Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 3:53pm On Apr 03, 2009 |
sugabelle: na wa o
for dis thread, i dey trip e dey make me wanna skip take care to keep am going make sure no space 4 overthrowing! Make u no skip de trip for Abuja come Easter Sunday, The Rotmy-Maedan wedding go give you joy all day. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 3:44pm On Apr 03, 2009 |
hackney: So how come you are refering to them as ladies? What else do you call them? Call girls? Those I saw dressed like real ladies only that their actions are unl-ady-like |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 12:40pm On Apr 03, 2009 |
oluwdashmi: @rotimy heyo, bililis, dahala etc, think say dem get mouth but u don show dem say ur love na meadan couch with your promise to bring her comfort even without much effort
I never come shake for de sake of other men, As dem fit try their luck on plenty of other women. Maedan no be de type dem call girl next door, She agree to marry me when I dey very poor. Because I dey very bold to tell her de truth from day one, E come dey hard for Heyo & others to truly turn her on. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 12:23pm On Apr 03, 2009 |
tpia: some dudes will believe anything.
Someone started a thread to announce he has money to buy popcorn and folks are carrying it on their big heads as usual. It will be very unfair to me to claim I started this thread to annouce that I have money to buy pop-corn. Pls be informed that I only wanted to warn gentlemen as what I percieved to be a charity or relationship scam! |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 8:59pm On Apr 02, 2009 |
qblaze: Fair trade. Popcorn for hand, toto for bed.  |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 11:09am On Apr 02, 2009 |
maedan: na 2day i know say we get d same mind, and dat lai lai, no1 fit break our bind na Onyeka i dey think go give us some vibes tho' some of her songs dey from other tribes i no mind make we mix am, with ibo n yoruba we go even invite a funky mallam 2 sing im own 4 hausa!  Jolly plus over happiness don make me add more kilo, Come see how our God come lift us to d top from zero! In our union together I go always and forever try to be your hero. I go take good care of U dat U go dey laff when you look for mirror |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 10:47am On Apr 02, 2009 |
|
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 8:08pm On Apr 01, 2009 |
soloqy: If they could afford the ticket for the movie or even transportation to that place, couldnt they afford popcorn as well?
I think it was just an excuse to get to meet/know you. Am not encouraging girls begging around but maybe you are not telling us exactly how it happened.
I cant imagine a girl walking up to me at the Galleria or Shopright and outrightly asking me to buy something for her without my saying hi or acknowledging her presence in some way.
I just dont believe they would walk up and ask you to buy something.
Maybe you started a conversation or gave an inviting look or something.
and why is this topic in the romance section? I obtained a ticket of an evening movie titled WATCHMAN. After buying pop-corn and drink, I was about to enter the movie room when a lady's voice said EXCUSE ME SIR! The only thing I said when I turned was YES CAN I HELP YOU?. She said something about waiting for a friend and wouldn't mind a pop-corn and a drink! She looked well-dressed and I handed five hundred naira to her. She thanked me and demanded for my phone number which I declined to give her. Since then I have met two others saying the same thing. I decided to warn real gentlemen to steer clear from them. In this days of violent robberies, kidnappings and other crime, those ladies might mess up a gentleman. I put the post in a romance section because by demanding my phone number, i guess she wants to be romantically linked with me! |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:36pm On Apr 01, 2009 |
Tayo-D: @Rotimy, This your contradiction don give me brain bloc How I go recover after this great shock Abi na the test Maedan talk about be this Get behind me satani, you no go fit win! I no wan shock you as dey serious to get dat lady, De only thing you go need is to be humble not heady, Then I go ask her sista if she dey available and ready. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:29pm On Apr 01, 2009 |
maedan: @rotylovy, make we no 4get who go b d entertainer i no mind if dbanj go b d wedding singer or if u prefer,we go hire deejay wey go mix tunes of d latest & of yesterday! Since you like dat entertainer D'banj to be our wedding singer, I go allow am perform so far he put him long thing for hanger. Yes Madam Onyeka go "come sing one love keep us together", DJ go mix old school, new school and even future school 2gether |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 5:21pm On Apr 01, 2009 |
Waxxy: These hustler babes are everywhere. In Abuja, we call them "Ceddi plaza" girls. You can find them perching around Bon Cafe, Barcelos on the first floor waiting for suitable prey. U'll see them at d start and end of every movie, sumtyms in groups.They shld not be confused with normal cinema-going ladies Pls don't ever bring up the issue of the hustling Abuja ladies up. It will take eternity to discuss them and their antics and tactics |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 5:08pm On Apr 01, 2009 |
maedan: d tym don dey reach to draw d NL guest lists 2 include d wellwishers 4 NL, even plus d confusionists  e go take some time, but i go try do am well make no one come miss d sound of d wedding bell! I dey suggest make our royal wedding be on Easter Sunday, So that we go leave for honeymoon at Bahamas on Monday. I don book the congress hall at Sheraton Abuja for reception, Dem say everything go get attention and bring us satisfaction. As many fans don promise us to from very far and near, Even Prido Yar'dua say him go come to smile ear to ear. I trust say you go do real justice to the list and the i.v, Those wey we forget go relax and watch am live for t.v |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 4:49pm On Apr 01, 2009 |
Tayo-D: @maedan, [b]Make your fine sista the Chief Bridesmaid I will be Rotimy's Bestman for that day[/b]And just in case you two withdraw 4 altar We go step in, marry, no wahala!  I dey fear for you to be my bestman, As your body dey jigi-jigi for a woman. As you wan stand with her dat day U fit get heart-attack, And such calamity fit derail our royal wedding from d track |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 12:01pm On Mar 31, 2009 |
maedan: yes o, to satisfy d guests na im dey beta make dem no come reject our invitation letter i go make sure we go put them first esp those who stand by we for our time of test  I come dey think say I dey for another world, How your advice come de help us work in accord. We go make sure we keep strong our super bond, Because we go always be the the first no be second. |
|
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 11:45am On Mar 31, 2009 |
maedan: ah ah, roty my baby why u go dey disgrace me  i don already promise denony chopchop now u dey ask am make he go dey shop shop if gifts go dey, good, if not, no stress all i need b say, make d guests dress to impress  Because na your day, I no go put you for disgrace, I go make sure that our fine guests we go impress. No be only rice and stew go dey plenty but meat, Make Nairalanders come jolly and see plenty to eat. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 11:37am On Mar 31, 2009 |
denony: Now i have seen the end of the saga Heyo is bowing out with a testimonial song
Love can't be bought with gold nor silver It is extremely priceless It's something you feel inside, heart convenant. thats why u see some people kill theirself becuase of love chei Love is powerful.
So guys can you all do a massive bow Lets arrange this wedding for Roty and Maedan They are the best couple of the year in Nairaland.
As for me all i need is Maedan sister as my reward to this whole saga. Na massive bow Rotimy and Maedan go chop? You no hear say things don too cost for shop? Our own wedding no be rice and stew very plenty, We go need massive gifts make we no go empty. I go help U see U win de love of my sista in-law, Because from your poems, U no be an out-law. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 11:24am On Mar 31, 2009 |
spoilt: girls are begging for popcorn at silverbird cinema?  Yes! But very few of them are doing so. Others are there to look for Salsa dancing partners on Sunday evenings! |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 8:39pm On Mar 30, 2009 |
honeric01: Strategy begot strategy
Not only men can change strategy to catch girls, they also have theirs too lol I have been going to the Silverbird Galleria on weekdays but yesterday being Sunday, I was there for a 4.30pm movie. When we came out by 7.00pm, the whole ground floor have been taken over by all manner of guys and ladies. Real Salsa music and dancing was on with hundreds watching, geee It might really be the management that have their own strategy to keep the place busy and retain customers! Dancing with a half naked lady might motivate some guys to go beyond pop-corn and move into the fast-food joints located at the 1st and 2nd flloor! Soon Ben Bruce and his brothers might add chalets for randy men and their salsa pop-corn babes |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 8:24pm On Mar 30, 2009 |
dalaha: i dont know how i read this to the end  but some one has to pay for my time  if not i would take this script to nollywood and make some pay for my time hope u would buy the movie it would be coming out soon 
when i find maedans real huby and make him break up with her then adobe rotimy with my x girls naked pic and mail it to maedan ,
there has to be an end and i smell heart break 
the only thing missing is a bad guy in this plot so i guess i'll be him No be today you begin dey smell things like rat and heart break. But soon you go come jolly for our wedding and eat our cake. Almajeri na de bad boy wey dey cause wahala for de North, For the East we come get Ofeke wey de behave as him be nut. West get im own Alaye wey day take violence as their handiwork. Even in South de militants and kidnappers dey talk bad guy talk. But me and my Maedan no go mind them as our wedding day dey tick for clock |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 8:06pm On Mar 30, 2009 |
denony: Roty why you dey shiver like say u get fever because now i wan shizzle cos i gat the brizzle and the gizzle Rotimy dey healthy and he no dey shiver as he get fever, Maedan love for me dey strong and dey flow like Naija river |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 12:17pm On Mar 30, 2009 |
maedan: I try my best 2 put enuf welcome banners, make al of una no tink say i get bad manners i try make una feel at home but now una dey throw me stone, by putting san-san 4 my garri, wit my roty wey i wan marry i blive time don reach2 face my wedding plans,
&4get heyo&bililis wey claim2 b my fans! Mummy,You don try for them no be for small, All of dem want My Maedan both short & tall. You be fine flower wey dey open for de sun, All incests wan come perch & others wan born. Make you draw the lists of officials of de day, Because in this marriage you go dey have a say! |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 12:03pm On Mar 30, 2009 |
|
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 11:53am On Mar 30, 2009 |
@ denony Chai, a butterfly dey think say e be bird because e dey fly, A small boy wey throw him elder for ground na him go first cry. |
Romance › Re: Pop-corn Begging Ladies At The Silverbird Cinemas by rotimy(op): 4:13pm On Mar 29, 2009 |
|
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 4:06pm On Mar 29, 2009 |
heyo: @denony
homeboy,u can cross ur finger pass the one of calvary roty is clinchin sh*t! dats my boo he wants 2 marry and tanx 4 being reasonable i can see u want maedan's sis dats available i can see she sey stubborn 4 dat one my guy carry on
@dmitri
where the hell did u come from?
@maedan
my queen,i no b americana and i no dey smoke marijuana but i am just bein my fly self roty tite 4 d naija rhyme no doubt but i am walkin in my shoes,dats wat i'm about if u want me 2 break it down 4 ya,i will but happy i want u 2 make me feel by adding some suspense in this fiasco even tho u no be lupe or johnny brasco let the readers feel some suspense and keep them yearnin for more don't let anyone snore shift sides a little bit baby either 2 mine or billis maybe he has more action like bruce willis who knows? but i am PDP so u gatta come 2 mine cuz i rule up in this mothaf*** roty's love show is old news am new school so lets play by my rules so do ur thingny!!enuff said Chai, a butterfly dey think say e be bird because e dey fly, A small wey throw him elder for ground na him go first cry. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 3:57pm On Mar 29, 2009 |
maedan: 2 my roty
i almost wan dey start 2worry say u no wan finish dis love story but as u xplain say u dey prepare, i don already stop to dey fear  because some men dey run wen competition too hot dem no lyk stress, so dem go comot hand 4rm d pot but as u stay n fight u make my smile shine bright
now back to our main agenda, on how 2 keep d love strong yet tender 4get Diana n Charles, even Michelle n Obama na we be d original couples, our lv dey bammer!  [b]ur sweet words of lv dey rub pancake for my tummy soon we go start family n i go b ur pickin mummy! :[/b]o  2 my mama maedan I be de true son of my father wey be an ogbenga fighter, But my Papa warn say de fight for a woman go dey tighter. No be say I no go defend you when you don become my wife, I go do so at any time and for you I go even lay down my life, But person wey wear him fine clothe for body no dey pursue a naked man, I no dey shake for any competition as you don assure me U be my woman. The news dat you go soon be the mama of my pickins come sweet me for head, As I pass one super market today I come take style ask the price of baby bed. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 3:44pm On Mar 29, 2009 |
heyo: @roty
homeboy!! u r cementing wat? yo!! its high time we fought i am not gonna take this likely i am gonna pressurize u definitely to leave my future wifey u r busy sharing cards? u jokin rait?one of those ur blabs? yeah it should b ur blabs just like saying usher got no tummy abs thats how unrealistic you can get sharing cards?i think i would like 2 hit u below da belt if i don't have maedan,none of us will so better back off,hope u get the drill Walai countryman no get any time for your english, Because the whole thing dey sound like gibberish. I don finsh the sharing of cards & now wan hire the reception hall, Mature men no dey see love as a civil war or a game of football. |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 9:06pm On Mar 27, 2009 |
heyo: @denony
hey,take a chill pill or rather like statue of liberty,just stand still i haven't seen any love story that has no bad guy involved to let the chic in question tell her guy bye i am not starting any drama with u i just want to focus on roty n his boo but u called me a yahoo boy n a militant so i had to make the beef constant no b me find trouble but if u want it,i go give u double wat the hell? u r making me waste my rhymes wey i suppose dey drop 4 maedan make she get the signs hommie lets just enjoy the game no time to call each other names,no time 2 lay blames pisso @billis tanx 4 attacking me indirectly but let me brush u up properly i am the foremost loverboy on this thread so do ur thing and leave me instead let me do my chase cuz i am number one in this love race if u claim u r d baddest and meanest let's see who gets maedan first or rather lets see who rhymes best they r a lot of judges let's just do this and leave all the grudges didnt come here 2 fight no one am just here 2 get maedan n catch fun
@maedan my princess d love i v 4 u dey excess i can see u r not a material girl so like cassie,u could be my official girl i wd listen 2 ur problems and find ways 2 solve ur problems my shoulders r broad enuff 4 u 2 lean on like usher,my love i would let it burn for u,only 4 u so much dat u cannot comprehend even if u no fine without make-up,i no send u need to concentrate on me a little more cz u gat the keys 2 my heart which is door 2 ur emotional happiness and satisfaction if u need me 2 bring ur breakfast 2 bed,don't mention we could stroll at the park hands in hands tellin u hw much i care as we sit on the beach sands we could kiss at night on the rooftops while the cool breeze sensitizes us,as we caress with no full stops like 50cent said,all i need is a liitle bit a little bit of ur time,b4 u know it u wd b mine so maedan stop the frontin and the long thing u aint nobody's wife yet so i can still place my bet u said next time i wan vex,make i chill 4 swimming pool? dont worry with u by my side 4 d pool,i go cool enough said
@roty
i gatta give u props tho 4 this initiative real talk wat dat dude said,u r creative read the first 4 pages b4 i came thru and i must say u r good but the way u were rhyming got me in d mood 2 wanna put some drama into this and see if u r stil worthy of d marital bliss with maedan so dude kip doin ur thingny cuz this is a freestyle thingny i wanna see how much more u gat cuz u v been quiet as a matta of fact since i stepped into the scene come on, u gatta a lot of fans out there [s]so fight 4 ur love ,maedan's teddy bear hahhahaha[/s]!!! enuff said A wise man wey him Papa born well do dey fight woman fight, because dem fit wound am below him belt or on his lips give him a bite! I dey use my energy dey do something wey go cement my marriage, Walai, I no sure say I go get time to fight or with you exchange rage! |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 8:37pm On Mar 27, 2009 |
dimitri: @ roty
guy make you no fear because of these guy wen just appear your lyrics wen u sow like seed don be like the proverbial mustard seed make you make sure u tend am make e no turn to weed because the heart break, i sure say u no need de girl correct indeed she no dey for any deceit but if you dey fear her deeds u fit carry her go Redeem,  The rope wey dem don tie double, To break am na to look for trouble |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 8:33pm On Mar 27, 2009 |
gReenmAn: A beg where's roty?
Or has all these hot blooded rhymestars scared him off the chase. Waiting  Roty dey very busy dey prepare de wedding, because with Maedan e go be a happy ending! |
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 8:29pm On Mar 27, 2009 |
kidgenious: Hey roty,y d freak jeez did u freeze either ur system was attacked by a virus catalyst or ur internet subscription suddenly cease maedan hope dere's no crisis or u guyz ar trippin across d sea dis is gettin interestin we 1na c mor thrills n flicks. Rotimy no freeze or attacked by any virus catalyst, I dey busy de share our wedding cards from de list |