Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 11:04pm On Oct 01, 2018 |
WHIZKIDEFE: Oboy, see as men don yan everywhere full, choi.
Ona langua dey make me wan laugh my liver-pull.. ..
I greet the house oh!
Op, dis race wey you start so, you fit finish am so? To give monkey tea for cup easy oh, na to collect the cup back from am yawa go dey.
Make I relax dey observe how the go dey go for here..
Make E for nor loss, Happy Independence to Naija! E nor easy. Omen Me sef don de jam head sef o. the tin do hook me I no bin knw seh e go make Front page |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 11:01pm On Oct 01, 2018 |
Decapo: This isn’t pure pidgin bros...you’re an adventurer wida u aro Na u Sabi! Pidgin is a language it absorbs things from around it. it just so happens that Cultism is like a way of life in the South where pidgin is Gallant. if u wan judge me say I be Aro then go judge everybody for Bayelsa including middle aged people and children weh no go fit talk if they no add Wida. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:53pm On Oct 01, 2018 |
cadre88: Why you comment untop the post. You wan make popo catch you? Help me tell am o |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:31pm On Oct 01, 2018 |
Ishilove: Ofurukpe nigga...what does this mean? Pidgin : Ofurukpe Nigga English: Pussy ass Nigga |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:26pm On Oct 01, 2018 |
Youngetskilz23:
Omor today get as be oh mehn. Me and my PADI we just ball in another town , we jam some old time nigas , na so we deck for one side we dey brew monkey tail, they shayo dey go plus arizona Omor no be small thing boys don high wella. We just dey laugh they gist dey go, as e be like this eh. Pressure dey our body . Men don dey cap careless. Based on say today na 9ja birthday we dey celebrate ooo. Like this like this we no no when the shayo go quench.. we just dey jolly they go. My people na so my day be today oo . Updates brekete for ground.. make una stay tuned. Reporting live from alode Eleme pH city Confam Pitakwa boy. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:25pm On Oct 01, 2018 |
bomasek: I understand wetin the manchi talk,nothing eso or teric der You no go fit quote her wen u not go insult me? Una Nairalanders sef ehn. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:19pm On Oct 01, 2018 |
Ishilove: You speak in esoteric tongues...  No bi so o! Where are you from sef |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:12pm On Oct 01, 2018 |
adaksbullet: Am just Dy looked all off una wey his Dy speek pijin, are u no no say pijin his orijin from ekiti 
My ekiti ppl Dem, how far na  Na joke bi dis Abi? |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:08pm On Oct 01, 2018 |
|
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 10:08pm On Oct 01, 2018 |
|
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 7:55pm On Oct 01, 2018 |
Ishilove: How on Earth did you decode that?! My eyes glazed over halfway through Simple I'm a native pidgin speaker but If u noticed didn't get all though because its not my native pidgin dialect an more used to Yenagoa pidgin more. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 7:51pm On Oct 01, 2018 |
ehis05: chai dis one is strong That's just a typical way of speaking pidgin among Nigerdeltans especially those from PH and Yenagoa. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 7:46pm On Oct 01, 2018 |
daveP: Lol. (smiles) English itself is one of modifications of languages down from that event. Dig deeper, don't just talk surface. Gracias. Its still desame thing na then Pidgin that we both speak too is a modification from that event too.. so because peanut was made from Groundnut does it mean peanut too is natural. Dig deeper too. English started off as a pidgin language of German French Latin greek. u knw. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:59pm On Oct 01, 2018 |
daveP: Lol
It's not just Bible that supports this fact. the Mayan, the Babylonians, Egyptians and the Chaldeans, Persians and other ancient cultures have this very event in their history penned down by them.
Yeah it was a mono tongue till then. One general tongue till then.
Historically, every current location of any tribe can be traced back to the Middle East and Africa. And the dispersion is as accurate as the date given for the Tower of Babel incident. Proofs exist alot. Language is a man made thing because even English wasn't there 2000 years ago. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:43pm On Oct 01, 2018 |
sichri: Your pidgin nor pure sef. Warri nor fit carry last sha cos anyhow e be, ogoro must jump. Anywayz, I dey hail every. because say no bi Warri pidgin no mean say e no pure. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:42pm On Oct 01, 2018 |
Olodo24: if u no fit tell bobos "aro".....u dey jonse Na u sabi |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:39pm On Oct 01, 2018 |
HardMirror: make we use our sense not ankara. You miss that part bro. Na you be the reall gee for this pidgin. Thanks no be all I go knw na. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:37pm On Oct 01, 2018 |
Lothbrok: There is a huge difference between pidgin and capping. .
All the Germans on this thread should capless for the days are evil. . . Apply 99.1 If na so everybody for Yentown and PH de Cap na. How u see am |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:35pm On Oct 01, 2018 |
infinito1990: Waffi I dey hail ooo I greet d house specially Na our papa dem talk say 'Ear way nor hear word go follow the head go ground' Nobody 5 Kobo state fit drag pidgin with waff town especially Uvwie Udu and WARRI E don tail wen we dey tear pidgin Small pikin way think say he fit use he touch count he teeth nor go old pass he papa Wafi men too de buga Sha. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:35pm On Oct 01, 2018 |
Igerizee: I rep Ph city nd waffi no wori urself. 2 secs make i decode dat ur chaise cappings
Yesterday me n my guy go lap in house, sit down 4 in frontage, we bin plan to go ashawo house cari okpo so our preek no go too wori us 4 nite. B4 we knw Area boys burst out na we run enta house, wen tins com cool smal na my bros say make e check outside, na police burst out we area, dive am give am charge say e follow d area men buga nana, no b small mata o, bros dey jail nw but me still reach my house dat nite, My girl com around, omo d way i Bleep her, she fear life.. Oil de your head. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:34pm On Oct 01, 2018 |
killuminati: Omo dis ya yarns strong wela. But man code base on Lag Barracks tinns. How e come go with ya Padiman? Omo no bi small tin o. Im komot di next day Sha. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:32pm On Oct 01, 2018 |
reciprokal: This is area slang! Not necessary mastery of pidgin English.
In many pidgin English areas, slangs are demographic and never general. Only few slangs becomes acceptable as general slangs.
Mastery of pidgin English is more pronounced in fluency in speaking without having an underlying tribal accent at the background.
It is never by slangs per say as every street and area get their own slangs and only one or two becomes acceptable and generalised by the pidgin community . Well what u say is true and the way I see it. people who are fluent in Pidgin are those from Metropolitan places like Warri Portharcourt Yenagoa Lagos etc |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:30pm On Oct 01, 2018 |
SultanYoung: my padi man no worry I jazz back me go flex you for pepperoni we de ekeki before assembly quarters I bin think say Pepperoni don move komot Ekeki naw |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:28pm On Oct 01, 2018 |
justdollars: U no fit decode d ankaras? No wahala sha. Ur teeth complete. Ur head balance for ur neck well. Ur mama born u for ur papa but u be apampam for pidgin language sha. No bi every I go knw na. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:28pm On Oct 01, 2018 |
viktohmarkz: brotherly you tight pass my mama wrapper so because you show say you be man inside street. I be Victor na phcity my yarns deh come from, Happy fun fool to the Olodo naija, as we deh loli today make we code say tomorrow all men gats run out for belly runs,december no far e short like callertune, head gats reach ground so body no go enter 6ft, I hail the OP for this platform where em arrange give us. so lass lass we gats give am back the joy. I sight you Oil de ya head |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:17pm On Oct 01, 2018 |
reciprokal: This is area slang! Not necessary mastery of pidgin English.
In many pidgin English areas, slangs are demographic and never general. Only few slangs becomes acceptable as general slangs.
Mastery of pidgin English is more pronounced in fluency in speaking without having an underlying tribal accent at the background.
It is never by slangs per say as every street and area get their own slangs and only one or two becomes acceptable and generalised by the pidgin community . I understand. I de feel say everybody de para say the first lines weh I put for the thread too be like English. I bin wan put am so e go clear for everybody nai make e be like DAT. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 6:07pm On Oct 01, 2018 |
Barfibassey: I salute all dey boys and girls were dey follow shuku mouth for dis mata, who nah too much naija we no dey carri last....Op nah beta oil dey ur head twale 4u baba but you Bleep up sey you no mention Akwa-cross side The mumu Nairaland distin no free me add una put. if for say no bi so I for add Aj city sef for lag too. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 5:55pm On Oct 01, 2018 |
infinito1990: Wetin you dey try yan be say You and your guy won go run lash ashi for ozed junction nai kporkpor go show for area Nai men discharge but base on say your guy won go observe the area weda dem don march Nai dem gbab am join The guy crash station till dawn You self con go comb your banni with pepper eye Konfam Wafi guy u get levels |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 5:52pm On Oct 01, 2018 |
SultanYoung: oboy me de feel you die, me remeber wen we beende go artalin junction go meet mutumina change some obama for him hand then we go branch hospital junction go discharge fluid, oboy I the mount you for back you three much Abobi Three Gbosa for your head. |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 5:41pm On Oct 01, 2018 |
TroubleMaker47: Mild translation.
My brother na so e go o, Yesterday, me n my friend go house, chill for him varandah, we been dey plan go brothel go carry ashi make konji no come hold man for night, so wen evenin don reach, my bros say him wan go look as tins be outside, na so police begin arrest oo, police dive am say him follow for bad boys wey dey obtain ppl, as e be now, d guy dey police cell now sef, but as i reach my side dat night, i fvck my babe well, chai! She fear better fvcking!
shey i try? You don code am for normal pidgin weh even Lagos peeps fit understand. you try Sha |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 5:36pm On Oct 01, 2018 |
HMZi: Me ma lap this thread jagadly....Na to pin dey kpor wetin dey sup...#Makurdi no follow for competition but we mount..Op tis thread make, I dey with you. I sight you which Unit you de rep? |
Culture › Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(op): 5:34pm On Oct 01, 2018 |
Edoziesmart: Abobi me I dey feel your parol wella like woman couti. Which unit wey you dey rep for yen town? Me nah swali I lap like ozed.
You no the matter be say flood just dey tear person nyash for nkoro here. As things be now we gat to shele, carry head put for one corner dey watch the careless flood. I dey tells you. Abobi your Face de Shoe Boloki. Mi na Amarata Ebis street. Flood Neva reach My way Sha. make our two gather rep yentown for this Kabal na. be like Waffi men don full the place kperere. |