Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 4:58pm On Apr 16, 2009 |
Dis Guy: chei i heard the number of customers coming to silverbird has skyrocketed since erm mr rotimy started this thread!!
are you sure rotimy is not their business development officer?
whats the cinema like sef, are people allowed to loiter around doing nothing? Walai, I am not working with the silverbird cinemas, but if their customers are increasing because of these, then the must pay tithe to me and larayat |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 4:49pm On Apr 16, 2009 |
 To marry the person you love and enjoy your honeymoon dey cool, Maedan sweet love don turn me to an aje butter from de old school |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 6:44pm On Apr 10, 2009 |
larayat: hun, so mr nigeria,i dont believ ur story n might b d opposite of wat u intended saying lol  LoL If you want to see my pics, ask and like pop-corn and ice-cream, it shall be given to you. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:41pm On Apr 10, 2009 |
Tayo-D: @Maedan, Which kain yeye descretion Let me bring to your attention Person wey like humility No go marry Maedan the beauty
Person wey drive Bentley go turn head Especially if hin go Ajegunle Maedan too na head turner Hot mama, like Tina Turner
Like many people, me sef I wonder How Rotimy manage be your lover But if I dey think like that Wetin I go say for Ojukwu and Bianca
I know money fit do anything Bring together, Beauty and the Beast Seal and Heidi Klum tell me say With money, you go get the whole package Maedan dey make my heart yori-yori, And our royal marriage go be jolly-joli |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:33pm On Apr 10, 2009 |
princesa: was up all of you am loving thia hread invincibly Maedan a lady that rule supreme nice flow u got whatever language to use nice up rotimy too and tayo d
i never could rhyme in pidgin not my knack besides my fire is out i can t even rhyme for a money sack
later then  Thanks for de encouragement, I go soon hear of ur engagement And me & Madam Maedan go come for enjoyment. |
Christianity Etc › Re: Global Meltdown: What Should The Church Do by rotimy(m): 2:53pm On Apr 09, 2009 |
Maybe, it is time for pastors and GOs will buy more private jets to fly all over the world and monitor the global meltdown. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 2:46pm On Apr 09, 2009 |
larayat: abeg ask am again,i suspect foul play LOL  But on a more serious note, some guys are lucky or damn unlucky. I don't know where to place myself. Erase your foul play theory. If a guy says an unknown lady flashed his GSM number and he called her. It will sound unbelievable that this unknown lady who claims she flashed the number in error will try to get intimate with the guy and even have the boldness to request for a recharge card worth 200 naira. It happens everyday in Nigeria. Mine might be a case of fatal attraction may be because I am power dresser or cos I"m standing at 6ft 2. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 2:37pm On Apr 09, 2009 |
maballack: @rotimy, a food 4 thought, hws it only u they hve met 3 times, I don't know why but my hunch tells that those ladies might be in a gang or group. Maybe, the first one might point to the mugu for others to try their lucks on him later. Another thing, from the responses, I have come to aconclusion that there are variations of relationship scams going on in Lagos and many guys who are victims don't want to speak out or share their ugly expriences so that others will shout , SO WHAT?. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:20pm On Apr 09, 2009 |
@ Nairalanders, count down to d our e-wedding! Easter Sunday, April 12,2009.10.00AM @ Abuja.
If you never get our card. I beg make U no dey sad. Make you drop your name and address, We promise to get to you without stress.
signed , MAEDANROTIMY |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 7:18pm On Apr 08, 2009 |
lexdino: 5card icecream  Pls what is 5card ice cream? |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:08pm On Apr 08, 2009 |
Tayo-D: @maedan, Which one you dey sef Why reveal this bombshell U for wait till after wedding To reveal this shortcoming
Rotimy no dey play with hin food Steaming hot, no be one wey don cool Nothing dey remain mama sikira soup Which hin dey chop everyday at noon. Walai you be true son of your father, But I get cooking training from my mother. Mama Sikira dey use white maggi dey cook, E don tey I went there to eat or to book. True true I No dey play with my correct African delicious food, I go prove to Maedan say I dey cook food wey dey very good. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:57pm On Apr 08, 2009 |
maedan: verrry nice 
but i must to warn u say, i no b fantastic cook instead 2 dey stay kitchen, i go dey read book but i sabi prepare indomie well well e beta pass pounded yam wey go make ur belle swell!  My African Princess, Cook or no cook no go be a problem to us, I no go marry you make you come work and tire like a horse. But I think say dat Indomie na for our children wey dey come? Na true na only dat kind oyibo food country man go chop for home? Anyway shaa,I sabi cook very well and go take time teach you gently, When you get belle, I go dey cook all de food and feed you lovingly. You go try read all the fine cooking books and about men & their lives, Even films go help you adjust esp dat series about " Desperate Housewives". |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:41pm On Apr 08, 2009 |
Tayo-D: @Ritimy, Ha-tchoo! God bless me too much This sneezing, where hin come from To say na bird flu or cold I catch I still no go dey sneeze like that.
Surely this na case of allergy My only way to detect true bullshit Inside wetin Rotimy write and tell There is a lie hin dey try to sell
Last week d guy say hin dey too broke To manage money be hin only goal This week hin dey throw dollar around Like I no know what its all about You know from time I dey by your side To marry Maedan my hand dey inside But no try to score a cheap point By throwing your guy under the bus! A man wey wan be true man no dey annouce all him wealth, Rotimy no dey very broke, just dey save and dey tight my belt. When I wan insist that our honeymoon must be for Calabar, Abi I no agree to take her to Carribben when she shout "haba"? Rotimy don dey poor before and no wan be poor again, He dey reluntant to throw money around which can't be regain. In dis e-love story, him strong love for de wife dey motivate him, To make his pretty caring wife happy now seems to be his life aim. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:03pm On Apr 07, 2009 |
maedan: @rotylovy i don almost finish 2 dey compile i know say e go take a while bt d long list dey almost ready 2 invite al those who dey hold us steady 4rm olulu 2 even dat tayo-d both d haters & naysayers,make dem no talk say i dey heady My egg-yolk,I sabi say you dey wetin oyibo de call meticulous, U go make sure all are invited so dem go take us very serious. I happy say soon I go de eat your food wey go dey delicious. I beg no forget all those wey dey cheer & those wey dey jealous! |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 5:03pm On Apr 07, 2009 |
oluknower: See Una ! i just dey wonder werrin cause all the bruhuiahuia, shei the girls wen dem dey hungry make dem no ask? it is written axe and it shall be given! sorry i mean ask, asides that u watch a film for 1 grand chop guguru no ground nut inside only butter with either salt or sugar for 400 box shei dat one make sense? please answer me oh!! There is nothing wrong in asking only if with good intention. And nothing is wrong with watching a film with 1 grand and N400 POP-CORN. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:05pm On Apr 07, 2009 |
@ Nairalanders
If you never get our card. I beg make U no dey sad. Make you drop your name and address, We promise to get to you without stress.
signed, ROTIMAEDAN |
Dating And Meet-up Zone › Re: Dating And Relationship Troubles With Expert Solutions by rotimy(m): 1:50pm On Apr 07, 2009 |
dreming of bahamas
|
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 1:18pm On Apr 07, 2009 |
larayat: can some one buy me an icecream, pls  What type, vanila or what? |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 8:22pm On Apr 06, 2009 |
Tayo-D: @maedan See me see wahala, abi na trouble Why this unnecessary hustle and bustle You overlook my very smart and good intention Designed to help you for your special occassion
I say I know a generous sponsor No be by force by force make u concur All I know be say u get power to choose If u no like am, make you just press snooze
No be say I wan cause any wahala But funding a wedding no be small matter As for Rotimy, hin don catch my clue Him luv don drive am to love-vendor for you Na wa for this man way say I get clue, May be him dey suffer from de bird flu. |
|
|
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 6:57pm On Apr 06, 2009 |
platinumnk: Can someone buy me some popcorn please ?`  LOL. Since pop-corn is becoming controversial and common, why not ask for ice-cream? Ask, you shall recieve. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 2:19pm On Apr 06, 2009 |
Seeing is believing |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:15pm On Apr 06, 2009 |
[quote author=rotimy link=topic=232650.msg3695260#msg3695260 date=1239023498][/quote]@ TAYO-D Na before Rotimy say he no get money, But God come butter my bread with honey. I no fit afford all de fine things in dis world, But I not fit leave my sweet wife naked for cold. We dey take wisdom dey spend for dis marriage, Maedan na very good wife who know how to manage. Tayo, you kin sponsor na type wey get big K-leg, because your type dey pursue person's wife with him 3rd-leg |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:11pm On Apr 06, 2009 |
Tayo-D: @Maedan, Your silence has been astonishing And your reply is no less comforting Per your Sista I am still pursuing Though her hand you are witholding
He dey hard to always rhyme No matter how hard a broda try But so far luv dey abound Inspiration go come around.
Good luck on your your shopping spree But tell me who dey pay the bill Rotimy talk say hin no get any dough How u come dey manage am so?
[s]Let me know if you need a sponsor I know one for the city of London All dey need is a night with the bride-to-be And with dat they go meet your every need. [/s] [/quote
Na before Rotimy say he no get money, But God come butter my bread with honey. I no fit afford all de fine things in dis world, But I not fit leave my sweet wife naked for cold. We dey take wisdom dey spend for dis marriage, Maedan na very good wife who know how to manage. Tayo, you kin sponsor na type wey get big K-leg, because your type dey pursue person's wife with him 3rd-leg |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:56pm On Apr 06, 2009 |
maedan:

so i be a princess wey dey priceless and a gift wey dey give person heart a lift?
diamond wey dey like almond, na only me?  even a rose flower and mindblower -chei, see me see
i[b] sure say u dey sweeten me up for that our honeymoon u wan make sure we rock am pass d one for mills & boon[/b] no wahala, as an e-hubby, u go electronically enjoy ur maedan  and then carry am go ur house make i come be your madam!  }}}}}}}}}}}}}}DAYS AND NIGHTS OF OUR HONEYMOON{{{{{{{{{{{{{{{[ Days of lovely laughter, Nights of inimate matter. Days of sweet kiss, Nights of honey bliss. Days of watching de waves, Nights of making de moves! Days of feeding each other, Nights of loving each other! P.S, Onyeka Onwenu for our show charged five hundred thousand naira, I do pay am and she promise her best for people from land of naira. Pls suggest the man of God wey go officiate for de Church, Dem be so many now and I want de best from de bunch! My travel agent don book our 1st class flight to Island of Bahamas, De beach of that Caribbean and their hotel go make us go bananas |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 6:33pm On Apr 05, 2009 |
aktunde: I think this is a nice piece of information for guys seeking women on naira list. Just get to silver bird, dress well, and buy pop corn. It's done! With a total of N200 worth of pop corn, bought at different time intervals, I think you can have enough samples to choose from. Nice one poster! Do you really mean it or are you joking? |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:31pm On Apr 05, 2009 |
heyo: Posted on: Today at 03:57:47 PMPosted by: rotimy Insert Quote ***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN***********
Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto, My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto. Your face no just dey very fine but na shining angel face, No beauty contest you enter which u no go win the race. Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise, And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice. You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer, And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer. Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach, And when we marry I go take time and lick them inch by inch.Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya, And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya. With only one week to our speacial wedding
@roty
dats so disgusting brother ur sexual tactics are like those of a villager, yulk!! Bros wetin dey disgusting for couple wey don marry? No be anyhow dem like am na so dem go try & no tarry? When you marry your own, make you no kiss d mouth but her toe, No matter how you abuse or curse me, I no go ever be your foe. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:18pm On Apr 05, 2009 |
maedan: @ heyo i no jus understand i think say u b civilized man those very lines u dey call disgusting be d kind wey dey last without rusting na so he take capture me 4rm d 1st page so i beg make u save ur rage me wey don already write ur special I.V. Card bt now i go tear am bc ur heart too dey hard I beg you my love make Heyo still get our speacial card, Two people at the time no de show say dem dey mad. No matter wetin e say he no go succeed to me make sad, Make e come dat day look as Roty & Maedan go[b] kiss [/b] hard. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:07pm On Apr 05, 2009 |
maedan: @ my romantic, caring, sexy & CIVILIZED rotimy, sweet'art, pls no mind heyo, e no get clue, about d diamond wey dey deep inside of u na ur kind humble guy dey get all d chicks wey hot, while d show-offs dey get d back of pot. In fact, na dat ur poem we go print 4 d wedding programme make pple see say u truly luv ur maedan!
***kisss*** ))))))))))))))))TEN WORDS TO DESCRIBE MY MAEDAN(((((((((((((((((((((( Princess Priceless Gift Lift Diamond Almond Rose flower Mind blower Lovely Maedan My only Madam |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 3:57pm On Apr 04, 2009 |
***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN*********** [color=#990000][/color] Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto, My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto. Your face no just dey very fine but na shining angel face, No beauty contest you enter which u no go win the race. Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise, And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice. You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer, And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer. Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach, And when we marry I go take time and lick them inch by inch. Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya, And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya. With only one week to our speacial wedding, I wan promise that our love go be unending. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 3:15pm On Apr 04, 2009 |
johnnygan: Honestly, i dey swear by the yansh of my fore-fathers. You no holy at all I for dey happy if your swear with the juju or shrine of your fore fathers! Dem de potent pass dem konko below |