₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,588 members, 8,422,689 topics. Date: Monday, 08 June 2026 at 04:33 PM

Toggle theme

Rotimy's Posts

Nairaland ForumRotimy's ProfileRotimy's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 (of 20 pages)

LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:56pm On Mar 13, 2009
olulu:
una show i for like to join, huh
since no need to pay coin.
but i no dey pursue women again tongue
cause i no dey see d gain. huh
cos now na women dey seek me out wink
in order to ask me out, cheesy
cos i b a self made man, cool
d dream of all fine fine woman. kiss
i no go even wan rock una love boat lipsrsealed
since rotimy don dey sew him wedding coat,
make una continue una love show,
make i just siddon dey feel d flow grin
Good pretty wife like Maedan na correct gift from yonder,
I dey thank Baba God well well say you no put assunder.
Make you dey jolly with us as we prove love to be a wonder,
No be a thing wey person go dey fight with fire & thunder!
1 Like
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:47pm On Mar 13, 2009
maedan:
see as u dey talk like say na me toast u cheesy
na so all u men for naija dey do
once girl don gel, u come get mouth
people go hear from north to south

i no mind sha, say u dey boast
at least for naija love rhymes na u rain most
u start am well, so finish well
i send u big time, but make ur head no swell grin
I de offer apology for my mouth wey dey open like doughnut
Forgive If my mouth run pass dat of tory-teller Basketmouth,
Because if we start carry face now,my sugarcane,we go gain nut,
Make you 4get I dey beg on my knees with a flower coconut!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:20pm On Mar 12, 2009
maedan:
thanks, babe! smiley. Na rotimy teach me o. wink
Make you no mind am, without her poems wey de fine.
I no think say I go fit think at all & write even one line!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:02pm On Mar 12, 2009
maedan:
dis one u organise bed wey pink,
wetin u wan make i tink! cheesy
d air-condition kitchen dey nice
but e go turn our hot fufu to ice
i don tell u say i no mind ur status
rich, poor, e no go affect us
make u dey continue to plan
i know say u no be talk-talk but action man! cool
If you like pink I fit change the bedsheet to red,
But e good say status no dey enter your head.
I do tell Esther say vacancy no dey my heart,
Make she go another man's house put her hat!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:54pm On Mar 12, 2009
firestar:
Rotimi make yu take am small small


Dis one wey yu yarn so - yu apply for Guinness records?
E mean say you dey follo our love tory,
Rotimy and Maedan dey do e-love story.
Madean like Rotimy and say she wan be in wife,
But Rotimy no get money but wan give him life!!
Now things don better for the country man,
Na im e take excitement de tell d woman.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 5:52pm On Mar 10, 2009
maedan:
lol . . .

which Esther, which eye
abi she wan dye cheesy
make she stop to dey looku looku
or she go feel some chuku chuku grin
wit my roty sweety i no dey play
our tym dey near, e no go tey
just dey exercise patient
u no say we stil dey for lent!! grin
I dey worried because e go good if we plan for this lent,
I dey jolly say I don fin a big house & come pay de rent.
I don take style de put things wey you go like for de house.
Thank God I don comot for de other house I shared with mouse!
Dis new one get very big fine kitchen with good air-condition,
You go relax there dey cook and dey smile with satisfaction!!
De bedroom get fine bed wey I cover with sheet wey dey pink,
Aaaaa, we go dey relax and our two hearts go be one love link.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:59pm On Mar 08, 2009
FOR MY MAEDAN

When you think say our time go come?
We go dey worried when to make a home.
We de move from valen-thing de go Easter,
And one fine lady dey eye me wey be Esther!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 4:58pm On Mar 06, 2009
stillwater:
Lol, beautiful concept. I'm liking it.
Thanks o jare. We wan make stillwater of love run deep
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 4:54pm On Mar 06, 2009
Moyola:
AwWwWWw!! kiss

M likin it wink
Just dey wait for like go soon turn to love!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 4:48pm On Mar 06, 2009
maedan:
smile na my second name smiley
ever since we start dis game
yes i sabi say na play
n my heart fit break like clay
but i go try to dey stay
i promise i no go run away

make ur liver no choke o
or ur chest make i come stroke?
abeg o, i dey joke! cheesy
Na like play play butterfly dey take enter bush,
We go turn play to fight if we give our love a push.
De day stroke go come bi de day you love me again,
Na dat I go shout say I no go love any Eve again!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 5:45pm On Mar 05, 2009
maedan:
roti, my papi
u don make me hapi
even tho' all na joke
i know say u be good bloke cheesy
wey fit make woman smile
n stick by am come rain or shine
but i hope say all d competition
no go make u run b4 completion
of dis post-valentyne weather
hope u know say, na 4 beta, 4 eva!!! cheesy
How you go come take say love na joke?
When my heart and liver for you dey choke?
Love wey dey true dey shak like orobo coke,
Which go make you have a smile for your look
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 5:38pm On Mar 05, 2009
meexteriox:
@Rotimy
My broda no vex
I been just say make i flex
Na jealousy overtake me
But wait ooo, na so luv be?
Dem say love go make you mad,
Even sef it fit make very very sad.
But we no be women we be correct men,
And we no go fight at all because of women.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:08pm On Mar 03, 2009
for MEEXTERIOX

No be by force dem de use open flower petal,
Men like you think say words go hard like metal.
But my peak milk Maedan dey soft because she be mortal,
Pls take easy dey yab me if you no wan see kolomental.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 7:03pm On Mar 03, 2009
meexteriox:
Maedan, you don wound my heart
How u go shoot me dis kin dart?

Aaaaah, wetin i do u?
So u wan turn me to jew?

Me i no go gree lai lai
Rotimy n Jollof yarn na so so lie.


No be by force dem de use open flower petal,
Men like you think say words go hard like metal.
But my peak milk Maedan dey soft because she be mortal,
Pls take easy dey yab me if you no wan see kolomental.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:55pm On Mar 03, 2009
@ Maedan

Nne, na true talk say true love go find a way,
As things dey now, na for your love I go stay.
I no say other girls go try make I from you stray.
But I go shout am for nairaland say my love na for Maedan,
For cave or mansion,mat or gold waterbed, you be my Madam.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:11pm On Mar 02, 2009
maedan:
@ jollof

no be say i too lyk money
but i wan make e spend from 'im honey

no b say my love na for sale
i jus wan make e act like male! wink

anyway, ur poem dey v. fantacious
but takia make rotimy my sweety no catch us!!! cheesy
Na jollof rice,ofada,coconut abi na fried rice?
If you dey eat him poem make you dey wise!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:06pm On Mar 02, 2009
maedan:
me, dey for ur mind?
u think say na lie i dey find? cheesy
u dey deceive me like all those ur many girls
i catch u as u dey buy dem flowers & pearls

which one u buy 4 me? nothing!
na to use mouth dey treat me like common fling grin
ok, if u dey sincere, one thing u fit bring:
next time u post 4 hia, make u add my engagement ring!!!! shocked cheesy
I no dey lie lie to you my sugar cane & sweet heart,
Only say things dey hard for me and I dey sleep for mat.
So you too come believe say no romance without finance?
Well, because I love you pass suya I go control my annoyance.
For fine things I go buy for you I dey save plenti money,
So dat our love go sweet and flow like milk and honey.
I know wan send a ring wey go be bring suffer-ring,
Rotimy na your action man who go soon be a king!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:01pm On Feb 28, 2009
maedan:
i don fear say u abandon d project grin
come make me feel like one reject
thank God u remembr us today
u for see me for dream both night n day! wink
How I go atart and abandon a project way be a fine thing?
How I no go finish with joy a jolly wey start for Valen-thing?
You dey for my mind day and night,
And I go make sure say u dey alright!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:28pm On Feb 25, 2009
maedan:
hmmn rotimy my man
i see u don get another fan
make u no fear say i go dey jealous cheesy
i hapi say u don become famous
so come one, come all
i no go vex at all at all grin
If na only me & you dey for dis wetinbesite Nairaland,
We go take our love rhymes turn am to fantasyland.
If na only me & you Baba come put for dat garden wey dey for Eden,
We go kneel down beg am make E no create Okoro, Olulu and Edem!!
If na only me & you come dey for one corner dem call love zone,
I no mind tell you say you be my torso flesh & my missing bone.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 2:13pm On Feb 25, 2009
Moyola:
Oya write me a poem jo! cool
Some dem-too-sabi people dey see only doom,
Others wey say dem be money experts de halla gloom.
Dem de talk say the world economi dey meltdown,
Dat we no go see moni again to jolly for town.
But our bones dey strong and walai, we no go shake.
because de God Naijas dey serve no dey make mistake.
Me I know say De sun go shine again,
Wheather after de storm or de rain!!!
So make you no worry oh Mayola,
Things go get better from Lagos to Yola!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 5:33pm On Feb 21, 2009
maedan:
na these kain lines wey make me first fall cheesy
i too dey feel ur romantic call
but this ur sweetmouth fit turn head
or make i keep to myself instead?
becos dem say quick in, quick out,
if u break my heart i no fit shout cheesy

i know say na so u dey tell all d gals
so i go wan make we just stay pals
i no wan rush, d speed dey too mush cheesy
dis tripping for NL don turn to crush
i still maintain, ur mind no get stain
i happy say we don link like chain

any which way, make we still dey look
just want u to know u dey my good book
unlike those yeye guys wey dey dis thread
u & me flow like butter n bread! kiss
E dey good make our Life be upward movement,
And make we dey give our hearts better enjoyment.
We don start our movement as Vals,
Now we don upgrade as correct Pals.
I no dey like things wey dey too much cold,
Africans dey like take soup wey hot with fufu mold.
But I promise you from now I no go rush,
Because from my heart I go give you much.
As we don become Agege bread and Auchi butter,
Make you relax your mind for with me, things go better.
PoliticsRe: Ojukwu, Orji Uzor Kalu And Uwazuluike. Who Is The King Of Igbo Land Today by rotimy(m): 8:26pm On Feb 19, 2009
@POSTERS
stop wasting your time on something that is an illusion! Igbos know the Kings in their villages but to have one common overall king is IMPOSSIBLE. Kalu is not fit to even lead a family talkless of a clan! Go to Abia now and see what the king kong did to the state with his mother exellency and others. Orji K alu RAPED, RUINED AND ROBBED ABIA STATE!
PoliticsRe: Ex Governor Bola Tinubu Was A Drug Baron by rotimy(m): 8:04pm On Feb 19, 2009
@Posters
Don't be decieved at all! I am very ashamed of Nigeria Journalists! Tinubu owns The Nation Newspaper while The Nigeria Compass is owned by Otunba Daniel, the governor of Ogun. What is at stake is political war for the soul of the West and the two papers have been fighting proxy war for their masters. I am not saying that Tinubu is guilty or innocent but shame on the so-called journalists at The Compass for not asking Tinubu or his lawyer for their defence . The story was filed by reporters because the editor knew lawyers will soon knock on his door. If the editor was so sure of his facts, a senior staff writer name would have been used. I am trained journalist but I am truly ashamed that some journalists have sold their souls to wicked politicians IN THIS COUNTRY
PoliticsRe: Madueke Lied About Our Correspondence- Ambassador Oluwole by rotimy(m): 7:49pm On Feb 19, 2009
@ Posters
pls note that that ROTIMI is not related to me at all! He must be a general but a fine diplomat? Hell no! Let him come back and become a farmer somewhere at Otta, Who knows, one day, he will become a President! Tempramental ex-general, now ex-diplomat!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:23pm On Feb 19, 2009
maedan:
yes o, true true wahala we no get
na only one troublemaker make us forget
d real purpose of this sweet thread
but devil is a liar, 'im go regret
d day e try disturb true vals cheesy
who don dey turn into real pals
so rotimy, how u dey
hope u still tanda as u say
abi d love don dry
well, friend in need na friend indeed
remember say u don plant d seed
make u no slack make e turn to weed . . . grin
My love 4 U still tanda like Olumo rock,
And playa Olulu I go soon give a knock!
I dey wonda how e like always to make trouble,
But we go soon join hands to pay him back double.
Him own na e-jealousy on 2 hearts that beat as one,
But even sef e take head waka, You be my only one!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:10pm On Feb 19, 2009
[quote author=olulu link=topic=232650.msg3482690#msg3482690 date=1234

oya i no fight again,
since my love u no fit gain,
and if i don cause u pain,
no seek me to slain,
so go deal with ur love matters,
but abeg, no do love for corner corner
[quote][/quote]I beg make you no fight,
Quarrel and fight no dey right!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 1:09pm On Feb 18, 2009
Moyola:
hehe! weldun yu lot! cheesy
Ah, thank you Moyola!!
Here we no get wahala
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 12:47pm On Feb 18, 2009
$Iceee$:
DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt
Eninem no rhyme pass our own Tuface,
Naija get talents wey dey set de pace!!
You talk say your username na Iceee,
If u be rapper or rhymer we go soon seee.
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 12:37pm On Feb 18, 2009
maedan:
@ rotimy


i know say u be beta person
wey we fit trust for any season
even if na e-love, nothing spoil
at least e good to ease d toil
na true say whether na valentine or wintertime
correct couples need to flow n rhyme
so make we jolly dey go
with this our pidjin love show . . . kiss
One fine female singer wey get big bobby,
Talk say love wey be true no be for puppy.
She say love dey flow and float like butterfly,
Which mean say na patience one go apply.
Weather e-love,v-love or even sef 365-love,
I go tanda like rock and dey gentle like dove.
E dey do me for heart say you go dey always talk true,
Dat's why I wan flow and see this love show through!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:26pm On Feb 17, 2009
olulu:
i no fit fight woman,
afterall, u dey in dis world to serve man,
u think i like to yab?
and u can shut me up with ur jab?
hey, go easy,
don't lets get messy.
u even say i get bad mouth
well, by dis end of month
na dat same mouth
u go dey kiss on top couch
grin
OLULU
OLULU
OLULU
How many times I call you name?
True true I no sabi your game!!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(op): 6:08pm On Feb 17, 2009
maedan:
@ rotimy smiley

my guy dis is getting curious
i no believe say u dey serious
valentine don go since now
its high tym we take a bow
but since u say u be gud friend
make we stick dat way till d end. . . . cheesy
Who come dey talk say Valentine don pass?
Every day na for true lovers wey get class.
I no be Police or soja wey go take a bow
My love dey plenty like[b] fura[/b]for Fulani cow.
My heart dey jolly as U say we go be good friends till end,
But I dey fear say like Naija babes ur word go soon bend.
Asssure me you no go try break my heart,
Na only then I go truly throw in my hat.
PoliticsRe: Indian Beats Nigerian Prostitute To A Pulp by rotimy(m): 2:51pm On Feb 16, 2009
maxell:
Moderator - what does this have to do with politics abeg ?
Ah plenty! International politics. Another classical case how foreign investors are milking our citizens dry especially the Asians!

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 (of 20 pages)