go cor sponsor bill for repentant bandits use taxpayers money dey feed dem All this northerners dey do themselves, no be me dem dey do
|
heysquare:Fixed...go check it now. Thanks |
People still dey watch TV? Apart from football nothing else for me....movies on my laptop. Dat time I still dey sleep sf. If the speech come out before the video make dem hold Femi Adesina o Thanks Major General 'Mumummadu' Buhari, slave master of the west, tyrant of the east, sponspor of boko haram, miyetti allah Godfather, fulani herdsmen caretaker, looter of treasury, borrower of our children future, grandfeeder of school pupils, greatest yahoo boy ever, chairman: Owners of Nigeria association. We thank you in advance sir, and also thanks for nominating NOI (Delta State Amaka) for that post. The boys from the south loyal sir. |
See fight, people papa just dey disgrace themselves...Aboki dem. Make dem send these ones go Sambisa na make dem fight boko boys elyte89:Calm down, e dey happen everywhere you no see those kung fu lawmakers for hong kong months ago? |
Yope I think both are still in my parents place, anytime I visit I will check. Memories don't die |
R.I.P. Mr Nicholas Ofodile This was an assassination, where dat Abba Kyari wey dey celebrate e post...oya work dn come o make ona cor find the culprits dem I blame that goat Yahaya Bello, as if say e gree say covik19 dey d state...no be dem for ban interstate movement or even dey on lockdown self |
E be like Kaduna dey hot this period o, make dem small small |
'Incompo wetin' Abeg we need more details Shebi ona dn seeam o, north dn impeach deputy speaker o but Obasa still dey go work and ball with im mistress. Kali Orji go dn resume work but according to some people dem say na north be the problem of the country.
|
One Abba Kyari go, na another replace am o see mata Make I no talk wetin dey my mind before some people go bury me alive |
Who still dey give this Al-Mustapha interview self, after he dn take codeine and kpansh all those 15 years old muslim galz finish, e go cor come dey talk rubbish Bubu dn talk say Abacha no thief, we argue? no problem. So all the money wey Government dey recover since na wetin?. Some kind times politicians go dey talk as if say we no get sense. Na dem know o |
wetin concern me, if she like she follow am enter hotel room...dem no dey carry girls Mata for head these days |
For him mind before, he dn scam the guys o 20k for Iphone 7? Him n know say the guys no dey smile this period. But wait o, wetin this pale wan do with iphone 7? E wan start hustle? OP, when was this?, No social distancing, no face masks dem no dey fear covik19 |
Mraphel:The Akwa Ibom girl I had was too skinny, maybe I need to dey with thick one to confirm. I dey hear Edo galz scores o, i neva really dey with one o my guys dey say dem be blast o |
Who curse the black race? The person no try atall o We still dey acquire stimulator for 2020? When we go start to dey produce our own stimulator talkless of plane nah?. Innoson Biko help us now even if na to arrange parts bikonu |
iLegendd:I hear you |
Meedon:Fill me in na, I'm all ears |
So you just relax, dem money go fall from heaven go meet you shebi? |
R.I.P. Sir thanks for serving our great nation |
My problem is not with OP but this comments, why are you guys talking it personal? OP is obviously trolling cuz okpo dey all states, but even if he's not nothing spoil so far e no mention your family members Abeg OP, how you tey do the survey? |
For where?? This lie no be here o |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 26 27 28 29 30 31 32 33 34 (of 37 pages)