Youngzubi's Posts
Nairaland Forum › Youngzubi's Profile › Youngzubi's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 21 22 23 24 25 26 27 28 29 (of 29 pages)
donaldphilipizu:tank u my G |
rowdymind:welcome bros |
WarriFirstBorn:i sight u my man tanx,u be sure peson jare |
I NO JUST WELL,I DON DEY TYPE TODAY UPDATE SINCE ONLY TO DEY WAKE UP AND SEE SAY NAH WAKE I JUST WAKE FROM BETTER SLEEP WITH MY PHONE STILL GIDIGBA! FOR MY HAND ABEG MAKE UNA NO PARA FOR UNA GUY,AS I NO TOO WELL TO RELEASE TODAY DATE,ABEG E GO LAND EH!, STILL YA GUY YOUNGZUBI I NO RUN NAH JUST SMALL COMMERCIAL BREAK BIKO BODY NOBI FIREWOOD. ONCE I GET MY SEF I GO WAYA D DATE BIKO NU..E JOOR! THANK UNA FOR THE BETTER LISTENING |
Speakout03:Lolz |
pradoic:abi ![]() |
stevodot22: ![]() |
psybuk:u welcome my guy |
WarriFirstBorn:no mind her,guys go lash her pole |
WarriFirstBorn:wow u be sure peson jare i dey feel u bro ok i don see ya corrections and observation my man you welcome brotherly |
Episode....................15 welcome to my home in warri -------------------------------------------- meet my guys omo dem too rugged --------------------------------------------------- "warri girls sha!,i been dey think say by now dem for don change as church don full every wia, ahah!,na the olosho wey i carry log yester night o! she don almost carry all the money wey big mama dash me run,nah gawd just save my destiny as i quick open eye wen i hear door sound,Chai i fly up as i rush her, "wia u think say u dey carry my money go,....i yan as i grab the olosho girl tight ah! bros u don wake?.......the olosho girl ask as she begin scratch her head,maybe better lie never surface "wia my money dey follow u go abi u dey follow my money go?....i ask am as i tear her one hot slap wey make her loose balance aahh! bros abeg no vex,see nah Satan cause am, me no dey look peson property o! ,na Satan just push me,abeg bros use church mind abeg!........the olosho girl begin beg "one mind dey tell me say spana use this opportunity rape her to coma,at least she go faint she no go nor wen u go disappear,u no go pay shi shi be that o!,spana waya this olosho nah!,my second mind nahim win as i count 15 k give her then free her make she dey go, omo nah so e take happen this early mo mo o!,time dey talk 10:12 i don already call my ma'le yan her say i carry night bus enter warri sey i don already dey road wey lead enter our house ,she happy nobi small as i cut phone, package my loads,house straight, as big boy wey i be,i don pass okada level so i chater taxi wey toll me from gravity hotel wia i log go my cabar,omo the journey make sense,some of my guys don already gather for 360bar dey shark things Chai i for jump down go meet dem but i need to go see mama first nah,so make i drop loads for house,my guys go nor say i don land "as the taxi tear road enter my compound,na my papa wey my ma'le yan me say him dey sick nahim first come outside with him chewing stick stationed in his mouth like tv antenna the taxi man jam leg for brake as the moto obey him with instant stop aaahhh!! chinedu! nwam (chinedu my pikin) so nah true u talk,i been think say nah lie o! even as u call me this morning ask ya papa watin i tell am,i tell am say nah till i use this my eye see ya face na then i go believe even i nor bother myself to cook.......my ma'le yan "ah! mama nobi so o!,abi u no trust me again,see eh mama i for don land tey tey but onto say i enter one police soldier case......i still dey yan wen my ma'le cut in sharpaly eh! police Kwa? my pikin watin happen wey u enter police hand,oya begin enter house make we go talk am inside i nor want make people hear anything biko.....my ma'le yan as i pay the taxi man carry my bag omo nah inside house be that o! i don almost enter house wen 7 of my guys maybe dem don get info say i dey town omo naso dem take troop inside my cabar o!, "spana!!!!!!! spanaaaaaaa sssspppppaaannnnaaa!!!!!!!! Chai naso every wia just dey boom! trust my guys dem fit shout ya name sotey u sef go begin feel like gawd so i kukuma carry my bag give my ma'le as i turn back begin salah dem better hand shake and frezy hug Chai i don miss my guys!!!!! o boy na wia u tear run go ah ah see as u just fresh like water melon,rugged show we boys dah way nah....erotic yan"erotic nah my padi the guy get mouth die him sabi woman infact nah ladies dictionary we dey call am eroty eroticalllll !!!! my guy nah lag i.port go o!! ,man pikin need to hama! ,na wia smell dey fly dey gather nah....i yan as all my guys begin hail me Ehen! wia bobo and stevo dem...i ask as nah those two with erotic plus spata be my closest pady.. o boy as u tear race go lag eh! naso bobo go hang him destiny ontop one onyibo woman onto say him dey run G level nah,guy him dup the lady o! nah confirm 150k him waya comot for the onyibo account as him tear run come back to warri all the way from portacut......erotic reply ah!! Chai dat naija oyibo guy smart o!"if una see bobo eh" Chai the guy no different from white people o!,but him bad like babest nah bobo we dey call him,so i don introduce bobo to una,ok, oya make i ask about stevo nah him be the strongest among us the guy don upgrade as him don get high rank in the field of igbo smoking Chai all of us go dey our first tap from our early mo mo igboo competition ..omo stevo for don dey light him 3rd lump" erotic!....i call my boss....erotic answer "Wat of stevo nah hope say ara never nack him brain so....i ask chaiii!! stevo full ground na,as i dey yan u eh both him and bobo dey 360 dey kiss beer as i dey yan u now......erotic answered Ehen! ok u know watin go happen now.....i yan no boss nah ur command be our wish .....erotic yan make una go wait for me for 360 i go show face naw naw naw lemme just settle small matter with my ma'le i dey come....i yan dem onto say i won go follow my mopsi settle issue at hand since i go dey travel tomorrow ok na we go dey wait ya arrival abeg do sharpaly o!,guys dey red eye o,we need to shayo guys must see red men go see red!!,.......erotic yan and na red we go paint de sky!!!!....all my guys respond as them begin waka haay!! omo today nah today o!,i enter house as i sight everybody well seated in the parlour omo i know say i don enter am today becos my junior sister nkechi she dey try pass me one kind info through eye contact but i nor just get watin she dey try yan at all chinedu sit down...my ma'le yan as i stand confuse becos e get one village girl wey dirty like lagoon pig she sit down jeje near my pa'le my son have ya sit nah....my pa'le yan as i sit don facing them emm! my son shebi u know say me and your mama don dey old well well and nah only one thing just one thing remain for us to grow old with happiness,biko my pikin listen to watin ya mama have to say biko i nor want make u vex and comot as u always do so biko grant us ya listening ear!....my pa'le yan to me as i breath down and relax for chair, omo i don already know say na grand pikin be the wahala chinedu my son....my ma'le call yes mama.....i reply before i go into the main matter,abeg na watin cause the wahala between u and police them.....my ma'le ask ah mama nah my neighbor o! hmm una need to see watin happen,thief enter our compound come steal all our money nahim dem come kidnap my landlord pikin naso police together with soldier people come pack all of us o!,dem come dey ask us stupid stupid question say make we yan them watin we know about the armrobbers ah ah! how we won take talk about people wey we never meet abi nobi all of us dem rob so how come dem go come dey harass us onto say we sabi something about them,one man wey be my neighbor come dey para for them nahim dem come use vex cut the man hand........."i yan them correct lie ah! u mean say they cut the man hand.....my ma'le shout yes na gawd save me sef,see nah the case make me never come home since nah....i yan shey the man wey them cut him hand don marry.....my pa'le ask yes nah,ha! him get plenty pikin o!.....i yan Chai wickedness,so as them cut him hand how him go take dey feed him family nah......my pa'le ask abeg allow me make i hear word you wey get two hands we don chop??,....my mama reply my pa'le ah! mama take am easy nah,no dey talk to papa like dat.....nkechi yan as my ma'le fling broom to her side but nkechi dodge am, emm my son,abeg make we go straight to the point since ya mama choose to insult me......my papa yan chinedu my son,see eh since u nor won bring us ur wife i mean the woman wey u go marry nahim me and ya papa join together put eye down go our village for nkanu go bring this young lady,very beautiful and she be better wifematerial o!,Chai chinedu look her well na..my ma'le yan ah mama e don do mama enough is enough....i still dey yan wen my ma'le samah me stainless cup for head ko!!!!! ah mama why na?,i go vex comot for hia o!....i yan as i begin rub my head for wia my ma'le hama me the cup oya agnnes stand upu! andy greety ya husbandy naw....my ma'le yan to the dirty village girl as the girl stand begin match wia i dey sit down Chai as i look the girl eh! the kind vex wey full my body eh blother gudu mony.....agnnes greet as she kneel down for my front ah! agness watin be uncle so u don forget all the sweet sweet name wey go shark him brain wey i teach u oya greety am again now...my ma'le yan to agnnes emm! em! ok sweety mu,...she yan.as my vex increase Ehen oya another one....my ma'le yan tomato jos mu..agnnes yan nahim i use vex push her go jam for wall gboossaaa!!!!!! aaaaahhhhhh!!!!!!! isi mu o! awura mu o!!!.....agnnes scream as she hold her head omo i tear race go outside as i head straight to 360bar,onto say i won reach dia fast fast i enter bike wey transport me go 360bar Chai come see as my guys come dey hail me as them sight me coming down from okada spannaaa!!!!!! twale !!!!!! spana the driver spana the apata one!!!!!!!!...omo naso my guys just dey hail my,Chai the whole bar don full gbiimm just on my name o!,na battalion full hia as i begin shake hug even the one.i.know and the one wey i nor know but all na my pady sha! "ah spana see as u just fresh dey shin like toto,Chai guy show us the way nah,...stevo yan as i sit down near him and bobo ah ah!,i said ah ah,twale to baba,but boss as u don go lag go clear bush nah to carry we ya boys along o!,abeg bros show us the way i swear we go loyal die,even if na shiit u dey pack we go join if na ashawo u dey do my guy we wear pant join u......bobo yan onto say them won join me go lagos hahaha !! bobo so u never Change Chai,ok make una no worry i go arrange una arrival once i go back tomorrow just relax i go holla una for phone....i yan to stevo and bobo onto say i go like make them join me for the senator part of the offer by big mama oyyaaaa twale for u baba..abeg two for oga spana stevo yan as all the guys wey full 360 bar shout gbosaaaa gbossaaaa !!!!!!!!! oya attendant abeg carry 30 crates of beer come make my guys begin tear red eye biko...i yan to the bar attendant as all my guys begin jump dey hail my name,some don dey comot clothes sef as them dey ready for the drinks omo we begin drink beer,win as we dey pump jombo join,condom begin fly for air as plenty runs girls begin troop inside the bar omo na spana night e be oo as guys begin waya olosho as them dey smoke and drink dey hail me!,omo night don reach so every wia dark and na red bulb dey the bar so my guys just dey waya olosho ontop table for ground even ontop air sef ,,Chai i dey enjoy my self too as one olosho babe dey suck spana i come dey dilute the pleasure with star and igboo ******* meanwhile back in my house i still dey bar but something dey para for my house******* agnnes take vex rush kitchen as she go grab one sharp kitchen knife,she tear run enter street that night as she begin find spana ahhh i go kill peson i must kill peson this night,a whole me agnnes nahim that idiot pushu liky lagy ahhh!! nooo!! i must pushu this knifu insidy him stomach aaaaahhhhhhh ara ara ara!!!!!! agness scream as she begin fin spana up and down to be continued dropping dis night so stay tuned just drop ya comment i dey come |
stevodot22:hmmm!!!! ok i go grant ya wish just watch out for next update u will be introduced my man @stevodot ------ stevo |
Horlaslim:gee i go waya the date very soon |
Speakout03:abi,bros ya head dey dia jare! |
EstatesinLagos:thanks man |
pradoic:i dey feel u bro @pradoic |
stevodot22:u welcome my man u.land well jare |
[b][/b]EPISODE.....................14 welcome to warri --------------------------- runs guys biz intro ------------------------------- "e get one thing wey every woman get for their blood"e dey common among them"too much preparation,dem go rub rub sotey their face go come be like watin gawd reject"imagine"since morning we don prepare finish but big mama still sit down face mirror naso so rub rub"i just relax for bed dey look her come dey wonder if na she wey won marry abi e still be her friend daughter"hiyaa!" "we no quick reach warri dat yesterday but as big mama get mouth wella"we no experience any waka waka at all as we reach the hotel wia we suppose log come see respect,everything don dey down"all the guards get diar own room even spata sef get him own personal room while me and big mama dey for thesame room"trust me nah"i waya her tire till she sleep off by 5:45 am"she just wake by 9 and time dey talk 11:10. she still dey prepare "spana!"........big mama call me as i sit down for bed dey wait for am "ma!".....na me answer "abeg come hold this thing for me make i rub am fast Eh!".....she yan "hold watin? ah big mama so u still dey rub upon say u don apply like 4 different emm! em! ah watin dem dey call all this una thing sef Ehen!! pancake yes pan-cake" "will u shut up and get ya stupid sef hia now!!!"......big mama shout"i no even know when i take reach wia she sit down dey do her make up rubbish as i grab one silver box with golden design for him body,she begin take some powder wey dey inside begin rub" "good boy" u better stop all this ya yeye talk"......big mama yan as she begin rub her face "eh! mama shebi nah reception we go'go straight abi".......i ask onto say i nor dey like church,asin nah from church gate sleep dey always begin catch me "yes nah abi u won go church??....big mama ask "no o!" e beta make we just storm the reception lagadat ".....i reply "ok"....big mama answered as her phone begin ring nahim i rush go carry am from side stool wia e dey" Chai na iphone x "help me pick am"....big mama yan "ehh!".....i yan "pick it spana"......big mama "ha! nah only for ear i dey hear iphone x till now i never see am kolokolo"my wahala sef na say i nor know wich one be the back and front as i begin turn the phone around hiyaa!! "abeg mama come pick this thing o!...i yan as i begin confuse "Wat? so u can't pick the phone ha nawa for u o!"spana give me my phone yeye human being""......big mama yan as she grab the phone comot from my hand "hello".... "yea am on my way already" "no dont worry trust me nah"am with him just relax u will meet him face to face "sure there are even two"very cute guys trust me only looking at them u gonna go wet"yea bye am on my way" "oya make we dey go"people wey i won introduce una don dey wait o!...big mama yan as she carry bag and we waka comot" "spata them wit all the security guards don already kit gan! Chai money good o! as i bounce outside with big mama come see as all the guards just dey samah me respect"nah only spata just stand dey look me like fish head" "we all enter moto as we zoom off straight to party" "after 28mins drive we land for one huge gate come see security both police soldiers thugs all of them full every wia like fly come dey patrol with ak" "them no even check us as them sight big mama nah just sure ma! welcome ma! i dey hear"i even dey peep maybe i go fit sight oga frank or musa nah those two dey fear me diee!!" "we land inside the compound as our moto park"all of us waka come down as the security guards direct us enter the gaint hall omo i happy onto say i no appear poor at all,becos the kin big big lady and girls wey full dia Chai come see as dem dey look me dey wink ,big mama sef notice am as she direct me and spana go one table as she waka go dey greet her friend"hug"peck u know all that kin greeting nah" "as big mama take instruct her body guards she tell dem say four go stay wia we park our moto two go follow her then two go dey with me and spata" "Chai e sweet me diee! as those two huge giants take stand for my back as i sit down with spata" "hello" na one fine hot babe like dat waka come meet us for our table Chai see packaging she dress pkaa!! "hi"i reply as i take eye scan her body assets "please excuse us"nobody is allowed to talk to him"..striker yan to the hot babe as him direct her away" "Chai stroke abi striker u dey mad asin dem dey do u??...spata para as him vex die! "shut it man"ok sorry man for chasing the big fish away but thats Wat big mama instructed me to do"......striker yan "ah! so that woman no want make we get connection abi"ok na we go see we sha see!".....spata yan as him relax for him sit "striker, i call him as one better idea struck my head" "yes boss man"....striker answer as him near me" "help me get that lady contact"500k if tinz work out well"....i yan striker "hmm ok but u gat to make it 1mile man i deal in million bro"...striker yan "ok deal"....i yan "no p i go run tinz normal before we leave just relax"u'er damn hot man see, a lot of them will still come so have it in mind dat each bae is 1mile x the number i l'll get for u man".....striker yan "ok just dey get diar contact me and Spata go dey arrange diar change".....i yan "omo plenty artist them together with top top comedians full the event"hot hot ladies and babes wey full every wia no even gree me concentrate at all"if i carry my head go this side naso my eye go jam one bae like that she go smile and wink"nah the same thing dey happen to spata sef" "we tey for the event o!"come see drink e be like water"spata don drink tire him wey nodey run for drink"trust my guy him don drunk die!"as him begin shout today na my birthday so every body drinnnnnnnnnk!!!!!! drink drink bill na for my head" "big mama later come our table come tell us say time for introduction don reach"na two hot twine slap striker take clear spata eye as him drag am go backyard" "we reach wia the big big ladies sit down omo nah V I P section be that o!'" big mama begin introduce me and spata as we begin greet and shake them,we follow them talk small,some of them come dey drag us say we go follow them go log for hotel tonight but i no ready at all"trust spata him agree sharpaly but we collect contacts sha" "after the women part we waka go the senators them side"guards no even gree me and spata enter there as only big mama waka enter"nah later she waka comot come carry us enter"come see top top senators them "omo nah that moment i know say nah big job i dey into so"becos babies no dey among them at all!" "nah dia me and spata relax till big mama come signal us say nah time to go" "we shake hand with some of them before we tear run go outside" "so spata u have a date tonight"...big mama ask spata "yes o!"infact my body just dey jolly since"....spata yan "good so u will go with her'..make sure u do ur job very well am sure u won't be getting anything less than 20million from her".....big mama yan "ehh!! 20 mile ontop the enjoyment again ha! best job so far"....spata yan as one long white moto wey resemble remozeal abi nah watin dem dey call dat moto wey long die aha! nahim blow horn for our back as the door open Chai spata dive inside as him jam door gbiimm!....voom!!! they zoom off "so watin be ya own plan spana big mama ask me' "emm! ah big mama e get one better runs wey i won stay back handle for hia in warri nah next tomorrow i go come back to lagos....i yan to big mama onto say i won reach my cabar go see my ma 'le" "ok take this""big mama yan as she carry heavy bundle of money give me" "ah! big mama all this one for me! Chai na baba gawd go samah u better money jare"..i yan as i grab the money "i follow them comot reach one junction like that as i waka come down wave dem good bye"they zoom off as striker trow paper to me omo i run go grab am Chai nah list of contacts"oh! boy i pocket am as i enter bike go log for hotel but i sha carry one fine olosho wey go keep my night frenzyy"nah tomorrow morning i go dey go my ma'le dem place.. to be continued |
no dulling |
sorry for the late update Episode...............13 GBEDU!!!!! calabar girls too rugged ------------------------------------ warri guys dem no dey carry last ---------------------------------------------- "bros open ya eyes na"nurse yan,but the sweetness wey she dey samah me eh!"Chai na express to heaven i dey" "bros time no dey we side o!"you better open ya eyes make we do quick quick becos madam fit enter hia o!"bros open eyes!! "Ehe!!"i just too like this calabar nurse"only her voice dey nack wave enter my cavity"quick runs no just good for this kin gbedu!"i won take time work on those mammalian balloons like spana dey work for nut "aya yaaa!!" i just dey reason all this stuff as the calabar lady keep on manipulating spana with her gbeducious siginima gavanta " "bros u well so? chuck this thing enter me na"make we run down small"see i nor get that kin time o!"i go leave hia if u won do am"nurse yan "make this one no go pass me by,i kukuma tear eye open nah gawd go punish Satan if this kind babe pass me by"gaawaam!! i grab her waist as her yansh vibrate like bolom bolom"no need for long thing so i sit down wella as i position spana inside her nunu hole "aaahhhsss!!!"......she gasp! "eeehhmmm!!! aaahhhh!!!"....na me com dey moan pass"nawa for calabar babes them no get human sympathy o!"even with all my struggle with gra gra i dey moan join self" "she just dey shout" bros start nahw "so as this ya preek long reach u no fit use am reach my T junction make i sweat small ah bros na fvck up e go be o!"she yan "ah! as i hear watin she yan e pain me reach my pkekus"i swear noting dey vex me reach wen woman dey look down on spana"i been dey take am easy slow and steady onto say body nobi firewood shebi na hell fire i just from come"even spana never recover finish sef"but as things take be now"monster mode nahim sure pass" "i push her comot for the cow girl position she been dey samah me... as my eye turn red omo na rough rider straight no mercy" "i lay her flat for bed like foot match as i hang her leg for one drip stand wey near my bed,then her second leg for window omo.come see as the coast take clear like dstv"na terry G apkako come dey play for my head as i grab spana tear race enter like recharge card" "aabasi mbo!!!!!! brossss !!!!! easy! ooo!!! "she never see anything"......na introduction i just do "i push spana dey go inside like say i won make e comot for her mouth"omo i reach wia e no gree enter again then i drive out complete viaaamm!!! "uuuuhhhhhh!!!!"..........she never see anything"she still get mouth to moan "i dive enter again as i begin fire!" tatatatatatatata!!!!!!!!! no stopping no reducing na journey to no mans land"but the babe tooo make sense o"u know that kin babe wey all her assets go dey shake and vibrate as u dey fire"naso this calabar babe dey samah my brain comot" "30mins later she pour holy oil"but i no even give am space sef as i increase my pumping" 45mins later i been dey plan to change position when i hear ko ko ko!!!! ....for door "fear catch me as all the sweetness evaporate viaaa!! comot for my body" "piam piam we don wear clothes as i just lay down flat for bed"spana never gree go down" "who is there?,nurse ask as she go open door" "what is going on hia"why are u guys taking too long?? "nurse Stella i thought i told u that i would be travelling this evening?....big mama ask as she enter wia i lay down "emm ma it was the emm! no yes" "nah the wounds she just finish treating big mama"blood just too much for my body and the thing don stick tight gawan gawan nahim make e tey before she fit clean am finish".....i samah big mama sharpaly as nurse just dey shake mouth" "fuuu!! this place dey smell some how"spana watin una dey do for hia!, "ah ah!,why u come dey look me like that nah"shebi na treatment i just dey receive from the nurse before u come nock for door".....i yan madam as i frown face join so as to make her believe" "Stella!"......big mama called "ma!"....nurse reply "go to the doctors office wait for me dia"....she yan the nurse,as nurse waka comot" "you won pursue her"......i ask "e no concern u spana"oya carry this bag i don buy clothes for two of una,carry am go meet ya friend make una wait for me i dey come..big mama yan as she drop one big fancy bag and waka" "as big mama comot i drag my lazy sef com down from bed as i open the bag to look things wey dey inside"omo na better gucci wears even versacci sef"i still dey look the things when the room door open as a very fat nurse wey be like bamboo she wor wor die like nigerian used pampers"she bounce inside come see her muscle like 50 naira fufu.... "bros bros!!! i hail o!"Chai u be expert o! see as u just dey waya Stella"i open door peep as my eye jam your big thing ,bros u get heavy stamina o!...the fat cago yan "oya begin clap for ya sef nah"shebi u don look my necked body finish"....i yan "see bros u turn me on".....she yan "ah ah! i turn u on"u be switch??.....i ask "no bi watin i mean"bros i want make u sef com shin my congo nah"i been dey pray say make u reserve strength for me after i sight u sampling my calabar sister..she yan "eeeeehhhhhh !!! u be calabar too!....vimm!!! i dive my bag as i tear race run for my life" "bros i go burst una belle o!"u better com give me my share!.....she shout as i run begin locate spata them "hey mumu wia u dey run go?......spata ask me as i run pass them "i look back as i sight spata with the security guards standing for one corner " "ah na hia una dey"thank gawd o!"....i sigh as i drop my bata for ground and wear" "watin happen na why u com dey sweat"hmmm watin i dey reason"aaaahhh!!! spana u be devil o! so quick? no dulling u sha shin that fine nurse Congo hayiiiii why better thing like This dey always pass me by??.....spata yan "ah spata she be fire o!.....i reply "fire?...spata "yes fire ya yaaa!!!..i reply "u mean na she u dey run for so?..spata ask as him fold hand dey look me "ah no o!"see eh madam almost catch us na just gawd nahim save us but the wahala naw be say as madam and the nurse waka maybe madam won trow her over board onto say she figure things out"nahim one beautiful slim and figure 8 nurse i swear spata if u see this nurse eh! she make sense diee!!! "so watin do her na why u come dey make my preek stand like this go straight to the point nah....spata yan as him comot the hand wey him fold" "see the nurse wey get figure 8 catch me and the other nurse when we dey samakwe but as madam come carry fin nurse go doctor office nahim the figure 8 nurse come enter begin threaten me say if i no samah her too she go burst our secret;but she too fine like mamy water come package join" but my body don weak nahim make me tear race o!.....i explain to spata"i been dey plan to set him up with the fat bamboo nurse "aaaaaahhhh aye meeh!! spana u mean say u run for that kin toto?"no no no!!!...she still dey dia!! spata ask "yes na as i tear race she dey shout say make i come back oo!"...i reply "oya idiot carry me go meet her"come show me the nurse becos as u take describe her ehh! i fit sell my papa land just to nack her"...spata yan as he drag me along "free me nah shebi na dia we dey go....i yan onto say spata just dey drag me like goat "we waka reach the door" wia them treat me earlier"but the door dey locked so i nock ko ko ko!!! "i nor say u go come back oya open door and enter"..the nurse yan from inside but her voice wor wor pass her sef "ah ah why her voice come get bass like That"e dey vibrate like home theater nah...spata yan as him draw back ""ah! see na only her voice spoil her o!"if u see this babe ehh! u go fall spata i said u go fall diee!!....i brain wash spata the more "ehen! ok oya open door nah"...spata yan as him step foward "as watin i won do don already dey my mind omo i turn the door nub open as i push spata go inside viaaa gawwaam !!!! i lock door as i stand outside "Jesus!!!!! aunty goodevening ma!..na watin i hear spata shout as him enter the room "ah ah! who u be"....the fat woman yan as she sight spata "noo !! i nobi anybody o! nah toilet i dey fin but i mistakenly enter hia please no vex ma!..make i begin dey go"spata yan as him try open the door but i don lock am tight from outside as i put ear for door so as to dey hear watin dem dey yan" "ehen! but u fin o! e get one fin bros wey run comot just now e never tey sef the two both of una com resemble somehow una be twice"....the fat woman ask "twice? watin be twice??"oh ok noo we no twice o!,na only me waka come,na my bp i come check"see aunty make i begin dey go abeg no vex na toilet i been won enter" abeg no vex ...spata beg "ah why u dey call me aunty nah"oya come make i give u something wey go sweet ya head sotey u go begin call me baby"....she yan "ehhh please nah! i don tell u say na toilet i been won enter before"please aunty no vex....spata yan "u dey crasssseee i resemble u jey jey cee abi na gawd go punish ya mama idiot oya come hia or i go begin shout rape!!! help!!!!!! and as i wear only pant nobody wey no go believe me say u dey try rape me. oya come hia now!!!...the fat woman shout "spana madam dey call u and ya friend"u gat to be quick man"..striker yan as him turn to go "Chai ooohh !! gawd why now ehh i for like make this woman teach spata lesson " i push the door open as i sight the fat woman forcing her gaint br**t inside spata mouth"ewwoo!! my bros no even gree suck as him tear race dash outside like breeze as i open the door" "ah! why u dey run come back nah!"the fat bamboo woman yan as she sight me" ahhhh bros so u don come back oya come to mummy "watin!!!!!! piiiaaaammm!!!!! i tear race! "as i burst outside the hospital Chai everybody don already enter moto including spata naso i rush enter as i jam door gbeemm!! we zoom off"warri straight to be continued sorry for not updating yesterday o!! |
once my wife is ready for delivery i will be like mama nkechi oya pack ya bags lets go to shoprite and born this pikin biko!! from today onward i won't waste money in the hospital again since easy and cheap means which come with alot of assurance ranging from free food to job! things don better na still your guy youngzubi!!!! |
mixter:yes nah, only reading their requirements am frustrated already i wonder what happens if i eventually get the job,their terms and conditions would be hell like somebody in U S A will be closer to his family than u that is just in lagos Nigeria i swear them go use u sotey u go useless pass nigerian used pampers!.... ![]() still ur guy youngzubi |
jozee8:yes bro u l'll get my massage as the story goes on,we are just starting so stay tuned everything that has advantage has disadvantages what sweets also kills something must kill a man! still ya guy youngzubi |
u guys should have make it to be 40-70. so that i can go and bring my grandpa from the village the man get experience die!!!.....he repairs his bicycle till he died since 2010...... ![]() |
Episode..........................12 something must kill a man (2) -------------------------------------------- spata my sure guy!!!! --------------------------------- i been dey reason am tey tey say spata don trow me side base"but as matter take tear open yansh "nobi so",my guy spata use him head well jare"na only gawd forsaken bamboo go see men in kakki and still confront am"nah brain work e require and na watin this my man here do be that"tem tem!! twale!! for him joor o!" "spataa!!! chop and clean mouth one!!!!" see eh! for this thing wey u do for me eh!"i no go quick forget am"i don memory card am store for head" "you be sure guy oya chop am"....i hail spata as we chop nockle" "so we go visit mamy water them place be that?....na spata dey ask that one "ah!! no worry"just reserve ya strength"nah you go tear race,na u go tire infact u go dey point them finger like say them be point and kill"...all u go dey do nah to just point any one you like,i go pay then na journey to dah kingdom dah come e go be"u go fvck tireeee!!!!!! "mamy water them place,nah our coded way of calling prostitutes joint"so spata just yan me onto say na olosho toto him want make i take appreciate am"only if to say him know watin dey front Chai him for reserve strength wella" "tho na hospital we dey head to naw"from dia we go branch boutique go shop wears after that,we moto go tear race enter road warri straight " "why u still dey dull ya sef onto the offer matter sef"...big mama "i no dull anything o!"infact i don accept all"na me and this my guy hia go dey run thing together".........i reply am "wow e make better sense like that"so him go follow us chuk head enter warri be that...big mama asked "warriiii!!!"......spata shout! "Ehe! spata relax i go yan u better later"i said to spata as i face big mama "yes na"we be like bread and tea"beans and rice"so there is no how him no go follow us"....na me reply "good nahim be say i go dey introduce two of una be that...bg mama reply we are here ma! ....na striker talk that one onto say we don reach hospital" "we waka come down enter the big hospital"as them direct us go one better side for the hospital"me sef i begin reason whether na V I P be this place too" "e surprise me as i found out say na big mama get the hospital"Chai this woman just too much"...na so so ma! ma! i just dey hia every wia"but watin i like pass na the fine fine nurse wey full dia,e be like say na their beauty be the CV wey them dey take employ them"fine pink gown wey no even long at all e just stop for their laps ewooo!! "watin man no go see"if them turn their back to waka eh! na hell ,e dey vibrateee !! like caterpillar engine" "one nurse come meet us wia we sit down dey enjoy better AC" "please sir u can follow me now"....she yan "ehhh!!...i open mouth "u can come with me for your treatment sir".....she still yan again "watin u talk"..... i still ask am "see make una no blame me na my sense wey no gree function again as i begin use eye to dey waya her like that"she toooo ! fine dieeee !!!!."make una follow me hear voice nah"e be like piano abi trumpet for my ear" "dont be stupid spana!!"....na madam shout for my head "Chai see rubbish voice why this woman come use this her mama voice pursue the angelic one wey dey my head"ha!,i vex as i stand begin follow the fine nurse for back" "nah gawd be say i no grab her bouncing back side" "one mind for my head dey shout eyyeeehhh !! spana grab this thing nah!! "another one shout gbese le oo!!! "this one fit be commander pikin oo!!!" "i still dey wonder which mind to follow"i nor even know when the nurse branch enter one room like that nah when i reach outside the hospital my eye clear! "i begin turn around like ceiling fan" "you are not serious"what were u think if may ask" the nurse ask as she waka come meet me for outside" "ah ah i think say i dey follow u for back o!...i reply "what!!"i guess your brain is affected too"....she reply "no go insult me o! abi u don tire to dey work for hia!"....i vex for the nurse "oh i was only joking bros"oya make we enter inside so that i go treat u abeg no vex eh!.....she yan correct PIDGIN wey sweet pass stupid English "Chai so u sabi yan correct"nahim u come dey tear my ear drum with ya grama" "i be confirm calabar babe nah"i dey chop PIDGIN like yam bros" "aahhh!! iren pkoo !! "e Bleep e kpoo !! asin!!!""Chai!! so u be calabar ah ah ah! noo wonder!,,,,,,,omo e sweet me die as the babe yan me say she hail from calabar" "ha ha ha ha!!!! u funny o bros so for ya mind all this ya iren kpoo! na calabar u dey yan abi??....she yan "oya make we enter wia u go treat me"we go talk tire becos i like calabar girls well well!!...i yan as we begin enter the hospital "e sweet me reach my kpekus as e come be say na only me dey inside the fine room wey she dey treat me"i just balance for bed as she close door and begin mix some liquids and injection wey she call pain relive" "i dey enjoy am pass "anytime she bend down for ground to pick something omo she go bend down come expose yansh like plasma tv" "oya turn ya back make i inject u the pain reliver before i go begin clean the wounds with spirit"....she yan as i turn my back,she come say make i comot clothes leave only boxers"i quickly tear everything off sharpaly with hope say she go comot her own too" "oya your bom bom" "ah na for yansh u won shuk me the injection ...i ask becos i no dey like am "yes na"no worry i be expert e no go pain u at all"...she yan "ahhh !! ....naso i take collect the injection as she use cotton wool rub am small before she tell me say make i lay down back" "i obey as i lay down jeje"but when wahala come enter na when she begin use the spirit clean all the wounds for my body,as she clean my back and chest finish"she come yan me say i go comot boxers say the wounds affect all my body reach leg" "na who no go gree comot boxers for this kind matter"i stand up as i draw boxer viaaaa!!! "aaaaahh!!!!!"......she scream "watin i ask"... "you be calabar boy??....she ask "i be confirm warri guy i nor say as u be calabar girl u go like this kind long thing abi"....i ask as i do like better peson go lay down back for bed" "she manage near me come dey clean my wounds wey dey my laps"but each time her soft palm touch my laps spana go increase in size" "ah ah!! why your grand father come dey long long like this e go tear ceiling o!....she yan as i just smile dey wait make she touch spana kpakam omo na carry go o! "she clean reach my leg as she continue to dey fight the urge to grab spana wey stand like electric pool"she reach my foot come turn her back side face me as she continue her cleaning" "omo if she fit hold her sef"her father!!"i not fit"i grab her a*s and handle it" aauuhhhh!!"she trowey the towel viaaaa!!!! dive spana gaawwaaaam! enter her mouth "aaaaghhhhhh!!!!!!!!!"i scream!!!!! to be continued...... |
JOGICE:o boy u try jare oya clap for ya sef !!!!!! now make we break am down to think and imagine a single update fit high and scratch yo brain pass one roll of igboo! so 1*5 updates na 5 updates that is equals to five roll of igboo per day bros i never marry o! infact i still dey hustle make i enter school i.be very young guy between 18 to 21 so u see i still young as my name talk youngzubi twale baba o! joor o! still ya guy youngzubi |
after u na u bros |
Episode..................10 something must kill a man (1) --------------------------------------- if e nobi woman e go be money ------------------------------------------------- "I just pray this people no go make me bring out the demon in me"nah to shed blood be that o!"but onto say i don learn to dey control my temper nahim make me to dey chop all this kind insult and beating without showing them my real sef and through colour asin the main reason why them dey call me spana"......i been get one kind spiritual demon wey dey inside me"una never reason watin dey make me get monster mode wey dey always turn my eyes red anytime i dey waya woman"no go stress ya sef with that one becos story still long like spana so as time goes on una go find out" "come hia my friend!!!,dont even waste my time at all!.....oga frank bark ,as him carry my mind land for reality" "no o!,i must do something how a whole rugged warri guy like me go still dey alive and peson go carry needle chuck inside him prick"Chai no nah"i nobi chali for soldier Mata nah"after all na something go kill a man"either he die fighting to live or him go die uselessly without proving him manliness"no! spana nobi weak guy no dulling moment for him side at all"naso i take boost my moral,come begin dey calculate my moves how i go take throw them overboard' "i look around as i sight one better pka ko! for ground beside musa"exactly watin i need at the moment" "musa don already hold rope wey him go use tie me for hand"but i get my own plan as i move close to him ....as oga frank command me"them still dey try to cut oga landlord hand" "oya! bend down! make i tie this rope!,,,,musa shout for my head as i reach wia him stand" "i obeyed but still get my plan and moves intact for my head,as i bend down"omo i expertically dive the plank for ground as i waya am poossaaaaaa!!!!!! for musa prick region" "aaaaahhhhh!!!!! Allah!!! Allah Allah!!!!! walahyiii !!!!!! e burst!!! ahhh!! e burst!!".....musa cried out in pain"but that one na genesis compared to watin i still won do am" "within a second i grab oga frank as i seize him up"and position the needle wey dey him hand for him neck then push am in small as him scream nahim blood come dey drop small small" "oya make una pack go one side like sadine or else i go use this needle tear oga frank throat complete"i command the policemen as i seize oga frank and use him to shield my myself"....ah no go try naija police dem fit use bullet waya ya head comot if u no smart enough" "ahhhhhh !!!! please listen to him boys"ple ss see!!! obey him am dying here this needle is killing me!!......oga frank yan as i position the needle wella for him throat" "ayo !!! free that man abi u won chop burial rice?? becos oga frank go be dead body if u try touch that wire for that man hand again"....i commanded again as i begin plan how i go fit take escape with oga landlord without raising alarm" "i still dey reason my next move when one beautifully endowed young female police bounce inside" "stop dia!!!!!! i scream as she stop instantly"Chai this lady package ooo!! ah ah! how come she take carry all this loads even after police training and exercise"Chai see heavy backside abi nah the front side all too make sense"wait oo hope say nobi standing spana dey stand so??" "i swallow spit as i regain my sef from the better thought wey i don dey reason for head Chai shebi if nobi say i dey wahala now nah to just toast am"....i still dey reason before three hefty security guards bounce inside the place"their face look familiar"i still dey wonder wia i meet them "just one seconds wey my attention comot for the lady police side" "gwaaamm!!! she dive me as she seize me up"release oga frank then put in the position wey i put oga frank before"Chai that needle dey painfuuuuuuuullll!!!!" "wah dah hell is going on hia".....woman voice scream from door side" "all our attention move towards the door side as i sight big mama (jolade)" "the thing come be like say na dream"oh now i remember those macho guys"na thesame bouncers wey i see for 5 star hotel" "ah" big mama what are u doing hia??....i asked as i surprise becos i no expect her hia" "she just ignor me as she face oga frank and the soldier boys" '"good day ma!!!!!!!!!!!"all the police including oga frank stand still with their chest up and hand against their skull as they salute big mama" "Mr frank"...she called out "Ma!!!".....oga frank answered "what is happening here....she fired at him "ma actually these two ritualist wey dey hia"we catch them with five human head nahim we come dey try investigate them for we station but they just dey prove stubborn them no gree talk pkikiimm!"after plenty beating for station them no gree talk nahim i come carry them come here for better and proper beating"......oga frank blow him lie" "what!! spana is that true"....big mama faced me" "trusth warri guy nah !! i no say this one nah matter of who blow lie pass so i start my own with confirm warri scream!" "aaahhhhh!!! ayee mee!!!,oga frank ya father i said ya papa yansh dia"me wey nor sabi kill tolo tolo me wey no fit kill ordinary snake nahim you talk say i kill peson come carry him head ah nah gawd go tear u better slap dia" oya wia the head show me the five heads?....i asked as oga frank begin scratch him head "no nahim wife him and that oga wey they dia dey use do janglova"......musa said still holding him prick" "big mama see them "u see them now from human head to oga frank wife"ah! i nor do them anything nah house i just dey comot sey make i go buy the clothes wey we discuss say i go buy nahim them come catch me for road force me enter their moto"......i lied as i begin show the blood wey full my back to big mama " "as big mama sight the blood come see as vex take full her body her eye change"frank!!!!!! how dare u do this to my boy!!!!!!....she fired "ah!! na your boy??....all the police including oga frank shout as them use their hand to cover their mouth.. "how dare u!!! mark my words you will be sacked before tomorrow morning"...she fired again "ah please ma!"i nor know say nah your boy"oga spana why u no talk since nah ..ah ma please dont get me sacked please!!!!.... "and for you policemen just know u have meet your doom,una go see pepper"...she barked at them "nah gawd go bless u big mama just make sure say musa"see am this short one Ehen! make sure say him go dey front seat when them go pack them dey go sambisa forest and this omo ibo hia this huge one wey be like banabas"no give am gun at all na tooth pick una go give am"......i still dey talk when big mama shout "shut up!!! idiot!"just look at the mess u got yourself into"see what u have made of your handsome sef"what is it that lady have that you can't get from other women??...big mama fired at me "no vex ma nah devil hand work"....i said "devil my foot"...big mama "now listen to me Mr frank"just make sure that man laying over there is released right now and well treated" carry am go hospital treat am well well and that arm must not miss if it miss then count ya sef as armless man too!,becos i will personally make sure yours would be cut too"after he recovers from all this then i would think if i should reconsider or not good bye Mr frank till then"..big mama concluded as she waka go outside"omo i rush follow her sharpaly as we bounce go outside with her 8 body guards like say she be god" "Chai some people get mouth for this country o!"some people just get high rank like kilode!! see as those goats just dey answer ma ma!! ma"like say them no get mama" anyway am still to discover her true identify but e nobi now make i relax for now" "naso we waka reach wia them moto park"na three moto dey dia one humar jeep and two range rovers"big mama me and striker enter inside the humar jeep while the remaing guards occupy the two range rovers" "hope we can still make it to warri today?"big mama asked "ah ah! why not"see big mama nah u save those gatemen wey call themselves soldiers "i swear if not for your intervention eh i for kill peson!!! i for tear red eye give them "shebi u see as all of them kneel down as u waka enter..nah punishment wey i give them be that"...i boosted "ha ! spana u and this your mouth eh"see how blood stained your body is" u can't even thank me for coming to your rescue"...big mama said "ah big mama one!"u too much jare Ehe! how u take know say i dey hia na?..."i asked "i came to your house to pick you as we discussed after trying your number several times without you picking but when i got to your house"i met everywhere filled with people talking about a landlord and tenant that impregnated a d.p.o.wife so i asked about their location this young man beside u said he knows the place becos he had followed u guys"he brought us hia but he refused to follow us in when we got hia" "ah him try nah gawd go bless am"i said as i turn to thank the young man only to see spata coil himself for one corner beside me i surprise as i scream " ah spata!!!!!!!!!!!!!!! to be continued |
you be my sure guy @ youngimporter thanks for voting for me at Jul 5k award u are a through fan bro i hope others would do thesame and go to the thread to vote for me thank u all for your supports so far... still your guy youngzubi |
Ann2012: tank u Ann |
coolaustyne:sure sir! i for like grant ya request this evening but as things take be i won't be updating for today or maybe i will try to do something but am not promising o! its under probability thank u sir for appreciating my work! still ur guy youngzubi pko ka!! |
coolaustyne:go try am with soldier or d.p.o wife u go see ya ancestors that day fear soldier u think say na proverb e be abi.ok... |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 21 22 23 24 25 26 27 28 29 (of 29 pages)

